Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,334 members, 7,819,156 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 12:04 PM

I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe (1721 Views)

How do you really feel after s*x? / Thread For People Who Have Or Still Suck Their Babe's Kpekus. / I Really Feel For This Girl (screen Shot) (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by Nobody: 12:13am On Oct 18, 2011
Omo e no really easy for some bobos.I mean for naija the economy is comatose,no job, no food and nothing and yet some bobos dey really stress themselves financially just to satisfy the greed of some of their naija girlfriends.And the worse thing of all is that most of these babes even no dey appreciate at all.A bobo wey graduate from university about 5 yrs ago with no job in sight go take to the street to hustle and if no be bike business im dey do he go take to opening a shed selling articles for im shed.Bobo go sweat am really hard and upon all that he go use im hard earned money take maintain im girlfriend and instead make im girlfriend cut coat according to size she go wan flex all the money in one day because she wan live the lifestlye of first lady.She go halla bobo for money for hair,for shoes wey she wan buy and if the bobo no give am the complete money na quarrel go dey for house that day.Many naija women no even dey ready to help assist their boyfriends or husbands.A bobo go dey outside dey hustle and think of how im go feed im girlfriend and the cloth wey im go buy for am and the babe go dey house dey do nothing but watch nollywood home video from morning till night and if the bobo come late from his day"s job the babe go ask am why im come late and that night na quarrrel the babe go wan use kill the bobo.If the babe get money she go come go hide am and still dey halla the poor bobo for money.Honestly speaking i really dey feel sorry for many naija bobos back in naija and the stress wey their naija girlfriends dey give dem.I mean u no even dey benefit anything from a naija babe when u get am as a girlfriend because all she sabi do na to chop all the food wey dey ur house apart from the regular quarrel wey she dey give you.No wonder many naija men back in naija suffer from premature old age grin.

1 Like

Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by slimyem: 12:18am On Oct 18, 2011
trash!!!
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by emofine(f): 12:22am On Oct 18, 2011
If na so dem dey shuffer for world come sponsor dey omoge den y many bobos come carry 5+ babes for dem arm . . small time dem go dey scream of heart attack wen dem no fit afford one yet wan juggle 20 eyah. . .
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by Nobody: 12:55am On Oct 18, 2011
[size=14pt]Elefu were! For the first time wey i agree say you talk 80% true of the yarnings!. . . . smiley

The guys dey work for Mugu Nig LTD? cheesy[/size]
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by lilkech(m): 12:58am On Oct 18, 2011
happy are guyz without babes , for they shall flex THE WHOLE OF THEIR SALARY COMPLETE!
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by MrsChima1(f): 1:00am On Oct 18, 2011
If the men learn to pick better caliber of women in term of well-balanced then they wouldn't undergo stress in their relationships. You are what you make of your relationship and no one is to blame but you.
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by Nobody: 1:23am On Oct 18, 2011
sexkillz:

[size=14pt]Elefu were! For the first time wey i agree say you talk 80% true of the yarnings!. . . . smiley

The guys dey work for Mugu Nig LTD? cheesy[/size]

for once u don agree with me grin grin grin grin
anyway sha na the same thing wey dem go refer to as monkey dey work barboon dey chop.I know many unemployed graduate bobos wey dey struggle night and day just to satisfy their girlfriend but then i think we go dey too harsh to refer to such bobos as mugus because such guys just dey provide for the babe because dem love the girl but the foolish girl in question go just eat all the guy money and upon that one she go dey stress the bobo with nagging and to top it all she go refer to such a bobo as a mugu grin.Na guys back in nigeria dey feel the pinch the hardest because the nigerian economy right now dey really bad.
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by Nobody: 1:26am On Oct 18, 2011
emofine:

If na so dem dey shuffer for world come sponsor dey omoge den y many bobos come carry 5+ babes for dem arm . . small time dem go dey scream of heart attack wen dem no fit afford one yet wan juggle 20 eyah. . .


See ur heart wey be like stone grin grin grin grin grin grin
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by femzy(m): 1:33am On Oct 18, 2011
Mrs, Chima:

If the men learn to pick better caliber of women in term of well-balanced then they wouldn't undergo stress in their relationships. You are what you make of your relationship and no one is to blame but you.

Maybe you should teach me undecided
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by Nobody: 1:39am On Oct 18, 2011
Mrs, Chima:

If the men learn to pick better caliber of women in term of well-balanced then they wouldn't undergo stress in their relationships. You are what you make of your relationship and no one is to blame but you.
U talk as if they pick women as articles from the market place grin grin grin grin grin.A jezebel can pretend to be the next mother theresa just to deceieve a man grin.
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by freecocoa(f): 1:52am On Oct 18, 2011
Finally lefu and sexkillz agree on something,okay that's nice.we are progressing.
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by Nobody: 1:54am On Oct 18, 2011
lefulefu:

for once u don agree with me grin grin grin grin
anyway sha na the same thing wey dem go refer to as monkey dey work barboon dey chop.I know many unemployed graduate bobos wey dey struggle night and day just to satisfy their girlfriend but then i think we go dey too harsh to refer to such bobos as mugus because such guys just dey provide for the babe because dem love the girl [/b]but the foolish girl in question go just eat all the guy money and upon that one she go dey stress the bobo with nagging and to top it all she go refer to such a bobo as a mugu grin.Na guys back in nigeria dey feel the pinch the hardest because the nigerian economy right now dey really bad.

[size=14pt]Guy! Any unemployed bobo or any bobo at all, wey go sweat, hustle, stress im self financially, make im hard earned money, just to satisfy woman wey im neva marry, dey work for [b]Mugu Nig LTD!. . .

And the person graduate from University of Magadom, with First class in Mumutology from the Otondo Department!. . , . . I don talk finish!. . .[/size]

1 Like

Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by Nobody: 1:57am On Oct 18, 2011
freecocoa:

Finally lefu and sexkillz agree on something,okay that's nice.we are progressing.
[size=14pt]Hmm! Dont sweat nor bet on it babe! Be on tippy toes! I'm unstable. . .[/size] wink
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by freecocoa(f): 2:02am On Oct 18, 2011
Abi o,anyhow all join.
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by Nobody: 2:06am On Oct 18, 2011
smh. it's the return of mobo. tongue
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by Nobody: 2:15am On Oct 18, 2011
who be mobo? cheesy
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by HighChief4(m): 3:04am On Oct 18, 2011
Lefulefu is at it again. But for real some guys are in such condition and I always wonder why people stay in a relationship they are not happy with
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by kasiem(m): 3:18am On Oct 18, 2011
MHmm
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by Flashaldrin(m): 5:47am On Oct 18, 2011
That doesnt work 4 me at all. Its for guys with low self esteem that feel the only way to keep a gurl is by spending.
If i'm in a relationship then everytin must b mutual! Spending nd being spent on!.
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by lindabon: 6:32pm On Oct 18, 2011
sexkillz:

[size=14pt]Guy! Any unemployed bobo or any bobo at all, wey go sweat, hustle, stress im self financially, make im hard earned money, just to satisfy woman wey im neva marry, dey work for Mugu Nig LTD!. . .
[/size]


I wonder ooo. Some will even be tidying more than two girls at the same time, yet they complain. If dem no want woman stress, make dem live d woman or go find better woman somewhere else.No! them go still dey there dey nag . I no no if them use woman swear for them. You don't want trouble, yet you knock on trouble's door. Complete ignoramus  . . . . SMH
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by femzy(m): 8:20pm On Oct 18, 2011
lindabon:

I wonder ooo. Some will even be tidying more than two girls at the same time, yet they complain. If dem no want woman stress, make dem live d woman or go find better woman somewhere else.No! them go still dey there dey nag . I no no if them use woman swear for them. You don't want trouble, yet you knock on trouble's door. Complete ignoramus  . . . . SMH


Guess you are one of the troubles as well
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by HighChief4(m): 12:00am On Oct 19, 2011
lindabon:

I wonder ooo. Some will even be tidying more than two girls at the same time, yet they complain. If dem no want woman stress, make dem live d woman or go find better woman somewhere else.No! them go still dey there dey nag . I no no if them use woman swear for them. You don't want trouble, yet you knock on trouble's door. Complete ignoramus . . . . SMH


Maybe cos they are necessary evil
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by BloodShed1: 12:31am On Oct 19, 2011
When will men understand that marriage/relationships are legal prostitution?

Just work, hard, live life, and spend your hard earned money on YOURSELF!


Forget about what African culture, society and the Bible say about it.
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by MrsChima1(f): 12:40am On Oct 19, 2011
lefulefu:

U talk as if they pick women as articles from the market place grin grin grin grin grin.A jezebel can pretend to be the next mother theresa just to deceieve a man grin.

What do you think a ho house is if it is not a market place? undecided YOU are the one complaining remember?
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by Nobody: 6:39am On Oct 19, 2011
Flashaldrin:

That doesnt work 4 me at all. Its for guys with low self esteem that feel the only way to keep a gurl is by spending.
If i'm in a relationship then everytin must b mutual! Spending nd being spent on!.
u r on a long tin if u need a naija babe to spend for u, BUT here are d category of naija girls that will spend for u, rich obessed/excess fat girls, very very wor wor rich girl, disabled rich girl,  very old ladies lookin for their missin hubby, runs girls that wants to keep u for marriage after sharin their kpormor outside, infact d list is negatively endless!
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by Booty4me: 5:57pm On Jul 28, 2012
.
Re: I Really Feel For Some Guys Wey Dey Undergo Financial Stress Coz Of Their Babe by Nobody: 6:35pm On Jul 28, 2012
grin

(1) (Reply)

Is This A Relationship? / You And Your Ex / Guys Your Advise Is Highly Needed Please See This Photo

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 45
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.