TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:16pm On Jul 26, 2020 |
We been dey vibe on a London level, with Erica and Kidd
See, as I just dey nod my head, for my mind, I don reach Tampa, Mayfair, I dey go club with Erica.
next thing, Kayode shift camera to this dry Ozone couple and their boring conversation. Nengi don go Tampa before? Ozo know road to MAyfair? E be like Kayode no like better gist |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:49pm On Jul 26, 2020 |
Smartmed: mehn the kind of hate you guys are spewing towards nengi E pass the one wey she dey do her 'friend'? |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:48pm On Jul 26, 2020 |
E get this thing, about hanging with people wey get bad energy dey affect you.
Since Ozo begin dey hang with this Nengi babe steady, him favour just dey drop dey go. Very soon, viewers no go wan see am for their screen sef.
Na the same issue Tobi been get with CeeC. As e dey follow her, him stock dey drop, if no be say dem pull am out on time, and e begin dey follow dem Miracle wey get good energy, only God know wetin for do Tobi for BBN
And the thing be say, the people wey dey get bad energy, dey always thrive. E dey like dem dey suck the good energy from their victims, dem go come dey use am dey excel.
Make una no vex, na highness reveal this thing to me. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:20pm On Jul 26, 2020 |
semid4lyfe: If it ain't working don't force it.
This Ozo & Nengi ship can't sail.
Their conversation is so bland, uninteresting and Ozo is not really feeling her. He obviously vibes better with Dorathy..... because Dorathy na free spirit. She no dey carry people for mind. Pesin like Nengi go get negative energy. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:17pm On Jul 26, 2020 |
As long as correct way dey to play game, and you bone am to play dirty, e no go ever be 'just a game', e don turn personal.
Na the code be that. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:12pm On Jul 26, 2020 |
stephleena: And to y'all saying this is a competition and not some sort of family reunion.. for Christ sake there are a thousand way of outshining your rival, in a pure healthy way.
in the case of Erica her strategy might be smiling with everyone, Nengi should try to out do her by going extra positive and cool..
but going through this means, is ghetto! garish! And gaudy!
I've always known she's street, forget the outlook bitch is really ghetto! You sabi |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:04pm On Jul 26, 2020 |
Nexus25: Whether she wins or not is not my business, my point is she should not be castigated for playing the game. The point of being on this show, is for viewers to watch, condemn or praise the actions of every housemate E no get who we no go castigate if dem mess up. This your talk no gel |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 10:02pm On Jul 26, 2020 |
Announcement!! Announcement!!! This man has been KIDD-napped and is being held against his will, by this nefarious woman. It behoves on us all, to free him from this bondage Kiddwaya fans, ARISE! 
|
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:58pm On Jul 26, 2020 |
Nexus25: Nengi is there for Nengi, she's not there for Erica. I need to remind you this is a competition.
What's Jazz? Office politics doesn't need that, all you need is sense. Nengi has sense Not enough sense, if her aim is not achieved. So far so good, she dey collect the L steady. Very soon, her mugu go go house. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:51pm On Jul 26, 2020 |
Only God know how many men dey do relationship with their kidnappers
God save us |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:45pm On Jul 26, 2020 |
Nexus25: Biggie's house is not for family reunion. They're there for a reason, use whatever strategy you have to get the price. Hms are there to "game" and be "gamed".
Are most of us here not in the Cooperate world? What's strange in the politics of love Nengi is spearheading? Are competitors not to be annihilated?
The show mirrors capitalism in reality where you ruthlessly muscled out any imagined threat. Erica is a threat to Nengi, breaking her supporting pillars is a task Nengi must achieve. If na so you dey run your own game, no wahala. I no follow una dey corporate world, but I hear say una dey even jazz each other to get ahead. If na that kain life una take pride in, no problem. The only joy wey I get be say, the foolish Nengi just dey waste her time. Evil people like that no dey win show, dem go either chop disqualification, chop eviction, or escort the good people to finals, to clap for them. Tomorrow get belle |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:36pm On Jul 26, 2020 |
Make nobody ever compare this Nengi girl to Mercy, Tacha or even CeeC again for this thread.
As those girls been crase reach, dem been no dey set their friends up like this. Na this babe be the real head of any coven for this country. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:31pm On Jul 26, 2020 |
carammel: In the end, its only game, you are not there to be friends with anybody as you are all contesrimg for the prize. Let the smartest survive.. Like Tayo used to say on BBA "House drama is only for a short time, there is still life outside" Make everybody get am for mind, because when the show is over, evenryone's deeds will be analysed, and it will determine what relationships you build. I hope Nengi go get the right relationships at the end of the show, no be just to play yeye game. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:23pm On Jul 26, 2020 |
Nengi to Wathoni
"I picked Kidd for you, because I thought you would be most comfortable with him"
Shut up! Calculating, manipulative liar oshi! |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:17pm On Jul 26, 2020 |
Nengi na real Mamba
With friends like that, we no need enemies
Such a bitter, vile person. If she no dey shine, she no wan make another person shine. If she no get the top guy, she no wan make another babe get the top guy
She dey look that mumu Wathoni like who dey beneath her, so, she no fit dey threatened if she get the top guy, but Erica na correct competition. She know say as she no get stable guy, Erica fit overshadow her with Kiddi.
She wan scatter that ship
She dey like Genevieve Nnaji for Blood Sisters, then Erica na Omotola |
Celebrities › Re: Kiki Mordi Releases Phone Conversation She Had With Sega About Seyitan And Dbanj by InSanety: 9:09pm On Jul 26, 2020 |
Kobicove: Is the Segalink guy a police officer? e dey rapport with police, to release guys wey SARS people dey harass. E get police connect |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:08pm On Jul 26, 2020 |
aroundnaija: Why this silicon albino dey push this naive rafiki kenyan girl like this Na force make she be with Wire Wire  Lol. Kenyan girl go soon go house, she go find who she go use tire. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 9:07pm On Jul 26, 2020 |
Eyah
Nengi talking to Wathoni about the vibe she had with Kidd.
Wathoni says there was a vibe on Sunday, but now....
Nengi says "He has been kidnapped"
Wathoni says, "It's not about me and him anymore"
I know say na Erica dey Netflix, but Nengi na very good actress. See as she dey try sow seeds of discord left and right, manipulate Wathoni to fight for Kidd's love.
A true Manipulative Queen. She no wan help her own sinking situationship, she just want scatter another person own.
Patience Ozokwor no sabi work where she dey |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:51pm On Jul 26, 2020 |
Na so Erica don locate Kiddwaya lap
Tochi and Vee flank the guy, so, the only available chair na the guy lap
Organic growth |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:39pm On Jul 26, 2020 |
Acidosis: Add Evangelist, Neo, etc. Don't take it personal, he doesn't have that time.
And BTW, Ebuka did wonderfully well He acknowledge Neo, with the question to Vee Na observation, nothing personal, you no go understand. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:29pm On Jul 26, 2020 |
Eric say "We go nominate tomorrow"
LOL
E go shock am |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:27pm On Jul 26, 2020 |
Neo dey try explain the status of him ship |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:21pm On Jul 26, 2020 |
Eric say Ozo just clear everybody.
Say, dem think say anybody just come house to dey play relationships? |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:19pm On Jul 26, 2020 |
Na so Ebuka just sly Laycon and Erica for this week Q&A
Aside party shout out, no question, nothing
We dey observe. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:10pm On Jul 26, 2020 |
MJBOLT:
one man army no dey this season Just do your own and hope say another person dey do something |
Celebrities › Re: Kiki Mordi Releases Phone Conversation She Had With Sega About Seyitan And Dbanj by InSanety: 8:09pm On Jul 26, 2020*. Modified: 9:13pm On Jul 26, 2020 |
Sega wey no be straightforward person.
That guy like make people dey hype am, and he feel say he dey above being reprimanded
A real egoistic modafucker. E dey try for SARS work, but the guy dey like Dictator, he no like criticism of any sort. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:06pm On Jul 26, 2020 |
MJBOLT:
abeg make una vote Tbaj o you fit vote her |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:02pm On Jul 26, 2020 |
carammel: The power they are about to give to the housemates will backfire. The housemates may gangup on someone while the viewers feel otherwise. Let's assume there are still 20 of them next week, the 20th and 19th person could be saved by the housemates while the 17th with higher votes gets evicted. To me, that's waste of voters money. Anybody that ends up in the Bottom 4, mean say viewers no too like them. Any of the bottom 4 can leave. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:00pm On Jul 26, 2020 |
Amya: This season won't favour shippers. This season na about who hold bar pass If money finish, e don finish Ships wey no get separate fanbase go fall |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:48pm On Jul 26, 2020 |
Ebuka has given a special shout out to
Erica Laycon BrightO TolaniBaj
For their party vibes yesterday
Omo, some people go beef |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:47pm On Jul 26, 2020 |
Housemates will have the power to kick out one of the bottom 4 housemates during each live eviction show
Mad o |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:45pm On Jul 26, 2020 |
Gboliwe: Copied from Facebook.
I agree sha 
Unpopular Opinion on BBN.
Ozo is NOT as good looking as most people think he is. Most light-skinned guys are just average or less than average, but their light skin gives people a mirage that they are better looking than they actually are.
Or... maybe he just isn't my type.
Strictly based on looks; I'd choose AT LEAST 5 guys in that house before Ozo.
A lot of Nigerian girls might want my head for this. But besides looks, I do NOT like his (Ozo's) vibes. There's something about him that puts me off. He's a type I'd snob. I most likely wouldn't reply to his inbox message if he sent me one.
I don't like that busty girl. We know you are busty but can you close your breasts for a minute and try to show us your talents (if you've got any) or intellectual prowess? I find the excessive and compulsive exposure of the breasts quite unappealing. Like is the breast the only thing she's got to offer?
And don't let that thing ring in your head. It's NOT jealousy. I'm quite very busty too. I wouldn't want a bigger size or I might go for a breast reduction surgery.
Kate still remains my most likely favourite.
I'll give it another one week then have an opinion on all the housemates and then decide for sure who my money would be on. In other news: Kano Pillars Football Club, have insisted that they have no interest in buying PSG sensation, Kylian Mbappe. They encourage other interested clubs, to make a swoop on the Star forward. |