TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:41pm On Jul 26, 2020 |
Blackhawk01: Ebukz, help me ask Wire wire howfar abeg. Lemme know wassup!  E no dey touch them this week, maybe until next week |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:39pm On Jul 26, 2020 |
MizzD: I like how Vee owned it.
Lilo looks older with this hair. just seeing it Her face dey one kain, I no just understand wetin this hairstyle do am |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:38pm On Jul 26, 2020 |
Next up, Vee and her baby
Ebuka come hail Eric |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:35pm On Jul 26, 2020 |
Ebuka open show with Ozo and him entanglements |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:34pm On Jul 26, 2020 |
Una go vote tire
Nothing like saving for any finale, if money don finish by then, e don finish |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:27pm On Jul 26, 2020 |
Anyway, Power Couple
|
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:21pm On Jul 26, 2020 |
This new twist means that the actual Top guys could very well make it to the finale
Laycon Erica Nengi Ozo Kiddwaya Dorathy
Give or take, in the absence of one or two, at least four of these guys, could make it to the finale. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:19pm On Jul 26, 2020 |
Thank God!
Useless Borites will never escape with this new method |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:15pm On Jul 26, 2020 |
Venita: Yeah I know what you mean, but how does a 24 year old man have memories of karashika? Though I haven't seen it but I know it is old. But I could be wrong, maybe it isn't that old  Haba I have memories of Karashika, and na one year I take senior the guy The film still dey Youtube sef, so, anytime wey you ready, you fit still watch am. Which day, I go watch Violated and Diamond Ring again. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:09pm On Jul 26, 2020 |
Venita: Some mathematics just didn't add up, considering some people just got past 20. Oh well... Some things no dey match up, no mean say, a no true I fir identify more songs from 70's and 80's, than anything from 2014, forward Na the kain house some people come from and wetin you grow up with. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:07pm On Jul 26, 2020 |
ArchAngeI: where will you see them to watch Netflix?
They are old, the way tochi and praise where traveling back, abeg those men done old, tochi be like all those village old men, remove the beards, reduce his height E be like dem no free you watch television when you small. If I list the old movies wey I don watch, e go shock you when you know say I never reach 30. Some people dey watch film from when dem fit waka, and some families go siddon, watch old movies. Especially that time wey video clubs dey Anyway, if you need old movies, google "YTS" old movies full the site, anyone wey you want. Most people no dey use Netflix sef. Who get money? |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:01pm On Jul 26, 2020 |
Venita: Ok question... How do these supposedly young people in their 20s remember all these old ass movies??  Being young does not mean you have not watched some old movies. E just mean say you young, and some young people dey watch old movies wella |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:18pm On Jul 26, 2020 |
ArchAngeI: I dont even know what to say  see as the billion dey sweet them to write. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:05pm On Jul 26, 2020 |
At least that person wey been dey think say other houseates no get talent, and na only Laycon sabi rap, don see say the Uber guy sef dey rap Make Laycon just thank God say Tochi dey into transport, because if say he dey serious about music, e don be for Laycon for that house. Correct competition  |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:43pm On Jul 26, 2020 |
Layrica for the gang dem.
Who need Wathoni hugs, when e fit dey chill with him real G?
|
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:39pm On Jul 26, 2020 |
SirMichael1: This one that everywhere I turn, it is 'Prince is my type of man, prince is such a nice and perfect gentleman, prince doesn't grob, Prince this, Prince that, bla bla bla'. I don go register for saloon to learn hair dressing because I dey go BBN next year.
Nobody talk about the girl wey help Tricky T barb him under beards oh. Awon hyprocrites. The girl no get name? Talk am now Na Prince me I see, when I begin watch |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:38pm On Jul 26, 2020 |
Amya: Eric is just too vain for my likening. Dude we know you have a nice build... Please go and wear a shirt or polo. With the freezing temperature in that house dude still prefers to go shirtless. As e no sabi anything else, make e dey show body I just pity am, because he no know say e dey irritate people. For all the official and unofficial ships, na he and him babe dey down down. E no pass five housemates wey dem go fit comot |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:36pm On Jul 26, 2020 |
mizz2posh: It's those guys that don't really have much going for them after the show that stick to their babes, e.g Ike, teddy a, gedoni because they need them. If not why did efe not go after the Marvis that he so much craved in the house? If you believe that a kiddwaya will stick with any of those girls after the show then you don't know whatsupp. Efe been no crave Marvis. I no know how anybody been reason say that kain relationship for fit work. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:33pm On Jul 26, 2020 |
Lhimeet: I was about saying same thing
People dey prepare for the match by 4PM True, that one dey. Final final. Some people go know where their club stand today. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:30pm On Jul 26, 2020 |
E be like people go church for this thread
Updates no too dey come in. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 3:16pm On Jul 26, 2020 |
ArchAngeI: quote? Retweet is the killer, someone with 15k followers retweet you tweet, you done cast, they will bomb you Quote and retweet dey get the same effect |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:59pm On Jul 26, 2020 |
Gbegiri: Twitter takes the cake anytime. I'm a testament to That. Twitter is war. I like Nairaland because you can type an Epistle of words without repeating yourself.. Nairaland dragging dey remain for one thread. You gats only face like 5-10 people at most, at a time. For Twitter, once person quote you, na so your gist go reach another Timeline, up to 100 people fit drag you in one hour. Only thing be say, for Twitter, you fit mute person. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:55pm On Jul 26, 2020 |
humility101: So will be barbing dem when Prince is evicted? Make dem keep am as long as they can. Or, make Laycon begin dey understudy am, since una don secure him place for finale. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:54pm On Jul 26, 2020 |
vickydevoka: O.k. thanks. As u said "sexually attractive", I got de message very well. All na to chop n move on, na en be dat kind gals Sexually attractive babes no be for chop and move on, no reason am. Some of them fit hold your destiny, go ask August Alsina and Will Smith. Dem fit chop any babe move on, na even babes wey dey form humble dem dey chop pass. Those ones wey no too sharp. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:42pm On Jul 26, 2020 |
humility101: So biggie no bring barbers and hair stylists for them. No ningas also. E no make sense na. D can sanitize and wear nose mask na e better make dem no try themselves. No outside contact at all. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:42pm On Jul 26, 2020 |
NewDelhi: Highest likes for this thread so far.. shows say our beloved laycon get secret admirers.
#Icons Hope say e get secret voters too Na votes dey win, no be admirers |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:41pm On Jul 26, 2020 |
Venita: He's got a good sense of style but that's all I see for now. That one dey |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:37pm On Jul 26, 2020 |
Prince dey explain how vaccines dey work.
If una dey find who to call intelligent, na Prince, better all-rounder.
If I be babe for that house, na Prince I for follow. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:35pm On Jul 26, 2020 |
Venita: I think he should avoid her like a plague. She's obviously repulsed by him, and she ain't even that fine. Mchwwweee Heavily repulsed. Make e just give her space, because babes like that, dem fit put you inside gbese wey you no fit imagine. |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:34pm On Jul 26, 2020 |
smellingKPEKUS: even the ugly waroni sef dey discriminate The babe no ugly. She get eyes for billionaire baby boy |
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:31pm On Jul 26, 2020*. Modified: 3:30pm On Jul 26, 2020 |
Laycon dey hug Wathoni, she come talk say make e no dey harass her. Na so my guy comot hand sharp sharp..
He come even add disclaimer, "Abeg, na play o, I no dey harass anybody"
Man gats drop disclaimer, very necessary. In these volatile times, anything can happen |
TV/Movies › Re: Kiddywaya Gropes Erica’s Breast While Dancing And She Reacts by InSanety: 2:30pm On Jul 26, 2020 |
K |