₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,327,731 members, 8,432,317 topics. Date: Tuesday, 23 June 2026 at 02:33 PM

Toggle theme

InSanety's Posts

Nairaland ForumInSanety's ProfileInSanety's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 28 29 30 31 32 33 34 35 36 (of 90 pages)

TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:59pm On Aug 07, 2020
empress101:
Lazy Erica...She has formed d habit of eating frm people's food..u go carry food come,nxt tin ,she is seated beside u with a spoon..she hardly cooks...na so she go chop belle full..Tueh
Forgive her, she don dey work hard this week, e no easy to win two group tasks, come still play lead for house production wey dem still win task, and cap am off with wonderful performance in Arena games, some hours after washing clothes.


Forgive her, you hear?
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:57pm On Aug 07, 2020
homesteady:
I didn't even know he was sleeping on his shoulder sef, I just saw the video on Twitter after you posted this.

It even makes the whole stuff less serious sef. Will he be lying on someone's shoulder that he is not comfortable with or friends with? Laycon fans are really over sensitive.

Anybody that wants the complete video should watch here.
https://twitter.com/coachbana_/status/1291818253384392706?s=19[/quote]My dear, people dey laugh about the thing for Twitter, e surprise me say dem dey vex for here.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:35pm On Aug 07, 2020
empress101:
Ozo wins...how come..? Thought he finished at 3:00
Nah. It was 1:08 at most
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:35pm On Aug 07, 2020
Ozo, from HOH to winning Thursday night task, and now Arena Champion

Perfect week
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:34pm On Aug 07, 2020
Blackhawk01:
Delete your draftsssss!!! My girl did it! cool cool
No mind them.

She even got one of the best times, but dem no go talk that one.

All of dem wey wan suck Kiddi balls don dey use am yab her, now, see silence inna the streets.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:11pm On Aug 07, 2020
Eeghe:
To the last letter
shocked cool
The dreams and delusions these people dey come up with dey always funny.

Dem go just siddon dey make up theory for their head, come discharge am for here, make bad belle people dey enjoy the theory.

E shock them say the guy never leave the babe go meet another girl after Sunday's incident, so, now, na to dey make up story, say a whole Kiddi wey Wathoni still dey find, dey intentionally punish himself, by being around girl wey he no like.

These theories ehn.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:47pm On Aug 07, 2020
xenoo:
Is like Erica is by all means forcing herself on Kiddwaya, She is even telling other housemates as if they have something serious going but Kiddwaya doesn't even feel the same about her.

The other day when Nengi and Kidd were eating and she said she felt bad coming in between his relationship with Erica and that Erica is giving her attitude whenever she's with him.

Kidd said Nengi should not feel bad and that Erica is not his girlfriend or wife that they are just friend and that nobody can change him from his normal self. He also said he loves flirting and being around with other girls too.

Summary is that Kidd isn't into Erica like she is in him...
LOL

Go and tell Kiddi to stop cooking food for Erica and stop following her like fly wey dey follow shit.

She kuku never tell anybody say she dey into the guy, I no know where this your mumu theory come from.

Even Neo admit say Kidd no fit sleep for night if Erica no dey. Shebi after he don tell Nengi that nonsense wey he tell her that night, e no fit sleep for night, dey toss and turn, before e finally comot from bed, maybe to go beg the babe wey e no dey feel, because the next morning, he follow babe wey he no like, dey talk career and who go date who. He even dey teach her boxing to help her career, as she dey irritate am reach.

He no send her sotey this afternoon wey she go wear that her red dress, as the babe reach parlour, my guy lose concentration of him game, dey look her like who never see human being for him life, next thing, we see am for her corner, like who dem use kayamata do.


Once he see say any guy dey near her, he go dey monitor am, if she no dey him side, he go dey find her. He no dey even gree him guy, Tochi, touch the babe. Tell your guy to leave the babe, if na so e easy reach, since he no send her.

People wey no dey watch show, go come here with stale gist everytime.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:26pm On Aug 07, 2020
ArchAnge1:
couples indeed

Kidd and erica aren't a relationship


It's a suituationship
They are in more of a relationship than that Bondage wey your guy dey.

LOL
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:11pm On Aug 07, 2020
Couples o

TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:08pm On Aug 07, 2020
See TolaniBaj, possessing her possession.

Just hold Prince arm, dey rub the arm special rubbing

Rub the arm well my dear, na you get man
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:42pm On Aug 07, 2020
Jake420:
When pls WETIN happen? Was it mistake?
No be kiss, na peck and no be for mouth
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:42pm On Aug 07, 2020
Nengi to Kiddi:

Please, we will eat this indomie from the pot, because, washing plate is another thing
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:41pm On Aug 07, 2020
heartofcity12:
Kidd and Nengi are trying to be close. The coaching is just an excuse to always be together.. They will get intimate at some point.
We can't wait
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:36pm On Aug 07, 2020
stanisbaratheon:
Kayode seem to be panning the camera anywhere Nengi is.. cheesy

The babe set I swear
Dem dey call am Production Pet.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:34pm On Aug 07, 2020
ArchAnge1:
wasn't just ozo, all the guys
Okay
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:34pm On Aug 07, 2020
ArchAnge1:
the more she keeps saying that they are friends, the more stupid she looks
Are they not friends?

Wetin make she talk say dem be?

To the best of her knowledge, na friends dem be. She no look stupid, na the other one wey don follow her born seven children for him mind, no get sense
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:29pm On Aug 07, 2020
ArchAnge1:
Who heard kidd and nengi just now

I'm too angry to post it
LOL

Wey Nengi talk say she dey follow Kiddi advice on how to follow the guy (Ozo), but she go need more coaching grin

Kiddi say, anytime, he dey available for coaching
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:27pm On Aug 07, 2020
Dem don enter Ozo matter, say dem no know if na triangle he dey or another thing

Lucy come mention say dem see Ozo with person, wey the person bend over for kitchen, Dora say she sure say no be bathroom? Lucy say no, na kitchen, wey she the person. Dora ask na who, Lucy say she said the person, na so, Dora waka go meet Lucy

Dem come do small aproko between each other
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:21pm On Aug 07, 2020
MissAnnBoleyn:
Do the house mates know Erica and Kidd have consummated their showmance?
They know about some duvet dealings, but no proper consummation

Dem been dey yab her say dem go use wetin dey cupboard (condom), so, Kiddi no fit get white substance for bed, na so, she tell them say dem no dey reach that base, dem dey ask her say which base dem don reach.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety:
Lucy and Dora talk say Kiddi dey move for straight line, but na Erica dey triangle.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:10pm On Aug 07, 2020
Dannyxy:
My only issue right now, is that Kayode is giving her relevance through laycon..

Laycon stop giving this girl relevance and watch her fade... Damn

When anyone asks questions about the situation, say ziltch, any one inquire, no comment.. Her fans are grasping for breathe, and are really leeching on this badly..

Ebuka will do the rest.
LOL

Even Kayode know say Erica discussion na content.

E no get any other talk wey Laycon wan talk if no be Erica matter, zero content.

Even him music now, na to write music about Erica he dey plan grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:07pm On Aug 07, 2020
So, na Tolani and Prince been dey kiss serious kiss last night
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:06pm On Aug 07, 2020
goldenone:
If I wasn't watching I wouldn't know people spin the narrative a lot around here.
Kaisha asks Laycon if he is offered 3m and leave the house would he take it since he's not sure if he would win the grand prize.
Laycon responds that he wouldn't take it and would prefer to stay another week. He enjoys the conversation he's currently having with Kaisha, he enjoys seeing Erica even though he can't be with her, he enjoys seeing Wathoni intentionally avoiding him because she wants to. Every other thing he said about Erica were specifically asked by Kaisha.
Including "Do you think I'll be fine with her in the house?"

Thank God say we plenty wey watch, and of all of us, na only two of una just water the thing down.


Say dem ask you about person, no mean say you must answer in detail, "I'll be fine" is also an answer, except you just want the whole world in your business.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:59pm On Aug 07, 2020
ArchAnge1:
malicious report

Why didnt you say that it was a joke
No dey police my posts, Erica own wey I post, I no mention say na jokes, and dem dey laugh for that one too.

Another person post Erica and Kiddi talk, I no police the person.

Write your own, I no hold you.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:54pm On Aug 07, 2020
ArchAnge1:
they are joking na
I know.

I just dey report
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:53pm On Aug 07, 2020
Dora dey cast Ozo and Prince, say dem dey see tissue and white substance between their beds.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:52pm On Aug 07, 2020
Erica say if she pick Kidd for HOH room, say e go dey risky
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety:
Akshow:
Kaisha asked him about Erica pls. Don't make it look as if it's him that brought ou her issue
Bright asked Kiddi about Erica, did he pour out his whole mind on her matter?

Must he use twenty minutes to talk about it?

He keeps moaning, and giving housemates this impression that they even had a relationship.

After what Praise told him yesterday, he no for dey talk the matter again.

Now he dey ask Kaisha, "Do you think I'll be fine, with her in this house?"

Why e dey ask am that question?

On Sunday, Ebuka go still hear this lamentation again.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:43pm On Aug 07, 2020
Innocentchild:
Baba thinks Erica liked him in the Beginning .


Lol, he's definitely delusional .
Can you imagine?

Na Erica bring this insult come.


Every moment, he must mention Erica. E no get who he never follow talk this girl matter.

At this point, he is doing it to get pity from viewers, make him fellow rejected guys dey concur
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:41pm On Aug 07, 2020
Why the heck does this idiot keep talking about Erica?

Laycoon fans, please, tell your guy to start forming activity, and leave Erica's name out of his mouth.

After everything Praise said yesterday, this fellow has tabled her matter to Kaisha again.

Is this not an obsession?
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:19pm On Aug 07, 2020
Skrrrrrrr:
Chairman... Laycon is a very relatable individual.
Plus he is way more schooled than Efe...
And a more talented artiste.
Na wetij make am Efe 2.0, an upgrade of the original, but still the same components.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:17pm On Aug 07, 2020
carammel:
Praise, how is golden eaglet so hard?
Dem go use pride dey talk of foreign clubs, but dem no sabi anything about Nigerian football

Na so most Nigerians dey

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 28 29 30 31 32 33 34 35 36 (of 90 pages)