Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,195,264 members, 7,957,651 topics. Date: Tuesday, 24 September 2024 at 04:48 PM |
Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (62632 Views)
Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (40) (Reply) (Go Down)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 8:03pm On Mar 25, 2009 |
lagbaja: You never hear dem oyibo say life dey start at forty? At this age I no fit behave like a boy wey dey naughty. Life like good wine dey mature well well with time. Dat explain why Me & Maedan de do our love rhyme. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 8:11pm On Mar 25, 2009 |
safex101: Stainless Safex, I beg make your fine head no burst, As you de get and enjoy this e-love story at no cost. Make you use am clean your relationship if e get dust, For in dis world we de, we must dey in love or we get lost. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by BILILIS: 9:51pm On Mar 25, 2009 |
Hmm this tread is really interesting makes me wanna start my own rhyme testing meanwhile, i"m tryn to find out before i take my time out props and big ups to y'll even dropped lines not wack and a very big hug to maedan, cos u got it like dat i feel u girl u got flows dat make my toes curl am seriously trippn , no bullsh*tting, cum into my world we can make d best valentine date cos u deserve my love n no jealousy and hate from dudes who show no love n neva know how to relate trust me i got the solar power supply u full current every other hour gotta take a bow and hope we later connect somehow |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by heyo: 12:41am On Mar 26, 2009 |
@maedan am d newest loverboy on this tread even tho da sparkle of luv here is dead am gonna bring some spice of romance like red roses on a bed i am here 2 capture ur heart with my words 4 a start i believe u r so sweet like fanta if i hav u,u go always dey my medulla oblanganta u gonna b d only bullet in my gun while i'l be ur sunshade from da sun i no send where u come from i go stick 2 u pass paper gum i'l prove my luv by buyin u gucci watch than flower then send u sweet poems 2 ur phone hour after hour i don't need 2 hav a bath cz ur luv wd b my shower and ur care my towel while my tender kisses wd fill up ur bowel don't take dis hard on me sayin all dis 2 u even tho we no go see but 2 say this is 2 break free and 2 prove that in love rhyminothology, i gat a master's degree |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by kingzli(m): 12:49am On Mar 26, 2009 |
Nice rhymes guys. Keep it up |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by heyo: 1:16am On Mar 26, 2009 |
@roty u think u r smooth like butter but am here 2 make u smell like gutter i am the villain of this luv drama u don't need 2 talk,ur relationship already gat stammer don't worry u would be the dishwasher at my wedding when i take maedan 2 d altar don't cry yet cuz i gat a better offer hw about u bein in control of the video camera so u can witness hw ur luv has been taken away no matter hw hard u fast and pray it wouldn't stop the baby from comin our way so think twice before u send ur reply or else i would send u to a pig sty @maedan no matter hw deep ur luv is 4 roty i would erase it by gettin u a bentley i v observed this guy is so broke cant even buy a bicycle's spoke i go take u go st.tropez,paris we wd live in a duplex with well-mowed grasses am givin u romance backed with finance,wat more cd b chasis? ignore rotimy's village man's style of making passes |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 4:16am On Mar 26, 2009 |
Like play like play, heyo wan come put asunder But i hope say heaven no go strike am with thunder. Even Maedan head go don dey swell like balloon While him roty bobo go dey quiver like baboon. Who no go even shake if him dey compete with a business tycoon? Walahi, those guys dey spend money like say dem go die soon. Roty, take heart even if heyo take your woman To fight with am no be the way to know a real man But if you wan win a naija babe love back Then get ready to pack enough expensive goodies for sac Though none of these go make sense if u no buy her a house and a car Cos na so she go dey nag you anytime she see girls in convertibles for park |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 5:20am On Mar 26, 2009 |
But this na big challenge for maedan Like how my teacher test me last night with mandarin Luckily, i pass the test cos i dey impress her for bed She even confirm say my skills dey sweet her like mad Say she don test other guys but them performance dey bad Na why she dey always call me for night so go i fill in the gap. Ahh. . . so she too dey jolly with other guys? Na 'im me i come tell am say make she take a hike After all plenty cinco girls dey wait to be chiked Na to take my time to find the one wey i like I only go dey hope say my teacher no go find out Cos if she do, i know say she go quick quick strike And i no go like anything wey go disturb my psyche Cos i dey always like my grades for class to dey high. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by kidgenious(m): 5:38am On Mar 26, 2009 |
Roty n maedan,una don try i dey fil u guyz lyk chicken n fried rice no mind al dis yeye rats wey wan chop where dem no invest dey r pest al nairalanders go kill wit nest kari on we dey await news of una union cuz dat will d icing on d cake 4 al dis notion.Luvly thread! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 6:00am On Mar 26, 2009 |
kidgenious: Na so me too wish them Hoping say them no go fall into winch den Like how dem accuse and kill Akwa-ibom children Dem even drive 6inches nail into the head of Eden Him papa wey be Akpan even disown am Na so oyibo come show them for TV like comedians. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:31am On Mar 26, 2009 |
from heyo wey flow like neyo 2 bililis wey do im ryhmes justice even denony get im own harmony - and thanx 2 oluwdashmi, d official bridesmaid na u go dey wit me 4 d bridal escalade 2 evryone wey take d tyme to write and post even one line u all dey cordially invited, 2 d wedding of rotimymaedan united!! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:38am On Mar 26, 2009 |
nuzo: nuzo: u dey very very funny u must 2 b d MC for d ceremony which go surely take place soonest b4 anyone try tiff me from my roty dearest dem fit promise to give me even buckingham palace but d sweet naija luv 4 my roty no go lose balance!!! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:45am On Mar 26, 2009 |
kidgenious: thank u for all d good advice with my lv i no go gamble nor throw d dice u go see 4 d wedding how my lv 4 roty go true true stay in fact, na u i don appoint to be d father of d day! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:55am On Mar 26, 2009 |
roty sweety, to pick honeymoon site no be beans, but as u insist, i go choose d carribeans . . . dem get plenti palmtree n coconut for dia we go relax n drink 4 d beach without fear u know say na from d start u use ur lv rhymes capture my heart with this, no one fit compete i go stand by u til dis journey go complete n for all wellwishers for nairaland, una dey welcome d wedding go hold, both thru sunshine n rainstorm! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by chubistone: 10:14am On Mar 26, 2009 |
, can i contribute? i dont mean to intrude dis is just an interlude pls dont be rude!!!! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 12:00pm On Mar 26, 2009 |
maedan: As I dey read de latest post from my Sugarcane, big smile dey my face, Oh my belle come de sweet me pass honey as my life de enter new phase. My heart come jolly like dat Mama Cas jollyof rice because I go soon marry, My own country men and close paddies dey worry say the d-day don tarry. De finest lady for the whole world and nairaland go soon be my wife, God I no go thank you enough as you don use her better my own life. I go prove in our marriage say African men true true sabi romance, De kin sweet kiss I go give Maedan go even suprise oyibo men from France. As she still dey relax for bed, I go prepare for her a delicious food, After she don eat, I go carry her go bath so she go de always look good. I agree with you, our honeymoon na carry-go to Carribieans for romantic mood. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by ebami007(m): 1:38pm On Mar 26, 2009 |
warri chicks go really trip 4 this poem |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by heyo: 2:22pm On Mar 26, 2009 |
@roty u talk 2 much but show no workings maedan is gonna fit me like feet 2 a stokings this is beyond literal mockings only that i compete with real men not dumplings like i said i am the villain of this show and i v got the right swagga so let go i no be mike adenuga but i go make maedan glo u would earn my respect if u cd buy her lambourgini diablo u said no one can compete if u hav a car, i v got a fleet u would be drinking in the beach with no fear? homeboy,when coconuts go hammer ur head then u would have a lot 2 fear cuz i would be everywhere u take my maedan 2 and even if u r not there i got not only my eyez on her but also the C.I.A's no she's not a criminal i am just bringing more game 2 ur league like the NBA's stay clear and stop sending more love trash 2 maedan cuz on this thread,am ur nitemare,and i got the upperhand @maedan tanx 4 identifyin me with loveboy neyo but this tyme u r dealing with money speaking heyo u and i know that roty can't take u 2 da carribeans just 4 d simple fact that he has no financial means baby we gonna blend like gin and juice lovin roty when there's no doe,what's d use? my love tanda gidigba like mount everest if u r in doubt,come and put my limit 2 a test pastor chris is gonna be our wedding pastor using a limo 4 our bridal train wouldnt be a major factor wole soyinka go b the father of the day onyeka onwenu mother of the day fashi oluwa whoeva,genevive go b ur brides maid eko le meridian thats where we would get laid on our wedding night,power speaking,roty can't fight think about this darling maedan |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by gReenmAn(m): 4:19pm On Mar 26, 2009 |
Coooool stuff But can you guys fast-forward please, am eager to see the end: ~ and they lived happily ever after or ~ and maedan left rotimy for heyo waiting! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Ascony(m): 4:32pm On Mar 26, 2009 |
chai!!!!! This thread don dey shark me like tombo but maedan, mind u say rotimy dey eye ur tonto Him na old skul guy wey still dey wear bongo Be careful b4 u follow am dance tongolo |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by denony(m): 5:55pm On Mar 26, 2009 |
Rotimy and maedan make una no mind heyo na him kind of person na him dey sleep with person wife what God has joined together let no man put assunder If your na asumpta make u dey use sawanata Heyo the wey u dey talk e be like say u be yahoo heyo abi u be militant wey dey kindnapp people for business You self wey dey promise am heaven and earth u sure say u fit surface when she deman for any? i mean no harm, but u are puting assunder i beg u make u do aswire my dear maedan make u shine your eyes, some men can be dangerous just like women i know say girls dey trip for this kind heyo empty promise make u no change your mind because alarm go blow cos' as i dey see things roty fit dye because of you. |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:36pm On Mar 26, 2009 |
Ascony:I dey happy and jolly say I be old school, Maturity and wisdom de make life just cool. To fall in love, I no go cover my eyes with wool, Because I no be a yahoo boy wey use lies as a tool! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by BILILIS: 6:38pm On Mar 26, 2009 |
like play like play dis thread don dey cause traffic but today na today me i must score my own hatrick e no matter whether na valantine or not becos we go just dey jolly everyday like say we hit jackpot to rotimi n neyo walahi una dey try una best but here, i'm d hero so make una no try contest unless d end go dey too grotesque |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Chuckdee(m): 8:07pm On Mar 26, 2009 |
my oh my!!! Roty-mi & Maedan you guys are sooooooo Hot!! I dey feel the rymes like hell! Una too much nobe beans. One tin i dey promise una, i no go fail: weda for calabar, Aruba or Yaba Una wedding me most show!!!! lol!, big ups to you guys for real. I cant believe i read thru 5 pages of rymes w/out blinking and still on it. Thats how captivating you guys creativity are. I like!!! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:51pm On Mar 26, 2009 |
d thing wey impress me pass wit all dis publicity b say NL guys true true dey rhyme with alacrity see heyo n bililis, dem really get good taste if only dem go face other babes make d skillz no waste as for me, i dey hooked and d day of the ceremony don dey booked from february come reach march d love grow strong like say e get starch i know say in my choice i no go regret & no matter d temptation, i must pass d test! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:22pm On Mar 26, 2009 |
to chuckdee n denony, i no go 4get say u stand by me tho' heyo wan turn my head with im promises i go need to take care b4 i fit be im "Mrs" some guys go wan tiff person wife 4 tiffing sake no be say dem true true lv d thing wey dem wan take so even bililis i go also ignore, tho' he dey threaten n dribble more n more but in dis case he go miss d goal no way for hat trick, im don hit d pole! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by heyo: 12:03am On Mar 27, 2009 |
@denony hey denony y r u lookin 4 ma attention? u r a nobody i aint a yahoo boy just wanna give maedan so much pleasure and joy but u cd call me a millitant cz am here 2 kidnap maedan's heart with her consent and make her life more pleasant i can prove myself worthy if she demands anything am not like u dats hungry,u r thinner than a pin this is true love not a fling so close ur mouth up or u want some bling? nah i no be gay so i aint buying u sh*t i cd help u pay ur bride price with what's on my wrist and yes i am here 2 put asunder cuz roty and maedan together is a total blunder so if u have a problem it u can kip typing or maybe grow hairs on ur teeth don't have ur time so free me like terry gee @maedan why r u so blind 2 see dat u r meant 4 me they say the best things in life r 4 free my luv is the best thing 4 ur life so roll wit thee cuz am worthy and wealthy so fresh and so clean not dirty u r conversatin with one of N/land's enviable bachelors get u designer bags and shoes of different colours u said i am wasting my skills u aint seen nothin yet come check out more skills when i take u 4 shoppin sprees and 4 wat i can see,u r stickin with roty bcz of una 5pages just giv me 3 pages with ya,i would take u thru real stages dat would erase that brokea** from the picture and soothe ur nerves,heart even throat like cough mixture make warri boy vex call men from hin area no doubt say i don put omo 4 hin ariel but i dont giv a damn my care,tender touch is seekin 4 ur demand enough said |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:50am On Mar 27, 2009 |
@ heyo how i go fit convince u say u dey waste ur effort roty get all i need to give me comfort even tho' u feel u get more levels u no supposed pick quarrel like say we b rebels dis place na love zone, make we keep am cool next tym u wan vex, make u chill 4 ur swimming pool |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by ashmanpolo: 2:06am On Mar 27, 2009 |
@maedan, hope ur sista name no bi kate. My last date name was kate. She almst make me suffocate.Wen we start 2 date, she con de behav lik say we be mate. Girl wey de eat rice like 5 plates, drink beer like 2 crates. Serious i no de exaggerate. So i pray make her name no bi kate. I prefer immaculate |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by kidgenious(m): 5:23am On Mar 27, 2009 |
Like play like play,heyo wan use brute force open lock wey roty n maedan don clock wit rock guy go write ur rhymes com 4rm heaven i assure u say she no go chop am like pringles cos roty boy waz so creative n inventive 2 start sumtin conjugative n superlative so stop al dis deceptiveness beta stil find anoda chick 2sing al ur shitfulness.4k! |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by BILILIS: 8:18am On Mar 27, 2009 |
wetin N/L don join together abeg make no man put asunder becos me and meadan na bumper to bumber as una see us so we don already dey jolly dey go but just incase u neva know she dey kill me soo sloww tru tru i serious i no dey try dey funny as dem other dudes like heyo, roty n denony |
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by BILILIS: 8:36am On Mar 27, 2009 |
kai who dey claim loverboy for this thread abeg to the left go chop ur akara n bread no come here dey form superhero but rather keep ur cool instead slow and steady they say wins d race n me i dey ready for meadan to cure my craze ahead ahead i go dey flow dey go with my style too numerous to mention n nothing can stop me except divine intervention |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (40) (Reply)
Out Of The Blue / Nephilim / Rhoda
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 86 |