TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:39am On Aug 05, 2020 |
doziefrank07: Hope it isn't that Laycon trying to make the housemates hate kiddwaya and Erica? Because I don't understand this his silly search for advice It is tiring Dora dey even advise am say make he just remain friends with the girl, say she be nice girl. I know say Dora no tell am wetin he wan hear, so, later today, another pesin go hear the matter. E never still talk say Erica tell am say she and Kidd don dey serious yesterday, anytime person ask am about her response to his feelings, he go dey talk wetin she tell am last week, like say she never update am on cureent standings. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:35am On Aug 05, 2020*. Modified: 9:51am On Aug 05, 2020 |
Erica and Kiddwaya don give Laycon food this early morning, after he don talk their name 50 times in 10 minutes.
Dem dey try be nice to the guy, to show am say just because dem dey do whatever, no mean say dem wan alienate am.
The guy dey there dey catch feelings, dey talk about the two of them like say dem tie him destiny. Say he fit chop their food, after the way he don mock two of them finish since last night, is very telling. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:23am On Aug 05, 2020 |
yunafa: Something is not right. Nengi Kiddwaya, Laycon, Bright O, TrikkyTee playing ludo then adverts came on, after 3 minutes of advert, everyone is fast asleep like they've been sleeping for an hour...is this show live at all? Are they cutting some parts off so we don't criticize the show or are they protecting some housemates misbehaving? Threebear, what do you think is happening? Dem dey control narrative, so, dem dey skip things. That thing wey dem say we no dey see half of wetin dey happen for house, na true. Eric sef been mention this 30-minutes thing just last week. At least now, viewers go know say dem dey intentionally no show us some conversations, or cut am, make the narrative wey dem dey try spin, continue It takes a huge chunk of legitimacy away from the show. I sure say na because of their need to control narrative, wey make dem no wan get two channels |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:19am On Aug 05, 2020 |
This morning and Dora na the latest persoj to hear of Laycon's obsession with Erica
The guy just dey repeat the same thing, "Kiddi keeps holding her on the waist when I'm there"
He come talk say dem talk last night
Dora ask am wetin Erica talk.
Instead make Laycon answer wetin Erica talk last night, he dodge the question, dey yarn another thing.
Before the end of today, another two people at least, go hear this story.
Last week, people been dey get irritated when Erica talk she and Kiddi matter two times in one day, hope Laycon matter don dey irritate una too. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:01am On Aug 05, 2020 |
homesteady: But this Nengi sha Sitting on Kidd's lap is just so unnecessary and inflammatory. That's why when people start insulting her, I will just stay and be looking. Make I go save that picture, so the next time Vivipop abi wetin dem dey call am, quote me to yarn dust, I go show am why people dey hate on Nengi. I no dey like make people wey no too dey watch the show dey drop commentary like say dem sabi everything wey dey happen. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:57am On Aug 05, 2020 |
stephleena: lol, Kidwayya isn't changing for nobody.. I told my friends yesterday, that dude is just a bit calm because he feels sorry for the backlash Erica would be having outside the house, and knowing that moment they had was a sign of commitment from Erica to him..nothing else.
Erica shouldn't have allowed things go down between herself and Kidd.. she for use the guy too catch cruise. and yes he hasn't even asked her out or professed love for her Kiddwaya never touch that babe since she balance for him lap. If say she siddon for that lap four days ago, he for dey touch am well well. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:56am On Aug 05, 2020 |
burner44: I spoke with friends who knew about us and they encouraged me to keep up and subtly remind her i wanted more than friendship which worked out. There is no way you will never discuss your relationship issues with a friend or group of friends when you think you need counselling. Fact I did not say at any point, that you won't discuss with a friend. You talk to up to 10 people? |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:47am On Aug 05, 2020 |
burner44: Bro this is the more reason i I'm a young guy but I'm dating a working class lady and I'll tell you it took time b4 we hit up she said she wanted only friendship but now we dating Na so relationships suppose start If she pick interest in you with time, fine, no be say she go tell you say she don see who she like, you go come dey spread her matter to everybody |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:43am On Aug 05, 2020 |
orgylover: she was sitting beside eric o. then she sharperly wake up go sit directly ontop kid preek. i hate boyfriend snatchers like this  Uniquegodly and Vivpop don sleep, dem no go see this one. Nengi na just nice girl, she no dey do anything wey dey make people insult her. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:29am On Aug 05, 2020 |
burner44: I'm very well to do brother, but when i see what i like i persist. And if what you like does not like you, you should desist. It is very unhealthy to force yourself on any woman romantically. Let her no be no for you, no be say she go tell you she no want, but you go dey insist, dey disturb her In case you don't know, na creepy behavior be that, and for abroad, dem fit give you restraining order on top am. Learn to accept rejection from some women and move on. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:23am On Aug 05, 2020 |
orgylover: this is wht most people dont understand, they dont know there they are people greater than u. if they dont come to you, u should respect your self and stay in your lane. i have been in a party with daughters of billionaires, they greeted me normally, i greet them back. i o say ma try luck because i know say their level pass me by far. but my prayer be say let them make move on me. some guys no know say level dey pass level Na very big problem. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:16am On Aug 05, 2020 |
Dansuqi: What do you mean by babe wey pass person class? You think say na every babe you fit toast? |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:12am On Aug 05, 2020 |
Fucknengi: Nengi.. i don't want a relationship.. (2 pointer)
Ozo.. who wants to even date you? (3 pointer) Nengi "Why Are You Catching Feelings Then?" (Doublee 3-ponter) Make your guy catch him L |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:10am On Aug 05, 2020 |
Finally, some of these housemates don see say if dem no dey some complicated relationship or shook their head for entanglement, dem fit no get talking points.
Na only BrightO, dey trend without catching feelings. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:07am On Aug 05, 2020 |
burner44: Maybe you go for classless ladies, or immature girls No be the ladies get problem, na you get problem. Except You dey imply say you no get class, so, you dey go for babes wey pass you, na wetin make you dey wail to the whole world when you chop your L, like Laycon. In which case, na still you get problem. Guys wey get level no dey wail up and down, say babe no accept their advances. Dem go tell one or two close G's, no be to talk to 10 different people. You go look like clown. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:00am On Aug 05, 2020 |
geezprince: You dey para this early momo o. Just dey diss everybody. Anybody wey do anyhow go collect. So many unnecessary conversations this night. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:58am On Aug 05, 2020 |
Chiefheywhy: It is direspectful because Erica no be Kidd wife and Laycon fit follow am talk when he like .
Nobdoy get right to dey disturb him convo . Erica no be Laycon babe either, and Kiddi no owe am respect for anything. If he get issue with Kiddi, make he go meet Kiddi tell am as man wey e be, since Erica no be Kiddi wife, no be to dey give him gist to the whole house |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:55am On Aug 05, 2020 |
Blackhawk01: I'm glad she's giving him gbasgbos. Let him work for it if he wants it, not trying to shade her because she repeated something she's always said. Na real goat hin be.  I don talk am before for this thread, and I go talk am today again, Ozo na coward. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:53am On Aug 05, 2020 |
Chiefheywhy: You obviously didn't get what he was trying to pass across like anytime he is trying to have a convo with Erica , Kidd is always sniffing around and trying to come in between the convo .
He finds that disrespectful and disgusting ..
Which is true , na biggie house dem dey . How e take dey disrespectful? Wetin bring Biggie house enter the conversation? |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:52am On Aug 05, 2020 |
Venita: Let's not forget also.... Ozo might be book smart but he's very timid, lacks self-confidence when it comes to women (Bleep the gentleman bullshit), chivalry has nothing to do with this level of mumu  Na wetin make he no dey too dey relationships. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:50am On Aug 05, 2020 |
Vivipop: What do you mean when you called Laycon fans to come witness Nengi manipulating Ozo? Some person's only rely on the updates here, they don't watch, and when you make certain statements together with your updates, you unknowingly give those people the wrong impression. These two people are having honest conversation and you called one party manipulative. Would you say that if it were your favourite? Well, like you said, they are "your" updates, I am sure people like us who don't get to watch all the time will be wary of these "your" updates.
Safayi girl, bless your good heart. Yes, anything wey I talk about Nengi, no take am to heart. If you never clock that one, you no too sharp be that. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:40am On Aug 05, 2020 |
Wait....
Laycon say when Kidd come dey kiss Erica, dey hold am for him front, that he finds it, "irritating and disrespectful"
As, who, abeg?
Make una break down this guy reasoning to me. How Kiddi kissing and holding him babe, dey disrespect Laycon? Laycon get babe? |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:30am On Aug 05, 2020 |
Vivipop: It feels good to read posts from rational thinking individuals, there is still hope for Nigerian men.
A monicker named InSanety will see A and report it as B, just because it's Nengi. He never says anything good about her. Check his last 5 updates about this convo between Ozo and his love interest-Nengi, read how he turned the whole thing upside down. Thank goodness a lot of people are watching at this time.
It is well sha. I dey report wetin Ozo talk and wetin Nengi talk. If you no like am, watch your own report wetin you wan report. I no owe you update |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:27am On Aug 05, 2020 |
burner44: Hypocrites we all do what laycon is doing when we see a girl we like alot Na only you dey behave like this. You fit confide in one or two of your guys, for this situation, but if you don talk am reach four people, then make the girl go do thanksgiving say she reject you, because you no normal. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:25am On Aug 05, 2020 |
Psychedelia: Erica is actually Laycon's biggest fan in the Big Brother house. That somebody admires and respects you doesn't mean you have to emotionally arm-twist them into dating you; but that's what many of Laycon's fans don't want to understand.
Now I've seen them on Twitter saying things like, "Laycon will blow in the future and Erica will feel sttupid and helpless for not dating him". - Like Erica is just going to remain stagnant and worthless with no goals to pursue in her life.
Last last, many of Laycon's bandwagon supporters are irrational. Na losers dem be. All of them na losers and rejects, na wetin make dem fit support reject with their chest and approve his silly behavior |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:23am On Aug 05, 2020 |
Even Prince dey advise person
See who una wan convince us say he be correct G, this one.
All these okirika men, cannot understand 'no', na to dey waka from Owerri to Ogbomosho, dey advertise their loss to the whole world.
Laycon is not intelligent, and he is definitely not good enough for any woman in that house. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:20am On Aug 05, 2020 |
This idiot Laycon don carry Erica matter come meet Tricky and Prince again.
Which kain pathetic 'man' some of una dey support? Such a wailing pussyass nigga |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:19am On Aug 05, 2020 |
RTSC: True, I didn't watch their fluttrwave presentation this evening. Was at work.
Nengi is far more Intelligent than Erica will ever be. That is a fact.
Look at how competitive she is during games.
Erica can hardly give you that. Which competitive? No be dice dem dey roll for HOH games? Na luck she get |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:17am On Aug 05, 2020 |
Laycon fans, shebi una dey see how dem dey blackmail people?
This one dey tell Ozo, "I thought you were my friend, now, I don't think you're my friend anymore"
Make una watch well, for those of una wey no sabi how dem dey blackmail guys. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:15am On Aug 05, 2020 |
RTSC: Erica intelligent and productive?
If I hear. Which game either of them Don win.?
Talkativeness is not productivity.
Nengi is productive and intelligent. Clearly, you no dey watch the show. The FlutterWave presentation today, who win am? Una go just come here dey talk nonsense, because na from 2go you dey watch the show. Wetin Nengi don ever win wey show intelligence or productivity? |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:13am On Aug 05, 2020 |
We don almost forget say Nengi dey this house, now, Ozo don dey give her highlights.
Yesterday too, na Ozo give her highlights.
Ozo, stop wasting highlights on this babe, wetin dey worry you? |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:12am On Aug 05, 2020 |
Blackhawk01: Hey God!!!!
Nengiiiiiii! Why didn't you smile nauuuu  LOL |