TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:20pm On Jul 29, 2020 |
Kaisha computer brain strikes again |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:12pm On Jul 29, 2020 |
Liposure: nengi is just having fun. Its not what you think. Nothing like fun for her If e click, bye bye to Abuja helper. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:06pm On Jul 29, 2020 |
homesteady: To be fair to Nengi, it is Kidd that has been doing the chasing. Na equal things. He go do, she go do. To be fair. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:05pm On Jul 29, 2020 |
The way wey una dey remember unaselves for this thread ehn. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:03pm On Jul 29, 2020 |
ArchAnge1: Erica messed up, how will she take that guy serious
Wathoni, now nengi She no take am serious. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:03pm On Jul 29, 2020 |
Broobembem: Nengi Na attention seeker No be she call Kiddi, na him waka go meet her How she take be attention seeker? |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:55pm On Jul 29, 2020 |
Broobembem: Eric feeding Vee.
I hope Lilo won't cry Kiddi feeding Nengi. I hope Ozo no go cry |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:53pm On Jul 29, 2020 |
Na Dora dey flex this house pass.
Enjoyment officer.
She no dey find entanglement, she no dey follow man, she just wan laugh. Correct babe |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:50pm On Jul 29, 2020 |
Amya: Staying my lane jeje, minding my business. Hardly quote people sef. But I just say something and they'll want to die ontop my mentions. They'll be in perpetual tears be that. Me I don't send. I'll keep airing my opinions. If it pains you, hug transformer.
I've listed my faves, all 4 of them. They've all received thorough bashing here but you won't find me there feeling pains and trying to defend because I believe everyone is entitled to their opinions. I say my own and they start to feel uncomfortable.
If they think I really care about the what their faceless selves think about me, they must be sleeping on a bicycle.
If I write my opinion about a HM, write yours and keep it moving.. No be anybody dey buy data for me. You no send, na him you write all this epistle |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:34pm On Jul 29, 2020 |
Dem don fine Lilo for audio infringements, her betway wallet go hear am. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:17pm On Jul 29, 2020 |
Ozo na coward |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:53pm On Jul 29, 2020 |
Dozo!
|
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:49pm On Jul 29, 2020 |
MamBi: Tricky said his own is from Unilag....
Then Laycon said winter/autumn lines...
I almost fell off my chair with laughter...  Correct cruise guys  |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:30pm On Jul 29, 2020*. Modified: 2:03pm On Jul 29, 2020 |
Kiddi and Erica dey talk about clothes from fashion designers, Erica tell am say she wear the summer collection of one designer, Kiddi come ask her say she no like the winter collection?
Na so Trikky ask Laycon, "Guy, which collection you dey buy?" Laycon come answer, "Yaba collection" na so two of them begin dey laugh, Tricky come talk, "Because I no fit relate" |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:17pm On Jul 29, 2020 |
DownChelsea: Fun facts OPINION..
1. Eric is always either with Lilo or eating something.
2. Laycon is the hardest housemate to hate on (by other housemates)
3. Tochi already has a feeling, that he's going home.
4. Nengi is beginning to realize that her games of pretence may not favour her.
5. Kidd is jealous of Ozo and will do anything to ensure that Ozo and Nengi never spend time together.
6. Trickytee is ho-rny
7. Wathoni and Nengi will become worst enemies in a few days time. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:36pm On Jul 29, 2020 |
Kiddi wear peach cloth, with red shoe.
Be like Ozo don dey give am fashion tips |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:35pm On Jul 29, 2020 |
Wathoni wan enter relationship by force for that house.
She dey reason the guys wey she fit follow for house, now wey Kiddi don show her red.
Anyway, she say she dey miss her pikin, make una try send her go house, make she see the pikin |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:24am On Jul 29, 2020 |
NegroAcheiver: Omo this laycon v waya waya case na just clear instance of money v street.You guys saying Erica just sees laycon as a friend will be dumbfounded when he gets the cookie.When talent gets lazy hardwork beats it. Laycon no go get any cookie, even Waya fit no get any cookie. I no know wetin some of una dey look women as for this thread. Any small thing "this guy will get the cookie, that guy will get the cookie", una think say girls no dey wey just wan catch cruise? Enjoy the company, laugh, have fun. No be everything go end for cookie. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:56am On Jul 29, 2020 |
stephleena: Chile..
from wathoni to Nengi now, don't y'all get tired of being unsolicited relationship expert..
I laugh in Nengi isn't giving Kidwayya Attention, you mean an attention seeking LovePeddler, who flings herself at every male housemates or objects available..
the same Nengi, who said if she had known she'd had flown with Kidwayya to Abuja.. ?
the same Nengi, that sings of Kidwayya praises at all times?
humour me pls.. I've told y'all to stop taking Kidwayya cruise to heart, y'all started with wathoni till he cleared your doubts with different type of kisses last night..
and in case y'all missed, kidrica conversation this morning, they've agreed not to rush anything yet.enjoy each other's company, let the chemistry flow, and if Erica is willing to take it further then it's fine..
so just chill, he's a player yen yen. every player get their bustop..he catches cruise but his heart still wants what it wants. Nengi dey give Kiddi attention steady, just this night sef, for Ozo front, she dey lowkey flirt with am. Sunday night too, when Kiddi dey promise am diamonds from Botswana, she dey flirt. Nengi dey on permanent flirt mode, especially for night, when she go dey wear all those her bumshorts wey be like pant, dey parade Anybody wey say Nengi no dey reciprocate Kiddie flirting, either no dey watch the show, or dey do selective watching, but Nengi dey target Kiddi heavy and actively. She no just dey do am as brazenly as Wathoni, because she get small sense, unlike Watho. She wan make Kiddi move on her first. Make she try her luck, shame no dey finish to share. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:51am On Jul 29, 2020 |
Everybody just want catch highlights this night.
If not, why some of these people dey here sef? |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:47am On Jul 29, 2020 |
Amya: This is the most boring thing I've watched all day.
Had to change my channel. Go sleep. Make we wey like am, enjoy |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:45am On Jul 29, 2020 |
Amya: So It's Laycon that Erica wants to to use to make Kidd jealous? Laycon of all people. All these will definitely backfire on her. You watch. E no fit backfire. Worst comes to worst, Kiddi go move on. You go happy Erica cruise continue. Watch drama and be entertained. Una too dey take things serious, na reality show, na drama carry us come. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:43am On Jul 29, 2020*. Modified: 1:24am On Jul 29, 2020 |
See as these people dey give us content this night.
Full drama, staring:
Laycon Husband
Erica- Wife
Kiddi- Side nigga
Prince - Erica's lawyer
Tricky- Laycon's lawyer
Nengi- Laycon's replacement wife
Praise- Judge |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:36am On Jul 29, 2020 |
Wathoni, Bright, Prince and Tochi det watch film, between Laycon and Erica.
Dem dey draw up divorce proceedings.
Kidd no like the game again. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:34am On Jul 29, 2020 |
Lhimeet: Did Erica just call herself bad biiitttch?  I'm THAT biiitchh |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:33am On Jul 29, 2020 |
Beorn: I'm not against Kiddywaya's flirting o. LOL. I'm just here to remind Kiddrica's shippers to wake up before it's too late.
P.S Erica hasn't said quarter of what Kidd had said to other girls. Praise said those things and Erica laughed if off. I don't see how Erica and Laycon has been flirting. Everyone including Kidd knows of their friendship. Erica does her play in Kidd's front, while Kidd says all those erotic stuffs behind Erica's back. Facts!! Kidd na talk guy, Erica na action babe. Everything wey Kiddie don talk, e no dey do am for Erica front. She never hear anything wey e dey do with other babes, but for him front, Laycon and Praiz wine for her. Action dey pain guys pass, because e mean say the babe no rate you like that. If the thing crash, na based on mutual understanding. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:23am On Jul 29, 2020 |
Beorn: Kidd has been flirting with Nengi all week long, it's just because Nengi is not reciprocating, that shît hasn't hit the fan. From saying he'd sleep in her bed tonight to telling her few minutes ago that she'd come and remove the pepper in his mouth with her lips.
Kiddrica ships, it'll end in premium tears outside the house.  Kidd flirted with Wathoni, she reciprocate finish, na premium tears e end for. Erica has been flirting with Laycon and Praise the whole day, sometimes in front of Kidd sef, I never see you drop any correct take. Kidd dey barely even look Nengi anywhere Erica dey, but for Kidd front, Erica dey flaunt ring wey Laycon give am since morning. Praise don dey joke say he and Kidd na Erica side chicks, and Laycon na the husband, in front of Kidd and Erica, she never talk anything. Kidd get license to flirt with anybody, e don try for today alone. Na the same babe tell am this morning say anything wey dem dey do, kiss no go dey involved for the house. E be like you no dey follow us watch her since morning BTW, Nengi has been reciprocating, this afternoon, she been dey whine bumbum for Kidd, waka pass am, e look am, triwey face, she waka back, tickle him ear, e look am trowey face again. I no get work, I dey watch this show the whole day, so, I dey see things |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:08am On Jul 29, 2020 |
Who cook this food?
See as Tochi dey sweat, dey chop food. E be like pepper dey |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:02am On Jul 29, 2020 |
ArchAngel, wetin happen?
|
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:48pm On Jul 28, 2020 |
Dansuqi: That's not laycon bed oh yeah, I been click am, later |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:47pm On Jul 28, 2020 |
Bookworm001: I just remembered Erica is an actress oooo hope all this things she is doing is not acting  I don see some videos of her with her friends, as she dey do for house, na so she dey do for those videos If na personality, na so her personality dey. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:46pm On Jul 28, 2020 |
See as Ozo don regain him complexion since he eject himself from bad energy
Kiddi, Laycon, Ozo, Erica, Dora and Praise don give me better laugh this night |