Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,004 members, 7,817,969 topics. Date: Sunday, 05 May 2024 at 12:29 AM

Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef (2511 Views)

An Example Of The Way Naija Babes Act Nowadays / Guys Or Babes, Who Lose Their Virginity The Earliest? / Why Are Do All Naija Babes Have Stretch Marks On Their Behinds? (2) (3) (4)

(1) (2) (Reply) (Go Down)

Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Nobody: 6:33pm On Oct 09, 2011
Naija babes make una open una ears wide and listen to wetin i wan tell una.Una forming don too much.No be say una even fine sef but na una dey form pass.Other women from other countries get open mind and dem dey smile wen a guy dey toast them but for naija women case na different issue entirely.A guy go wan hala at a naija babe and the babe go just dey squeeze her face like orange wey dem don suck im juice comot.Una go just dey make yanga dey catwalk for road dey shake una small yansh and yet na una dey complain pass about not getting a husband.Why una go get a husband wen una too form.Abeg make una reduce una forming because now the thing don even too much grin.
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Nobody: 6:48pm On Oct 09, 2011
lefulefu:

Naija babes make una open una ears wide and listen to wetin i wan tell una.Una forming don too much.No be say una even fine sef but na una dey form pass.Other women from other countries get open mind and dem dey smile wen a guy dey toast them but for naija women case na different issue entirely.A guy go wan hala at a naija babe and the babe go just dey squeeze her face like orange wey dem don suck im juice comot.Una go just dey make yanga dey catwalk for road dey shake una small yansh and yet na una dey complain pass about not getting a husband.Why una go get a husband wen una too form.Abeg make una reduce una forming because now the thing don even too much grin.

here we go with this shiet.
you see one thread full of hot foreign women and you decide you wan lecture Naija babes. grin

Nigerian men. smh. lol
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by ijawgirl: 7:07pm On Oct 09, 2011
shakara dey 4 our blood, no b fronting @ all na nature
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Nobody: 7:11pm On Oct 09, 2011
lefulefu:
Naija babes make una open una ears wide and listen to wetin i wan tell una.Una forming don too much.No be say una even fine sef but na una dey form pass.[b]Other women from other countries get open mind and dem dey smile wen a guy dey toast them but for naija women case na different issue entirely.[/b]A guy go wan hala at a naija babe and the babe go just dey squeeze her face like orange wey dem don suck im juice comot.Una go just dey make yanga dey catwalk for road dey shake una small yansh and yet na una dey complain pass about not getting a husband.Why una go get a husband wen una too form.Abeg make una reduce una forming because now the thing don even too much grin

Them dey smile because na sweet sweet lines the guy dey whisper for e ear. "You're my heart's desire". "There's no me without you". "Did it hurt when you fell from heaven?" Naija bobo no fit whisper. Them go dey shout like agbero no 1 first. If them no shout, them go dey make that noise like say na rabid dog they dey call. Already, babe don frustrate. Still, she go waka to the bobo, only for the bobo to drop one useless line. "FINE BABE! You no know say you fine? So are you from abroad? I'm from abroad too: South Africa. Ehen, make you holla me your pin. Ahn ahn, babe I say give me your pin na." A babe with sense, like me, go walk away. Then agbero no 1 go shout again "GO JOR! WHO CALLED YOU HERE?! You're not even fine!" Husband material abi?

1 Like

Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Dynamique: 7:18pm On Oct 09, 2011
smiley smiley smiley,mr man,dem no gree 4u?
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Amya(f): 7:33pm On Oct 09, 2011
Oh geez!!! What have naija babes done again!
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Nobody: 7:44pm On Oct 09, 2011
ogugua88:

Them dey smile because na sweet sweet lines the guy dey whisper for e ear. "You're my heart's desire". "There's no me without you". "Did it hurt when you fell from heaven?" Naija bobo no fit whisper. Them go dey shout like agbero no 1 first. If them no shout, them go dey make that noise like say na rabid dog they dey call. Already, babe don frustrate. Still, she go waka to the bobo, only for the bobo to drop one useless line. "FINE BABE! You no know say you fine? So are you from abroad? I'm from abroad too: South Africa. Ehen, make you holla me your pin. Ahn ahn, babe I say give me your pin na." A babe with sense, like me, go walk away. Then agbero no 1 go shout again "GO JOR! WHO CALLED YOU HERE?! You're not even fine!" Husband material abi?

Translate please

1 Like

Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Freiburger(m): 7:52pm On Oct 09, 2011
MsDarkSkin:

here we go with this shiet.
you see one thread full of hot foreign women and you decide you wan lecture Naija babes.  grin

Nigerian men. smh. lol

grin grin grin
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Nobody: 8:00pm On Oct 09, 2011
Ok! We like them like that! So?. . . Buzz tha hell off! cheesy

1 Like

Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Nobody: 8:45pm On Oct 09, 2011
sexkillz:

Ok! We like them like that! So?. . . Buzz tha hell off! cheesy
sharrap there u albino virgin lipsrsealed.wetin u know about women? tongue.
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Nobody: 8:55pm On Oct 09, 2011
lefulefu:

sharrap there u albino virgin lipsrsealed.wetin u know about women? tongue.
Cheeeiiii!! See this olodo! Wia you dey sef? Me and your sister don wink wink wink. . .

1 Like

Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by justwise(m): 9:02pm On Oct 09, 2011
lefulefu:

Naija babes make una open una ears wide and listen to wetin i wan tell una.Una forming don too much.No be say una even fine sef but na una dey form pass.Other women from other countries get open mind and dem dey smile wen a guy dey toast them but for naija women case na different issue entirely.A guy go wan hala at a naija babe and the babe go just dey squeeze her face like orange wey dem don suck im juice comot.Una go just dey make yanga dey catwalk for road dey shake una small yansh and yet na una dey complain pass about not getting a husband.Why una go get a husband wen una too form.Abeg make una reduce una forming because now the thing don even too much grin.

Hahaha, i feel ur pain, 9ja girls don't fall for cheap chat-up lines. You need to upgrade to stand a slim chance grin grin

1 Like

Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by koolJ1(f): 9:27pm On Oct 09, 2011
ogugua88:

Them dey smile because na sweet sweet lines the guy dey whisper for e ear. "You're my heart's desire". "There's no me without you". "Did it hurt when you fell from heaven?" Naija bobo no fit whisper. Them go dey shout like agbero no 1 first. If them no shout, them go dey make that noise like say na rabid dog they dey call. Already, babe don frustrate. Still, she go waka to the bobo, only for the bobo to drop one useless line. "FINE BABE! You no know say you fine? So are you from abroad? I'm from abroad too: South Africa. Ehen, make you holla me your pin. Ahn ahn, babe I say give me your pin na." A babe with sense, like me, go walk away. Then agbero no 1 go shout again "GO JOR! WHO CALLED YOU HERE?! You're not even fine!" Husband material abi?
babes yu got me reeling wit laughter!
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by tellwisdom: 10:06pm On Oct 09, 2011
sharrap there u albino virgin  lipsrsealed.wetin u know about women? . tongue

[size=24pt] grin grin grin grin Albino virgin  cheesy cheesy cheesy grin grin grin grin[/size]

1 Like

Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Nobody: 10:28pm On Oct 09, 2011
ogugua88:

Them dey smile because na sweet sweet lines the guy dey whisper for e ear. "You're my heart's desire". "There's no me without you". "Did it hurt when you fell from heaven?" Naija bobo no fit whisper. Them go dey shout like agbero no 1 first. If them no shout, them go dey make that noise like say na rabid dog they dey call. Already, babe don frustrate. Still, she go waka to the bobo, only for the bobo to drop one useless line. "FINE BABE! You no know say you fine? So are you from abroad? I'm from abroad too: South Africa. Ehen, make you holla me your pin. Ahn ahn, babe I say give me your pin na." A babe with sense, like me, go walk away. Then agbero no 1 go shout again "GO JOR! WHO CALLED YOU HERE?! You're not even fine!" Husband material abi?

grin grin
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Pweety4me(f): 10:32pm On Oct 09, 2011
I see so no more me & my oyinbo gf?no more 'i too fine my neighbour dey eye me'. . .u don tire u want dey face reality now abi?lol
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Mcleo007(m): 10:47pm On Oct 09, 2011
Laughs out loud! grin
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Orton10(m): 11:04pm On Oct 09, 2011
Hehehe. . .Ogugua don kill me, i don wet my night gown with laugh. wink
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Orton10(m): 11:05pm On Oct 09, 2011
Hehehe. . .Ogugua don kill me, i don wet my night gown with laugh. wink
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Wizkhalifa2(m): 2:18am On Oct 10, 2011
@Op
LOL!!! I AGREE ITS KINDA ANNOYING, ESPECIALLY WEN D GAL FRONTING IS WOGLY, U CAN IMAGINE?!, BUH I MST CONFESS I FRONT 4 GALZ 2 SHA,
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Nobody: 4:22am On Oct 10, 2011
Orton1_0:
Hehehe. . .Ogugua don kill me, i don wet my night gown with laugh. wink

Lmaoooo.
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by toyemz(f): 10:26am On Oct 10, 2011
@wiz-khalifa



@Op
LOL!!! I AGREE ITS KINDA ANNOYING, ESPECIALLY WEN D GAL FRONTING IS WOGLY, U CAN IMAGINE?!, BUH I MST CONFESS I FRONT 4 GALZ 2 SHA,



In your dreams right?
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by emofine(f): 10:38am On Oct 10, 2011
Mr. Man una neva tire? . . .for breakfast, lunch and dinner una go chop naija babe palava finish abi na wetin?. . .very soon you go dey carry mouth tok say na naija babes be the cause of super eagles exit. . .

Sha mek I tell you something for free abeg . . . no be effri Naija girl wey tek eye dey shook guy anyhow wey wan form shakara . . .  some girls no wan do . . . no be hard to get thing, she just no wan do! or na by force she go gree for anyhow bobo . .  shebi is that not what oyibo girls are for? . . after you don finish your preliminary with your oyibo kele and your yanga don expire no be una wey hunt Naija babe wey never soil her body finish come wife am?

In fact no be our ways wey dey need refining jo na una men . . . wetin? some of una tek be methusala age mate still you no dey shame carry eye for fresh babe begin to salivate . . . and you come say she dey form for grangbaba lipsrsealed

Pweety4me:

I see so no more me & my oyinbo gf?no more 'i too fine my neighbour dey eye me'. . .u don tire u want dey face reality now abi?lol

No mind am . . . shakara don end.
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Basildon1(m): 10:41am On Oct 10, 2011
LOL @ Albino Virgin. How the hell do you come up with that! LMAO!!
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by r231(m): 10:47am On Oct 10, 2011
lefulefu:

sharrap there u albino virgin lipsrsealed.wetin u know about women? tongue.

below the belt grin grin grin
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Wizkhalifa2(m): 12:38pm On Oct 10, 2011
toyemz:

@wiz-khalifa




In your dreams right?














TOYEMZ XOWIE DO I KNW U??
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Nobody: 1:37pm On Oct 10, 2011
lefulefu:

sharrap there u albino virgin lipsrsealed.wetin u know about women?
Lefulefu,
ur mouth na real razor blade. grin grin grin
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Nobody: 4:54pm On Oct 11, 2011
sexkillz:

Cheeeiiii!! See this olodo! Wia you dey sef? Me and your sister don wink wink wink. . .
Come if u move three feet near my sister na razor blade and koboko all together na im she go use waya ur head.Make u no try wetin pass u oo! shocked shocked shocked
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Nobody: 4:57pm On Oct 11, 2011
bennygee:

Lefulefu,
your mouth na real razor blade. grin grin grin
na today grin grin grin grin grin grin grin
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Nobody: 4:58pm On Oct 11, 2011
justwise:

Hahaha, i feel your pain, 9ja girls don't fall for cheap chat-up lines. You need to upgrade to stand a slim chance grin grin
Chei na these ones naija babes dey use as maga grin grin grin grin grin grin grin grin grin
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by Nobody: 5:12pm On Oct 11, 2011
emofine:

Mr. Man una neva tire? . . .for breakfast, lunch and dinner una go chop naija babe palava finish abi na wetin?. . .very soon you go dey carry mouth tok say na naija babes be the cause of super eagles exit. . .

Sha mek I tell you something for free abeg . . . no be effri Naija girl wey tek eye dey shook guy anyhow wey wan form shakara . . .  some girls no wan do . . . no be hard to get thing, she just no wan do! or na by force she go gree for anyhow bobo . .  shebi is that not what oyibo girls are for? . . after you don finish your preliminary with your oyibo kele and your yanga don expire no be una wey hunt Naija babe wey never soil her body finish come wife am?

In fact no be our ways wey dey need refining jo na una men . . . wetin? some of una tek be methusala age mate still you no dey shame carry eye for fresh babe begin to salivate . . . and you come say she dey form for grangbaba lipsrsealed

No mind am . . . shakara don end.
ok i don hear u but make u no come dey beg me to be your husband when old age come dey knock at ur door ooo! grin grin grin
Re: Naija Babes Una Forming Don Too Much Sef by pendo89(f): 5:30pm On Oct 11, 2011
lefulefu:

Naija babes make una open una ears wide and listen to wetin i wan tell una.Una forming don too much.No be say una even fine sef but na una dey form pass.Other women from other countries get open mind and dem dey smile wen a guy dey toast them but for naija women case na different issue entirely.A guy go wan hala at a naija babe and the babe go just dey squeeze her face like orange wey dem don suck im juice comot.Una go just dey make yanga dey catwalk for road dey shake una small yansh and yet na una dey complain pass about not getting a husband.Why una go get a husband wen una too form.Abeg make una reduce una forming because now the thing don even too much grin.

ogugua88:

Them dey smile because na sweet sweet lines the guy dey whisper for e ear. "You're my heart's desire". "There's no me without you". "Did it hurt when you fell from heaven?" Naija bobo no fit whisper. Them go dey shout like agbero no 1 first. If them no shout, them go dey make that noise like say na rabid dog they dey call. Already, babe don frustrate. Still, she go waka to the bobo, only for the bobo to drop one useless line. "FINE BABE! You no know say you fine? So are you from abroad? I'm from abroad too: South Africa. Ehen, make you holla me your pin. Ahn ahn, babe I say give me your pin na." A babe with sense, like me, go walk away. Then agbero no 1 go shout again "GO JOR! WHO CALLED YOU HERE?! You're not even fine!" Husband material abi?

emofine:

Mr. Man una neva tire? . . .for breakfast, lunch and dinner una go chop naija babe palava finish abi na wetin?. . .very soon you go dey carry mouth tok say na naija babes be the cause of super eagles exit. . .

Sha mek I tell you something for free abeg . . . no be effri Naija girl wey tek eye dey shook guy anyhow wey wan form shakara . . .  some girls no wan do . . . no be hard to get thing, she just no wan do! or na by force she go gree for anyhow bobo . .  shebi is that not what oyibo girls are for? . . after you don finish your preliminary with your oyibo kele and your yanga don expire no be una wey hunt Naija babe wey never soil her body finish come wife am?

In fact no be our ways wey dey need refining jo na una men . . . wetin? some of una tek be methusala age mate still you no dey shame carry eye for fresh babe begin to salivate . . . and you come say she dey form for grangbaba lipsrsealed

No mind am . . . shakara don end.

WOW. This english is soo sweet.Even though emofines' was a bit conc. Wish I knew what you mean by the bolded.
Una make shakara '*shakira* grin

(1) (2) (Reply)

14 Secret Things That Turn Men On / Lady Gaga Flashes Her Nude Panties In Daring Red Gown(photos) / To Side Chics (photo)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 59
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.