Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,401 members, 7,822,839 topics. Date: Thursday, 09 May 2024 at 05:51 PM

Man Wey Dey Reason - Literature (5) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Man Wey Dey Reason (549972 Views)

As E Dey Happen (pidgin Tory Wey Sweet Wella) / AS E DEY Happen(a Pidgin Story) / Ibo Boy Wey Like Yoruba (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (112) (Reply) (Go Down)

Re: Man Wey Dey Reason by YOUNGKAHUNA: 6:12pm On Mar 09, 2013
Flow U No Try Ooo....How U Go Start Story Without Lettin Me Know? Sha Nothin Spoil I Still Catch Up........Let The Tales Flow.
Re: Man Wey Dey Reason by 4kizo(m): 8:11pm On Mar 09, 2013
Flow dis 1 wey u high dis evening, make u no com sleep off wey u go dy type
Re: Man Wey Dey Reason by MrAnoTi(m): 8:31pm On Mar 09, 2013
FLow no be only Man hand you fall yu fall my own sef
Re: Man Wey Dey Reason by Therock5555(m): 8:43pm On Mar 09, 2013
Flow continue o. Abeg ushers show me seat pls
Re: Man Wey Dey Reason by Emperortj93(m): 9:42pm On Mar 09, 2013
Where flow go nah?, or dat 1759 (or so) no bah stil clear 4 him eyes.
Re: Man Wey Dey Reason by 4kizo(m): 9:42pm On Mar 09, 2013
Hia! Flow nawao, u neva type anytin so fr

1 Like

Re: Man Wey Dey Reason by flow1759: 10:23pm On Mar 09, 2013
"guy dis kponkpon work make sense oh" i said as we walked home after work. "when i dey tell u say kponkpon work na the best work, u no believe" Man said. "Man wey dey reason!! Man wey dey reason" I and Brainbox hailed.


It was for sure the best work like Man said. because i was smiling home with 2400naira, though the work i did was worth it. And if u multiply 2400 by 30days in a month, then u would aggree with me that Kponkpon work was more Lucrative than a Bank job. I promised myself i would put in more effort to earn as much as Igbakwambo. It was only a promise.


"Brainbox how much u get sef?" i asked. "Omo na 1200 oh, but tommorow na another day sha" he responded. If only Tommorow could speak. "oboy i dey hungry oh" I said yawning. "we go chop na, we go enter Obele canteen go chop" Man added.


"who be Obele?" Brainbox queried, "no worry when u reach the canteen u go see who him be" Man said. "guy all my body dey pain me oh" I complained. "no worry, e get one strong drug wey we go buy, if una dey drink dat drug everyday after una work finish, una no go dey get body pain, the drug dey give power, nahim i dey drink sef" Man said. On hearing that, i was happy my "kpokpon strength" would be enhanced by an elixir. Not knowing the drug Man was talking about was almost like c'ocaine, it was killing.


Obele!!The only thing i knew about Obele was that Obele meant Small in English. I never knew the person we would meet at the Canteen would be small but mighty.

2 Likes

Re: Man Wey Dey Reason by princesa(f): 11:02pm On Mar 09, 2013
why do you always have to spoil the suspense...you don't need to give the spoilers for the next update jó :-/


*opens the next box of popcorn* cool

1 Like

Re: Man Wey Dey Reason by Madawaki01(m): 11:24pm On Mar 09, 2013
We dey wait ooWe dey wait ooWe dey wait oo
Re: Man Wey Dey Reason by seunblack(m): 12:10am On Mar 10, 2013
Flow my man,try update b4 day break na
Re: Man Wey Dey Reason by Gepheral: 7:06am On Mar 10, 2013
Ha!!!.... gepherality on board, my flight to this thread was delayed but am glad I'm already reaping the fruit of my ticket even before landing....
Hehehehe enough laughter here oo..., good work bro!!!
Re: Man Wey Dey Reason by ocee31(m): 12:57pm On Mar 10, 2013
Flow how far na? Why u dey do us like dis?
Re: Man Wey Dey Reason by valboy20(m): 1:04pm On Mar 10, 2013
Mehn...finally dx bouncerx wey flow hire for his thread jux allowd me in after a lil bribe.

flow...u @ it again...kip id up n make sure u consistent wd ya update
Re: Man Wey Dey Reason by 4kizo(m): 1:48pm On Mar 10, 2013
Ooh, continue nah
Re: Man Wey Dey Reason by yoyothefirst(f): 1:51pm On Mar 10, 2013
Oga Flow I won kill myself with laugh with d third update. sha.... U too much weldone
Re: Man Wey Dey Reason by FoxyUltimate(m): 2:32pm On Mar 10, 2013
Flowwwwwwwwwwwwwwwwwww
Re: Man Wey Dey Reason by alfablondy: 3:28pm On Mar 10, 2013
oga flow wetin dey happen now? by this time yesterday u don update twice. we dey here dey wait o!
Re: Man Wey Dey Reason by FKO1(m): 5:07pm On Mar 10, 2013
flow i follow u like twitter !
Re: Man Wey Dey Reason by flow1759: 5:13pm On Mar 10, 2013
"Obele give me indomie and Egg, and u go make custard for me sef, u go put enof milk for the custard oh, so the blood wey don comot for my body as i dey work go come back" Man said as we entered Obele canteen. "Obele which soup una cook?" i asked. "u dey mad? Dis place be like where dem dey sell soup?" Obele cursed. "see dis small pekin oh, na me u dey tell say i dey mad? I be ur mate?" i said. "i be like small pekin for ur eye? na ur papa be small pekin" Obele cursed. I was getting mad at the way Obele was insulting me. I never believed Children could be that rude. It was driving me crazy.

I stood up and said, "na one hand i go take finish u oh, ur mate dey primary sch, u dey here, who be ur Oga sef?". Man stood up, came close to me and whispered to my ears saying; "guy na him be the main Obele oh, him no get Oga oh, na him get dis canteen oh". I laughed out loud and said, "how dis small short guy go get dis kin big canteen". I tot he wasn't the main Obele, i tot there was another Obele inside. "na me u dey call short guy?" Obele yelled, keeping his guard and ready to fight. "na me u wan fight? una no get old man for una Village abi?" i yelled keeping my guard also.

"Flow see small pekin wey u wan fight, u no dey shame oh" i said in my mind. It was as if Man heard what i said, he stood up, came close to me and whispered to my ears: "Flow that Obele no be small pekin oh, him just be like Aki and PawPaw Wey dey act film, na Married man him be oh". I just wanted to beat the hell out of Obele so i didn't believe what Man told me. I didn't believe Obele was a Pigmy.

"i go beat u oh, i go blow ur face oh" Obele yelled. "u wey short like dis, how ur hand go take reach my face?" i tot. I never knew that even if his hands couldn't get to my face, there was somewhere it could get to.

My d'ick.

He grabbed my d'ick with so much fury. I cried out. I pleaded with him. I even told him i was sorry, yet he still held my d'ick so tight. I heard a sound as if something had burst. I tot my s'crotum had burst. "Man make una beg for me na, make him no cut my p'rick oh" i cried out.

Man and Brainbox came to my rescue saying; "Obele abeg leave him p'rick na!! Obele abeg no cut him p'rick!! Him no go call u small pekin again!!". "i dey mad wey i go call you small pekin? u be big pekin oh!!!" i cried out.

7 Likes

Re: Man Wey Dey Reason by opeoluwa2(f): 5:22pm On Mar 10, 2013
Happy sunday,
Oga flow pls flow the flow for us to flow with ......
*lol*

1 Like 1 Share

Re: Man Wey Dey Reason by Hydronium(m): 5:27pm On Mar 10, 2013
**Crosses leg on a stool and lifts a goblet of G4 heavily laced with sugar to mouth, just then phone rings, he reaches for it and flings it into the nearest wall** No disturbance pls!!

2 Likes

Re: Man Wey Dey Reason by Emperortj93(m): 5:37pm On Mar 10, 2013
flow1759: "i dey mad wey i go call you small pekin? u be big pekin oh!!!" i cried out.
mehn dis part gat me laffin lyk a possess witch btw flow u just made ma sunday

2 Likes

Re: Man Wey Dey Reason by flow1759: 5:45pm On Mar 10, 2013
opeoluwa2: Happy sunday,
Oga flow pls flow the flow for us to flow with ......
*lol*

happy sunday Opeoluwa, u go church so? I will try my best to keep flowing. Remember, STILL I FLOW.
Re: Man Wey Dey Reason by flow1759: 6:38pm On Mar 10, 2013
We left Obele's canteen at about 6pm and we walked home slowly. Slowly was how my two legs could move because my third leg couldn't help hasten my steps. It was weak.


"all my body dey pain me oh, my p'rick sef dey pain me" i complained. "ehen, make we go Oga Benson shop go buy the drug" Man said. "wetin be d drug name sef?" i inquired. "the drug name na Tramadol, but i baptize am, com give am new name, the new name na Tea. So if we reach there na Tea we go say we wan buy, if not Oga Benson no go sell for us" Man responded. "him say plenty Kponkpon boys dey over use the drug, say one of the boys almost die because him take overdose of the drug. Dat na why him no wan dey sell am for anyhow person, na why him code the name of the drug as Tea" Man added.


We bought the Tramadol or rather Tea and headed straight home.


We met only Baba jay at home. "Baba jay u don chop so?" Brainbox asked Baba jay as we got home. "i never chop dis nite oh, but i chop P-square in the afternoon" Baba jay responded.


P-square wasn't the twin guys that sings. It was coined out of paw paw. It was yet another code name.



Before i forgot, we had a neighbour i didn't mention earlier; the two big paw paw trees in our compound. The trees that produced P-square.

4 Likes

Re: Man Wey Dey Reason by princesa(f): 6:57pm On Mar 10, 2013
more like it...suspensful!

and am the first to read......*sings*cheesy

1 Like 1 Share

Re: Man Wey Dey Reason by flow1759: 7:29pm On Mar 10, 2013
princesa: why do you always have to spoil the suspense...you don't need to give the spoilers for the next update jó :-/


*opens the next box of popcorn* cool

Princesa i no dey spoil suspense na. BTW give me small popcorn make i chop na, e don tay wey i chop popcorn, na guguru and ekpa i dey chop everyday.
Re: Man Wey Dey Reason by Gepheral: 8:30pm On Mar 10, 2013
Hehehehehe....cheesy cheesy cheesy ....

Flow buddy, good job o...... Happy Sunday to ya!
Re: Man Wey Dey Reason by esn1(f): 8:46pm On Mar 10, 2013
Nyc one flow. I dey feel ur flow.
Re: Man Wey Dey Reason by skoloppy31(m): 9:09pm On Mar 10, 2013
Flow you are really a badth guy..@ da mention of that tramadol,I imagine illicit act and affair u for dn engage.tramadol,benylin wit codeine,sk laced wif weed..u b correct badth boy.TRAMADOL chei...flow I fits arrest u for illegal consumption of da drug...
Re: Man Wey Dey Reason by donifez(m): 9:36pm On Mar 10, 2013
Flowey...i dey feel u
Re: Man Wey Dey Reason by opeoluwa2(f): 9:41pm On Mar 10, 2013
flow1759:

happy sunday Opeoluwa, u go church so? I will try my best to keep flowing. Remember, STILL I FLOW.


Oga flow I go church ooh.
But
#sadface#
Your update is tooo short naaaaaaw.
Pls longer update.
Plsssssssss.
Thanks inadvance
Re: Man Wey Dey Reason by flow1759: 11:24pm On Mar 10, 2013
"which Medicine una dey drink sef?" Baba jay asked as he saw us swallowing the drug. "na Tea oh" i responded. "no be only Tea, na cofee, abeg tell me the medicine wey una dey drink jor" Baba said. "ok na Tramadol" Man said, "aaaaah Tramadol!! That drug wey be like c'ocaine, una don take c'ocaine be dat oh" Baba jay said staring at us keenly. On hearing what Baba jay said, i instantly wished i could turn back the hands of time, but it was too late because the Tramadol was already seated in my stomach. "so i don drink coco be dat? Baba jay dey lie abeg, how dis drug go be coco" i tot, no knowing Baba jay was telling us the fact.

"na ur papa go drink c'ocaine no be us" Man insulted Baba Jay. "na my papa u dey curse like dat? U no dey fear me? I be ur mate?" Baba jay attacked. "how many years u be sef? Wey everytime u go dey tell everybody say u be old man" Man attacked. It was really a war of verbal attack between Man and Baba jay. "i be 39 years old, i be ur mate?" Baba said. I tot he said 29, not until he repeated; "39 years na beans? I sure say dem never even born u when i begin to drink beer, even sef, e fit be say ur Mama be my babe before she marry ur papa, before dem com born u" Baba jay said. "u dey mad, no talk of Mama and Papa like dat oh, i dey warn u oh" Man cautioned.

As the both of them continued raining abuses on each other, all i was thinking was; "so Baba jay na 39 years, mehn him senior me with 12years oh".

Baba jay looked a bit matured facially, but i never expected he could be up to 39. I now saw why he insisted he should be called "Baba jay" instead of "Jay" because his name was Jachimike. He should have told us to call him "grandpa Jay" instead of "Baba jay", because he was old enough to be a grandpa, or so i tot.

3 Likes 1 Share

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (112) (Reply)

BROKEN HEDGE By Toyin Taiwo / My Life On Campus (A True Life Story). / Red Ashes

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 45
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.