Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,195,059 members, 7,956,960 topics. Date: Tuesday, 24 September 2024 at 12:07 AM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance (3006 Views)
Handsomeness Is No Longer A Passport To Getting Girls / My Handsomeness Is Becoming A Problem To Me. / Handsomeness Of Nairaland Men (2) (3) (4)
Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by Breastman(m): 7:39pm On Jun 28, 2012 |
If na handsomeness, I sabi say I try wella. I dey represent, and my okrika fitted shirts dey fit me die. But as I fine reach, for the past one month, all the girls wey I dey toast no dey even respond to my greeting. But na today I con understand where the problem dey. I manage carry my friend uncle Honda Evil Spirit drive go car wash for Surulere. As I wash moto finish na im I take style drive the machine around dey find where I go buy boiled corn and coconut, na so chicks full every corner for road, I finally toast 7 girls within one hour as I fit no see moto drive again until further notice. Inside the 7 babes, na 6 and half of them give me number with all pleasure! Abi I handsome today pass before? One of dem sef don first call me less than 2 hours after we exchange number. I dey think as I go take follow up their runs, as e be say dem no go see me with moto next time. Walahi, na devil go baptise all of una wey be nowadays girls. If I go do rituals na una fault oh. A whole fine boy una go dey useless am because say things never too bam. Okay na, make we dey see. 6 Likes |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by bashr8: 7:46pm On Jun 28, 2012 |
lol which one be honda evil spirit again, well i can relate to what ur saying cash rules everything in naija. |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by blackbalang(f): 7:52pm On Jun 28, 2012 |
can't stop laughing |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by Nobody: 7:54pm On Jun 28, 2012 |
mukekekeke |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by MrsChima(f): 7:56pm On Jun 28, 2012 |
Why do men think we want ugly partners? 1 Like |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by slimyem: 8:04pm On Jun 28, 2012 |
lmfao.... Na so e be! who nor like better thing? |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by Tyche(m): 9:10pm On Jun 28, 2012 |
To follow up the runs just keep borrowing your friend's uncle car. But recite Psalm 23 bị going out make you no bash the car. 1 Like |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by Mynd44: 9:19pm On Jun 28, 2012 |
Stop hanging out with hungry women. They will only feed off you and your evil spirit 3 Likes |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by Breastman(m): 12:06am On Jun 29, 2012 |
Tyche: To follow up the runs just keep borrowing your friend's uncle car. But recite Psalm 23 bị going out make you no bash the car. Bros if I tell you how the car take enter my hand today eh, you go know say Aboki go first learn how to recite Psalm 23 first before I go ever see that moto drive again. But the moto bad no be small. The Wizkid Azonto wey dey blast for the stereo come be like say I dey club. Chai. Under two hours sef the AC don make omo boy fresh small. God dey. 2 Likes |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by Nobody: 12:09am On Jun 29, 2012 |
Naija is a truly funny place |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by Breastman(m): 12:13am On Jun 29, 2012 |
slimyem: lmfao.... You see am? Na the thing wey I dey talk be that. Una want make spiritual konji kill man pikin because say im never hold side. One day na one day. If na rituals we go do, no wahala |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by cindyrella(f): 3:42am On Jun 29, 2012 |
Laugh wan kill me. @op remember say borrow borrow no good oh.. |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by Mynd44: 5:46am On Jun 29, 2012 |
cindyrella: Laugh wan kill me. @op remember say borrow borrow no good oh..The OP and the whores he toasted are the same thing. FAKERS |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by bestofthisyear(m): 7:37am On Jun 29, 2012 |
Hilarious |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by Nobody: 7:44am On Jun 29, 2012 |
lmao. |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by Nobody: 7:48am On Jun 29, 2012 |
Mrs.Chima: LOL you don't get the "joke"? Mynd_44: Stop hanging out with hungry women. They will only feed off you and your evil spirit LMAO!! |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by Oxone(m): 9:41am On Jun 29, 2012 |
Mrs.Chima: well antecedents madam! how are u? long time! 1 Like |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by paix(m): 1:32am On Jun 30, 2012 |
I no blame you my broda. Even d girls na so so fake fake tin dem carry for body. Fake eye lashes, fake nails, fake complexion, fake boobs, fake butts, fake open teeth, fake hair. Everytin na fake. |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by Nobody: 5:27am On Jun 30, 2012 |
paix: I no blame you my broda. Even d girls na so so fake fake tin dem carry for body. Fake eye lashes, fake nails, fake complexion, fake boobs, fake butts, fake open teeth, fake hair. Everytin na fake. WTF!!! is that even attractive? |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by Daywalker1: 5:39am On Jun 30, 2012 |
Omo you try no be small but dey still dey toast them? Na them dey even toast guys nowadays |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by ArQueBusieR(m): 10:14am On Jun 30, 2012 |
Being handsome is a plus. |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by Nobody: 5:43pm On Feb 14, 2013 |
ArQueBusieR: Being handsome is a plus. Na so, Not a prerequisite.... @OP No lele, one day things go bam! |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by Nobody: 9:41pm On Feb 14, 2013 |
rokiatu: For some babes, open-teeth is hawt actually. |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by KINGwax(m): 12:21am On Feb 15, 2013 |
2buff:hot=original hawt=fake U be fake too? |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by Nobody: 12:32am On Feb 15, 2013 |
Seriously though, for those in naija, what are you still doing on NL? Una suppose dey do real life paroles Me just dey wait make work finish. |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by pleep(m): 12:56am On Feb 15, 2013 |
isnt a honda spirit a bike? imma get me one, ironically that makes you more attractive over here |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by Nobody: 3:34am On Feb 15, 2013 |
pleep: isnt a honda spirit a bike? imma get me one, ironically that makes you more attractive over here |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by Desloaaa(f): 3:52am On Feb 15, 2013 |
i can imagine..but d last time i checked,it ws still***MONEY MAKES THE WORLD GO ROUND..n all em pretty gals go down low...all d fine boys wey no go stop to dey look mirror.abeg make una activate HUSTLING MODE |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by gothrones(m): 12:04am On Apr 28, 2013 |
Bump. |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by 190: 12:08am On Apr 28, 2013 |
da hell a 5yr old thread all about |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by gothrones(m): 12:37am On Apr 28, 2013 |
5 year old thread? Of course, Math is not your forte. |
Re: Handsomeness Is Useless In Nowadays Romance by 190: 12:48am On Apr 28, 2013 |
gothrones: 5 year old thread? Of course, Math is not your forte. its as old as the last strand of hair on your pubic nut case 2 Likes |
Undergraduate Couples / Ladies: How Do You Identify A God-fearing Man? / How Do I Stop Loving Her?
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 24 |