InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 65 66 67 68 69 70 71 72 73 (of 90 pages)
Neo voice don return Oracle don show |
MamBi:Long Live Soma wey use teeth comot bra These people no dey creative at all I remember BBA The Chase, when Feza lick Melvin from head to toe, intense stuff, no be mumu kiss everytime. |
Dansuqi:How many others dem dey "let" win for Nigerian elections? This na the only thing wey merit dey for this country, na who people vote go win. Una no fit do rotation for the main thing, una wan dey do rotation for BBN Na this kain rubbish talk spoil BBA |
Make pesin tell Erica say her shift don finish, make she free Kiddi go him second babe |
Eric and Wathoni are not working for these votes Vibeless souls Eric just siddon, dey reason him life. E be like e don occur to am say ship no go save am. He dey always talk like he don sabi game finish, this twist reset him brain and e never recover |
Laycon don turn choir master, collect work from Praise ![]() This guy love music die. The way he beams when he hears music ehn, na him true love be that. I understand |
As Erica dey busy, Laycon don come siddon between Kiddie and Wathoni. His sister's keeper ![]() Make e balance well for there, pepper this babe wey don take am do rubbish |
Sambaby7640:LOL Na wetin you for talk be this, instead of telling me "BrightO and Wathoni cannot go home" Dem no get enough alliance for that house to save them, if dem enter bottom 4 with the likes of Tochi and Eric |
Sambaby7640:I no say dem go go house, but dem fit dey bottom 4 I use 'for instance' for a reason. |
dominique:Neither of Liric go bounce, na my fear be that, but one of them go dey bottom, na my aim |
doziefrank07:Yes o, Ka3na dey escort Lucy go her new abode |
It's ya boy, Johnny Bravo Vote for him, to see more of this
|
fitzmayowa:4/1 |
Sunnycliff:He fit get higher votes, but he go still dey bottom 7 |
Meanwhile, make una hold this one as exclusive: Wathoni go sleep for Kiddie bed this night. Make una no talk say I no tell una o |
aroundnaija:I mean the streets in the house, I don't mean viewers. You think say I never talk this one before? |
MamBi:I swear, na wetin I wan come talk The guy dey parade with boxers. |
Tochi don comot shirt for the first time. The hustle is real on these streets ![]() |
LOL Dora dey tell Ozo, "You are useless, this could have been us, but you're useless" ![]() Ozo say, "I could've picked you" Dora "You don't have any options. Who else you for pick? If not me, because you can't pick the love of your life (Nengi)" Ozo "I coukd've picked Erica" Dora *shouts for Erica* "They said they would have picked you" ![]() See the better banter |
I no even wan see these people...I just dey eager for Sunday, make some people know their place for these streets |
70% of my online votes, na BrightO get am, the remaining 30% na for Trikky |
sammyesx:E no go go house Anyhow wey e wan be, e strong pass at least, three people for that house. I just want make the guy shock small, but even so, e fit escape bottom 4 still If somehow, e land, he get enough friends wey fit save am, over BrightO or Wathoni, for instance |
MMXX:We go catch her next week |
This Prince just dey cruise ![]() |
Tricky Tee Wathoni Bright0 Tochi Kaisha Praise Eric These ones go share 5% of votes Na 0.3%, 0.5%, 0.6% you go dey see for their name. If you get 1% you fit dey safe |
Voting opens today 10PM Closes Thursday 10PM Dem no dey allowed to campaign for votes in any way or manner |
See these two mumu Leric I pray make Eric at least enter bottom 4, make e shock am |
fitzmayowa:E dey crase wey e no go accept? It's good to be good abeg. See where goodness and niceness carry Prince. |
Bighie say she has to pick second and third choices, in case the first choice no gree (the person dey mad?) She think am, she no too sure about other guys, finally, she pick Laycon and Neo as second and third choice |
Lucy don pick Prince, because understands her God bless you for saving my baby boy Prince |
caprini1:LOL |
fitzmayowa:She no dey me like who wise. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 65 66 67 68 69 70 71 72 73 (of 90 pages)
..... Brighto, Trikky and Wathoni are my fav 
