Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,158,493 members, 7,836,921 topics. Date: Wednesday, 22 May 2024 at 02:36 PM

Abi Na D Sacking Of Dambazza Come Cause Wahala For Gej (in Pidgin) Humour - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Abi Na D Sacking Of Dambazza Come Cause Wahala For Gej (in Pidgin) Humour (872 Views)

Stella Oduah Debunks Reports Of Supreme Court Sacking - Channels Television / How Obama Influenced The Sacking Of Service Chiefs – Vanguard / Who Is More Relaxed Here (GMB Or GEJ) In The Meeting With John Kerry (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Abi Na D Sacking Of Dambazza Come Cause Wahala For Gej (in Pidgin) Humour by KnowAll(m): 3:32pm On Jan 22, 2012
b4 oga jonna, sack that oga for army, hausa maraba see vision for am, say "oka" jonathan I beg sofly,sofly oh!!!,  make u no sack am now, I here say TB Joshua sef see vision, pastor been tell madame patience wen she use style come for night come see pastor.

Pastor talk say no do am now, but madame Patenice talk say oga jonna no fit sleep for night, na so-so army tank e dey see for dream, e go come wake up for night dey shout " my hands are up oh" the tin don tire me, meself i no fit sleep na im i talk say make i come see u. i hear say u and holy spirit dey communicate like no man's business, u fit just siddon for ya bedroom, na so angel gabrel go just appear,  na im i talk say make i come see u. I beg help us oh.

Na so PASTOR TALK say make she tell her husband make e no do am now, Madame Patience come carry her wahala go Abuja, no sooner as she reach Abuja, na im Oga Jonna come tell im wife say e don get one better plan, of how e go take sack Dambazza, na so patience begin beg am, look no turn me to widow, i still dey young, i never reach 50 sef, but im husband tell am say make she no worry.

Na so all Nigerians wake up for July abi na june sef,  last year dem come annouce am for radio, say oga  Jonna don sack dambazza, na so I been go internet, go sahara reporters go read all the better jara wey don no put for our dailies, na so e come transpire say oga jonna use style deceive oga dambazza go amerika for a course, as dem dey reach their hotel room for New York na so oga Dambazza get message for e phone, come see as the man eye change, people wey dey there say d man talk say our preisdent behave like a coward, the man come dey rake say why e no sack me for Niaja, I don talk am this una new president e no get liver.

3 months after sacking na so so bomb dey go off all over the place like say na knock-out, one of my friend dey wen d first one been blow, e think say na knockout but e come see human-torso for sky, human leg for one side, human yansh for another side, na im e talk say this one don pass becareful.

I beg make oga jonna beg dat army oga make e come back, d igbo army oga wey dey there now don talk say im go be deputy,  becos b4 e been sack am,  no bombs at all,  now na so-so bomb, even sef now na bomb be alarm clock for abuja, one go off around 4:00 clock for morning, den talk say dat one na our soldiers wey dey practise but d one for 5 0 clock na Boko Haram get dat one, dem dey remind us for aso rock say dem still dey kampe!! undecided
Re: Abi Na D Sacking Of Dambazza Come Cause Wahala For Gej (in Pidgin) Humour by KnowAll(m): 3:55pm On Jan 22, 2012
e be like our president no get liver TRUE-TRUE with all that have happened ever since. Is it true he has isreali body guards undecided
Re: Abi Na D Sacking Of Dambazza Come Cause Wahala For Gej (in Pidgin) Humour by KnowAll(m): 5:06pm On Jan 22, 2012
Abeg my people make una help me beg oga dambazza, haba e don do now , abi d man still dey vex undecided

(1) (Reply)

First Legislative Summit On Collaborative Agenda By Southwest States / Kizzy Kalu . Human Trafficker / Slave Trader Arrested In Colorado Usa. / Drama Linking Jonathan To Farouk's Travails

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 19
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.