InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 56 57 58 59 60 61 62 63 64 (of 90 pages)
I like this Ka3na and Lucy relationship. Even if Lucy no hold money, Ka3na fit set her up outside house |
WetSmoke:As in, correct gist. |
Ka3na say her oyibo husband na the best man she go meet for her entire life. Lucy say e go shock her. She come dey tell am say all her men na older men. She dey used to dating older white men, so the 64-year old no be her first oyibo. Oshe! Mama! |
Akorkor:Bear in mind, she been dey London for 11 months last year, so, 11 months of the 1 year + dem fit no dey together. E don dey resemble BrightO relationship The story no dey add up, but make we dey look am. |
Ujay01:I like the consistency. |
Kiddwaya dey gist them about how e no fit travel road trip again, and na wetin make am fly with him Private Jet. He dey tell them as Airport authorities been dey rake for am, say nobody dey allowed to fly. He mention him connect...Kayode come remove camera Nengi, Laycon, Tolanibaj follow for who dey listen to the gist By next week, we go hear this gist again |
I don see Laycon, una thank you. |
Iwaniewa:Another testimony. A nice girl. So, no be film she dey act for us |
I never see Laycon like one hour now. Abi e dey sleep? |
CallMeAthena:Erica get ulcer Nengi too get ulcer Erica psychologist Nengi too psychologist. Remain make dem share man |
Blackhawk01:LOL |
MamBi:I just change format. I no too dey crase for him house, but once I comot, if dem no tie me with rope, I never start ![]() For him mind now, him pikin don get sense |
Erica don go paint face, dey check herself out. E no easy to fine. Make she remind herself say she be correct babe |
Iwaniewa:oya come gist us Na so she dey smile everytime? |
MamBi:Some people mumsy dey send their children go some kain schools to humble them. Na so my papa carry me go one rugged government school that year, e think say e go change my life, but God pass am ![]() |
Iwaniewa:Maybe her mama choose command for that reason |
Owner of babe don show Tochi, you can leave your duty post |
Ebuka, I take God beg you, questions For Ozo: "You mentioned Prince and Kiddi's constant interruptions of your time with Nengi, what's that about?" For Kiddi "Kiddi, you seem to be a man of the ladies, from Wathoni, to Erica, and you also seem to enjoy your time with Nengi, what's all that about?" For Nengi "Who do you really like? Ozo, Prince, Kiddi, or your boyfriend at home?" Scatter table, abeg. |
Tochi use American accent dey gbagaun "She didn't knew me as someone...." |
She don mention this her boyfriend to Tochi again Another puppy wey she no like, she don trowey am on the altar of "I have a boyfriend for now", she no tell Kiddi this one |
Shey Tochi wan make Nengi set am up with her friend? He ask about one kf her girls, She say, "Most of my friends are dark-skinned, so, don't think she looks like me" She dey like who go dey keep mumu people like Wathoni as friends, people wey no fit "outshine" her, make she dey throw them to kpanla like Tochi, while she dey chop big fish |
All this time, some people don dey accuse Laycon of smoking weed. Hope say una don see self-confessed weed smoker. |
Fucknengi:Lol Na Lucy call Tochi her puppy |
Who dey vote for Tochi? |
Acidosis:Na wetin she say she wan do after the show, here na audition |
Nengi "I'm a beer kind of girl, I don't like champagne. I've had too much champagne" "I'm a London girl, When you go to London, everybody drinks beer, so, I don't know about all this champagne" |
Fucknengi:Tochi na her puppy |
Nengi: "Me I no sabi form o, forming na the last thing on my mond" |
Nengi don dey gist with her puppy. |
Wetin Dora talk about Erica? Why Dora think say na the talk make Erica comot? And why these people dey blow the thing out of proportion? Dem dey talk plenty talk, when she for fo meet the babe ask her, "Babe, wetin I talk offend you?" Erica been tell Praise say wetin e do yesterday offend her, yet, na this same guy dey discourage Dora from asking her if she been offend her. She go hear from Erica, if true true she offend her. |
Geezeem:Even if e enter bottom 4, him babes go save am. Na Lilo dey in danger, because e get people wey dey target the guy. |
Watho say she has been waiting to see Nengi's pick, but she no know yet. Make her madam pick man, then she fit manage the left overs with TolaniBaj and the other babes wey nobody send. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 56 57 58 59 60 61 62 63 64 (of 90 pages)
