Brownlord's Posts
Nairaland Forum › Brownlord's Profile › Brownlord's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 110 111 112 113 114 115 116 117 118 (of 173 pages)
And when i lost my papa, not even one sinator sorry senator flash me let alone come visit me. |
RedBenson: Op, pls can undergraduate apply?Yes you can apply wit ur 1.0 CGPA, olodo shebi dem fence ur eye, if u cld not read and understand ths, I wonder wht u doin in sch. |
E dey do me say, this range na male. I don use the female specie of am before for my former life Chai, I don die why peter waiste ink write PLEASE SAY YES. Em for just write ? God of abraham, Isaac and jacob, abeg if na butter won delay my bread, abeg just give me the bread like that, I go use groundnut and 7up chop am |
Sometimes I think our journalist never visited a higher institution let alone attending one, was there any need for this " Chairman of Gidan Boss Mechanics, Lawan Hassan, who reported the matter" in this report and his work place even made public? If it where to be a matter btw, goodluck and amechi, pdp, apc, the eye withness wld speak in annonymity but now, see as dem publish the guy name is it to protect him or expose him to danger? And tomorrow they want citizen to help the police with information to combat terror. What a joke |
imag5: chairman gudmorn u need to start ur HSE very important oh,well na British safety council na i register with, for coppers 80pounds i.e 20k for the level1,2,3 and u get extral certificate on fire safety and Risk assement from DPR,making it four certificate u receive after nysc na 100ktins so hurry while stock last lol,they are recognised internationally,INduction na 24th of august come register,engr and rig job full ph oh..they say when preparation meet oppurtunity sucess is sure.....umfImag and omni sparrow, greetings from ma shrine, i no sabi say ekp many like this for ths thread, anyway imag, what up with this HSE level now, i dey interested u fit give me clue hw i fit take run from OSUN, i bn dey in contact with one MITA HSE before, nor know if na the same with this ur British safety council, u know say nja man no dey use ear hear wetin don cousine obodo oyibo, abeg just giv me info make i know if na to port enter the british own...pleasant day yall niggas. |
I talk am say, this one wen al mustapha comout dey waka from place to place, em dey up to somtin, he's gone to meet with all the boko sponsor then, him come plan coup take remove our democratic elected leader shekau from power. Chai this is wicked. Make I sip small from my alomo go back to sleep. Never knw wetin I go chop today inside this my place of promiscous activity ( Nysc ) |
tired of this word TO, WILL, WANT infact am tired of the future impossible tense of this government |
booqee: For those of us, dat were posted to school, pls when is it advisable to travel back since school is still on vacation. For clearance and stuffs like dat??If you dint sign pv for the month before traveling, you need to go back and sign for the month, is better you confirm from old corpers in your LG, some may allow corper to also go on vacation since school is on holiday, while some you need tander for ur place of promiscuous activity ( PPA ) 24/7 |
enesty: Hello all,pls my name is eneye and am new to nairaland.am a batch b corp member currently serving in mararaba,pls I would love to get link to get a job in abuja or its environs to go about with my service bcox am very free in d skool I was posted to,I only report once a week so pls fwends I woud really appreciate if any can b of help.tanks.08069360257 is my no and fredblink2003@yahoo.com is my emaiABJ1111 na my pin be that, just ping me your CV, make i forward am go give to my uncle for ASO ROCK, you fit do PA to Good luck? |
olabisi76: Sorry for posting late am also posted to Osun and ma PPA is Ikirun anyone posted to Ikirun this is ma BB Pin 223563BEWelcome to my hood, did you just redeployed or you camped at ede? there is no PPA such as ikirun, ikirun is the name of a town in Ifelodun local govt. so go back to ur posting letter and check out well for your PPA. 28de31ee if you need any assistant |
ebamma: .since i joined nairaland inYou see your life ungrateful idiot, you no go thank the doctor when dey give you drugs when make say your madness come down |
I JUST DEY LAUGH, ALL THIS PEOPLE THINK SAY NA EVERYBODY WHEN WEAR FINE CLOTH E BRAIN CORRECT, THE PHOTOGRAPHER NOR KNOW SAY OMAWUMI FIRST SMOKE WEED WHEN SHE DEY SCHOOL FOR EKPOMA..LOL |
PapiDShipCapt: Oh ma God, mehn A.A.U was fun still. who nor come nor know mehn...Mehn, u don remind me, 47 megasea one mornin and one punch, u won't to weed? Igbenedion rm 1, 11 and 13 LOL, |
Omni_Sparrow: Na so. Wen I de see drinks lik megasea and sabrina, I know say na we de drink am for nfa. Confirmed ekpoma.LOL, NFA that year, tariwalters area 4 nko, dino, sam and sam. Omni sparrow, I greet u specially |
PapiDShipCapt: Boss so u want make e do show off go spend 1 yr expenses for the full service year for inside camp den em go come de drink garri with salt for the remaining 11 months 1 week abi? babane u r heartlessBoss I tire o, the way dem dey talk the flexing, meself feel say I no even do reach for my time, any 12c osun dey this thread make e confirm, the edo boy wen cast mami if u see any fair police woman for mami, na me she dey wit, nysc official and soldier, to the extent wen I enter camp during batch A and B passing out recently dem still remember my name wit face for mami, |
Omni_Sparrow: Come o...u go okada or ekpoma?U no see ekpoma blood for my signature Confirm ekp ( ekpoma kill people ) |
yellowpawpaw: It might not be juju tinz Efe.Python, it is @topic, chai for my state again, na wah o, reminds of one woman in my area then, snake normaly play around her house like pet and domestic animals, all her tenants need comply, wen u see a snake in ur room anywhere, just walk pass but they don't hot, the woman wld just bring out native chalk and pour on the ground the snake leak and go, she normally says they are her visitors, mami water tins, some people dey crase jor I rather kill myself than commint suicide |
Very sure waec is broke, else they won't be advertising for the collection of cert. May be the director tenure don expire and e won quick gather moni before em move. Abeg make dem relax, if them so dey in a hurry to dispatch am, make dem post am make we hear word |
k10: thats how the guy lost the visa lottery shaOmon, if na me I go just commit suicide, see me see obodo amelica I dey help the guy cry for here |
Which one be legally married again come take spoil my butter, if I be the guy na to just start to first dey bleep the girl first first to take ease tension before I go know what next to do Btw, marriage no dey hard, dem fit conduct this tin this early mornin, abeg make dem free dem jare |
Omni_Sparrow: I tell u. Was lucky to meet d awesomest guys and gals in camp. We casted dat mammy. Those soldiers go too miss dat our squad. Especially ishaku, emma, bassey. Even durin passin out, we down 5 elliot wit those soldiers for field. Soldiers will even drive us to town without exeat. Emma de leave car for us. My guy no jst de sleep camp. E de go sleep guest house for nite. Enuf memories.Wtf, elliot I don die so na elliot una dey drink and una dey make noise say una cast camp, what a shame, this one una admit here say na elliot una drink who know if no be sabrina and megasea una drink rest of the dayz. Any osun ede 12c in d houz to confirm my claims, I took macdowells once or twice in camp and that was the only gin left, I no drink anytn less than red label, If una spend anytn less than 100k each make una no come here say una cast camp again |
manneger2: See hw he even write d awkaU don take ur drugs this mornin? |
2014 the year to correct the error made by that stupid and useless people called britain. By 2014 we be 100 yrs 1. BY 2014, NIGERIA SHOULD NO LONGER LEGALLY EXIST 2. NIGERIA WILL BE BACK TO PRE-1914 STATUS OF TWO STATES OF SOUTHERN NIGERIA AND NORTHERN NIGERIA BOTH LEGALLY AND TECHNICALLY, ALTHOUGH THE RULING ELITES MAY IGNORE THIS REALITY EXCEPT THERE IS REVOLUTION FROM THE PEOPLE. 3. PEOPLE OF SOUTHERN AND NORTHER NIGERIA MUST COME TOGETHER TO ENTER A NEW AGREEMENT UNDER THEIR OWN TERMS. |
melojames: Enjoy your wealth. Hope it's not ill-gotten wealth because your offspring, grandchildren & family shall bear the curses abundantly if it is.Bros package, notin like curse, for this con3 we dey so, the reach they always progress and the poor just dey where dem dey, I never see any big man or politican wen curst follow em nor e children or na wen dem reach graave the curse go start? Just thank God for their life and move on, btw God I need this oyel money, weather na palm oil or groundnut oil provided say I be billonaire I no care how the wealth take come. |
sharp man: Three weeks and we are making noise?My friend shut up, hv u experienced 48 hours before? If true Jst learn to be appreciative or better still move on if u hv notin to say |
Zooposki: Meanwhile no light in lagos. Fashola, you see your life.Em dey give mad people 100k now, u better go cowlect ur own before e share am finish |
nicxguy: Non of u̶̲̥̅̊ is talking abt d bills 4 osha were ¶ de we dey get light wella bt d bill na gbam phcn bill dn de pass house rent ooooCome u well? U tink say to enjoy better life na moi moi, if you no fit cope just move ur tins go village make u let person hear word |
Omon, see matter, them dey test run, and light don dey 24/7 for 3 weeks, what abt wen the tin come begin work fully, that means hope go dey say like go dey 25 hours a day, 8 days a week, and 6 weeks in a month. Quietly brushing my mouth with a bottle of alomo ( kasapreko ) while parking my bag heading straight to akwa to charge my fone |
Am Confused |
I withdraw all my insult, the media is our biggest problem in this country |
Walks into thread with my plate of afaan soup and edikainko, screw thread cant find any akwa ibom corper thereby declare myself as the emergency CLO of akwa ibom corpers till they gain internet access to tell us their experience in their various |
13C UNA DEY VEX O, 400 PAGE NOW NOW, ANYWAY THE BIBLE SAY GREATER THINGS SHALL DEY DO, SO I DEY FEEL UNA |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 110 111 112 113 114 115 116 117 118 (of 173 pages)