Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,577 members, 7,816,425 topics. Date: Friday, 03 May 2024 at 11:04 AM

Funny Pidgin Proverbs - Culture (7) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Funny Pidgin Proverbs (62666 Views)

Nigeria Pidgin Proverbs & Their Meanings / Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN / Igbos come show your proverbs skills (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (12) (Reply) (Go Down)

Re: Funny Pidgin Proverbs by Nobody: 8:33pm On Jun 28, 2012
fluid26:

shocked lawd hav merssi! grin grin

U go like miss d class?
Re: Funny Pidgin Proverbs by Otutu1(m): 8:39pm On Jun 28, 2012
Cunning man die cunning man bury am
Re: Funny Pidgin Proverbs by kennethromanus: 8:40pm On Jun 28, 2012
na wen wall divide 2..na him lizard dey enter.
Na 4rm mess dem dey take no poo wey go sweet.
Leg wey dey waka,.eye wey dey waka dey c am.
Foul wey get strong dey end up 4 grandmama pot of soup.
water and basket no b mate.
Re: Funny Pidgin Proverbs by Nobody: 8:41pm On Jun 28, 2012
Imanuelle:

U go like miss d class?

for wetin na? Hehehehe...grin grin
Re: Funny Pidgin Proverbs by kcreal(f): 8:41pm On Jun 28, 2012
Trouble dey sleep inyanga go wake am.
Re: Funny Pidgin Proverbs by Nobody: 8:46pm On Jun 28, 2012
A Bird,"if una dey pursue any animal, abegi gv am proper name o, I get chest pain, i no fit run till death."
Re: Funny Pidgin Proverbs by jamace(m): 8:52pm On Jun 28, 2012
Play play na im dog take bite im pikin.
Re: Funny Pidgin Proverbs by deolu2000(m): 8:52pm On Jun 28, 2012
Pikin wey say him mama no fine they use style call him papa blind man.

1 Like

Re: Funny Pidgin Proverbs by kenny987(f): 8:52pm On Jun 28, 2012
No take ur reggae spoil my blues.
Dem no dey drink panadol 4 anoda person headache.
Dirty no dey kill African man
.
Who go gree say him mama soup no sweet?
Dey dia make pant wear u!
Re: Funny Pidgin Proverbs by kcreal(f): 8:55pm On Jun 28, 2012
Eagle petch, Dove petch anyone wey say the other no go petch make him feathers scatter.
Re: Funny Pidgin Proverbs by kennethromanus: 9:00pm On Jun 28, 2012
dem say pikin wey him mama dey sell daddawa(one smelly locally made maggi)na him dey knw fly wey get 1 eye.

1 Like

Re: Funny Pidgin Proverbs by NaMe4: 9:00pm On Jun 28, 2012
As.hawo no be work.
Re: Funny Pidgin Proverbs by Nobody: 9:01pm On Jun 28, 2012
Na the woman wen carry belle be ashawo!!
Re: Funny Pidgin Proverbs by tintingz(m): 9:01pm On Jun 28, 2012
If u do me, i go do u, man no go vex
Re: Funny Pidgin Proverbs by since1914(m): 9:10pm On Jun 28, 2012
"Person whey wan peel roasted yam for blind man, make him dey whistle if not, the blind man go call am thief"

"mad man say nothing dey do am, but na the thing whey him dey do naim e no know"

"na cricket naim tell him children say no matter how ground strong, them no go sleep outside"

1 Like

Re: Funny Pidgin Proverbs by kcreal(f): 9:15pm On Jun 28, 2012
Man must waak.
Re: Funny Pidgin Proverbs by Sattors(m): 9:18pm On Jun 28, 2012
Small pikin wen go carry big big teeth, na hin no wea hin go see big big lips take cover dem

1 Like

Re: Funny Pidgin Proverbs by Nobody: 9:21pm On Jun 28, 2012
since_1914: "Person whey wan peel roasted yam for blind man, make him dey whistle if not, the blind man go call am thief.
lmao, i can't help laffin..
Re: Funny Pidgin Proverbs by Larrylarex(m): 9:22pm On Jun 28, 2012
Persin wey no get money for meat go dey call hin self vegetarian
Na when rain fall, okada owner go no say hin no be big man
Re: Funny Pidgin Proverbs by Ovems(f): 9:27pm On Jun 28, 2012
cockroach wen jam fowl, jam badluck.

1 Like

Re: Funny Pidgin Proverbs by tlops(m): 9:28pm On Jun 28, 2012
wayo man die wayo man bury am!

Na over experience na im dey kill monkey,

one day monkey go go market no go return!

do me I do you God no dey vex.

Everybody na thief, the person wey dem catch na 'barawo'

Yam pepper scatter scatter. (Isu ata yan n yan)
Re: Funny Pidgin Proverbs by Hardeyorlah(f): 9:31pm On Jun 28, 2012
i no fit call cow broda because i wan chop beef
Re: Funny Pidgin Proverbs by Idowuogbo(f): 9:32pm On Jun 28, 2012
fluid26: wetin concern cindyrella with underwear? undecided
wetin concern ijebabe with husband? undecided
Werey! grin
Re: Funny Pidgin Proverbs by Clemzy16(m): 9:33pm On Jun 28, 2012
Who no go nor know.
Re: Funny Pidgin Proverbs by Ovems(f): 9:34pm On Jun 28, 2012
shoe get size, okrika get quality.
Woman be like mango tree wen dem plant for centre of road, anybody wen pass, na im dey pluck am.
Re: Funny Pidgin Proverbs by StepG: 9:37pm On Jun 28, 2012
cindyrella: Na when soldier slap you, you go sabi say police na your friend!
Re: Funny Pidgin Proverbs by Hychineson(m): 9:38pm On Jun 28, 2012
Lucy001: Soap wen sweet na money na him kill am...
soap

1 Like

Re: Funny Pidgin Proverbs by darella(m): 9:43pm On Jun 28, 2012
BenJohnson better pass statement o, i no follow i no follow na after bail
Re: Funny Pidgin Proverbs by Nobody: 9:44pm On Jun 28, 2012
Idowuogbo:
Werey! grin

Iwono! grin
Re: Funny Pidgin Proverbs by Adeks(m): 9:48pm On Jun 28, 2012
Pot wey go chop pepper, im yansh go hot
Re: Funny Pidgin Proverbs by komek(m): 9:49pm On Jun 28, 2012
back tyre no fit pursue front tyre meet. 2. No mata d weight of an elephant,e no fit cause earthquake.
3. Monkey no dey smart for desert. 4. Who no go, no no.

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (12) (Reply)

Eredo, Ijebu - The World's Largest Man-made Structure / Imo State Mandatory Bride Prize List / In The 1930s, Igbo Men In Elaborate Hairstyles And Body Paint

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 17
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.