Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,727 members, 7,824,054 topics. Date: Friday, 10 May 2024 at 09:29 PM

Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) - Dating And Meet-up Zone - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Dating And Meet-up Zone / Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) (37679 Views)

Romance Chat/hookups/Poems Section(PIDGIN ENGLISH ONLY) / Dave2's Mahjong Parlour with his Buddies! / The Beer Parlour (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (30) (Reply) (Go Down)

Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 3:09pm On Jun 15, 2012
OKAY LADIES MAKE UNA OPEN YOUR TWO EARS WIDE OPEN AND HEAR WETIN WE WAN TELL UNA AS E BE SAY UNA NO DEY UNDERSTAND OUR ENGLISH, WE GO TALK AM FOR PIGIN


NOTE :Na ONLY PIDGIN Make Una Take Respond.

If You No Want Make Amadioha Pay You Visit no contribute if you no get wetin to talk.


*No be every man wey dey drive car get money. Some of them be driver, some na their papa car, some na their friend car, some na their neighbor car, some even steal the car sef. Be careful make them no catch you inside car with armed robber because na only man wey get car you wan follow.

* Marriage no be by force, if man say him no wan do again, make una no threaten to kill am. Like that woman wey chase her bobo with knife enter police yard, now na kirikiri she dey chop meal.

*You say you no fit follow small boy. Shey you don forget say that aristo wey you dey follow today na small boy him sef be yesterday. No dey look down on those bobo wey dey toast you today, you no know wetin dem go be tomorrow.

*No be every girl wey stand for road be ashewo. If you open leg because you dey expect brazillian hair, Blackberry, Gucci bag, Prada perf or pocket money after the 'action' you sef be ashewo.

*try dey take yourself out small, even if na mama put. That way una no go dey order like Oliver Twist when him carry una commot.

*Dey try spend small for your man, no be say na just to dey collect from am una sabi.

*No think say all boys wey toast you come for marriage. We wan study you before we for fit talk of marriage.

*Man wey dey find wife no go take you serious if you put pancake for you face like drawing board and wear cloth like say the material no reach. Na only boyfriend you fit find with that kin look.
If you wan marry, begin dress and act like wife material no be like ashewo for allen.

*You sef dey try buy small small thing for your man even if na small body spray. Shame no dey catch you if na just to dey collect from am una sabi.


LADIES MAKE UNA ALSO FEEL FREE TO TALK UNA MIND BUT NO FORGET SAY NA PIGIN ONLY OH!

10 Likes

Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Florentine: 3:15pm On Jun 15, 2012
Area.......I hail oo....I tro way salute......Una wel done oo....My warri boys,,una Bam wel wel......but ds one wen una dey yab we girls so,,,ee no gel @ al oo....Make una try put una mouth for Pit toilet.......

1 Like

Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 3:18pm On Jun 15, 2012
Florentine: Area.......I hail oo....I tro way salute......Una wel done oo....My warri boys,,una Bam wel wel......but ds one wen una dey yab we girls so,,,ee no gel @ al oo....Make una try put una mouth for Pit toilet.......

Omo babe, your head dey there joh! Nothing do you.

Na open ground oh! Make una too throway yab give the boys. Anybody wey no get mind, make e no show face.

I hail back mama. No kian!!!
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Nobody: 3:25pm On Jun 15, 2012
Smh.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 3:36pm On Jun 15, 2012
sexkillz: Smh.

Sango, Shopono, Amadioha and Esuwobata go hold emergency meeting on how to 'discombulate' that hand wey you use type that nonsense. You no sabi read instruction?

4 Likes

Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Nobody: 3:39pm On Jun 15, 2012
acidtalk:

Sango, Shopono, Amadioha and Esuwobata go hold emergency meeting on how to 'discombulate' that hand wey you use type that nonsense. You no sabi read instruction?
It's 'discombobulate'. . .
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 3:43pm On Jun 15, 2012
sexkillz: It's 'discombobulate'. . .

Okay sir.
Next time you go talk say "na discombobulate". No english for here.

By the way, where for this earth you pick that english from?

2 Likes

Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Nobody: 3:58pm On Jun 15, 2012
acidtalk:

Okay sir.
Next time you go talk say "na discombobulate". No english for here.

By the way, where for this earth you pick that english from?
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by nuattitude74(m): 4:01pm On Jun 15, 2012
Dat is eh, I taya for 9ja babes sha ! Especially the ones wey dey enta any car wey offer dem lift. For Lekki Yesterday na so one babe begin hala for night " I HAVE BEEN ROBBED O ! OMG ! Ye MO GBE ! I'm DEAD " etc etc. When dem ask her wetin happen she say one guy give her lift from CMS and when dem reach Lekki the guy pretend as if the car get problem and tell her make she come down help am push d car to start. Na so the babe come down and as she try to push the car, shuo, na so the guy start the car and JOIN BREEZE ( to Zoom off, disappear ) with the babe Bag ! When dem ask her wetin dey her bag say she carry 298 Thooooousand Naira! People begin hiss mtcheww, mtcheww ! Dem ask her why she nor take drop to Lekki. She say na because the guy look nice and she nor expect say na ominla the guy go be !

4 Likes

Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Nobody: 4:05pm On Jun 15, 2012
nuattitude74: Dat is eh, I taya for 9ja babes sha ! Especially the ones wey dey enta any car wey offer dem lift. For Lekki Yesterday na so one babe begin hala for night " I HAVE BEEN ROBBED O ! OMG ! Ye MO GBE ! I'm DEAD " etc etc. When dem ask her wetin happen she say one guy give her lift from CMS and when dem reach Lekki the guy pretend as if the car get problem and tell her make she come down help am push d car to start. Na so the babe come down and as she try to push the car, shuo, na so the guy start the car and JOIN BREEZE ( to Zoom off, disappear ) with the babe Bag ! When dem ask her wetin dey her bag say she carry 298 Thooooousand Naira! People begin hiss mtcheww, mtcheww ! Dem ask her why she nor take drop to Lekki. She say na because the guy look nice and she nor expect say na ominla the guy go be !
Hilarity. . . grin grin
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by 190: 4:16pm On Jun 15, 2012
Nigerian girls y'all nid help anyways
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by nuattitude74(m): 4:39pm On Jun 15, 2012
Chai ! Dem ask the babe which kain car the guy dey drive and she say NA HONDA CIVIC. Naim one guy say "HONDA CIVIC" !? " Dat means na AUTOMATIC na" ! Shuo ! See me see 9ja babe wey wan push-start Automatic car O ! The babe open mouth to talk but didnt quite make it. Na so she BURST CRY !

3 Likes

Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 6:47pm On Jun 15, 2012
nuattitude74: Dat is eh, I taya for 9ja babes sha ! Especially the ones wey dey enta any car wey offer dem lift. For Lekki Yesterday na so one babe begin hala for night " I HAVE BEEN ROBBED O ! OMG ! Ye MO GBE ! I'm DEAD " etc etc. When dem ask her wetin happen she say one guy give her lift from CMS and when dem reach Lekki the guy pretend as if the car get problem and tell her make she come down help am push d car to start. Na so the babe come down and as she try to push the car, shuo, na so the guy start the car and JOIN BREEZE ( to Zoom off, disappear ) with the babe Bag ! When dem ask her wetin dey her bag say she carry 298 Thooooousand Naira! People begin hiss mtcheww, mtcheww ! Dem ask her why she nor take drop to Lekki. She say na because the guy look nice and she nor expect say na ominla the guy go be !

Shooo!!!
Na wetin osho free dey cause oh! These girls like free thing ehm. If dem one go London and money for 1st class, dem no mind take free okada go there even if the journey go be 12years. All for free stuff
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 6:49pm On Jun 15, 2012
nuattitude74: Chai ! Dem ask the babe which kain car the guy dey drive and she say NA HONDA CIVIC. Naim one guy say "HONDA CIVIC" !? " Dat means na AUTOMATIC na" ! Shuo ! See me see 9ja babe wey wan push-start Automatic car O ! The babe open mouth to talk but didnt quite make it. Na so she BURST CRY !

If it be say na one aristo give am money for her house rent now. After six months wey she don dey do bedroom slavery, now all the money do follow 'osho free' go.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 9:03pm On Jun 15, 2012
Dem don use 'forming' scatter all of una head.

So because na time for pidgin now all of una come dey form butty? Una papa.

Whereas na people wey grow up for Mushin, Agege, Orile, Ijora badia, Okomaiko, Akute, Abule Egba, Bariga and Ajegunle full here.

Who una wan come form for?

*WAKA*

2 Likes

Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by millinmax2(m): 9:26pm On Jun 15, 2012
acidtalk: Dem don use 'forming' scatter all of una head.

So because na time for pidgin now all of una come dey form butty? Una papa.

Whereas na people wey grow up for Mushin, Agege, Orile, Ijora badia, Okomaiko, Akute, Abule Egba, Bariga and Ajegunle full here.

Who una wan come form for?

*WAKA*


My Brother i tire for dem all o..
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 9:30pm On Jun 15, 2012
[
millinmax2:


My Brother i tire for dem all o..

All these Pako pikin dem wey one dey form.

Me sef wey grow up for banana island embarassed no dey form.

Nonsensical jagbajantis.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Beync(f): 10:00pm On Jun 15, 2012
My brother that shnap wey u drink dis evenin don expire tey tey, check the bottom u go see am. If owu dey woryy u, talk am, I no dey stingy.

3 Likes

Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Nobody: 10:13pm On Jun 15, 2012
So, for your mind u be female counselor abi??!! Abeg! if u no get beta thing talk, u no fit dey chop epa keep ur mouth buzy?
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 10:19pm On Jun 15, 2012
Beync: My brother that shnap wey u drink dis evenin don expire tey tey, check the bottom u go see am. If owu dey woryy u, talk am, I no dey stingy.

Babe abeg I no mind. I go manage 12 alomo bitters, 2 shinapp, 1 keg of opa eyin, 1 crate of baba dudu aka the real man. And you go follow find 2 nice okpeke babes.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by annawhite(f): 10:19pm On Jun 15, 2012
Shuo na so
See as all dis small small boys dey form meeting for we head
Una don do yahoo yahoo finish
Who no like beta thing

2 Likes

Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 10:23pm On Jun 15, 2012
Shollypopz: So, for your mind u be female counselor abi??!! Abeg! if u no get beta thing talk, u no fit dey chop epa keep ur mouth buzy?

Epa don cost for we yard.
Even ashewo don cheap pass epa now for area.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 10:25pm On Jun 15, 2012
annawhite: Shuo na so
See as all dis small small boys dey form meeting for we head
Una don do yahoo yahoo finish
Who no like beta thing

Dey find yahoo yahoo boys now.
You never follow read that story wey wan guy zoom off with one maga babe money ontop say she dey find free motto.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Nobody: 10:28pm On Jun 15, 2012
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Beync(f): 10:30pm On Jun 15, 2012
acidtalk:

Babe abeg I no mind. I go manage 12 alomo bitters, 2 shinapp, 1 keg of opa eyin, 1 crate of baba dudu aka the real man. And you go follow find 2 nice okpeke babes.
shior, na for my head u won get pot belly? All these drinks sef don reach to do traditional wedding for one umunna village in otukpo state.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 10:32pm On Jun 15, 2012
Beync: shior, na for my head u won get pot belly? All these drinks sef don reach to do traditional wedding for one umunna village in otukpo state.

Pray make you no jam irobobo man, na3 years house rent he go drink finish for one sitting.
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Nobody: 10:34pm On Jun 15, 2012
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 10:34pm On Jun 15, 2012
Royal-VII:
..Pidgeon English?.....

Fhhuck Outa Hea.

Who be this village bush baby wey come here come dey form?

You wey be say na trailer them use carry you go city.

Waka enter BRT lane joh!

2 Likes

Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Nobody: 10:35pm On Jun 15, 2012
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Nobody: 10:40pm On Jun 15, 2012
Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by acidtalk: 10:42pm On Jun 15, 2012
Royal-VII:
Wer diese unwissenden Narren, der gegen korrektes Englisch sprechenden Menschen diskriminiert zugunsten der ungenauen Skizze schlecht codiert sein.


...?

Same To You.

3 Likes

Re: Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) by Beync(f): 10:43pm On Jun 15, 2012
acidtalk:

Pray make you no jam irobobo man, na3 years house rent he go drink finish for one sitting.
na dis kind man dey make me forget my wallet for house wen I wan take am out.

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (30) (Reply)

I Need A Rich Sugar Mummy Who Can Take Care Of Me Financially / For Those In Need Of Sugar Mummy In Abuja / I Need A Sugar Mummy

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 49
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.