Hungryboy's Posts
Nairaland Forum › Hungryboy's Profile › Hungryboy's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 18 19 20 21 22 23 24 25 26 (of 119 pages)
He warned you not to leave Christ, Yet, you are smooching beautiful girls in your Music videos and singing about girls money and sex? Mr Man , You are just another confused Christian |
If Na Nigeria e happen so , Our gullible Christian brothers for talk say, Dem don declare war on the church and Christianity and that, The Government wan Islamize the country My own be say, I no fit Waka for leg, go pay tithe for church were the Pastor dey drive private jet |
The Oba of Lagos sef, Look like retired agbero People been don suffer for this Man hand well well, the time him been dey police |
There are so many shady billionaires in this country How this one take make him billions, we no even sabi, Dem just tell us say him be software expert Tell us one software were him invent , We no even sabi Mr Churchill like Emoney and Ayiri Emami, Is just a shady billionaire |
Smellymouth:my oga Mercy no steal the man nah, Him be small pikin, He felt like divorcing his old wife and getting a new one Mercy committed no crime here, The ediot of a husband who beat Mercy up is the only criminal here Him get luck say, no be America or Europe were him dey, Cos, court for jail am still give Mercy half of him wealth |
Nigerians sabi react sha, Coke jump from 60naira to 90naira dem no react Ashawo increase short time price to 1500naira, dem no react Garri jump from 5cups 200naira to 3cups, dem no react Na Tonto Dike and other celebs matter were no even affect dem, were dem dey carry for head |
Our pastors now dey compete with our politicians on who go live large pass |
Let's be truthful to ourselves America , Britain and the French are still influencing elections in Africa Though am not a fan of Gej , But truth be told, The Americans and the British had a hand in his removal, The tried to sabotage his war on Boko haram , by refusing to sell him fighter jets and other weapons, Using human rights abuse as an excuse. But all of a sudden, The are about to sell weapons to the Buhari government, Under whose watch, More innocent people(Shittes and Ipob protesters) were killed by our Military in one year, Than throughout Jonathan's six year rule |
Nice pictures , But why d man come dey lie give us say bail is free? |
Person were still dey live with him Papa, dey chop Mama thank you dey claim most eligible bachelor |
Efe grace no go help you make am for music industry, Your rap no dey tight and you get frog voice If your songs no make sense, Nobody go buy am, Thank God say Churchill don give you free land, Carry some part of that 25million go build house, Invest the rest for business |
Hi bosses Abeg my tecno y6 dey always go from 100% to 60% or less after charge even without usage The phone dey hardly hold charge stay, And whenever I'm charging the phone, When I enter some apps, like my browser, It exits by itself Abeg, is it a charger or battery issue am asking , Since I do not use an original charger |
Naija boys no dey gree , Recession don make boys devise new ways to take hammer money Me where the hardly get luck for life no go try this pattern, Cos I fit trek finish go reach Port Harcourt , Wike no even send me , And Government house security go use koboko pursue me for gate My own strategy were i don dey map out Na whistle blower I just dey wait make one Politician like that. for my State, build him hotel finish, Make I snap the picture send give Efcc make dem give me my 5% reward |
Nairaland suppose start do psychiatric test to determine the mental health of some member's for dis forum oh |
Na things like this dey make people no dey gree go school again, After chopping free food and partying for 3 months in Big brother house, Efe was rewarded with 25million and a jeep, free land from Churchill, Ambassadorship from Plateau state government, Bisola, Tboss Miyonse Marvis And Soma are getting one endorsement deal or another. Yet somewhere out there. In the streets , A guy that graduated with Second class upper has lost interest in looking for jobs and is now learning a trade So that he can use it to survive |
Berlynn:aunty, If you are Dangote or Adenuga's daughter, many of us here go write application letter to be your pet for life, But, if na hungry girl you be, My only advice for you na, Beware of thunder that fireth by night |
Poverty no good oh, See as Stella were be my Mama mate, Come look like my Mama youngest sister |
Since everybody dey follow Make I join dem follow too |
xstry:Wetin dis one dey talk? Where Saint Buhari carry money from to contest election four times? All na thief dem be, But na only thief were dem catch were dem dey call thief |
xstry:fulani peaceful people? Which kind joke be dis early morning. This guys arrested are probably armed robbers and other criminals, who are being made to take the fall for all crimes committed by rampaging herdsmen in Benue Nobody has interviewed those guys to hear their side of the story , Or their confession of being responsible for those murders |
The USA have killed more people and destroyed more countries by "mistake" than Islamic State |
The only thing we are waiting for ,
Is when Baba Buhari will suspend himself from Aso Rock and the presidency |
I Go Die sef never see suffer na ajebutter dog food were him chop for Alibaba mansion were make am talk say him don suffer? Dog food get level nah Some dog dey chop steady rice and chicken Were even me sef no dey chop If you never sip garri with salt for one week, Or drink water for one full day You no fit claim suffer head were i dey |
FriendNG:abeg stop celebrating when there is no reason to celebrate abeg, Rice being sold by one Philanthropist in Kaduna for 11k for a few days Is not something we should be celebrating This is just a one off bonanza that won't even last up to a week , I bet by the time, Thousands in Kaduna hear about this bonanza and go looking for the 11k cheap rice to buy , Our "philanthropist" won't be able to take the losses anymore , and will lock shop and relocate to a new location |
CFCman:the are making crazy amount of money for just moderating a news show and giving their opinions on the news of the day, America is crazy country |
Him no talk lie Northern votes determines who can become President Except a Southerner rigs an election He can't win a free and fair election against a Northerners, who just need a few million Southern votes to win The only way to end this, Is to practice the electoral college system practised by the US But our own will be based on regions With each region having equal votes The North Middle Belt South West South East And South South The winner of the most regions Wins the election It will not matter if a region has 30million voters Or 5million All regions vote will be rated equally |
That one na dia cross Make two of dem carry am |
Ay you get mouth The ones were dey vex me na the Efe supporters were no even benefit anything from him winning At the end of the day, Ay is rich Efe just became rich And you were dey shout team Efe up and down, Dey find who go borrow you 1k to take chop |
I and majority of Nigerians have moved on,
From whatever happened in 2015, We dey find Wetin we go chop for 2017 so People like Reno no care about people like us, The only reason him dey rant on Facebook, Na because him lose him position and cash cow , after Goodluck was defeated |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 18 19 20 21 22 23 24 25 26 (of 119 pages)
