₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,330,564 members, 8,446,062 topics. Date: Thursday, 16 July 2026 at 02:37 AM

Toggle theme

Funny Pidgin Proverbs - Culture (2) - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralCultureFunny Pidgin Proverbs (67260 Views)

1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 ... 12 Reply (Go Down)

Re: Funny Pidgin Proverbs by denitro(m): 6:16pm On Jun 28, 2012
Thief wey jump fence enter house where owner dey wait for am, no go jump again
Re: Funny Pidgin Proverbs by switkaka(f): 6:17pm On Jun 28, 2012
good food na money kill am. Rat wey follow lizard enter rain na later e go hear am
Re: Funny Pidgin Proverbs by vinblastin: 6:18pm On Jun 28, 2012
Toto water small, but e reach prik take baff
Re: Funny Pidgin Proverbs by switkaka(f): 6:18pm On Jun 28, 2012
they no dey tel tortoise say race don start
Re: Funny Pidgin Proverbs by godzwilla: 6:19pm On Jun 28, 2012
Na happiness dey make prick stand!
Re: Funny Pidgin Proverbs by switkaka(f): 6:19pm On Jun 28, 2012
small pikin wey dey carry 4 back no know say d journey far
Re: Funny Pidgin Proverbs by Divine3: 6:22pm On Jun 28, 2012
Every malam with e own kettle
Re: Funny Pidgin Proverbs by NaMe4: 6:23pm On Jun 28, 2012
I no come look Uche face.
Re: Funny Pidgin Proverbs by chally02(m): 6:25pm On Jun 28, 2012
HIM WEY READ NA HIM SERIOUS , BUT HIM WEY PASS NA HIM KNOW BOOK...
Re: Funny Pidgin Proverbs by hbrednic: 6:27pm On Jun 28, 2012
yawaa don gas,who know no go know tongue
Re: Funny Pidgin Proverbs by Sijo01(f): 6:27pm On Jun 28, 2012
One day, one day monkey go go market e nor go come back.


Person wey dey cry dey c road.
Re: Funny Pidgin Proverbs by Amtired: 6:27pm On Jun 28, 2012
NAA YOU FAINT, NAA YOU POUR YOURSELF WATER..
Re: Funny Pidgin Proverbs by xrazzy(m): 6:28pm On Jun 28, 2012
vinblastin: Toto water small, but e reach prik take baff
Hakane Walahi!
Re: Funny Pidgin Proverbs by elgrant(m): 6:30pm On Jun 28, 2012
Wen breeze blow fowl yash go open
Re: Funny Pidgin Proverbs by Babewensabi: 6:31pm On Jun 28, 2012
I no see trailer not to talk of the driver
Re: Funny Pidgin Proverbs by NaMe4: 6:32pm On Jun 28, 2012
Ehen? So make I comot nyash begin cry?
Re: Funny Pidgin Proverbs by Amtired: 6:32pm On Jun 28, 2012
BREEZE WEY BLOW, DON OPEN FOWL YANSH..
Re: Funny Pidgin Proverbs by unipol(m): 6:33pm On Jun 28, 2012
when two elephand dey fight na the land na e dey sufer.
Re: Funny Pidgin Proverbs by unipol(m): 6:34pm On Jun 28, 2012
the problem wey i pikin dey hide for i pappa, na i pappa sabi the solution.
Re: Funny Pidgin Proverbs by eastman11: 6:34pm On Jun 28, 2012
Pen.nis se no give am sweet tin because e no de hard am to vomit
Re: Funny Pidgin Proverbs by Goldenheart(m): 6:35pm On Jun 28, 2012
No be u go tel me say na fish dey inside sandiene...........'made dat up jux nw'
Re: Funny Pidgin Proverbs by othenok(f): 6:35pm On Jun 28, 2012
Better soup na money kill am.
Re: Funny Pidgin Proverbs by NaMe4: 6:36pm On Jun 28, 2012
Body no be firewood!
Re: Funny Pidgin Proverbs by spikesC(m): 6:37pm On Jun 28, 2012
monkey no fine, but him mama like am grin

Before u see monkey, monkey don see you
Re: Funny Pidgin Proverbs by okparadamian(f): 6:37pm On Jun 28, 2012
pesin wey no dey kpuur dey say make dey givam soup wey dey kpuur.
Re: Funny Pidgin Proverbs by awesomet1(m): 6:38pm On Jun 28, 2012
At all, at all naim bad.
Re: Funny Pidgin Proverbs by Lucy001(f): 6:38pm On Jun 28, 2012
Na where soft na him bear-bear dey enter!
Re: Funny Pidgin Proverbs by NaMe4: 6:39pm On Jun 28, 2012
If pesin too tay for toilet, im go forget say shit dey smell!
Re: Funny Pidgin Proverbs by Soglad(f): 6:41pm On Jun 28, 2012
Dem no dey tell blind man say salt no dey for food.
Re: Funny Pidgin Proverbs by Lucy001(f): 6:41pm On Jun 28, 2012
Personi wen he dey cry dey see road oh!
Re: Funny Pidgin Proverbs by Osejie(m): 6:41pm On Jun 28, 2012
*"Na the fire wood, u gather wen you small u tak dey make fire wen you old".

*"Who say my water non go boil, hin fire non go catch" .
Re: Funny Pidgin Proverbs by swizzle(m): 6:42pm On Jun 28, 2012
Na over-skill dey kill monkey
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 ... 12 Reply

Nigeria Pidgin Proverbs & Their MeaningsSome Nigerian Proverbs – In PIDGINIgbos come show your proverbs skills234

Top Igbo Gospel Band In Between 1980s And Early 90'sOoni Ogunwusi And Wife At Lagos Airport On Their Way To The US, Caused A SceneOoni Of Ife Recreates Photo Of 4th Ooni Who Was Transformed Into A Deity