₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,329,376 members, 8,440,313 topics. Date: Monday, 06 July 2026 at 06:48 PM

Toggle theme

Funny Pidgin Proverbs - Culture (5) - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralCultureFunny Pidgin Proverbs (67171 Views)

1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 ... 12 Reply (Go Down)

Re: Funny Pidgin Proverbs by Ekpekus(m): 7:35pm On Jun 28, 2012
Dem nor dey tell crase man say war don start o.
I nor fit fear mellu, fear he s*it too o.
Threaten na water, action na blood.
Person wen do cutlass jass nor dey use bro*kus test am o.
I nor gree, I nor gree dey tear trouser o.
Dn nor dey use ur own near fire b4 u dey shout o
Re: Funny Pidgin Proverbs by Nobody: 7:36pm On Jun 28, 2012
Time na money
Re: Funny Pidgin Proverbs by switkaka(f): 7:39pm On Jun 28, 2012
person no dey stream soap enter him eyes, person no dey first him papa born 1st son
Re: Funny Pidgin Proverbs by nastydamus(m): 7:39pm On Jun 28, 2012
No be first to go river sabi swim grin
Re: Funny Pidgin Proverbs by Tinax(f): 7:41pm On Jun 28, 2012
person whe borow cloth go party no de dance too much.
Abeg make u no take ur rege spoil my blus
Person no de gree say him mama soup no sweet
Re: Funny Pidgin Proverbs by AAAdam(m): 7:41pm On Jun 28, 2012
vinblastin: Toto water small, but e reach prik take baff
Wetin U go say? wen u see granut grow on top of toto.
Re: Funny Pidgin Proverbs by slimyem: 7:42pm On Jun 28, 2012
Imanuelle: Whether nyash face east or west... Na still back e dey...





Money for hand....Back for ground..... Slimyem's favorite.
huh huh
Re: Funny Pidgin Proverbs by Ekpekus(m): 7:44pm On Jun 28, 2012
I nor fit stay near river dey use spit wash eye o
Man nor die, man nor rotten.
Instead of food to waste, make belle tear.
Re: Funny Pidgin Proverbs by tiebe: 7:44pm On Jun 28, 2012
who say make my water no boil, kettle no go de im house

inside who pound yam and who chop am, na who pound am no de forget

if shame catch mouth, hunger go catch belle
Re: Funny Pidgin Proverbs by kcreal(f): 7:45pm On Jun 28, 2012
Anywhere small pekin the cry the point hand, if him mama no dey there, him papa go dey there.
Re: Funny Pidgin Proverbs by no1madman(m): 7:45pm On Jun 28, 2012
Man weh get one shoe,na him dey do bad pass. . .
Re: Funny Pidgin Proverbs by Tinax(f): 7:46pm On Jun 28, 2012
leg whe de do kurukere waka, eyes whe de do kurukere de see am.
Re: Funny Pidgin Proverbs by no1madman(m): 7:46pm On Jun 28, 2012
Toto weh no dey wet,go hear weeee when show start. . .
Re: Funny Pidgin Proverbs by babeface3: 7:49pm On Jun 28, 2012
Good soup na money kill am grin
Re: Funny Pidgin Proverbs by Nobody: 7:49pm On Jun 28, 2012
vinblastin: Toto water small, but e reach prik take baff
hahahahahahaha...I don die oooooooooooo
Re: Funny Pidgin Proverbs by NaMe4: 7:49pm On Jun 28, 2012
The pesin wey sh.it for ground fit forget, but the pesin wey pack the sh.it no go ever forget.
Re: Funny Pidgin Proverbs by omalicha89: 7:50pm On Jun 28, 2012
Old woman never see race na hin dey make her hold breast run.
Better babalawo no dey get signboard na hin work dey advertise.
Re: Funny Pidgin Proverbs by Nobody: 7:52pm On Jun 28, 2012
Na poor man de call hummer lorry
Re: Funny Pidgin Proverbs by jamace(m): 7:52pm On Jun 28, 2012
Goat wey go attend lion party no go return in peace.
Re: Funny Pidgin Proverbs by AAAdam(m): 7:52pm On Jun 28, 2012
Wetin be dis yansh don die leave rafa?
Re: Funny Pidgin Proverbs by NaMe4: 7:54pm On Jun 28, 2012
Woman wey never see problem... Na im dey still hold breast run.
Re: Funny Pidgin Proverbs by HonSuQMaDIQ(m): 7:54pm On Jun 28, 2012
Na i-too-sharp make fa-rogue hide ote'dollar bribe inside cap
Re: Funny Pidgin Proverbs by Nobody: 7:55pm On Jun 28, 2012
Wetin cockroach de find for lizard meeting
Re: Funny Pidgin Proverbs by Dozieson(m): 7:56pm On Jun 28, 2012
who first buy motor na him get old model
Re: Funny Pidgin Proverbs by Tinax(f): 7:56pm On Jun 28, 2012
when pikin wash hand well,him go follow elders shop food
Re: Funny Pidgin Proverbs by NaMe4: 7:56pm On Jun 28, 2012
Khaki no be leather
Re: Funny Pidgin Proverbs by NonsoChris(m): 7:57pm On Jun 28, 2012
The death weh go kill small pikin dog no dey let am smell shit.
Re: Funny Pidgin Proverbs by HonSuQMaDIQ(m): 7:57pm On Jun 28, 2012
Man wey im wife no sabi blow grammar go know wetin im do im self wen dem make am president
Re: Funny Pidgin Proverbs by Och77(m): 7:58pm On Jun 28, 2012
E go soon land, e go soon land na him butter fly take dey enter bush
Re: Funny Pidgin Proverbs by chipet(m): 7:58pm On Jun 28, 2012
Pikin wey no hear 12 go hear 13!

Person wey go milipid burial go come back with ring wey full em hand.

Person wey no her BE CAREFUL go hear HOW MANAGE! Lwkmd!!!

Odechi no be for Boko Haram!

Them no de tell deaf man say war dey

One day monkey go go market, e no go return!
Re: Funny Pidgin Proverbs by bulkwide: 7:58pm On Jun 28, 2012
Belle no be show glass,₪å only U̶̲̥̅̊ sabi wetin U̶̲̥̅̊ eat.
Re: Funny Pidgin Proverbs by HonSuQMaDIQ(m): 7:59pm On Jun 28, 2012
Obj wowo but im mama like am
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 ... 12 Reply

Nigeria Pidgin Proverbs & Their MeaningsSome Nigerian Proverbs – In PIDGINIgbos come show your proverbs skills234

Top Igbo Gospel Band In Between 1980s And Early 90'sImo State Mandatory Bride Prize ListOoni Ogunwusi And Wife At Lagos Airport On Their Way To The US, Caused A Scene