Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,155,900 members, 7,828,173 topics. Date: Wednesday, 15 May 2024 at 04:19 AM

Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 - European Football (EPL, UEFA, La Liga) (5006) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / European Football (EPL, UEFA, La Liga) / Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 (10579322 Views)

Official Chelsea Fan Thread: Pride Of London / Offical Bayern Munich Fan Thread: 6x Champions Of Europe / Manchester United Fan thread: Forever Reds (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (5003) (5004) (5005) (5006) (5007) (5008) (5009) ... (19227) (Reply) (Go Down)

Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by dopeJemi: 4:14pm On Mar 22, 2018
diggz:


I get...but try have a reasonable and realistic one bro...cuz no be everybody dey fit arrange well before dem settle down....most guys can only afford basic things before them settle down e.g accommodation, a single vehicle and feeding.

You have a point, but wait oh, with all these plenty talks of sugar mummy, I think say una go make donations sef undecided as per una paddy wey I be. Na wa oh, so much for brotherhood undecided
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by diggz: 4:18pm On Mar 22, 2018
dopeJemi:


You have a point, but wait oh, with all these plenty talks of sugar mummy, I think say una go make donations sef undecided as per una paddy wey I be. Na wa oh, so much for brotherhood undecided

Ibime n that oloriburuku Raumdeuter suppose sort things out....
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by dopeJemi: 4:20pm On Mar 22, 2018
diggz:


Ibime n that oloriburuku Raumdeuter suppose sort things out....

Na wash
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by obainojazz(m): 4:36pm On Mar 22, 2018
Abeg.. I'm obainojazz and I dey single. I need a tall, fair, hairy and fat goat to buy this easter. tongue

2 Likes 1 Share

Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by afrodoc2: 4:41pm On Mar 22, 2018
Nihilstjnr:


good afternoon my chairman.

Bros we go need involve lawyer for this matter o. Our agreement was one-directional...airmax was coming from your direction only.

Ani you don go revise the terms of agreement Again ni?

Abeg wey Airmark the digger?

You are right, the bet was uni-directional. I no think say the guy suppose dey bet, this na at least the 2nd time wey e no go check the terms clearly.

1 Like 1 Share

Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by Nihilstjnr: 4:59pm On Mar 22, 2018
oboi you don ever razzle babe, wey even the babe hail your for your smoothness as you dey collect the number?

Omo things dey happen for this world.

Dopejemi I believe in you. E go happen
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by sod09(m): 5:04pm On Mar 22, 2018
diggz:


I get...but try have a reasonable and realistic one bro...cuz no be everybody dey fit arrange well before dem settle down....most guys can only afford basic things before them settle down e.g accommodation, a single vehicle and feeding.
why is everybody always saying this,you know marriage ain't for everybody right
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by Greatihex(m): 5:11pm On Mar 22, 2018
elrony:
Greatihex shall write a 5000 word verse of lamentations on this abode with ink of yokolised tears!!!


wetin I do you?
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by afrodoc2: 5:15pm On Mar 22, 2018
Nihilstjnr:
oboi you don ever razzle babe, wey even the babe hail your for your smoothness as you dey collect the number?

Omo things dey happen for this world.

Dopejemi I believe in you. E go happen

One of my guys for the Caribbean that time kpan one babe. The thing scatter the girl head, she talk say she no fit keep am to herself. Immediately she message her best friend say make she come collect. About an hour later the friend show, collect her own too.

3 Likes

Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by dopeJemi: 5:17pm On Mar 22, 2018
Nihilstjnr:
oboi you don ever razzle babe, wey even the babe hail your for your smoothness as you dey collect the number?

Omo things dey happen for this world.

Dopejemi I believe in you. E go happen

This one happen to me tire for school, the second one na when I use Magic tricks take Razzle babe from her boyfriend hand live and direct, I been sabi some kind magic tricks for school that time, as I sight the babe with her bobo from afar, na my body ginger me once based on say I dey very sleek with the thing, the next day na me and the babe for beach na
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by diggz: 5:21pm On Mar 22, 2018
dopeJemi:


This one happen to me tire for school, the second one na when I use Magic tricks take Razzle babe from her boyfriend hand live and direct, I been sabi some kind magic tricks for school that time, as I sight the babe with her bobo from afar, na my body ginger me once based on say I dey very sleek with the thing, the next day na me and the babe for beach na


For which kind school naim you use run that kind package for in front of the bf? If na wen I go school walahi....dem for use ur face use scrub Kota.......

1 Like 1 Share

Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by Nobody: 5:26pm On Mar 22, 2018
raumdeuter:


You fit marry diggz and follow am go Europe

Wtf mehn grin grin
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by Nihilstjnr: 5:27pm On Mar 22, 2018
afrodoc2:


One of my guys for the Caribbean that time kpan one babe. The thing scatter the girl head, she talk say she no fit keep am to herself. Immediately she message her best friend say make she come collect. About an hour later the friend show, collect her own too.

Chai doc. Una dey chop carribean fish too?

Your net dey reach that side all the way from Oz. Mehn I hail o...
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by obainojazz(m): 5:28pm On Mar 22, 2018
afrodoc2:


One of my guys for the Caribbean that time kpan one babe. The thing scatter the girl head, she talk say she no fit keep am to herself. Immediately she message her best friend say make she come collect. About an hour later the friend show, collect her own too.
I pkan one babe, she woke up 4 am to look me as I dey sleep..Her bf called her, she told the nigga not to call her again. embarassed Dumped her that day sha, later invited her a week later, she came... But still told her it won't work out embarassed Collected one more time before I evaporated from that area. sad
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by diggz: 5:29pm On Mar 22, 2018
GloryIsaac:


Wtf mehn grin grin

Raumdeuter is a shameless man...you no know?
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by dopeJemi: 5:29pm On Mar 22, 2018
diggz:



For which kind school naim you use run that kind package for in front of the bf? If na wen I go school walahi....dem for use ur face use scrub Kota.......

The tag wey follow my name that time sef no fit let anybody do anyhow come my side, the fear of a warri boy for my school is the beginning of wisdom, besides na the two of them I run the magic tricks for, but for my mind my main audience na the babe.

Na one school for Benin Republic
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by Nobody: 5:30pm On Mar 22, 2018
diggz:



Na here una take dey make mistake so....in life there's always the right time or period or phase for everything. if you no do am when time reach based on some side goals....e go turn into carryover wey fit affect you or stress you out in the future.

In essence, I am saying you should continue to live your life head on....if you think its time for you to marry, you have someone to marry and you can afford to marry and take care of your family......strolling abroad with your family shouldn't be enough to stop you from getting married now....if not, you go be like 70 years still dey train kids dey go....that's if you want kids to start with.

Words from the well of wisdom. Thank You, Sir. cheesy grin

2 Likes 2 Shares

Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by diggz: 5:33pm On Mar 22, 2018
dopeJemi:


The tag wey follow my name that time sef no fit let anybody do anyhow come my side, the fear of a warri boy for my school is the beginning of wisdom, besides na the two of them I run the magic tricks for, but for my mind my main audience na the babe.

Na one school for Benin Republic



Make e just be for there....cuz if na babalawo elrony school wey him graduate from with plenty waffarians.....you too know say all of una go die well on top the matter abi? cheesy

1 Like 1 Share

Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by diggz: 5:35pm On Mar 22, 2018
sod09:
why is everybody always saying this,you know marriage ain't for everybody right


Oga....most blacks ... especially Africans are wired to have a companion.....if you like pay money make am official...if you like get permanent gf ....all join but either way....no be by force to marry sha...Na by choice.

1 Like 1 Share

Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by dopeJemi: 5:35pm On Mar 22, 2018
diggz:




Make e just be for there....cuz if na babalawo elrony school wey him graduate from with plenty waffarians.....you too know say all of una go die well on top the matter abi? cheesy

Unless say I get two heads, I no go try am cheesy cheesy
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by Nihilstjnr: 5:36pm On Mar 22, 2018
dopeJemi:


This one happen to me tire for school, the second one na when I use Magic tricks take Razzle babe from her boyfriend hand live and direct, I been sabi some kind magic tricks for school that time, as I sight the babe with her bobo from afar, na my body ginger me once based on say I dey very sleek with the thing, the next day na me and the babe for beach na

When you say magic tricks...

What do you mean?

Hope say you no be one of those boys wey dey carry deck of Whot upandan shouting, pick a card, any card...

1 Like

Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by Nobody: 5:40pm On Mar 22, 2018
afrodoc2:


One of my guys for the Caribbean that time kpan one babe. The thing scatter the girl head, she talk say she no fit keep am to herself. Immediately she message her best friend say make she come collect. About an hour later the friend show, collect her own too.

Doc Doc grin grin
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by dopeJemi: 5:42pm On Mar 22, 2018
Nihilstjnr:


When you say magic tricks...

What do you mean?

Hope say you no be one of those boys wey dey carry deck of Whot upandan shouting, pick a card, any card...

Lmao, No. Na improv own I dey do, I dey use wetin dey around me, the only time I use cards na when babe come my house, but outside na improv, that day na paper wey I see for ground I use, I make the paper float for air
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by Nobody: 5:43pm On Mar 22, 2018
diggz:


Raumdeuter is a shameless man...you no know?

I weak sad.. the kin thing person dey read for here ehn grin grin..

Pick a card cheesy grin grin
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by Nihilstjnr: 5:44pm On Mar 22, 2018
dopeJemi:


Lmao, No. Na improv own I dey do, I dey use wetin dey around me, the only time I use cards na when babe come my house, but outside na improv, that day na paper wey I see for ground I use, I make the paper float for air

Good Lord

2 Likes

Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by afrodoc2: 5:47pm On Mar 22, 2018
GloryIsaac:


Doc Doc grin grin

No be me o, na my padi. cheesy
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by afrodoc2: 5:49pm On Mar 22, 2018
Nihilstjnr:


Good Lord


grin

You sef shock?
Paper float for air abi wetin i read? Dopejemi why you no float paper for these sugar mummies na?

2 Likes

Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by dopeJemi: 5:53pm On Mar 22, 2018
afrodoc2:


grin

You sef shock?
Paper float for air abi wetin i read? Dopejemi why you no float paper for these sugar mummies na?

Na floating paper those ones wan chop? This thing I dey talk na about 5 years ago, I don even forget everything sef
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by dopeJemi: 5:55pm On Mar 22, 2018
Nihilstjnr:


Good Lord


I had to get that babe one way or another, I am talking a Beverly Naya kinda chick, I don use tricks take date 2 of the hottest chicks for our vicinity, and no I didn't do card tricks
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by Nobody: 5:57pm On Mar 22, 2018
afrodoc2:


No be me o, na my padi. cheesy

All these "my friend" stories cheesy grin, Wehdone Sa wink grin grin
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by afrodoc2: 5:58pm On Mar 22, 2018
Nihilstjnr:


Chai doc. Una dey chop carribean fish too?

Your net dey reach that side all the way from Oz. Mehn I hail o...

I was there before i moved to Aussie. That na where i know Ibime cousin from.

Omo that place na efrebo, both from the women and their jealous n violent men.

The women no send at all, if they like you they will come for you and only Chukwu okike abiama can save you from them.
Re: Official Chelsea Fan Thread: Champions Of Europe 2021 by afrodoc2: 6:00pm On Mar 22, 2018
GloryIsaac:


All these "my friend" stories cheesy grin, Wehdone Sa wink grin grin

This one na my friend, no be me. He is in Birmingham now, left that caribbean side before me.

(1) (2) (3) ... (5003) (5004) (5005) (5006) (5007) (5008) (5009) ... (19227) (Reply)

Viewing this topic: 4 guest(s)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 42
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.