Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,769 members, 7,820,686 topics. Date: Tuesday, 07 May 2024 at 07:33 PM

Warri Parables: Words Of Our Popsi's - Culture (4) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Warri Parables: Words Of Our Popsi's (42684 Views)

Some Funny Warri Parables - By Rapmoney / Words Of Tribal Origin Used As General Slangs & Their Meanings / Warri Parables (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (11) (Reply) (Go Down)

Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Em2va: 10:32pm On Oct 16, 2008
All de bros yay! I dey hail oh, Mingwo, vre, una doh! , notin dey wida, make all de broses for hia tak time oh

Area na corekt place to be, but sha make una shine eye wela, becos , if u do any how, u see anyhow
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by naijadove: 10:45pm On Oct 16, 2008
Horse wey no get tail, na God dey pursue fly for am.

Instead trouble go happen make rain fall make everybody enter house.

e go better, e go better, naim make igbo man tey for lagos oh.

Provision store better pass kiosk.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Onyema1(m): 11:15pm On Oct 16, 2008
@poster, i dough my hat for you o! because my people talk am say-

i no fit climb na for ground them they talk am.

A beg make i ask una o,

mouth wey close and the one we open which one dey smell pass?
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Okijajuju1(m): 11:50pm On Oct 16, 2008
Area I dey hail O!
All the peoples wey don dey quote here, I throw way knockout for una.

Them say when person wan crase, ehn dey first grow dada.
Blind man no dey send wetin dey ehn eye.
Na wey wash hand na ehn dey follow elders chop.
The difference between choco milo and Maggi na housing.
Guns dont kill people, na the bullet dey kill.
Slow and steady na ehn dey carry last.
When breeze blow, fowl yansh go open.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by igbsam(m): 12:22am On Oct 17, 2008
Area! Area!! Area!!!, I dey hail all wafferians for house. Chai!!! I don miss ooo, anyhow sha, waferian no dey carry last as it is written in the 10 (11th) commandment. Moses no see am. I don miss wafi no be small, but nothing spoil, na house i still dey. Make I shoot my own gun too,

Trouble dey sleep, yanga go wake am

Pikin put me for ground i no wear drous (pant)

Begger Blind, make u near him money, na there you go believe say fore sight dey.

You dey gather chest like gorrilla, o ya make you go block bullet.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by laceybric(f): 7:06am On Oct 17, 2008
He who lives in a glass house. . . . na him pepe rest

Yes oo!!!na im pepper rest but also e no need mirror at alll ooo grin grin cheesy wink
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Chrisbenogor(m): 7:16am On Oct 17, 2008
Area! Area!! Area!!!
Who do anyhow go see anyhow
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Chrisbenogor(m): 7:20am On Oct 17, 2008
Area! Area!! Area!!!
Who do anyhow go see anyhow
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by AndyM: 8:34am On Oct 17, 2008
Abeg make I troway my own surugede proverb.

Na small small den dey take drive mosquito wey perch for one scrotum
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by orezo(m): 10:02am On Oct 17, 2008
Warri aw una dey

i dey feel all una talk since, so i say make i troway one make e no b sey i lost

Anyhow anyhow eeehn, ogoro must jump,
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by pnkydbrain(m): 10:11am On Oct 17, 2008
A friend in need, na longer throat go kill am
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Gamine(f): 11:14am On Oct 17, 2008
The day wey pesin decide go hunt

na the same day, antelope gree climb tree
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by igbsam(m): 11:18am On Oct 17, 2008
Birds of the same feather ehnnnn na the same mama born them.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by igbsam(m): 11:25am On Oct 17, 2008
Ehnnnnn aRea, I just remember this one.

Goat wey follow dog waka self go eat shit.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Mistiky(m): 11:54am On Oct 17, 2008
Errrrhhmmm.
Papa God, buka is good but i think BIGGS is better. cool cool cool
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Woodpecker(m): 12:15pm On Oct 17, 2008
una doh
"the evil men do- ol boy na another man go suffer am"
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by niles(m): 12:58pm On Oct 17, 2008
Area! I Throw way for una,
Omor, this kind gbedu dey here since? Nai i dey go where Shuor!
Nothin do we, make we just dey carry dey go,

Them say na Watchnight pikin dey resemble Landlord,
No money, no money nai papa Ngozi take buy morto,
Actor no dey die for film, instead, the film go end,
Anyhow anyhow, gorro must jump,
Who wake up for morning no clean mouth nai know wetin e dey find for market,
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by quadrillio(m): 1:19pm On Oct 17, 2008
I hail ooooooooooo

FOR A DOG: the fear of a calabar man is the beginning of wisdom
Na person person we don mess for molue go know the different btw CURSE and CAUSE
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by MrAAU(m): 1:24pm On Oct 17, 2008
pesin wen go tiff 4 cement store  -na em know d load wen e wan carri. grin
pikin wen use agbada take stat guy-e go talk wetin e go wear wen e old grin
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by favcom(m): 1:45pm On Oct 17, 2008
Brosses grin
I hail and digbe for una o cool
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by zukkymike(m): 1:50pm On Oct 17, 2008
bros i dey hail una!!!


na pikin wey no know im mama boyfriend na him dey call am uncle!!!
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Nobody: 1:56pm On Oct 17, 2008
Area!Area!Area! Ukwa say e don sufa no be smal,upon say e get sense nai mak me climb tre and i fal com down fawo laugh so tay e tit pul
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Nobody: 1:58pm On Oct 17, 2008
Area!Area!Area! Ukwa say e don sufa no be smal,upon say e get sense nai mak me climb tre and i fal com down fawo laugh so tay e tit pul
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by sylve11: 2:19pm On Oct 17, 2008
waffi hail,
no be small thing plantain see before them  call am bole.
no be small thing rat see when make am hiss o.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Nobody: 2:19pm On Oct 17, 2008
Area! just imajin dis kain tin,dem say mama bola rapa lose from her waist nnamdi dey ask if dem se drouse(pant) wen e be say forest ful ground wit two monky dey smil insid,
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by sylve11: 2:26pm On Oct 17, 2008
pikin wen him one first him papa get bald head, na sun go kill am.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by 2sleek2NV(m): 2:30pm On Oct 17, 2008
i hail all men as una tke dey yarn una mind here. e dey do my belle 1 kain.

e no get as e wan b, who belleful must hungry o.

wetin dey cover coook, dem must open am to chop am o
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by onethree(m): 2:32pm On Oct 17, 2008
You guys are grey8!!!
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by 2sleek2NV(m): 2:36pm On Oct 17, 2008
akamu no dey form shit o
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by chamotex(m): 2:40pm On Oct 17, 2008
na small shit dey block yansh
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by sylve11: 2:53pm On Oct 17, 2008
na wetin axe do for bush naing make them carry am 4 shoulder.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by sylve11: 3:03pm On Oct 17, 2008
chamellion resemble lizard no make am be lizard.

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (11) (Reply)

Meet Wodaabe Men, A Fulani Ethnic Group Who Make-up For Easy Marriage, / Naomi Oluwaseyi Stuns In New Photo / Xenophobia: Oluwo Of Iwo, Akanbi, Protested, Carried Placard In 2014 (Throwback)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 20
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.