Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,858 members, 7,813,931 topics. Date: Tuesday, 30 April 2024 at 09:52 PM

Na You Just Wan Kill Yourself. - Romance (2) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Na You Just Wan Kill Yourself. (2680 Views)

Hookup In Lekki. Agro Wan Kill Me Abeg / We Can Have Sex After We Marry. Na You Go Tire. / This Girl Wan Kill Me οΏ½οΏ½ (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (Reply) (Go Down)

Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by FRANCISTOWN: 4:45pm On Apr 14
LAXconfidential:

True words..
Baba make I paste aza make you help my weekend make e soft small. Everywhere tight like this, abeg. πŸ™
Make we gather meet for orphanage.
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by FRANCISTOWN: 4:47pm On Apr 14
WhiteIverson:
No cap.
Make i drop aza make you bless me. I go over happy, you sef go happyπŸ’―
Make we meet for orphanage. The kids go happy, you go happy, the keepers go happy, me sef go happy. Everybody go happy.
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by FRANCISTOWN: 4:49pm On Apr 14
Jeferious:
This Op just dey cap like one of my OG. That guy just believe say you fit even commit atrocities wey pass Hitler own for this world finish, still bribe God with better package make im open gate for you to enter Heaven grin

MEANWHILE, THERE ARE PROBLEMS MONEY CANNOT SOLVE. COUNTLESS OF THEM
Any problem wey money no fit solve no get solution. But money go still amend the problem small.

1 Like

Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by FRANCISTOWN: 4:53pm On Apr 14
tochez24:


Baba die dat reasoning⚠️

Money solves 99% of problems person fit get for this lifeπŸ’―

Nah wen i dey broke i dey 🧒 dis nonsense!!!
The guy never touch block, no mind am.
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by FRANCISTOWN: 4:55pm On Apr 14
Badmashiii:


One of the OGs worth following on nairaland. Bros na man you be.

Money should not be an end. Money should be used as a means to an end. Money is a tool. Just like a gun or any weapon,the skill of the user determine the extent of damage caused by the weapon.

You get am. Money na tool, na how you sabi handle am reach e go work for you reach.
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by FRANCISTOWN: 4:57pm On Apr 14
SenecaTheYonger:


Imagine a doctor that’s always failing but he keeps using money to sort his way out until h becomes a medical doctor.

If your child was in need of surgery, would you trust such doctor to operate on them?

I’m guessing your answer is no.

If you geh money. Carry your pickney, fly am go meet better doctor(specialist) wey get reputation for better country.

The country is happy, the airline is happy, the hospital is happy, the doctor is happy, your child is happy and you are happy. Everywhere happy.

1 Like

Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by FRANCISTOWN: 5:00pm On Apr 14
samwash:
See as the op analysis everything, but he dey sweet una.
Come to think of it, na una go first still dey shot say Nigeria is very corrupt, say the system don dey give room for merit.
Just imagine someone bought his way through all the phases of life and another person want to attent greatness through due process.
Let's just do the right thing all the time.

Success is all that matters. Nobody go ask you how you take attain am.
This world is not for good people.

1 Like

Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by FRANCISTOWN: 5:00pm On Apr 14
Dizzyyish:


The doctor go bribe the child illness so the illness go leave am. The child go dey happy, the doctor go happy, you self go dey happy. Bad news no go knack anybody. grin
πŸ˜‚πŸ˜‚

1 Like

Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by FRANCISTOWN: 5:02pm On Apr 14
DoWhatThouWilt:


How old are you? Anyway I don't blame you.

Not all problems in life can be solved easily with money.

And regardless of whether you have money or not life is brutally HARD. Even wise king solo with all the gold and women congratulated the dead for they are conscious of nothing.

Your write-up sounds like something you heard from a drunk motor park agbero.


Life no hard. I study what foolish people are doing and I dey avoid am.

By the time you become successful, you go know how important your time is. You go dey avoid unnecessary headache and waste of time.

2 Likes

Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by FRANCISTOWN: 5:03pm On Apr 14
Apus:
Yahoo boys thread...
I'm outa here.
I'm a successful business man.
I dey teach you how to live life.

1 Like

Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by Sapasenator: 5:03pm On Apr 14
FRANCISTOWN:
This life no hard at all. But some of you just wan kill yourself.

One of my philosophies of life is; if money can solve a problem, just use money.
But some of you are too stubborn, you always wan dey use coconut head.

Police stop your vehicle for road and you wan dey speak English. Baba just find them #2k make everybody dey alright. Police is happy and you are happy too. Everywhere good.

You failed tests and e dey possible make you get carry over. If you get money, just package something huge give your lecturer. The lecturer is happy, you are happy. Everyone is happy. You no go need dey over read.

If person reason you parallel for this street. No dey there dey blakata, if you get money. Buy dose for men make them assembuliaz. Men dey happy, you self dey happy.

If person run you street, no too caprisune. Enter zanga, call area boys make them wipe him slate clean. Everywhere good, area boys go hallelu eledumare, you sef go jollof. Everyone go happy.

Naija girls love money, if you get money. No dey talk too much. I no fit get money make one chikala come dey reason me foolishness.
"Fine girl how far, I hol' block". Normally, she go follow you if she don see the rabas and if you don pipe am, make you follow from window throway her.
Na mumu dey game woman.

If you go bank and person full your front. Go follow the security reason, give am like 5bay make him use am dey see front. The guy go happy, you sef go happy.

If you get boss wey no too like you like that. You just package better wine drop am for him table like 2times. Your boss is happy, you are happy too.

If you geh colleague wey no too dey feel you. Carry am go chop lunch twice make everywhere good.

If you go cause wahala, and the person come wan use police carry you. Normal, if you no get police connect. Jus find the person. Gee am dough, make everybody dey alright. If police carry you lasan. Mosquitoes go first chop your papa life for station.

If you bash person car and you been break him light. Before the person go begin speak English. If you hold your side, just ask the person how much for the light , pay am make everywhere good. The person dey happy, you too go dey happy, nobody go dey pour spit for your head.

If you geh broskies wey you never see for a while, and you be wan see am. Just holla at. Tell am make him paste aza. Biza am make him feel the weight. As he dey hear alert, na him go dey apologize say him no dey check up on you.

If you go interview and you see say ena plenty. Follow the HR head reason. Bargain with am how much you go dey give am for the first 6months just as appreciation ni o. The HR is happy, you self dey happy.

I once introduced a mechanic to one of my homies back in the days. After the repair, the guy talk say the mechanic wey I introduce am to don spoil something for hin engine. Haaa! I call the guy, the guy say the thing don almost wan spoil before but na for him hand e spoil finish.
I call the guy, tell am as the matter be. The guy tell me say normal normal say him mind no wan follow the mechanic work but as per say na me introduce am.
I no too reason am. I call the mechanic guy, I tell am make him buy that thing wey him spoil from ebuka, i wire am the money. E carry am go replace am for the guy car. The guy dey happy, the mechanic dey happy and I dey happy too. Nobody go dey reason me foolishness.

The bottom line be say. Money get power die. But if you no sabi use am. You are weak.

You go be my twin brother for real life that's why I dey always enjoy Nigeria when I dey around.

For hospital, anytime I enter, I look for the best doctor around , give am fat envelope with promises of more to come if they take very good care of my family members. This is excluding the hospital fee.

At MMA, I have personal accounts numbers of Immigration officers anytime I dey pass.

I nor dey queue or delay or speak big grammar and I get first class service anytime in Nigeria.

You go speak big grammar until Nigerian doctors go kill your family members.

Once we dey wait for passport office, I just sighted one big oga, walked up to him, introduced myself and give am envelope.
I was at the front of the queue instantly and got an expedited attention.

I love Nigeria die I swear.

My philosophy in life is that money has no intrinsic value in itself other than the comfort and benefits it can get you.

1 Like

Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by FRANCISTOWN: 5:03pm On Apr 14
LordofNaija:

Otedola despite being very wealthy, has an autistic child. Money nah comma nah God dey put fullstop
Any problem wey money no fit solve no get solution.
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by tochez24(m): 5:03pm On Apr 14
FRANCISTOWN:

The guy never touch block, no mind am.

I swear πŸ™ˆ

A broke person go think say him dey aliveπŸ˜†

1 Like

Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by FRANCISTOWN: 5:05pm On Apr 14
Tonnyray:
I'd have said you'll learn but people like you never really get to experience wealth in the real sense of it so go on with your delusions.
Lol... Okay. You never see anything. Go collect AC for body first.
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by FRANCISTOWN: 5:08pm On Apr 14
ayjay45:
What if you don't have money @FRANCISTOWN
Chai! I reject it.

But normal, if person no get money . The person gats dey with him wisdom. Know men wey strong and get plenty craze for head.
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by Uchenna10(m): 5:13pm On Apr 14
Mikuni:
"Fine girl how far, I hol' block". Normally, she go follow you if she don see the rabas and if you don pipe am, make you follow from window throway her.
Na mumu dey game woman. grin

Lol,na alpha males de say make we play games na
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by ayjay45: 5:15pm On Apr 14
FRANCISTOWN:

Chai! I reject it.

But normal, if person no get money . The person gats dey with him wisdom. Know men wey strong and get plenty craze for head.
I'm not saying you as in yourself.

What do you mean by know men wey strong and get plenty craze for head?
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by Sapasenator: 5:15pm On Apr 14
ayjay45:
What if you don't have money @FRANCISTOWN

Join the queue my friend or use agidi or be used as an experiment by Nigeran doctors and hospitals.
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by FRANCISTOWN: 5:19pm On Apr 14
Sapasenator:


You go be my twin brother for real life that's why I dey always enjoy Nigeria when I dey around.

For hospital, anytime I enter, I look for the best doctor around , give am fat envelope with promises of more to come if they take very good care of my family members. This is excluding the hospital fee.

At MMA, I have personal accounts numbers of Immigration officers anytime I dey pass.

I nor dey queue or delay or speak big grammar and I get first class service anytime in Nigeria.

You go speak big grammar until Nigerian doctors go kill your family members.


Once we dey wait for passport office, I just sighted one big oga, walked up to him, introduced myself and give am envelope.
I was at the front of the queue instantly and got an expedited attention.

I love Nigeria die I swear.

This thing wey you write sweet me die. How i go get money I go still come dey speak big grammar.
If money dey talk nobody dey check the grammar.

Lol! You sabi die. When I wan go my International passport that year. Them say na #15k, but normal normal people dey plenty for there.
I say "shey na me go come go queue".

The connect wey I get, I no wan make the person know say I wan run am.
I remember say I get one nigga for there. I ring the guy up, him say them don transfer am go another state. Him give me another person number.

I follow the guy reason, I pay am something nice and huge. The guy tell me make I come their office the following day. I go there, do everything, still tip the guy something.

Na the guy come deliver am to me by himself when e ready.

I no geh time to dey change napkin for hen pikin.
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by FRANCISTOWN: 5:21pm On Apr 14
tochez24:


I swear πŸ™ˆ

A broke person go think say him dey aliveπŸ˜†
πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by MONEY247: 5:23pm On Apr 14
But how we go take get the money....
I will do anything, anything to be financially stable..

πŸ™πŸ™πŸ™ Bros abeg show me the way
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by FRANCISTOWN: 5:25pm On Apr 14
Uchenna10:


Lol,na alpha males de say make we play games na
πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚. Toor, if I get money for hand why I go dey waste my time dey game person?


"Baby girl, hafa, I guide for my side gallantly. Let's go on a boat cruise"
If you dey with your wisdom and you fine join. Na now or never you go dey use women do

1 Like

Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by FRANCISTOWN: 5:26pm On Apr 14
ayjay45:
I'm not saying you as in yourself.

What do you mean by know men wey strong and get plenty craze for head?
Ha! I don talk my own. The rest is left to your street OT.
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by ayjay45: 5:31pm On Apr 14
Sapasenator:


Join the queue my friend or use agidi or be used as an experiment by Nigeran doctors and hospitals.

what is agidi
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by Sapasenator: 5:33pm On Apr 14
ayjay45:
what is agidi

Strong head/stubbornness

People wey nor get money get plenty strong head aka agidi
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by Badmashiii: 7:37pm On Apr 14
FRANCISTOWN:

You get am. Money na tool, na how you sabi handle am reach e go work for you reach.

True talk boss. That's why you i respect tinubu always. Him use money take achieve presidency.

Dangote follow too. The man use him money secure government connections come establish monopoly.
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by Dizzyyish: 8:00pm On Apr 14
...
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by Silentgroper(m): 9:02pm On Apr 14
MONEY247:
But how we go take get the money....
I will do anything, anything to be financially stable..

πŸ™πŸ™πŸ™ Bros abeg show me the way
I sabi pesin weeks dey find boys wey go transport food go Poland . You go do??

By food, I don't mean actual food. I no wan too cast the package.
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by ayjay45: 9:03pm On Apr 14
Silentgroper:
I sabi pesin weeks dey find boys wey go transport food go Poland . You go do??

By food, I don't mean actual food. I no wan too cast the package.
yes I go do bro.
I want to learn the drug business. I'm very interested pls help me
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by Silentgroper(m): 9:06pm On Apr 14
ayjay45:
yes I go do bro.
I want to learn the drug business. I'm very interested pls help me
you get passport??
Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by Sapasenator: 9:06pm On Apr 14
Badmashiii:


True talk boss. That's why you i respect tinubu always. Him use money take achieve presidency.

Dangote follow too. The man use him money secure government connections come establish monopoly.

I have maximum respect for Tinubu and Dangote.

They went for their dreams irrespective of the cost. Tinubu realized Buhari was his only shot to presidency and irrespective of what it would cost Nigerians and he went for it.

Always use what you have to get what you want is my mantra and treat every interactions and relationships as a transaction with you always gaining. Nothing personal.

1 Like

Re: Na You Just Wan Kill Yourself. by ayjay45: 9:07pm On Apr 14
Silentgroper:
you get passport??
I have international passport. Yes

But I've never used it to travel before

(1) (2) (3) (Reply)

What! In Love With A Cripple From Nairaland / Why Would A Married Man Or Woman Not Wear His Or Her Ring In Public? / would you do likewise?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 56
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.