InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 63 64 65 66 67 68 69 70 71 (of 90 pages)
Samueltemi337:Na only Laycon you dey read But we dey talk Erica and Nengi very well here, even Ozo Dey follow thread. |
Prince dey ask for basic cleanliness E say "Everybody is not out to get you. Watch your mannerism and the way you communicate with others...." |
Laycon spitting facts "You have to sacrifice your comfort, to live well with others" The only thing wey I no too agree na when e talk "if you are 100 in your house, reduce yourself to 20".... E no dey possible. Anybody wey be 100 for house, the best they can reduce to na 60 or 50, anything less, na pretense. |
Wathoni speech, she mention as housemates dey bully Kaisha Thank you for noticing. |
Tochi spitting facts. "Sometimes, once food don ready, I dey fear to bring plate, make dem no insult me" "Some people like some people over others, I no fit deceive myself say everybody like everybody equally, some people get who dem prefer, and it's not bad, e dey okay, but make we no dey pretend say, everybody like everybody same way" "Some people work for this house, na to nack two people head. Dem go talk one thing for one side, talk another thing for another side. Dem go do like say dem no dey do anything, but dem dey jam head well" (na Bright get this sub?) Vote Tochi |
Gmajor:Anybody that entertains me on a show, deserves to win, nobody is a wasted opportunity. Not all winners, must be entertainers, if not, make other people from other walks of life no even bother come BBN. I sure say you no be entertainer, if you go the show, you go happy if dem ignore you, dey find who dey industry? The show is for everybody, if dem bring entertainer wey no dey entertain, I go even vote engineer, anything wey he use money do after the show, I wish am well. Entertainment industry na very toxic industry, and some people no fit sacrifice their peace of mind for anything The way wey some people dey go ex-housemates IG to insult them, nobody fit go Miracle page drop rubbish, because e no dey even post there. Stop delegating potential winners, na nonsense talk be that. Wetin suppose concern us na housemates inside the house, anything outside the house, na asking for more than your money's worth- greed by a lot of una. Nobody be circus clown, wey go dey entertain you for long time. |
Kiddwaya say if dem no wan chop food, make dem chop cereal, Apple, chinchin, groundnut "We've all eaten chicken, plantain, rice before..." The guy no understand why these people dey hustle food like who never chop for their lives |
Vee talk some better things But essentially, she dey do "kumbaya" |
Praise don talk pass time slot E dey yarn dust now |
Praise don complain say e no like the play of "no meat for you, no food for you" E say e no dey hard am to cry once e vex I agree, me sef I hate that neat joke |
Very intelligent words from Ozo this morning If Neo no remind us say dem be 50 for their family, e never start talk. Dem still dey gree Eric talk for that table? |
galaxyball:He should deflect. The fact that they bring up his likeness for Erica so much, means, it is an actual issue and if it is going to put a target on her back, he should deflect. When they kept prodding Ozo with Nengi, he was also deflecting, just so he wouldn't hurt Dora or Nengi's feelings. Na wetin make una call that one player too that time. Una just want tag person "player" this season. As Ozo own no work out, Kiddi na the next person to be tagged 'player'. E no get one day, wey Erica don claim the guy with her full chest, so, no lele. Anyway, na all of us go dey watch. Some go dey enjoy the ship, some go dey look forward to 'true colors'. All na for entertainment PS: By this time last season, Ike been dey spend time with Ella, and some other babes, Mercy been dey hug Gedoni, dey twerk for Tuoyo. For context. Merike ship never sail at this time. |
Bretheren, I bring to you, an uncommon occurrence I want change mouth Yesterday, I talk say Ozo no dey go BBN guys meeting, but e be like the guy dey go, e no just dey concentrate for the entire meeting In another show of Bro Code-ing, Ozo take style sign Kidd to move go another chair, when aunty Nengi just dey trowey leg left and right, for the guy front, and Kidd decode, come shift.
I no go lie you, as far as the Ultimate Bro Sign Language dey, the guys for this year, get PHD for am. I dey very impressed with their decoding level. I like as dem dey so attuned to each other, wey dem go dey communicate, and most viewers no go notice, talk less the girls. These guys na correct G's in their own right. |
galaxyball:There is really no other way to say it. Do you like Erica? Yes Wetin una think? No be like e like the babe? E no get context, you can like ten people in ten different ways. Some viewers like up to 6 housemates, but na only one dem go vote for if e reach to collect money. Kidd can like the whole house, but dem ask the guy, "Who you wan date for house?" E don show us. Na the koko be that You fit like Ozo, Erica, Dora, Laycon, Prince, Neo, but if dem ask you, "Who will you vote, to win the money?" You fit choose Laycon. E mean say you no like the others? Na so una do Ike last year, when Mercy go rock Tuoyo for party finish, come follow the guy lie down for bed, una swear say outside house, she and am no go get talk. Yet, one year later, see where dem dey. |
I think the UK definition of "I like you" is different from the Nigerian definition of "I like you" In UK, Like is Like, Like is, "I enjoy your company" In Nigeria, Like is "I want to date you, and possibly marry you" Na wetin make when Kiddie talk "I like you", people go dey exaggerate the thing, like say e confess love to anybody. Meanwhile, for the guy mind, na just normal like. Na the same issue Ike been get last year; he dey talk things like say na America e still dey, without knowing that for Naija, the thing fit get bigger meaning than wetin e intend. |
Baba4kinatu:Or Kiddi, anyone wey click. |
Kiddwaya "I like Nengi, I like girls that are direct, and she's direct, so, I like that." At least this one dey maintain some stand. He like Wathoni because she dey direct. E no know say no be so Naija babes dey, Naija babes go give you signal until trafficator spoil. E like direct girls, like Nengi |
Nengi: "There are some things I can't do when they ask me, like all this, show someone your pant...." Chai! A friend She no fit show pant, but she fit set bumbum for Prince, fake decency. |
Eric sleeping on a bed alone for the first time in what feel like weeks Wetin do this ship?
|
Baba4kinatu:E be like e provoke the gods |
danie09:
|
ArchAngeI:Abeg, face your Ozo that is in Nengi's bondage. You have bigger problems than Erica right now |
Relevant question
|
Amya:Even me sef, the gist don tire me |
Even Kiki Osibanjo dey ship
|
Biggie dey conduct mental test before e bring people come this house? |
Laycon just dey waste English on this girl. |
Laycon ask Kaisha "Do you even remember that we were in the same group for facemask?" Laycon no trust this babe mental state, e reach to ask |
See final intervention for this babe, she still no gree Kaisha is doing this thing intentionally, she just don tire for that house, and she no wan do voluntary exit, so, she wan irritate housemates and viewers, enough to just go home. |
Housemates gather dey try ask Kaisha if she get mental problem from house. |
Oh, Erica never go inside, she siddon for that garden bed with Laycon and Kidd |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 63 64 65 66 67 68 69 70 71 (of 90 pages)
