InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 66 67 68 69 70 71 72 73 74 (of 90 pages)
I just wan make all the top people dey up, make we reduce some people chances of escape, especially relationship people |
Neo go kneel down, hug Erica, as na only she get lock down spelling |
I happy die for Lucy World people don already set her bag for front yard. |
Tochi, Praise and Prince too, make she consider them |
MizzD:Ka3na get lands and diamonds. She set. |
Make Lucy pick Bright or Trikky for Depity abeg Remove the weak people from equation, make Eric no fit escape. |
Lucy must nominate man for Deputy |
God of Lucy, locate me! |
Billionaire boys don't stress themselves Stress is for broke people |
Neo and tie na the same thing. Tie with madam last week, tie with oga |
dominique:No, it wasn't start. He stopped at 16 |
Even God no wan make Eric survive this thing |
Neo no dey ever dull |
dominique:3 |
Honorable failure for Erica |
E good as Laycon dey lead If e win now, he gets pick Erica. He don dey give her assurance since morning, "You can count on me", " My name na Fide, I keep my word" E don enter, where she dey. The babe go dey mark am. |
The Lord is with BrightO |
E don set Cold everywhere. |
As dem dare Erica to kiss Kiddie, na so Biggie go on break ![]() Even Biggie no like this ship....some people talk say Biggie dey crush on Erica, be like I go believe ![]() |
I like as dem dey enjoy themselves before HoH task. Na im be say the shock go really enter when Biggie drop him bomb ![]() |
Praise, Vee and Neo praising Laycon's intelligence, they all agree he is freaking cool. Make nobody come talk say housemates dey look down on this guy again. Just dey hail am dey go |
galaxyball:No, Kayode no show the beginning. |
How many times Laycon go dey sorry for this thing? The babe dey chill for her side, he still dey come explain, dey admire her anger, "Your anger is so calm" Wetin I dey watch sef?
|
If this Eric get vote pass BrightO, make I know wetin happen |
ImaMmakara:She nack glasses, she dey sit next to Tochi, but she never jok gist. Her own talk na night shift. She no dey shine for daytime. |
Kiddi leave Arsenal gist to wake Erica up, dey press her nose, dey admire her smile, rub her head. Which main guy be this? For night now, Sister Wathoni go block this guy dey giggle like mumu, "You said you loved me", " You said we will have ten kids togetherer", "Don't you remember? You said you will paint me nekkid", " You this guy, you're funny I" Brother Bright go dey corner, "Don't you like her?", " You look good together", "Kizz, brethren, kizz" Kiddie go dey him side dey shrug, "Yeah, I said that.", " Yeah, my bed is free", "Yeah, men, whatever. I look good with everyone" Mad people. |
MamBi:Man United wey finish Top 3 this season? Or the ones wey win Europa two seasons ago? Where Arsenal for table? If we dey yarn suffer, nobody suffer each Arsenal fans. Those people don dey suffer pass one decade now. |
nazablossom:I never see any of them wey cook pass noodles and fried things. Either dem no sabi at all, or dem just wan release and be taken kiarof. |
So Ozo na diehard Arsenal fan No wonder, those people like suffer pass their life |
Erica and Nengi sabi use men well. E don clear. The difference na with their style. Nengi style dey more obvious, than Erica own If two of them marry, dem fit lock their husbands down. Only say, for Nengi, all the man family members go know say she don bottle am. But with Erica, she go bottle the man, still bottle most of him family members with smile. Na only one or two go dey suspect her, but the rest go dey defend her well. The game is the game. Make we see who go win am. |
Jezking:Prince dey all the entanglements Naija August Alsina |
If these housemates like their belle, make dem just dey keep Ka3na and Lucy for that house, because if dem go, na only noodles and fryfry food dem go dey chop till they go. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 66 67 68 69 70 71 72 73 74 (of 90 pages)






