₦airaland Forum

Welcome, Guest: Register • Login • With Google • Trending • Recent • New

Stats: 3,345,923 members, 8,520,188 topics. Date: Tuesday, 17 November 2026 at 01:08 PM

Toggle theme

InSanety's Posts

Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 76 77 78 79 80 81 82 83 84 (of 90 pages)

TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:08pm On Jul 25, 2020
Eleniyan15:
Don't paint the scenario bad
Laycon and Erica came to the dinning together but it seems Erica went to tell kiddwaya something, laycon wasn't bothered he took his seat, few seconds later he went to the kitchen by the time, he got back to his seat Erica was already there.
Laycon took another position not to far from kiddwaya.
Any smart person that studied in Lagos state, most especially Unilag don't give a f*** about any girl majority of them are bullies.
Verify from the female ladies whenever they pass through boys hostel in unilag, although laycon might be a low budget artist now but ladies can't be his problem.


Cc: GrammerChecker Sos I'm not good with English cheesy I'll be taking corrections without offence
Grammar Checker, wey you? Wetin dem dey call this kain English?
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:29pm On Jul 25, 2020
MamBi:
Undercooking and overcooking is also a problem... wink
As in.

Plenty problem. E better make you just maintain the 6-8 people limit, before pesin troway your food for your front, because e no gbam
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:15pm On Jul 25, 2020
MamBi:
Getting the spicing right for the bigger quantity can be a hassle for cooks who are not experienced....
Both spicing and turning na problem.

Because, you fit no mix the thing well, up part go come dey tasteless, down part go dey too salty
Romance › Re: My Fiancee Insists We Spend N500k Or Less On Our Wedding But I Want To Spend N1M by InSanety:
Tales by moonlight.

500k for wedding.

Where in Nigeria, be that?

How many people una wan invite?
Where una dey hold am?


Any decent hall in a decent state, fit cost 150k at the least, for 100 guests o. Except Na for backyard una dey hold am. Drinks go cost you nothing less than 70k, and this one na for 100 guests. 220k don go. If she dey rent wedding dress, 30k don comot at least, for better dress, you fit wear suit wey don tey for your hand, you need music? If you dey pay DJ, another 60k at least, food nko? At least another 150k for 100 guests. Photographer, just one don cost you nothing less than 30k, and no be correct photographer. We never mention souvenirs, but make we assume say that one no dey. We never talk printing invitations, except na Bulk SMS you go do, even that one, money dey am.


This budget fit only hold for States like Osun, Ebonyi and Benue. No even reason any South South State.

Na wetin make I know say na lie you set lie. No dey deceive all these kurukere boys for this site, dem go come dey look their babes one kain, because dem think say e get one imaginary babe wey dey like your own, wey go dash them 300k take build house, come feed them through coro.

Where your babe see license to open pharmacy inside this period at that? How much be her salary as nurse wey she dey get all this money? Which work she been dey do wey she raise 2 million before she meet you? She come even dash you the 2 million, her papa na Otedola? 24-year old girl purportedly

Na who no get sense go dey believe this lie
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:25am On Jul 25, 2020
I no like as una dey reduce this Kiddwaya guy to just money

E no balance.

This na cireecr guy. Money or not, efet better cubes and flow wey people dey like dey around, e no dey try intimidate anybody, e no dey shout, e no dey disturb. People dey like those kain people wella. If kasala burst, e dey like dey there, make e do conflict resolution. See as e dey hug people left and right.

The money na just addition, but guys like that dey scarce. Even guys wey never see money reach am, dem dey carry shoulder, you no fit follow them talk.


Most people wey dey here dey accuse the housemates of gold digging, if na them dey that house, dem for do pass.

Make una no too reason am. The guy na vibes.
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 11:20am On Jul 25, 2020
InSanety:
Mercy go just dey cry for house

Why she no come this season, jam Kiddwaya?


She just go carry gbese with American accent, no money. Chai! This life no balance
Tears

Premium tears
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:41am On Jul 25, 2020
Eric dey kiss Lilo cheek, dem dey whisper to each other.
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:23am On Jul 25, 2020
topboss:
U said the billionaire talk make it happen quicker, which is also wat am saying, u dey argue.


who dem go put sugar for her mouth, make she say na salt better.


However, without that talk, Erica will still move to other guys in the house.
You no know if she for move, this one na assumption, no be fact.

Coulda, woulda, shoulda no dey my dictionary, na wetin be, I dey reason.

Anyway, no problem, make we dey look.
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:22am On Jul 25, 2020
Brighto dey trend in two places, yet, una go talk say the guy no get content.

TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:18am On Jul 25, 2020
topboss:
So it is the samething am saying now about go mingle.

However, i can tell u authoritatively that she is an item with Kiddwaya following the billion revelation.
I say dem for become item, if not now, then later in the show, but anybody wey get two eyes know say na there dem been dey head, either way.


E no get another babe for that house, wey you go see Kidd dey flow with, as e dey take flow with her. Anything wey you think say motivate her, na Kidd problem be that
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:12am On Jul 25, 2020
topboss:
I dont know wat is your problem with Laycon.

Is he the only guy in the house?
I no get problem with Laycon

You talk say Erica dey gum Kidd

I talk say she been dey follow dem Laycon gist this evening. Even pidgin English, you no fit understand, if say I write am for English, nko?

"Dem Laycon", na Laycon and others. This evening, she dey outside with Laycon, Praise, Tochi, Trikky, and some other people, dem been dey yab am say she no sabi pidgin, Kidd no dey anywhere in sight.

I dey tell you say she no dey gum body the guy. Na him dey even find her where she dey.


Make una dey watch show, no just come here dey drop lines like say some of us no dey watch. Na Kiddwaya dey track the babe, no be the other way round.
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:06am On Jul 25, 2020
topboss:
Eric tell her say him be Billionaire?

Mind u lilo still get boyfriend.
I no even get time to dey argue nonsense with anybody

Like say the babe never even chill with dem Laycon same today.

If na wetin dey give you joy to reason, enjoy.
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:48am On Jul 25, 2020
topboss:
So na billion dem day take secure relationship.

Which girl no go follow u the minute they hear billion? Take Regina Daniel as example.

Go round means, to mingle?

There are so many people in the house to be stuck with one person from the start.
Lilo wey don dey with Eric, nko?
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:44am On Jul 25, 2020
fitzmayowa:
Eric and Lilo just escaped Monday nominations straight up...
I swear

Big fish dey to fry
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:43am On Jul 25, 2020
topboss:
Kiddwaya should have kept his mouth shut about billions.

That girl would have still moved to another man.

She is a go round kind of girls.


That is probably y she started crying today and feeling alone.
No dey yarn that thing for here because you no like person

Wetin come be "go around girl", you know her from house, abi wetin? You know who don chop her?

I no dey like small pikin talk like that, guy.
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:41am On Jul 25, 2020
Lucy is shouting about the tampons situation and accusing Kaisha of leaving tampons, Praise talk say wetin she talk no make sense, she no suppose dey yarn that kain rubbish
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:40am On Jul 25, 2020
Meanwhile, Erica is seated next to her boo, watching proceedings.
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:39am On Jul 25, 2020
See as Lucy and Ka3na just dey tension the house.

Dem go nominate these girls.
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:38am On Jul 25, 2020
Neo dey follow Ka3na talk, Vee come collect her man, another quarrel don start
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:36am On Jul 25, 2020
Rahkman:
Disqualification go Dey this season walahi grin
no be if these ones dey long enough for disqualification?

Lucy now, dey go house by next week.
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:31am On Jul 25, 2020
topboss:
How does she like Kiddwaya?

Friend!
Kiddwaya dey you like who dem dey like as friend?

Why this babe strategy dey pain una so?
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:30am On Jul 25, 2020
Ka3na don come, rqzz babe.

Dey talk say all these nonse dem dey do, na because person no fit slap another person for BB house, if na outside, dem for slap am.
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:29am On Jul 25, 2020
Kaisha dey ask Lucy if she dey okay. Lucy Dey ask Kaisha if she dey deaf.


I pity this mumu Lucy, just being a bitch, only to come out with no fanbase. Waste of quarrel.

She don quarrel with like four people today alone
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:27am On Jul 25, 2020
topboss:
She said she liked him.
...as a friend

She even calm the guy her brother now now


Lucy and Kaisha don dey quarrel
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:25am On Jul 25, 2020
This frail Liric ship don get small airtime this night.

Dem no sweet again, in the light of latest events
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:22am On Jul 25, 2020
Eyah

Laycon don come hug Erica, e be like e hear say she dey down.
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:16am On Jul 25, 2020
topboss:
Oh! Kidd tell Erica dat that kind thing?

Ahhhh! Him don buy market be dat. grin grin grin grin grin grin


I think say she just dey lucky to like him before. cheesy cheesy cheesy cheesy
she been like the guy before, and he sef like her, but him revelation speed up the process
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:56am On Jul 25, 2020
Erica don bottle Kiddwaya

Ozo don bottle Nengi


Chai! Lockdown making sense by Day 5
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:55am On Jul 25, 2020
Nengi: "I don't know how to handle anyone telling me they like me"

Ozo: "Who likes you?" grin grin
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:52am On Jul 25, 2020
ItsCookie:
Lol, my pity isn't suposed to bother her, a bird in the hand is worth two in the bush grin grin grin

But her game plan don cast for where I deh.
E sha blend for where some people dey.

Na when voting reach we go know which person game plan gel pass
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:50am On Jul 25, 2020
Nengi dey tell Ozo say she be psychologist

Erica sef na psychologist

Abeg, dem dey teach psychology for MBGN?
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 12:47am On Jul 25, 2020
Ozo, my guy!

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 76 77 78 79 80 81 82 83 84 (of 90 pages)