₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,327,699 members, 8,432,181 topics. Date: Tuesday, 23 June 2026 at 11:31 AM

Toggle theme

InSanety's Posts

Nairaland ForumInSanety's ProfileInSanety's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 30 31 32 33 34 35 36 37 38 (of 90 pages)

TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety:
The way wey some people dey always use sex shame women dey funny me

Be like all of una be virgins, because if not, any woman wey una dey kpansh, na ashawo she be, slut, with itchy vagina. Even worse, if una broke, she no get ambition be that, dust digger.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:09pm On Aug 06, 2020
Why this bros dey lament for Biggie?
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:04pm On Aug 06, 2020
Be like Erica don enter her second position again.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:02pm On Aug 06, 2020
Innocentchild:
Why are you guys panicking?


I thought you said you've won the show grin
Winner by Week 3 after 2 voting rounds?

No be say na like those other times wey dem go dey save money for finale, as long as your fav no dey up. This one, you go dey use money vote constantly, and if your fav never gets HOH or Deputy, o pari.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:56pm On Aug 06, 2020
OffsahBoye:
So you can vote for someone else that you both are struggling to win the same price as the winner??

That means everybody will be winner cause it'll be one vote for each contender each
When others no come sell groundnut
Na to ask "Anyone but yourself..."


Na so Ozo go win grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:24pm On Aug 06, 2020
Dannyxy:
Many laycon fans threw Erica some votes last week sha.... Not insinuating anything, I just dey talk my own ni...
Thank God na last week be that.

Una no dey vote this week, so, make we assume say na her fans give her the votes.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:23pm On Aug 06, 2020
Hintona:
E pain me too Sha grin

But Erica is a good actress all this envious non-fans that have never watched her movie are here spilling rubbish. SMH
Dem go dey alright after the show, and they see her constantly on their screens.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:34pm On Aug 06, 2020
Threebear:
Prince can hang my legs upside down and ram me through , and I'll be screaming - Zaddy !!! grin cheesy
Whitepanda, na you be that?
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:29pm On Aug 06, 2020
Hintona:
Nife

Her name was Nife.

And she did very well in that movie, that was when I fell in love with Erica even before BBN. kiss
I swear, na that film I take like the babe.

E pain me small say the guy no end up with Nancy character grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:22pm On Aug 06, 2020
zicoraads:
I watched Hire A Woman on Netflix some weeks back...

Wait, was she the one who eventually got that guy? The travel agent... Can't remember her name.
Yeah, na she eventually end up with the guy. She be travel agent for the film

Her name na Temi or one Yoruba name for the film.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:20pm On Aug 06, 2020
mizz2posh:
Nengi is a business woman who has a shoe line of her own.

You say she's a sugar baby, but the person you claim is decent has made a fool herself already yet the one you claim is a hoe is keeping her self dignity, the joke is on you sweetie.
This your talk no follow

Olosho dey follow men for money. Why dem go sex anybody wey no dey send money enter account?
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:19pm On Aug 06, 2020
I don watch this their rehearsal so tey, I sabi all their lines and their songs.

Make Ozo come use me replace Prince, I dey capable grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:54am On Aug 06, 2020
I like Prince character die for this film grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:36am On Aug 06, 2020
Amya:
She has gone to sit on laps again. Smh... Tmrw now she'll accuse poor Kidd of being a player yet she can't seem to stay away.
Kidd wey Nengi advise to give the babe space, why he no wan give her space?
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:35am On Aug 06, 2020
Eeghe:
Dora please don’t kill Erica for me today, I nugo nne?
cheesy
Dora don tire.

She go chase Nengi finish, only for Erica to come dey follow Ozo chop again.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:34am On Aug 06, 2020
mizz2posh:
Wow she's already on the big screen, her movie is on pornhub, she made it cheesy
You no free go school, na wetin make you no know the meaning of "big screen"

Big screen na cinema, and yes, she don get movie there, watch Hire A Woman on Netflix. I understand say money been no reach you to watch am when e dey cinemas, just continue your midnight subscription, as you watch your pornhub finish, download her film.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:31am On Aug 06, 2020
Johnpaul01:
I will answer this question from what I saw in my mum while growing. My mum had a business while my dad was a contractor/property manager. My Dad paid our school fees and bought our textbooks and every other educational expenses, he bought us Christmas clothes but my mum took care of the feeding expenses of the whole family and bought random clothes for us. She also gave us money for books we need the next day at school if my Dad wouldn't return early, till she had an accident and couldn't operate her business for months and it crashed. That is the kind of woman I want as a wife and the kind of woman I want my daughters to be.
And you think Erica no dey like that?

You think she no go contribute for her children?

You dey alive when your parents been dey date? You know as their dating stage been dey?

Na the same Erica talk say she believe say relationship na give and take, no be only one person go dey fund am.

E sure me say you no watch that time. Una go just begin dey watch show for week 3, dey make judgments when you no sabi back story.


This show dey like some season films, if you miss two episodes, you go confuse finish.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:26am On Aug 06, 2020
Ujay01:
grin grin Some people go just open mouth dey comment based on biased post wey dem read for nairaland.

Na so Amya report say Erica dey there when Kidd dey report him private jet gist; and the narrative of her being a gold digger come stick...
Since safarigirl call that one failed runs babe, she never recover.

E sure me say na wetin activate her hate for Erica be that.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:23am On Aug 06, 2020
thatigboman:
imagine praise saying that on sunday night, dora didnt go and ask him how he was feeling. are u a kindergarten. stupid homosexual
The thing off me.

He talk say he don born pikin finish, next thing, he dey count who come tell am sorry when he end for bottom 4.

He go dey there again on Sunday, he never start.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:22am On Aug 06, 2020
MSGAMBLE9:
big time actress or u mean up and coming GOLDDIGGER
All na the same thing.

You can be a gold digger and an actress too grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:08am On Aug 06, 2020
Lazyyouth4u:
It happened on Saturday (the day after Erica had secured Kiddy with the cry drama). Erica was not even there when he told the story. It was Nengi, Tolani and Wathoni
She dey agend so tey, she no even know who hear wetin.

Be like I go believe that thing wey Zico talk about am.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:07am On Aug 06, 2020
Eeghe:
You can evict Praise now
Thanks
cheesy
The guy dey there dey list who he fit play with who e no fit play with.

I no blame am, na them save am. Somebody that was dead last on eviction list.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:06am On Aug 06, 2020
Eeghe:
Hei Ghod
So if you take a girl out on a date you won’t pay for the date?
Chineke mekweelu mu ebele bikonu shocked cry shocked
Nne, mark them.

People wey wan make women dey submissive like their mothers, but no wan foot bills like their fathers.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:05am On Aug 06, 2020
Eeghe:
Darling, Erica is bae (she has her weaknesses) but is a good soul (her game has not been manipulative, has not hurt anybody, has not been vindictive at all)
Pure and simple fact
Exactly

Na wetin I like her for be that.

You fit call her ashawo, slut, gold digger, but the main thing be say, everything wey she don do for that house, na herself she do, she never do another person.

She no dey hurt people, and that is a very good trait in any human being. That is the best trait anybody can have- consideration of the feelings of others.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:01am On Aug 06, 2020
RTSC:
I thought some people would have learnt by now not to take what women say serious.

Katrina says she only sleeps with older men.

We all know how that went.

Lilo says she like dark men, we all know how that went.
You no dey watch the show.

No dey talk with confidence like this, when na Nairaland you dey get your gist

Ka3na no talk like this. Ka3na say she no wan enter relationship, say the only thing wey she fit use small boys do na sex.

She even tell Praise day she no like as he dey give her space like say she dey catch feelings, say she don tell am before say na only sex she fit use am do, e no get another thing to offer her


Ka3na say she dey only use young men for SEX NOT RELATIONSHIP

Buy television and pay subscription, or turn yourself to ghost reader. No come here dey type nonsense
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:58am On Aug 06, 2020
Laycon and Praise dey talk.

Laycon dey tell Praise say e get where yabs dey, and e get where the yab dey pass normal level, e go come become insult

Be like some guys and Laycon don dey talk as Praise handshake dey reach elbow.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:56am On Aug 06, 2020
RTSC:
Her ambition na to be big time actress, yen yen yen.

That means she is not looking to ride on the kiddwaya billions like she is desperately to do in a slutty way?

Abeg shift.
If she ride am in a slutty way, how e take concern you?

You sef shift. Be like women don dey ride on top you to chop your own money, na PTSD dey worry you.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:53am On Aug 06, 2020
Dora come scatter the talk, because Bright cook egusi and okro, and na only ritualists dey chop that kain food, so, she no come chop yesterday night

She dey cry say nobody loves her, na wetin make dem chop, dem no consider her matter. She take solace say, at least, Ozo too no chop.

Anyway, Kidd and Bright don begin dey play Ayo
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:51am On Aug 06, 2020
RTSC:
I am not a misogynist.
I don't think women's ambition ends in the husband's house.

Erica's ambition is to end in kidd's house and she is going about it like a slut.
You no dey watch show

Erica's ambition na to end up on the big screen

Dem even ask her say where she dey see herself in 5 years, na only she no talk 'married with kids'

Her ambition na to be big time actress, but if she end up for Kidd house in the process, no harm done.

Na una go still dey insult women wey never marry, so, when did ending up in a man's house become such a great issue?

Talk from one side of your mouth, or no talk at all.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:48am On Aug 06, 2020
Eeghe:
You must take care of a woman
You are an African man
You are an Igbo man
You are a “Christian”
If you don’t know you have to take care of a woman that you decorate with a wedding ring, na big great shame be that ooo
Forever kwa
Lol
And take it from me, I am not broke
Maybe a whorre (since Erica supporters are whorres), buy a voting one
Dem no know.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:46am On Aug 06, 2020
Nancy Isime

Inidima Okojie

Now, Erica

All of them wan act action film, but Nollywood no dey do action film scripts. Na so so love in Tokyo
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:45am On Aug 06, 2020
Erica say she wan do action roles.


She say she been no fit remain for London after film school, she been dey part of an agency, but because she no get National Insurance for the UK, she no fit get jobs, so, she come back. He tell her say if she stay longer, she for get eventually.

She come tell am say she been dey shoot film for London, with her friend wey dem finish film school together, but na just short films.

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 30 31 32 33 34 35 36 37 38 (of 90 pages)