InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 67 68 69 70 71 72 73 74 75 (of 90 pages)
Broobembem:Simping na the act of being sympathetic to women, and promising them things, with the hope of getting favors from them. Some simping dey bring returns. Kiddwaya been dey simp. E go come dey blush, dey smile mumu smile on top am. |
So, Kiddwaya been apologise to Erica because e no help her during that game, he talk say e go make am up to her outside the house, she say no, make e do am inside house. He come gree, say e go cook for her. Una no see when Kiddi dey simp, but if na Laycon now, we go get three versions of how e dey simp. Selective reporting ![]() |
Sadly, viewers dey more entertained by entanglements than actual ships this year. Confuse us, scatter the place, jump around. Na wetin we want see. Too bad for all these ships, e fit be say na only 2 out of the 4 of them go reach Top 10 finally. |
nazablossom:Make she die because pesin sly her? |
Laslas na only Neo and Vee dey build deep, meaningful connection for that house. I just hope say e dey pure on both sides |
Munzy14:Everybody be villain, depending on who dey tell story. No reason am. Erica dey play her own game, she dey game the guys on the low too, but some kain agendas get as dem be. |
Munzy14:She no call am unreliable, na the guy talk "You think I'm unreliable" She never talk to Laycon anyhow at any point. I tire sef Anyway, e good make Erica turn villain for some people too. Dem talk pass this one for Miracle. |
nazablossom:Around that 1AM time, so, early this morning |
Amya:Too early to even start making right predictions, because everybody still dey unravel. So your 'correct predictions' fit change by the end of this week. All na for the good of the game though, all forms of unraveling dey good |
Amya:Na Laycon talk 'unreliable' As far as Erica matter dey concerned, any narrative wey you get no go pure. Same way Froshloaded no fit get pure narrative for Wathoni And ArchAngel no fit get pure narrative for Kidd Na only you dey make her talk sound bad, nobody else, which means, you see wetin you wan see, but as you talk am, no be so e be |
Amya:I'm watching, dem still dey laugh dey talk am This you talk say "she was pissed, she did it on purpose, she's wicked" No be so I read am. She fit dey offended, but the malice no dey involved na my point. You dey weave malice enter, but na you get your narrative |
Erica don go confront Laycon for not having her back at the game, and helping her do the dinner back Laycon say make she no vex, say na play, make she no get am for mind say e no dey reliable, because e get her back anyhow. Dem dey laugh, dey talk the thing. Correct relationship |
Amya:Na play o. Make una no read am like say e serious |
E be like Praise talk something wey no gbam, but I no wan encourage some fanbases for here. Anyway, Erica say Laycon ma her bestie |
MamBi:Na Dora market wey Tolani go buy Dem just want dey do Kaishaanyhow, because Tolani no get talk for the matter. She just insert herself |
thatigboman:Kaisha dey like all those girl for school wey everybody wan shine on top their head, even though dem no dey gree. |
Kaisha get fight for that house. She must not leave if she never unleash. |
Kaisha and Tolanibaj don dey quarrel small Tolani promise Kaisha say she go check am for that house |
See as una just dey insult each other for this place Na una dem for carry go BBN house, make we dey see savagery everyday |
This Wathoni hairstyle no favor am at all. |
MizzD:e go be 2go babe that year |
Kidd go play this game, and una no fit do am anything. Na wetin make I like the game pass, because public outrage no go fit affect am. The kain money wey dem don set for the guy, if nothing else, e go reach am for Top 5, before public outrage fit shake am. So, make peasants just dey shout, dey disturb, but dem gats still dey gather their money small small for their own favs, because Kiddi money don set. No weapon fashioned against the guy go prosper. |
Tatiana4u:Kidd no successfully grab Erica breast, and nothing like 'unapologetically', because he apologised. You dey talk am like say e cup the full breast, and she laugh. Him hand never reach destination, when she push am comot, e jsut dey slide for middle. Una dey talk 'grab', you know wetin 'grab' be? I for post example, but the images dey very pornographic, so, dem fit ban me if i post am here ![]() no be so e happen. Make una no dey change narrative because you wan hail your guy. Hail am with facts, not exaggerations. Na all this kain talk make dem dey discuss the matter for radio this morning. |
MamBi:nope. she don share bed with three different people in three nights so far. |
ntyce:Because he said so. You no read the rubbish wey e write to 'celebrate' her, some time back. Even the guy know say e mess up multiple times. |
Medunah:Yeah. They're not cuddling, because dem dey wrapped in two different blankets. she decided to sleep on Prince's bed tonight, na wetin make Kidd tell Wathoni say him bed dey free. The babe sly am. |
See Erica on top Prince bed. Wicked girl |
Froshloaded:Thank God for her. the boyfriend na gbef! Serial cheater, very good as she dump am |
Dem don dey go sleep. This week go hot. Once dem know say eviction na free for all, these people go unleash. Dem go wan form the most entertaining, the hustle for votes will be real. I cannot wait |
so much anger 'pon the thread ![]() Today go make sense die. So many tables to scatter, so many doubts to clear. |
So, Nengi know all these things, na im, she no leave Ozo for Dora? ![]() |
Wathoni say she still really like the guy wey she suppose get outside, but the guy been dey give her single vibes. Say, before the whole lockdown thing, the guy dey act like say she just dey good for sex. If she gauge herself well, she go know why the guy no rate her. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 67 68 69 70 71 72 73 74 75 (of 90 pages)


Let her go and call kidd unreliable na.