InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 27 28 29 30 31 32 33 34 35 (of 90 pages)
Bookworm001:And if no be say he dey Kiddi team sef, he no for fit win anything at all. Abi, how many questions he don answer through the last two rounds? |
Erica fans, I have bad news o Several of her former schoolmates have been on Twitter, and declared that Erica is indeed a good-natured and happy soul, who has never gotten angry to the best of their knowledge, or raised her voice at anyone. She is also a sucker for love, according to them. Wetin this thing mean be say, she go continue to "lead Laycon on", while not so subtly, guarding her heart from Kiddi. In other words, na one chance we dey so for her matter, not for the faint hearted. |
davodyguy:Vee has given more content than Erica? Erica's dancing alone on Saturday night has covered the whole thing Vee has brought to the show. In a bid to promote a useless propaganda, una go just dey lie unprovoked. When God want judge you for these lies, he no go know which one be propaganda lie and which one na necessary lie |
JuicyStar:Erica's offence now is that she is nice to Laycon, abi? Is it a crime to be nice to a facially and vertically challenged man like Laycon? Is there any crime in being a good human being? All those slutshaming Erica are high. My only anger be say, if man no wan accept your friendship, u move on. Sometimes, it's the "moving on" that earns you more respect. |
Blackhawk01:Na because of her I dey advice girls to be brutal. See, e no good make woman dey nice to men. Men deserve suffering ![]() |
Ambber:Kidd wey dey siddon for chair now? E no even dey near them |
CaSttLe:So far so good, he never dey bottom with that name |
homesteady:LOL Thank God he has seen the light, I wish Pribaj all the best |
Gbegiri:Why should I visit Twitter when my comment was on Nairaland? I posted based on the last 3 pages I had seen on this thread, wetin concern me and Twitter? |
Gbegiri:Not one Erica fan has dragged Kidd in all these things. We no send una Nengi again. |
cole01:Which supremacy battle? Him fave dey equation? How many babes Ozo dey control for that house? No be just Dora and Nengi? Any other babe dey look him side? If we dey talk supremacy battle, na people like Prince we go dey mention alongside Kiddwaya, no be Ozo. |
Gbegiri:Na pained souls dey drag am. I don read up to four pages now, na the same three or four people dey go on about Kiddi and him papa money, like say dem be him account managers. Kidd no get money, Kidd dey play girls, the girls go shock when dem comot and he no see the money. Kidd fit no get money reach, but the connect wey he get, dey enough to bring money, and after this show, e sure me say e go get more. Even the same Kidd, when Nengi dey ask am say "I know you have money", Kidd tell am say na him papa get money, no be am. Even the Kidd never talk say he get money before, so, I no know where all this unnecessary beef and drags from come. Na wetin make Davido say "Hustle, make your pikin no dey vex say another person dey chop him papa money" Na privilege Kidd get, he no kill person. |
Innocentchild:If you see Kidd playing board games or table tennis, the likelihood that the person playing with him is BrightO, is 95% All the tasks they won this week, BrightO was always with them. In fact, Bright don dey Kidd team from the first time dem begin dey group them. He dey silent, but he dey roll with Kidd and Tochi |
LOL. If Kiddwaya comot from that house, e no go even remember say he been wan chop Nengi at any point, all this talk about him waiting till outside house just dey funny me. By the time all those lecherous Abuja babes jump the guy bones, Nengi no go even see space take do one round of nacks. No be yellow and fake bumbum? Kiddwaya wan save Nengi indeed |
Munzy14:Just face your bandwagon wey you enter before you enter gutter. When dem dey accuse you your own, I no talk anything, because e no concern me. You dey find who go follow you dey unfortunate. Be like you don tire to dey suck Laycon balls for these streets, na ArchAngel own you wan dey find. |
ArchAnge1:Where you see say I dey support other people? Be like you don dey drink Nengi piss. Look my moniker well, I no be you wey throw your supposed fave under bus, because of Nengi yansh. If dem talk nonsense about some housemates, I clear the nonsense, e no mean say I dey support them over my fave, e mean say I dey clear nonsense. #FreeErica. |
ArchAnge1:LOL. See this one. Even plus the forces wey una join for iyawo, we still dey gidigba for our second spot. Which means, plus your boy, minus your boy and iyawo, you no fit move Erica like that. I no see you dey wail when Laycon people dey trend all sorts of nonsense everyday. Small #FreeErica wey we do for sensitization, you don dey panic. LOL. Lilo indeed |
Everyday, I thank God for Miracle, say he no dey do all these social media parole. |
Lazyyouth4u:Sorry, please, how was he there for her when no one else was? First time wey she cry, who tell am sorry? Na Kiddwaya Second time wey she dey moody, who go siddon with her to gist her? Ozo Who don dey push her since, to participate more for that house? Kiddi When dem dey find actress for this their production, who insisted that Eroca play the lead? Kiddwaya How many times Laycon don ever defend Erica when dem talk bad thing about her? Never How many times Laycon don ever follow Erica talk her acting work, the way wey Kidd dey follow her discuss? When he enter Diary Room, he dey mention her name? No. The only thing wey Laycon don do to show say he and her na friend, na when he give her jacket because cold catch her, and when she ask am to go talk to Praise about the side chick thing If not, he never dey there for her pass the way wey Praise dey there for her. |
Eeghe:LOL Frodd own been dey irritate me because, on the norms, the guy na spec, and he no suppose dey wail for woman like that But you see this Laycon, na effrontery and audacity e get. |
geezprince:Frodd own been dey irritate me sef, and I no like Esther for anything. |
Samueltemi337:
|
geezprince:I no for see am as cruise. No be normal behavior be this. Other people fans too, dey complain about am, so, where this your talk from come? |
Samueltemi337:And we will always drag your guy, when he does rubbish You better understand that now, rather than telling us to stop wailing, because then, it makes you a wailer too. |
Blackhawk01:Shebi dem say old things are passed away, we don come new thread, make all things dey new, including stance on some subjects. |
Eeghe:If say na Laycon bed she dey warm, dem for dey happy say their guy hook correct babe, but because dem sly their guy, the next thing na to dey slutshame the babe anyhow. Basic Loser behavior, very predictable. |
geezprince:Na cry Frodd cry, for the babe front sef. He beg her pass as e take go dey talk her matter with others. He no talk say Esther been dey feel am pass as she dey feel Nelson, he no dey talk, "I'm happy for her, as she's with Nelson", while still wailing. Frodd even dey useful during tasks and other things, so, him highlights no be just Esther. But you see this dada boy, him own don too much. Disgusting behavior |
Blackhawk01:She dey even follow agree say Erica lead am on. E get some opinions wey I dey skip for this thread, e get why |
Ujay01:She for no even try am. E get some type of guys wey babes no suppose dey friendly with, make dem for no catch feelings. Frodd no lament reach like this last year |
doziefrank07:Na she do mistake. Why will she even be nice to Laycon? Person wey she for sly, she dey follow am talk, see now, she don dash the guy content. Everytime, Erica this, Erica that. Donate herself as content to an otherwise useless housemate HOH task, we no go see am, group tasks, he dey fade, Arena Games nko? Zero, but once he find himself with even fly, Erica name go dey move everywhere. |
Women, no dey follow ugly men talk, una no dey hear word. See Erica life now. Small smile wey she smile for this guy, for him mind, she like am die, and na because he no move fast she go Kiddi. Ugly men dey catch feelings fast. We go dey hear Erica every single day, until finals. |
Hei God! Erica again? No be TolaniBaj bring the name up o |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 27 28 29 30 31 32 33 34 35 (of 90 pages)

