₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,329,949 members, 8,443,139 topics. Date: Saturday, 11 July 2026 at 09:32 AM

Toggle theme

Funny Pidgin Proverbs - Culture - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralCultureFunny Pidgin Proverbs (67247 Views)

1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 ... 12 Reply (Go Down)

Funny Pidgin Proverbs by stillme(op): 2:28pm On Jun 26, 2012
Here is mine;
Person wey go shop frog make im ku ku ma shop the one wey get egg for belle.
Lol
Re: Funny Pidgin Proverbs by Tsmooth1(m): 2:30pm On Jun 26, 2012
Pikin weh talk say him papa no go sleep, him sef no go sleep. lols
Re: Funny Pidgin Proverbs by cindyrella(f): 2:44pm On Jun 26, 2012
Persin wey no get money go say small stout dey bitter..
Re: Funny Pidgin Proverbs by stillme(op): 3:08pm On Jun 26, 2012
Man wey carry Ogbono soup pot for hand,and di man wey carry fufu for head,na who go find who go?
Re: Funny Pidgin Proverbs by cindyrella(f): 4:00pm On Jun 26, 2012
Wetin concern agbero with overload?
Re: Funny Pidgin Proverbs by cindyrella(f):
Na when soldier slap you, you go sabi say police na your friend!
Re: Funny Pidgin Proverbs by Nobody: 4:12pm On Jun 26, 2012
walker walker pikin, go cool down when e carry bele
Re: Funny Pidgin Proverbs by stillme(op): 6:57pm On Jun 26, 2012
Chop alone die alone
Re: Funny Pidgin Proverbs by Lagusta(m): 9:51pm On Jun 26, 2012
Na co-operation dey mak rice full for pot.
Re: Funny Pidgin Proverbs by stillme(op): 7:39am On Jun 27, 2012
Person wey madman don bite before if im see mechanic he go take off
Re: Funny Pidgin Proverbs by Talking(m): 9:12am On Jun 27, 2012
--Na condition make crayfish bend... grin grin grin
--Ear wey no dey hear word, go follow head fall for ground when dem cut am cheesy cheesy
--Na person wey shit and hin no clean nyansh fly dey follow pass grin grin
Re: Funny Pidgin Proverbs by stillme(op): 11:12am On Jun 27, 2012
Anybody wey do exam must get result. Either pass or fail.
Re: Funny Pidgin Proverbs by Nobody: 11:27am On Jun 27, 2012
Any joke wey stillme post must dey dry, drier or driest!
Re: Funny Pidgin Proverbs by stillme(op): 11:51am On Jun 27, 2012
[quote author=MOGUL.O]Any joke wey stillme post must dey dry, drier or driest![/quote]which kin' pikin be this o,ponmo u no chop,fish u no chop,u say na beef u won chop.
Re: Funny Pidgin Proverbs by bashydemy(m): 12:04pm On Jun 27, 2012
fly wey greedy na him dey follow corpse enter ground
Re: Funny Pidgin Proverbs by gulfer: 12:58pm On Jun 27, 2012
Na when rain stop ma hin person wey carry umblella dey know say na load hin carry.....
Re: Funny Pidgin Proverbs by bashydemy(m): 3:33pm On Jun 27, 2012
one day person wey die and person wey lost go see thereself face to face
Re: Funny Pidgin Proverbs by Kslib(m): 3:46pm On Jun 27, 2012
E don tey wey nyash dey back!!!!!
Re: Funny Pidgin Proverbs by courage89(m): 8:18pm On Jun 27, 2012
No be where ground dey man tey dey argue fight
Re: Funny Pidgin Proverbs by Idowuogbo(f): 8:24pm On Jun 27, 2012
It dey ur body u carry am for back and it dey follow u waka
Re: Funny Pidgin Proverbs by stpat1(m): 12:46am On Jun 28, 2012
Goat wey follow Dog waka go chop shit
which kind friendship dog dey do with Lion?
Re: Funny Pidgin Proverbs by bashydemy(m): 9:51am On Jun 28, 2012
if dem dey share dog laps he no fit reach Iman
Re: Funny Pidgin Proverbs by Nobody: 10:27am On Jun 28, 2012
e don tey wey yansh dey get centre parting for back.
Re: Funny Pidgin Proverbs by damilola15: 12:59pm On Jun 28, 2012
Character be like belle, una no fit hide am forever.
Re: Funny Pidgin Proverbs by Nobody: 1:03pm On Jun 28, 2012
booqee: e don tey wey my yansh dey get centre parting for back.
Must you tell us?
Re: Funny Pidgin Proverbs by misteri: 1:18pm On Jun 28, 2012
Na small shit na dey sink big hole.
Re: Funny Pidgin Proverbs by Nobody: 1:36pm On Jun 28, 2012
[quote author=MOGUL.O]Must you tell us?[/quote]you have a big problem. Just make sure u take ur drugs today.
[s]buh d way u modified my post actually made me laff tongue embarassed silly![/s]
Re: Funny Pidgin Proverbs by AAlozie(m): 5:08pm On Jun 28, 2012
If you wan see ancestral spirit, look booqee for face!
Re: Funny Pidgin Proverbs by Nasri100(m): 6:15pm On Jun 28, 2012
Dem noe dey tell Blind man sey Rain dey fall **coughs**
Re: Funny Pidgin Proverbs by denitro(m): 6:15pm On Jun 28, 2012
Because Lion say him stop dey chop meat mean say u go put your hand for him mouth
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 ... 12 Reply

Nigeria Pidgin Proverbs & Their MeaningsSome Nigerian Proverbs – In PIDGINIgbos come show your proverbs skills234

Top Igbo Gospel Band In Between 1980s And Early 90'sOoni Ogunwusi And Wife At Lagos Airport On Their Way To The US, Caused A SceneOoni Of Ife Recreates Photo Of 4th Ooni Who Was Transformed Into A Deity