InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 62 63 64 65 66 67 68 69 70 (of 90 pages)
igasiboy98:And Erica don tell Praise before, say she go like born son for am, named Nonso. Same way Kidd tell Wathoni say she go born daughter name Leila Na Kidd own we go dey see, but world people wan convince us say na the guy dey play the babe. All these things na gender inequality; when man dey do something, e be player, but when woman dey do am, she no fit be player. Dem don convince us say the guy go use am chop, but the babe no fit chop the guy. Na when guys dey form say na dem bad pass, na im girls dey chop them |
CallMeAthena:She sabi work. You no go like learn? |
If say na Kiddi dey collect cuddle, streets for bloody Dem for dey accuse the guy of playing her, say e no serious, e just want chop kpekus See Erica dey collect cuddle now, Silence 'pon the streets |
Make una see una babe Playa, playa
|
See mumu play wey Erica dey play with Laycon Tomorrow, when Kiddie put hand for person leg, una go wan kill am |
Dem off music Tochi sit up come talk "People don sleep o" ![]() |
Na when Biggie send Laycon and Erica go pick beans, na im dem go know say dem no suppose dey gist during yoga sessions |
Froshloaded:Those votes na minus, dem no go count them. If you no type "VOTE Laycon", your vote no count.The real vote no dey show for strap Anything wey you see for SMS strapline don waste. Deloitte no go count am |
Laycon and Erica no send this yoga session Two of them just dey gist for their corner |
MamBi:I'm Catholic, I sabi the music wella |
homesteady:they are me, I am them |
MamBi:It does o That type wey dem dey play for Catholic Church when they need you to think of how you have sinned and fallen short of His Glory |
MamBi:She don enter weeping so |
CallMeAthena:Why do you understand Ka3na's tears, but not Lucy's own? Lucy wey don suffer, sell bole, buy oven instead of microwave, get unsupportive family. E reach to cry |
MamBi: ![]() Dora sef dey cry |
Lucy sef dey cry Na the angry housemates dey cry. They need find inner peace. People wey get plenty anger, na bitterness and toxicity dey full them. Dem gats release all that anger. Meanwhile Laycon and Erica dey follow Vee gist, dey laugh sef. Happy people, dem no get stress Prince : "You're supposed to be finding your inner peace, not talking" Layrica, collect your sub |
Ka3ma dey cry She dey reason the strong thing wey she do that oyibo, dey find her inner self. Hopefully, she no go dey shout Boss Lady, after her soul searching |
Erica still dey wear Laycon ring ![]() |
E get wetin Prince no sabi do? |
Prince na nice guy, e dey cuddle everybody, Tolani testify |
Noises don dey happen for Liric room Dem say Lilo dey loud, but Vee dey quiet |
Dora say the other room na dormitory It is not normal noise happening, it is a different kind of noise So, things don dey shele and Kayode no dey show us all this time? |
Una don forget thread talk, dey yarn another thing |
Laycon dey follow Erica gist, Kidd don enter the chat. Dem dey ask Laycon if e wan collect Kidd girl ![]()
|
Neo "Manner of approach dey serious. If you get matter with person, no bring am come outside, turn am to general house problem. Go meet them, sort am between una selves, because e get wetin you go talk ofpeople, all of us go come dey look the person with one kain eye." This one na Lucy sub |
Prince "There is nothing wrong with having clique. It is normal for people to have those they click with, but it doesn't mean you should keep enmity with others" On Sunday, people go realise the importance of clique and vibinf with people. Lucy and Ka3na eye go clear |
fitzmayowa:LOL Another sweet part. |
Make una go learn how to cook o, make nobody dey insult you on top food. |
Tochi dey talk as e dey do am E say dem dey force people to cook, dey threaten them with no food if dem no cook, but e get some people wey dey special. Vee Say if you fit help, help |
Borussia1:"We" "They" LOL |
Na Tochi make the most sense so far, because e throw correct shots and e no try use diplomacy E talk am as e do am. |
Dannyxy:Dem bring am come from Twitter And dem dey bring am come this thread every year It's not an all-time low, na regular low for here. Every season, tribalism card. Last year na "Yoruba people no dey win this show?", " Why only Igbo people?" This year na, "Yoruba people dey push Laycon because na Yoruba e be" Before the show start, on Twitter person even talk, "The best housemates have been Yoruba, but those people of hate, always win" See, tribalism go always dey for this country. Just like race go always be topic for Nigeria, the only thing be say, make people dey ignore am, instead of feeding it. Still, say you ignore, no mean say another person go ignore Best we can do, is keep it minimal, but dem go still bring am up. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 62 63 64 65 66 67 68 69 70 (of 90 pages)


