InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 72 73 74 75 76 77 78 79 80 (of 90 pages)
topboss:Nobody wey fly $8,000 private jet? Omo, I no go mind that kain nobody Some people future glory no even lit reach the guy past glory. Beef, beef, everywhere ![]() |
Only reason Ozo is spending all this time with Nengi na because him real gist partner, Dora give am red card. He just dey force conversation, since e no get who e go run go meet again. |
lymelyte:Why una think say the guy be pastor before? Na wa o. Twitter just give the bros identity, because of him dressing and calm demeanor |
hiteelong:Na see finish |
Altrarecords:She no wan disrespect Prince, she no just want make Wathoni collect her reserve boyfriend. Nengi dey like who go happy if only one guy dey hype her? The day wey Ozo yarn anyhow, Prince go dey to hype her. She just send Wathoni go another side, make she no distract her flow. |
Trendsetter Trending everywhere.
|
And Erica sef na very convincing actress. We go see who be player between both of them sha, or if any playing dey involved |
Bars on bars Ozo suppose ask this guy for him playbook, see lines.
|
To win this game, you need strong alliances. People too dey reason this game like say na real life. Na game anyhow. Nengi play her own card today, but na who form the strongest alliance go go the farthest Kidd fit dey use Erica, and e go help the guy game. This ship don elevate the guy from 'boring billionaire kid', to 'romantic billionaire kid', the ship don elevate Erica too. Couple that, with her (friend/sibling)ship with Laycon, and the babe don build solid alliances Laycon get strong base She get her own strong base too. Dem go dey help each other, for nomination when time come. Kiddi get money, dem go help their "wife" sef, when tome come Kiddrica 'ship', go still bring them fans. Laycon-Erica-Kiddwaya, this kain alliance go mad. Make una no reason am. E fit be the alliance to beat this year. |
stephleena:Babe. Take am easy, your blood dey hot |
Lhimeet:All na the same thing Who no like better thing? If say Tochi fit kiss Kiddwaya, e for dey kiss am sef Na only one person fit win that 85 Million, and Laycon fit don secure am, make Erica secure her own bag. The game is the game |
Which kain agents of confusion be this?
|
Anyway, while some people dey create unnecessary drama to trend, see who dey trend WorldWide We no need unnecessary drama to blow
|
Kidd don carry Erica for back, dey go Billionaire money no fit leave the babe |
stephleena:Kiddi dey even put head for her picture, she dey laugh. Dem no dey drag crown with anybody for these streets. Queen na Queen anyhow. |
Ozo, Erica, Tochi, BrightO and Kiddi, chilling in the garden Erica still dey laugh, dey smile as Ozo dey hail her dancing moves Who talk say this babe go cry this night? |
Dem don show us Liric, the most unsinkable ship |
So these guys true true dey chop swallow this night. |
mizz2posh:We go see. Person mama mean say she go dey reason the guy join. KiddThoni don set We watch |
Munzy14:If e serious for the lady, e serious too for the guy? I dey talk say e fit no serious for Kidd, na there I dey go. Amya say she get 3 years relationship from kiss, I say e no mean say Wathoni go get anything from this one |
Prince wey Nengi still dey give close marking, na who she for pick? Prince na Assistant boyfriend, in case Ozo fail. Nengi no fit ask Wathoni to kiss am. |
Make Ozo just chop this babe. She no dey like who get plenty sense, na the guy just dey hold leash. |
Wathoni det swing for hammock alone. She dey like who dey either recover from shayo, or reason her life choices, or both |
Amya:Congrats on your guy The kiss no serious for my eye. Wathoni na person mama, e be like una forget. Kidd no go dey for that parole. |
Amya:If she cry, na Nengi cause am, no be Kidd No be she even scatter the game. She dey do like who shayo blind |
Na wa o I no even know who I wan send my thunder to. Na God go punish the person wey scatter this game. I wish them endless nominations and early eviction. Nonsense! |
The kiss been no even serious like that, I no know where the vex from come Na just mouth kiss, I no see tongue at all. |
suze:No be in her mind. Na straight facts Anybody wey no like am, make dem off TV |
Vee say if Neo wan kiss, make e kiss, na her bed e go still end |
Fear women o Bad belle strong for this house Game don finish |
Lazyyouth4u:Kiddwaya. You just dey find me since I deck you this evening. You go find tire. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 72 73 74 75 76 77 78 79 80 (of 90 pages)


