InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 55 56 57 58 59 60 61 62 63 (of 90 pages)
Blind them with that glow baby girl!
|
See as Vee fine |
vizkiz:Wetin concern who fine with innocence? Una sef. |
galaxyball:No be say in her mind. Argue with your own hula hoop ![]() |
galaxyball:Who Erica oppress? Any girl tell you say she don come meet her to oppress her? |
See as Ozo waka pass that babe, I gbadun the guy unlooking game ![]() |
Fucknengi:I like as Ozo dey talk. |
Sylviaunusual:You no see as Erica sexy for that outfit? If na you, you no go meet her ask her how far? |
Amya:Your guy never chop food reach four times since that chicken bone injure am for throat . As far coco pops dey, e go dey alright.Na Prince, Neo and Eric hunger go woz for that house. |
Even clown face fit Laycon, see as the hair style flow. And person talk say the guy wowo this morning. |
Section1000:You never see 16-year old and 19-year old wey dey the same class? All these private school children, come Government school, na 14-year old and 20-year old be classmates ![]() |
Amya:I gree |
zicoraads:You don dey use your guy lines ![]() Amya and Wathoni share a lot in common; two of them like Kiddi pieces, and two of them dey beef Erica, so this your request fit sail sef. |
ItsCookie:I agree |
Hazardfan1:Hope say the amazing pussy go save her. |
vanvick247:I wan make everybody confuse again, make Ebuka give them wetin go make them think |
Hazardfan1:No be who dey go dem dey send? She send Kiddi the same message yesterday. I sure say she follow for who no dey wash pot after cooking. |
Just last week, people been dey complain say housemates dey do kumbaya. See this week, everywhere don scatter, toxicity full house. Last week na "Everybody has such good vibes" This week na "Some people bring bad vibes from their cliques, and mix up in the house" Last week na "Everyone is so amazing, I couldn't have asked for better housemates" This week na "I've learnt to not judge people before knowing them" There is more to come. These people go worst pass Pepper Dem housemates for toxicity. Bad vibes everywhere |
zicoraads:I no dey follow people wey get skoin skoin for head I dey crase on my own, I no need crase woman for my life abeg.....that is, if na woman, because since I dey internet na only teenage boys I don see wey dey use "E pain am!" |
MamBi:If say love never blind Neo, I reason say na him for scatter table, but as it stands, I no trust any of the other housemates |
Amya:I never quote you since I talk say I sabi you If you like drop Erica, na your headache, I no go even read am. I dey post Nengi, post Ka3na, Kiddi, Wathoni, consistency. No be just one person I wan die on top. The day wey you post of another person wey no be Erica, you fit get cardiac arrest. Enjoy. |
Borussia1:No stress He mean team for washing plate |
Laycon and Erica dey gist AMVCA and COVID matter, how kasala bust after that guy bring the virus come |
Wathoni dey do social distancing with Kiddi, hope say no be so she wan sleep for the guy bed this night. After all her mouth, she must mount this night. I hate unnecessary shalaye |
Dora "So Jacuzzi is coming on tonight?" Housemates in the garden, "Yes!" Make dem fail task first, make I see who go enter jacuzzi ![]() |
Make una look that artwork for kitchen, wey all those people dey wear facemask. Shey dem no resemble Pepper Dem housemates for una eye? |
Froshloaded:No be only ladies, even the guys. That issue wey Ozo go complain to Biggie for, if say na Teddy A or Ike, e for go meet Kiddi ask am why e dey always interrupt with him babe. Only time Biggie for here the gist, na when Ike don collect strike because e nearly comot guyman head. The whole house no dey confront Kiddi and the PJ lamba dey really confuse them. I no fit think of one of those Housemates wey go fit confront Kiddi |
Una don hear Laycon? He say he and Erica dey the same team, Team Layrica Una hear? Na Layrica be their team name, Endorsed by Laycon. |
Plenty people wey dey annoying for this house Praise dey high for the list. |
Kaisha fine today o She do make-up, she don dey resemble her Instagram pictures |
Ka3na say she no send marriage or man, she wan build empire, she don get her kids, so, she no need man Lucy ask how far cuddling? She say she no need cuddling when she get her children, and if she wan the stuff, she know as she go fit get am if na that one Lucy say she want man wey she go call her own, wey go come house come meet her and she go get right to ask why e late, if e late. Not just who she go dey collect from Ka3na say, "Whatever, enjoy your emotional depression" ![]() Mama D mama! |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 55 56 57 58 59 60 61 62 63 (of 90 pages)


Now they are talking.....