InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 58 59 60 61 62 63 64 65 66 (of 90 pages)
stevebond007:Biggie no gree give her chess board, so, we will never know. The problem with her game plan is, camera dey everywhere and viewers dey see her. So, anything she dey try pull, the camera go reveal am. If she fit deceive housemates, she no fit deceive viewers and her game go scatter outside house Person wey dey play chess suppose consider every factor and angle. If she dey play chess, she no sabi the game well. Wetin Nengi get na faux intelligence, real chess players go clock her game, best her. |
burner44:He say he been no go the normal auditions, because e no fit stress himself before, but say, as dem talk say the auditions na online this year, e jump on am. |
Neo don start again, e dey use confidence tell Kaisha and Kiddi say July don pass, and we dey August. Na so he and him friends buy IPhone 12 before. The guy suppose be politician, e sabi deceive people. |
Hatima:Na wetin dey give her morale. Foolish men like Tricky and Tochi Yesterday, Tochi dey hype her, tell her say, the way wey Ka3na dey behave, e dey expect that same behavior from her, not from Ka3na. These local fowls wey never near girls wey yellow reach Nengi before, go dey hype her, because dem dey look her like unicorn. Some Of their type dey this thread |
Venita:I hate dishonest people. Nothing dey vex me pass people wey no dey get constant truth. She go come enter Diary Room dey talk about Esther, no be only Esther, na Potiphar wife she be |
NwaAro:She told Ozo and Prince she has boyfriend, because she wan discharge them in a way wey, ma dem go think say dem dey leave her. She come tell Kiddi (the real person wey she wan hook), say the guy na ex. The Babe na manipulative liar. She wan make Kiddi know say she dey available, but to Prince and Ozo, she no dey available, but dem fit hang around. Nengi lies don plenty for that house. Last week, she tell Prince say she no dey use her sleep play, na wetin make she no dey club. When Last Nengi sleep early? Na she dey always close door for house, because she wan prowl, hook men, when the women don sleep. The girl way no pure and the game go backfire on her |
stevebond007:She is doing a good job of playing dumb. I never see her dey play her chess, but I don listen to her talk, and she has never held an intelligent conversation. She is either talking light skin privilege, or relationship. I no know as you dey reason intelligence, but na from conversations I dey use know intelligence and Nengi never get one intelligent conversation since she come this house, even while conversing with Ozo wey get brain. So, if you think she is intelligent, then, she must be pretending. So, she is either dumb or fake. |
Hintona:Na just hatred Nothing about man here, even Wathoni get the man pass her. Na just hatred. |
Laycon talk say if you like somebody, every action you make, should be geared towards protecting the person from disrespect See, e get some kain values wey money no go give you, na only sense. |
aroundnaija:As in. She just waka go meet Ozo, make Kiddi see yansh, because I no know why she dey insert herself for the guy life. My guy just wan relax from her matter, but she no gree remove herself from him matter. |
Maduawuchukwu:Toh, I no know wetin dey happen if na so. Maybe leave it first. |
Kyra1:People wey go vote am go vote am, e no need campaign. |
Maduawuchukwu:Wetin you dey type? Na "VOTE Kiddwaya"? Because if na another thing, e fit be say you dey send SMS, instead of voting. |
Maduawuchukwu:Wetin you dey use vote? Which SIM? |
Kiddwaya talking lightskin with Nengi, because the only discussions wey her brain fit manage na either lightskin or relationship. If say she no dey sacrifice her precious sleep every night, to prowl for male attention, maybe her brain for fit expand to accommodate other discussions. |
Blackhawk01:Na only this morning? |
Amya:Since you tell us say you dey support Kiddwaya, na Erica matter you dey always talk. No dey hide behind Kiddwaya, you must not support anybody, you fit just dey against person, as you dey do with Erica. Even if the babe stop dey talk to Kiddi, you go still dey insult her. You and that.igboman na the same behavior una dey show, only thing be say, thati.gboman dey remember to support one or two other people, when e dey insult Laycon. I been dey take your post serious before, but I don sabi where to categorise am now. |
Maureenah: homesteady:Una thank you ![]() I don see the Nengi puppy The guy na person wey dey like elevate girls wey dey yellow like Nengi. He dey worship them, na wetin I don detect. |
E be like na Tochi these babes been dey dissect, say e dey follow Nengi like puppy ![]() |
Abeg, anybody remember the guy wey talk say if you no cut onions, dem no go give you food? |
zicoraads:Na the agenda wey una don discuss from group chat be this? Now, dissemination don start. Anyway, thank God you say Derica. E no get who be Derica for Biggie house |
homesteady:Na carryover discussion from last night, she and Laycon been agree say Laycon go follow Praise talk about some behavior wey e dey exhibit with her, the vulgarity follow join for the behavior. She also talk say the guy dey cut her off when she dey talk, and Kiddi no dey do so, na Praise been shout for her last night, cut her off during that their rehearsal. She also talk say she and the person been fight last night and e continue till this morning, Erica don follow Kiddi talk this morning, so, I no even reason say dem fit dey fight, if dem dey talk. Besides, why Erica go meet Laycon to go talk to Kiddi? Kayode fit no sabi the exact guy, so, he just carry camera go the main guy, and e also fit be say, Kayode wan build narrative. Na Praise she dey talk of, no be Kiddie |
yunafa:She don talk am before, say cooking no be wetin she dey like do, and if you see as she dey so body when she dey fry things, you go know say she no sabi |
homesteady:Praise, not Kidd |
Beorn:I wish her well |
Froshloaded:I dey really reason how Lucy take pay, and why she dey sabotage her investment |
The obsession with getting booed up inthis house, is beyond me. Everybody wan dey relationship by force, yet, na only four housemates really dey relationship. If we add entanglements, na 10 people. So, 10 v 10, why dem dey talk am like say na only four people no get relationship? I want to understand |
Beorn:I don't need to. Nengi is either lying, or she has short term memory, but she don talk say she get boyfriend. I can never forget her conversation with Pronce. She said when she was coming, she did not tell the guy on time that she was coming for the show, because e no dey like that kain thing, she told him like a day or so, before dem isolate them for that hotel, so, they could not sort out the matter. Be like the girl don dey lie to Laycon, make e feel say she trust am. |
Beorn:Nengi don tell Ozo of her outside relationship, I think on Sunday night or so. Nengi don tell Prince too of her boyfriend outside, last week Wednesday, when dem been dey do get to know you. Dey try clear some things, before you come post, I know say una plenty wey no dey watch the show proper, but some of us dey watch am. The two both of them, know of the outside boyfriend. |
nazablossom:Na true |
Tochi dey tell Nengi say wetin Ka3na dey do, he been expect her to do am. Na this same guy assume say na Nengi dem dash land and diamond onto say, she yellow, and na yellow people dem dey dash that kain thing. He get proper Naija mentality. |
Munzy14:Make the bottom 4 just favor am |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 58 59 60 61 62 63 64 65 66 (of 90 pages)
. Maybe na Prince go fall mugu for her shenanigans, good thing Ozo is staying far far away from her... Ozo just focus on the prize you are here for (the MULLA), flirt with all the girls to catch your cruise jejely while playing the game smartly. That's why I'm feeling this Kidwayya guy, bobo no even send... he's just messing with these girls and having fun with no feelings attached.


