InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 68 69 70 71 72 73 74 75 76 (of 90 pages)
Nengi still get the boyfriend wey she leave for Abuja, for mind she say the guy change her life, so, she no fit come here come disrespect am. E be like, na that guy set her up |
i jsut see one video from this afternoon, and men, Wathoni, I just dey even more embarrassed for her Nengi and Wathoni are gisting. Nengi say she like Ozo, he's a cool guy, but she no think say the shipping go work, because the heart is somewhere else. |
From today, henceforth, make nobody insult the evil genius, BrightO, by calling the guy, "Evangelist" This guy no be Man of God, na agent of confusion e be. |
Eeghe:I dey vote BrightO next week. He must remain |
Gbegiri:EOD |
Froshloaded:Thank God say dem no dey ask people to vote out housemates, because, if dem leave Laycon fans, Wathoni for break record ![]() |
See as Ozo don turn spectator for Nengi and Waya gist. Player, where? The babe just dey enamored with Waya, as e dey gist am where e sabi, because she no get her own gist to talk. She never waka far. At least, when he and Erica dey talk, if e drop location, she go drop her own back. Na so you dey know who be big girl, and who be social climber. But Gbegiri think say this guy go chop Erica and Nengi go escape? I laugh in Wathoni |
Gbegiri:Abuja babe Nengi? Dem no dey hard to waya. E don tell her PJ, her eyes dey shine, she don talk, "I wish you had told me, I would have hitched a ride with you" Babe wey don tell you that one, don enter 70%. E no get one thing wey Erica don talk, wey show say that guy go fit waya am easily. Anyway, I know say na your hope and dream be that. Just ready your mind for the L. |
gameboy727:E no concern am. the guy dey find drama. Make e help us |
Gbegiri:LOL You think say Nengi dey beyond gbensh? LOL. Pray say she no follow join for who e go waya for the house. |
Anybody wey call Ozo player for this thread again, I go track you ![]() |
DownChelsea:Erica is not with Prince, she just dey sleep on Prince bed this night. Na rotation. Friday, na she and Praise share bed Saturday, She and Kiddi Today, she and Prince. |
galaxyball: ![]() |
Thank God say Wathoni come that house with her Kenyan name, because this her behavior, dey very Kenyan in nature. I no beleive say Igbo girl fit dull like this. |
fitzmayowa:Erica wey dey sleep on top Prince bed this night? Wathoni no go even last long enough to establish correct triangle. Abeg, na only me dey pray make Laycon win HoH tomorrow? i wan see something |
BrightO looks unassuming, but that guy awareness level na top notch. E for be master strategist, but this game no go favor am. |
Saltandwater:Lol....I talk am say, she no like Laycon, na Kiddi she don dey reason since. even the BrightO wey people don ship am with, that one na cruise guy. all this unraveling and we are just in the second week. omo, game go long. |
MizzD:I like Bright. i no go lie you. E dey do him work well, na so he do Laycon and Wathoni yesterday, only that, e no dey shine in the daytime, so, people fit no notice am. |
gameboy727:Na mugu. e no get who no like mugu for relationship; love you to a fault. just hope say she no fall mugu for another guy, inside your relationship, because e no hard to turn their mumu button. |
Kayode don show Liric, the only true ship ![]() |
gameboy727:No be 'might be', she don already build house and life with the guy, she don born baby girl, named Laila for the guy, or Ngozi. You go think say one pikin out of wedlock go reset some girls brain, where guys dey, but a romantic is a romantic. |
Froshloaded:Na very emotional and sensitive babe. E dey surprising, because she's 29, she no suppose still dey like that, but I guess, na so she just dey naturally. |
Dem dey talk of the 2 million prize. I no know for which game. |
BrightO say they look good together Kidd say he looks good with everyone ![]() |
Wathoni dey gist Kiddi wetin e tell am yesterday for party. when this guy dey drunk, e dey wasted. Na this kain people dm fit collect their property if dem drunk. E just dey listen as she dey gist am, "You said we looked together..." "You said you'd have a daughter named Lila, or anything i want" she dey giggle, dey tell the guy. she say she go like get baby girl though. Wathoni dey dig for these vibes. she really feels slighted. I feel bad for her. BrightO dey form umpire. |
The funniest thing about this situation be say, Ozo still think say na him dey run things babe wey tell you say she go beat you for chess, and you no fear her She don give am checkmate, but e never see am, because the guy still dey eight steps back |
scondy:That general nomination go be problem for her, because she dey gather alliances wey no go too help her in the long run, based on say, everybody go dey up. triky and Prince fanbase no strong reach to give her boost, if dem go house, and if somehow, Ozo play himself comot from game, him fanbase for don deplete finish, so, dem no go fit help her, and even if dem never deplete significantly, dem go wan form alliance with her closest rival, because dem feel say na she go spoil the guy game. she fit no win, but she go gather fanbase. winning no be everything, ask Tacha. |
Smartmed:Make una enjoy am. Just paint her as victim, as you don start, she go come get victim votes like CeeC and Tacha. every game go still get you supporters, just turn every strategy in your favor. Be happy. Nengi don secure one of the necessary ingredients to win this show- Rivalry, real or imagined. |
Nengi just likes male attention. She dey wrap men around her finger, steady. she don hook Prince and Trikky. Ozo been dey difficult small, because of Dora, but once Dora comot herself from equation, she secure that mugu too. Neo and Eric don enter with Vee and Lilo, so, she no fit obtain their mumu button again. Laycon pass her power. E no send her, her yellow, or her bumbum. minus 1 BrightO na man of God, no weapon fashioned against him shall prosper ![]() Kiddwaya. Big fish. Erica hook am, before she fit send her stooge to secure am. Dem been no see the guy on time. Tochi, e dey mostly aloof, but based on say, him, na Kiddi right-hand guy, by extension, e no go too dey accessible again. Praise, another aloof guy. That one na one man army. She go hold Ozo, Trikky and Prince for now. I suppose write book, forget. |
overplay the guy don collect major L so early in the game. E fit no come back from am mattfeuter: |
So, Nengi just divide Dozo finish, only to curve Ozo. yellow gehs will shame you ![]() |
see Regression from Kidd and Erica to Nengi and Ozo now, Trikky and Wathoni. the only thing wey fit worse now, na Kaisha and Tochi. anyway, everybody deserve airtime. make we dey watch them, maybe Wathoni go find her missing vibes with Trikky |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 68 69 70 71 72 73 74 75 76 (of 90 pages)


