TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:33pm On Jul 28, 2020 |
Cruise everywhere this night.
I no even know where my laugh wan start from |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:27pm On Jul 28, 2020 |
Erica with her men
|
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:25pm On Jul 28, 2020 |
Praise and Laycon no get sense  Praise dey whine for Erica on top bed, na so Laycon shout, "Forget all these things, I can do it" he sef jump on top bed dey whine  I don laugh tire |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:18pm On Jul 28, 2020 |
Erica dey lie down for Laycon bed. The guy just siddon for the next bed, dey gist with her. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:14pm On Jul 28, 2020 |
Broobembem: Are they having issues? Dem see each other, ignore each other, so, yes, issue dey |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:08pm On Jul 28, 2020 |
Vee and Lilo having heart to heart.
Brethren, e be like all the ships go crash this week. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:46pm On Jul 28, 2020 |
Eeghe: She is from Kenya and used to call herself “Annabanana”. I even remember her tribe  She would say “obviously” about 100 times a day  And yes, there is a resemblance, they are both busty, but the big boobs are shaped differently Annabelle wey Melvin kiss for Truth or Dare that year, her nips just stand. Memories  |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:44pm On Jul 28, 2020 |
NENGIsmells: erica my erica , my prick wan scatter my jeans na Kaisha be that You don dey shout Erica since morning, yet, you no even sabi the girl |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:41pm On Jul 28, 2020 |
InSanety: This Erica wicked.
She siddon for Praise lap, dey follow Kiddi gist, Laycon dey the other side.
Billionaire pikin eye don see something for Naija girl hand.
Wicked girl Na even Laycon get the jacket wey she dey wear. I dey hear of babes like this, but I never see them in action. Lady Don Dada |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:32pm On Jul 28, 2020 |
See Lilo wey just cry for us finish, don go siddon for man lap. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:31pm On Jul 28, 2020 |
This Erica wicked.
She siddon for Praise lap, dey follow Kiddi gist, Laycon dey the other side.
Billionaire pikin eye don see something for Naija girl hand.
Wicked girl |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:27pm On Jul 28, 2020 |
Laycon and Erica, since morning.
This love is unbreakable |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:25pm On Jul 28, 2020 |
I like as Dora dey always give Ozo hard facts as e dey go.
She dey observe the guy well.
Na Dora Ozo suppose dey follow, she sabi the guy too well |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:24pm On Jul 28, 2020 |
zicoraads: That thing still dey work?
I am not sure it does sef.
I like the way you type. E be like you na law-abiding citizen, na wetin make you no believe am. Thank you, I appreciate you sef |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:22pm On Jul 28, 2020 |
Archangel. Your prayers and fasting don work.
E be like your guy don comot hand from Nengi matter.
E dey tell Dora say e don eject himself from the equation with Nengi and Prince.
Dora tell am say, na the same equation she and Nengi been dey with am, and now, he wan comot himself from the equation with Prince
Their discussions dey always sweet me. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:15pm On Jul 28, 2020 |
Liposure: which of them be him babe. The one wey yellow well well |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:14pm On Jul 28, 2020 |
zicoraads: What is your other moniker?
You come across as someone I know. Dem don ban am since like two years now, like 100 years ban, and I move on. Make nobody ban this one too, abeg. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:08pm On Jul 28, 2020 |
Ozo don come distract Laycon and Erica gamez to tell them make them come garden because "people are there"
Ozo waka pass him babe, to go tell another babe to come garden.
I no just understand this guy. These days, I just dey monitor their talk for any sign of coding. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:34pm On Jul 28, 2020 |
Nengi:
"Kidd is a cool guy though"
Tricky agree....
She adds; "And you know, he's from a really rich family"
Tolanibaj says "Yeah, people don't really know"
Of all the good things wey this babe suppose talk of Kidd, na rich home she see. E get day wey Nengi no go dey dance around Kidd matter?
This PJ gist don scatter her head. I no wan use the G word take describe her. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:55pm On Jul 28, 2020 |
Liric ship
7 days old and already e don capsize |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:38pm On Jul 28, 2020 |
Reussite: Threebear!!!!! welcome bk  Hmm but this current standing of HMs with Kiddwaya & Ozo above Nengi is unbelievable.  You see that Kiddwaya own, I believe am. I hear say him people don gather reach 3000 sim cards for voting, as at last week, and dem get enough money, plus all him rich paddy wey go dey organise for am. Ozo people dey try well well too, dem dey organise their voting and him people hold bar small, e get some strong guys wey dey organise for am, dem TweetOracle them. Wetin I expect, na for Ozo to just edge Kiddi small at the end of voting, but Nengi go remain where she dey. |
Travel › Re: Kurudu-Nasarawa Bridge Along Abaji-Nasarawa Highway Collapses by InSanety: 5:58pm On Jul 28, 2020 |
sandyd: In FCT !! Work of a shady contractor. No be FCT. That Kurudu is in Nasarawa. You no read the thing ni? |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:03pm On Jul 28, 2020 |
Biggie no wan make Kiddie use arms seduce una
Those him arms join for campaigning |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:00pm On Jul 28, 2020 |
DownChelsea: Whatever happens, I want to see Laycon, Ozo and Nengi as top 3. Lol, prepare for disappointment with at least one of those three |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 4:53pm On Jul 28, 2020 |
At least Kaisha happy today |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 4:17pm On Jul 28, 2020 |
Na everybody wan dey cry these days |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 4:01pm On Jul 28, 2020 |
Beorn: The permutations I used were 3 guys not Eric and 2 girls that you used.
Plus, the guys looking out for each other is not in doubt and I never brought it up, I was saying Eric is not that loved amongst the LADIES whose votes would likely decide in the scenario I used. Okay I no fit see three guys for bottom sha At worst two guys and a girl |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:56pm On Jul 28, 2020 |
MamBi: Prince go suffer for this DHoH position that Lucy gave him...
Lucy is going around asking others for what role they are going to play in the up-coming task. Prince is playing Ludo with others.
Mid play, Lucy asks Prince to finish the info gathering that she was doing... 
Meanwhile, Kayode switches to a sombre Ozo and Eric having a tete a tete...
Ozo says personal happiness is key so if one is not happy then it is not worth it...
Eric has this kind flat hard expression on his face
After some minutes, Ozo continues and tells Eric that Eric should not make any decision until he has spoken to "Lilo?"...
Does anybody know what is happening between Lirica? na Ka3na and her bumbum during Truth or Dare last night. She use bumbum rock Eric, Lilo been expect make Eric drink, instead of doing the dare, instead Eric dey tell Ka3 make she no fear to komole |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:41pm On Jul 28, 2020 |
HoH asking housemates wetin dem ho like dey involved in for the weekly task
Prince say Dancing, Gymnastics and Band leader.
Kaisha say cheer-leading
Tochi say Gymnastics |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:39pm On Jul 28, 2020 |
Beorn: The ladies don't like him I THINK. I don't feel he's very close to the guys either because he's always with Lilo. In a situation where HMs are to choose from a pool of Trikkytee, Tochi abd Eric, Eric might not make it. Trikkytee is loved by almost all HMs, while Tochi comes close.
It's an opinion not a fact sha. So, I'm likely to be wrong Those guys dey look out for each other very well. He vibes with enough of them, to get their votes. If na Eric and maybe Wathoni, Ka3na or Kaisha, Eric go dey okay. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:32pm On Jul 28, 2020 |
Erica don play finish, return to base.
|
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:28pm On Jul 28, 2020 |
Other people dey do design fliers, Kiddi people use full cartoon skit take campaign for am
There is money and there is money.
Levels
|