InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 57 58 59 60 61 62 63 64 65 (of 90 pages)
Like two of these three idiots go enter bottom 4. TolaniBaj say she fit shoot her shot at Eric, but she like Lilo too much. Second hand babes. |
Wathoni: "FYI, I can sleep on Kidd's bed today" Her friends, Trikky and TolaniBaj hail her. Same her: "Kiddi is not actually my spec....thee's a flow, but he's not my spec" God abeg! Give some people daughters shame. |
newguy1:Minus women. Ozo na diplomat. Diplomacy good, but not for every situation. E get where shalaye dey necessary, but the guy no strike me as who dey do shalaye |
Watho feel say person dey use her play game Wetin we no go hear for these streets? |
Erica say her mumsy make her cut her hair when she dey enter secondary school, because she say she been dey get plenty compliments and e go comot her mind from academics. Be like she and her mumsy no get good relationship like that. She say she been dey look forward to school, because na her friends for school become her family. E be like we plenty wey been dey use school run from house that year, to avoid bad energy. She still dey gist with Ozo |
bentenny:Na brave-hearted people fit do that kain thing, especially if the guy hold bar |
Say person mama die, or their papa die, or two of them don die, no mean say make dem dey show some kain behavior. Last year, person use say her mama die, wan kill the whole housemates for Big Brother house with bad vibes, thank God for iron and dragging of hair. One year later, she no dey remorseful, because people dey enable that behavior. E get one wey been come before her, wey use the same "my mama die when I small", wan finish omoluabi destiny for Biggie house, but e receive Miracle, comot from that bondage. This year again, dem don bring mama die, Papa die, so just dey do anyhow dey go, dey burn bridges, because na only you no get parents for this life. |
stanisbaratheon:Neither of them won that pageant Make of that information what you will ![]() |
Association of the booless, consoling themselves because nobody wants them This house and foolish relationship talk. We no go ever hear the end of am |
Wathoni: "Erica didn't really notice Kidd at first, I was the one that vibed with Kidd" A pained loser Erica don leave the Kidd for her, make she go collect. |
Lhimeet:The person wey born you do well I like as housemates no fit get emotions, dem no fit dey down because of events around them, all na strategy and acting for camera. Make people wey wan buy am, buy, and anybody wey no wan buy am, make e be strategy. For real life sef, people go dey ask for help, dem go say na plan, until dem die. |
ItsCookie:Good strategy on Week 2. She no get reason to dey sad, all her house friends dey loyal and loving. She just wan pull in fans. |
Erica say she no happy for the house, she dey miss her people, and the house dey bring her down, but she dey reason her career, and she need stay to push the career. Her voice dey like who wan cry. She said she will be grateful if dem call her on Sunday to go house. |
Erica say she no dey happy for house and she dey reason to leave. |
Erica follow Praise dey talk the matter wey she send Laycon go tell am. Praise come tell am, "Shey you sent Laycon to talk to me about it? He already spoke to me now" ![]() Anyway, dem don hug am out Laycon is RELIABLE |
Fucknengi:I fit no like person game, but I dey recognise potential. This world no go sweet if everybody dey nice and considerate, we need good people, bad people, neutral people. Same for Biggie house. |
Maduawuchukwu:You click 'send' for this message Then, some seconds later, dem go send you that message, the "30 naira" message. You type "1" for Accept, then, the vote go enter. If you never get that one about the thing costing you 30 naira, you never dey vote. |
Fucknengi:Nothing is impossible. Some people swear day CeeC no go enter Top 5, but she came second. Some people like sweet, unproblematic people, some people like Indaboski wey dey scatter everywhere, drama. Nengi dey bring drama. She join for talking points, that's Top 5 material, and depending on how the show progresses, she may come 3rd. |
Gmajor:Na market dem wan sell, anybody wey fall mugu, na dem sabi |
Fucknengi:Nengi na finalist, confirmed, anyhow wey she do. People can fall out of like with her, but e get who go still fall into like. Na sure finalist. |
Karlifate:The message na for all genders. E no get limitation. I been no look the (f) sef, I see stan, reason say na man |
earthsync:May notreduce, but it will control. If you wear waist trainer when eating, e go reduce the intake of your food, because e get where you go chop reach, e go dey uncomfortable. But, the name of the thing na GetFit, so, sense suppose tell the users say exercise dey involved. Na disciplined and dedicated people e good for, no be anyhow people. |
Fucknengi:Okay |
mediocre:LOL. |
Maduawuchukwu:Calm down first If Betway no send you message acknowledging the vote, e fit no dey enter. When you send the thing, message dey pop-up like this?6
|
DrakeBlend:Na most. People wey dey vote no dey post screenshots, I just dey laugh. Na Sunday go reveal everything |
homesteady:They knew since. Last week, she told Prince of her outside boyfriend, during get to know, she told housemates that she has boyfriend, but she no tell am on time say she dey come the house, because she been no wan vex am, so, she no know if e go dey unhappy when she return. I no understand why una dey lose track of this babe's conversations. On Sunday, she even tell Ozo of the boyfriend. Dem don know since. Make una dey try remember conversations, I been post this thing yesterday, but e be like you skip the page. I fit just screenshot this one for another person, because hand dey pain me to type the same thing. |
donstan18:She has been married before, e no work out. No dey look her like who never enter institution before, because e sure me die say you never marry too. She no dey find husband, she don pass that stage. |
Maduawuchukwu:If you don't get response, e fit no count. You never get response at all at all, or maybe na after 5 votes response go enter? |
MrEnigma007:Go tell the Erica hater that one. I have not manufactured any lie against Nengi, I have called her manipulative, calculating, dishonest, and her actions don show am. People never forget Dora, she dey okay. Nengi do her dirty too, so, no wahala |
Hatima:No even reason am. |
Maduawuchukwu:wait. You never use the SIM vote before? |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 57 58 59 60 61 62 63 64 65 (of 90 pages)

