₦airaland Forum

Welcome, Guest: Register • Login • With Google • Trending • Recent • New

Stats: 3,344,323 members, 8,511,225 topics. Date: Sunday, 01 November 2026 at 06:10 AM

Toggle theme

Eazilyfe's Posts

Nairaland Forum › Eazilyfe's Profile › Eazilyfe's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 10 11 12 13 14 15 16 17 (of 17 pages)

Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 10:44pm On Mar 21
capetownboyz:
This fuel price is taking a toll on the little profit margin and worst still low fare rate and over bearing riders looking for AC mostly from that cheap app called inDrive .. Spent 10k on fuel for a trip of 8500 and 6900 .. how much profit did i realize in such a wasteful
Adventure that took me almost 3 hours to complete .. this job sucks this season and hope it doesn’t go further than this cus for now I’m freaking tired of bursting my head through this Sun ☀️ and roads ..
As you just start, stick to Uber and dont take trips more than 3km pickups. Naso mesef dey do.

If u no sabi like experts or how to negotiate price with distance and traffic no shuck head for indrive.

If Uber see say dem underpay you for ur last trip dem go adjust your next trip to cover. Your waiting time(customer delay) are covered, if customer no gree pay you report and Uber will settle you... na professional & sane people be Uber riders na why we dey use 'ma' & 'sir' grin for each other. My Daily average NGN/KM today is N590/km. When i'm stucked i use Bolt comfort or Indrive
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 7:17am On Mar 21
Kumuyiii:
Indeed. The only thing that makes indrive price get better is traffic, it keeps these lowlifes occupied enough to cause a surge. No wonder these passengers no get respect for person, they be thinking na everybody be errand boy driver 🤦‍♂️
I use Uber mostly, by the time you complete 9-10 trips your average earnings is N550/km with 1230 per litre. Then you get 5K quest money to buy food. grin

For Indrive nobody dey gree set more than N371/km, if you see above na luck and dem dey quick chop am. Infact for long distance ride on indrive na N196/km those people dey set especially if its from Mainland to island and they know Indrive drivers wants to get ride to Island.

To me if Indrive Based and final price model no dey market, things would be better. Lets start from there

This thing no fit end soon because we need to first restructure the system
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 8:21pm On Mar 20
Jegheter:
Aahhhhhhhhh. Omo. There is hunger in d land. Men just dey pick useless trips haba. Drivers pls naw. Haaaaaaaa. 20km trip 5k mehn dey rush am....haaaaa

Indrive...indrive....indrive...haaaaaaa. like throwing meat in d midst of sharks shocked shocked

With all the useless prices today...drivers no even dey allow am land Dem don carry am.

God help us all
Lol, una go say Indrive good today, tomorrow una go say price don bad cheesy

Na Drivers spoil Indrive because of ridiculous price dem accept. If you no fit accept u go wait tire before you see quality ride.

I feel most drivers wey Bolt & Uber don block due to bad car or low driver score etc na hin full Indrive dey accept ridiculous prices because of pressure to meet target
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 12:02pm On Mar 20
Kumuyiii:
Drop from oyingbo Bridge, take left immediately you descend , straight down, you'll see a total fuel station by ur left , take right into the market... Ask questions tho, ask for the mechanic village
Thanks, i pass Adekunle side enter.

Na Willoughby street Adekunle
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 8:14am On Mar 20
Kumuyiii:
0803 822 2064... Tell am say you wan make Jackson work for you.... So make he call Jackson ahead.
My boss, pls best way to navigate this Oyigbo market from Yaba? Map dey tell me to pass 3rd mainland bridge.

I never go the market more than once, na Ladipo i sabi well

Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 8:11am On Mar 20
Jamie90:
Na juicy trip cause am. I don’t see a reason why a driver will be going to any suburb by midnight.

A driver said he hasn’t seen his friend who took a trip back to his base from VI to Awoyaya. It’s been 6 months, no car, no body seen.
Night trips abi? Nawa o huh

Anything 3pm i don dey set Navigation trips back to my area. I no dey find money pass my life
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 9:17pm On Mar 19
Jegheter:
So from ur calculations ur car is not working optimally for a 1.8L. it's doubling like I painted in the two scenarios. 10k making 20k now cause of the increment.

Ur 30k making 60k. Honestly this is about what my 2.5L makes me suing my AC on full blast. I don't think it's sustainable cause calculating depression and maintenance....

Yes u r making money but when the real wear and tear comes. It won't be sustainable. Just one major repair from bankruptcy grin

God no go shame us
I dey that Major repair phase now, na just fan stop to blow and e don affect Compressor and gear box. Upon say i don repair the fan today, i still get a lot to spend tomorrow huh huh
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 9:16pm On Mar 19
Jamie90:
Add 3500 to this amount and less 30k fuel. Is this in anyway sustainable?
To me sha sad, For this KM driven should be N85,000 above net income if Indrive don comot their share. N550 per km above

Fuel don cost
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 4:54pm On Mar 19
Kumuyiii:
0803 822 2064... Tell am say you wan make Jackson work for you.... So make he call Jackson ahead.
Thanks... Appreciate
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 3:37pm On Mar 19
Kumuyiii:
Omo
Boss abeg where you dey buy your compressors? My compressor get issue yesterday i havent fixed it huh

Abi which person for here say one market dey for Oyigbo to buy the compressor?
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 11:36am On Mar 19
Kumuyiii:
Omo
If you don clock am you go sabi say na Indrive be one of the issue. Although there are so many issues. Bolt & Uber are in competition with Indrive base price. The way my AC spoilt yesterday and it can spoil my Uber account e no be like dat for Indrive. Some cars dont have AC, all body dented and unpainted on Indrive. Indrive don low the standard of how a basic ehailing car should appear and that also reflects on the pricing.
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 2:51am On Mar 19
Kumuyiii:
Any. Money wey i no make for day, i no go see for night, na my principle be dat, this guy get luck say he get OT
Where this one take happen? Link?
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 3:58pm On Mar 18
Kumuyiii:
Pele , but i don't see the issue here.. Na 1 star he rate u?
Na 1 star he rate me with "mechanical issue" as preset comment. And we never move pass 1km when e tell me to end ride. Me i kuku collect the money uber say make e pay me N2600 for 1km. Good riddance tongue
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 3:57pm On Mar 18
Kumuyiii:
Tor.. They're not blind bro. Them no need protest to do the right thing, they just chose not to.... As fuel climb, same day, danfo, keke, bike, every body put money, na only us dey bonanza.
Like base price should be N800 per KM. Atleast N700 if dem wan pity riders, they would adjust as everybody sabi as e dey go with this economy
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 3:46pm On Mar 18
Reason i say no PITY riders sometimes... look at a Guy report me on Uber because my car developed AC issue at Phase 1, me wey dey like on AC for riders even when dem no ask. i just finished a comfort ride from surulere oo, wey i carry two NYSC ladies... I had to look for a ride back home, fortunately i met a nice guy who gave me 20K to quickly reach Airport so as not to miss his flight.

Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 8:01am On Mar 18
Kumuyiii:
Their sir no mean anything, it's not from their heart. Carry ur self with dignity, be kind... Throw away ma, or leave am for office workers.
grin oya na. I don hear you boss
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 9:59pm On Mar 17
Kumuyiii:
Make una no dey answer these women with 'ma'.... Ma as how? Na ur boss? Na una dey gas these fooles up wey dem dey carry their werey come meet me, expecting me to ma them, people wey no fit look my face if no be uber platform... The other day, I saw an elder man answering one small girl ma, wetin dey worry una? Na only man you suppose dey address with such respect, cus na only men no go take am for granted. Address women by their name!! Stop the rubbish ma!! 😡😡😡
Lol, Ma no mean say you stoop low... some riders especially female say "sir sir" i do feel uncomfortable too... person wey use ma for u this minute fit change am for you next minute. Whatever way you feel okay to address riders while communicating shouldnt be a general standard applied to everyone.
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 5:12pm On Mar 17
ebiye55:
Ewoooo, how you take get your rider WhatsApp number? Omooor u try o

But you know say if na Uber be dis, she fit use this chat report you & na instant blocking

But this is the main sh*t why I dread Indrive. E dey mess with my head 😐

The other day, I pick up an item from phase 1 going towards Ilasan, the trip of <25mins turn almost 40 mins. The trip fare more than doubled 😎. Na me come dey pity the lady wey get parcel
Bro dont pity riders, 99% wont pity you if your vehicle breaks down or get arrested by law enforcement. its business as usual for them.

I carried someone to Lagos island, Lastma later harassed me dem come down dey go. But the woman called back to ask abt my wellness. I later reported to Uber to adjust the price for me

Another one recently, those girls order ride on Uber frm Gym dey go Ologolo because of traffic on Express dem say make i pass Coastal road, i say okay ma, we no con quick see turning she con dey complain asif i opt for coastal road. Na so bill fly from 3K to N12,500 she say na N7000 dey her hand. I say pay let me go, she begged not to report but i later reported to Uber and Uber paid me the remaining money. In her next ride she will pay that balance

Even waiting time or Cancellation, uber will charge riders later if dem think say dem wise. So the lady might be paying for a sin she committed before

One lady too paid huge after i dropped her, she just dey vex but when i see description i know say na because she dont commit either TIME WASTING, INCOMPLETE PAYMENT make her bills high grin

But i cant explain to them e go touch nerves or cause quarrel tongue
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 6:59am On Mar 17
Kumuyiii:
See eh, if say no be heat wey dey worry during day time, I no mind pick only 3- 5 extremely good rides a day... Park motor dey study or stream movie, if i see wetin worth am, i start motor... The only time you fit catch me dey take rubbish trip na vi, just to go back to base, cus that vi, you'll never find good trip there, no matter how long you wait.
You no fit on AC grin while waiting for better trips or find one tree park under for Phase 1?
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 8:18pm On Mar 16
Pearl1910:
A State of Emergency should be declared.
Ones fuel money is begining to be more than your take home profit, then it's no longer a good business.

I only fear one day strike will not really cut it. Plus it was not properly planned and communicated in advance. The publicity is very poor and many drivers aren't aware of the strike so it will not be effective.
Mass action should follow like protests to Uber and Bolt offices, if Indrive refuses to have an office then the app should be shut down by the govt. Everybody must be dragged to a round table and a fare pricing system must be out in place.
The better way is Indrive, Bolt, Uber office protests. This unanimous protest wont work becos there is no proper communication
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 8:15pm On Mar 16
capetownboyz:
This conversation lol .. mehn today was hectic got trapped inside Lagos airport ,vehicle decided to go dead(refuse to start after topping fuel ) due to running out of fuel which I was unaware of due to bad a fuel gauge reader that I have been managing..coughed 15k ,mech plus car park trying to solve this issue..well today wasn’t it at all ..never been this stressed lol ..This job don test me in so may ways I never imagined ..Soft bobo like me 😑 need to tap out of this current reality until then,I’m humble and looking forward to a better life .
One of the reason person no need to dey buy small small fuel for car if na personal motor. E good make fuel pump dey swim inside fuel well because of the impurities down the tank and bad fuel being sold in naija

I refill to full tank almost everyday atmost 2days before i start driving. I reset my Trip B to zero after every refuel to monitor usage.

May we not see Fuel pump & Injector wahala. I battle am for 6months when i get starting issue. Changed almost 4 fuel pumps from tokunbo to new. Until i later changed all fuel injectors before motor balance
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 6:31am On Mar 16
Happy striking
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 9:42pm On Mar 15
Kumuyiii:
bro eh, that's the hard part, the make majority of the trips... Men wey dey order them like food, all EVERY SINGLE bad rating wey i don get na them... Imagine 3 days ago.... Coastal road BLOCK, as in complete block... I wasted 3 hrs stand still, everybody begin do uturn... see wetin this f00l write, i con later ask, shey if na bolt you book, you go yarn me this rubbish..? Abi no be you go use ur hand abort mission, so becus na indrive, you no really send, and as ur slave, make i dey stand still becus queen Elizabeth wey you be, you dey go work.... To show you say na rat brain these creatures dey take waka, i actually told her I no care about the money(16k), make she just find her way, still!! These creatures are insufferable... Na why dem selves no dey like work with each other, terrible people... Today again, i don carry one reach street wey she dey go, these people begin feel entitled, like I'm supposed to wait for you to get the accurate house number... I carry dem reach first number 8, the second number 8 was 5 steps away, no wahala, i reverse carry them go there... She do money, i say, 'have a nice day'... She still sit down dey wait make person come carry them, i come tell am oya oh, fuel is 1300 abeg, the female dog tell me, what if i never send money you go hurry me... Na so she come down, the werey rate 1 star... Tag me rude... Omo i off... Na him i decide show her rudeness, according to her reply, dis clown actually know wetin she do, she did it intentionally... But i serve am hot food wey she no go quick forget... She f00lish girls know wetin dem dey do oh. Moving forward, I'm sure she'll think carefully b4 moving werey
Bros you too like fight, see wetin person passenger dey comment grin cheesy

Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 7:11pm On Mar 15
Glithronix:
I'm not against the strike, but I hope it won't later result in government intervention.
And when government comes in, y'all know what next.
Nigeria government fit even get hand in all these things wey those apps they dey do in order for them to wade in.

BTW, I neva believe say there's going to be any protest/strike action until it happens sha.

Much respect, baba.
Its not hard to guess these apps also pays heavy tax to the govt. So indirectly the Drivers and riders pays the tax through that channel.


Na Uber, Bolt & Indrive dey chest all the blames. Not saying they too are not bad. A review needs to be done
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 7:08pm On Mar 15
Kumuyiii:
After sorting this immediate bill wey hang my neck, I'll make a conscious effort to avoid picking women... Unless i don't have a choice. All the problem wey i don face for this work na women... Man these creatures, and una say make i no be misogynist..oya na
80% of riders are women, you cant avoid them. Dem too like soft life grin

Jst pray not to meet the ones that will ruin your day. My biggest tips so far are from women, the soft heart ones. The same bad ratings i get na from women too. huh
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 7:02pm On Mar 15
Since nationwide strike dey tomorrow

Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 12:03am On Mar 15
If you car breakdown for road, its hard to see help grin

Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 3:45pm On Mar 14
Dabadwela:
Una and pride

What's wrong in asking riders to rate you?
E go reduce hin steeze by 25% grin
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 9:28pm On Mar 13
All these VI offices people especially bankers, dem go don dey inside AC from morning till evening dem go still tell u to on AC for them for evening ride

I on AC for one sotey her nose dey comot catarrh cheesy, later off am because her friend dey cough immediately the friend dropped and we dey 1mins to destination she say make i ON the AC back huh
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 9:22pm On Mar 13
Bintasukai:
This fuel hike is not making any sense on my calculations. If I buy 5k petrol for instance, I use it to make 12500, Bolt remove 4,125. E remain 3375 for me wey do d work.
Lol grin

Use Indrive, where you control price. Na anything wey Bolt or Uber like dem go give u from trips
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 5:03pm On Mar 13
Even if you will later tip me $1,000,000 i hate it when riders delay more than 5mins. undecided


Dem fit later cancel you e go affect you
Business › Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 10:56pm On Mar 12
TUBLEZ:
on weekends?
Weekdays and weekend

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 10 11 12 13 14 15 16 17 (of 17 pages)