₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,327,819 members, 8,432,727 topics. Date: Wednesday, 24 June 2026 at 08:46 AM

Toggle theme

InSanety's Posts

Nairaland ForumInSanety's ProfileInSanety's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 75 76 77 78 79 80 81 82 83 (of 90 pages)

TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:35pm On Jul 25, 2020
zicoraads:
There was no rivalry between Efe and TBoss. Na una been dey create a semblance of one.

IamJ... Jude Jude...where you dey? cheesy

Na Jude and Tiribeer been dey push that TBoss rivalry.

Kai... It was hot. cheesy
Efe wey been hate TBoss like say, if no behouse, e for do her strong thing? Haba.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:30pm On Jul 25, 2020
Their OPPO phone don show.

Housemates dey video themselves with am, dey snap picture. They are so hyped
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:29pm On Jul 25, 2020
Eeghe:
Kayode
Africa knows what cornflakes look like
Mxm!!!!!!
But you know wetin KELLOG'S cornflakes resemble? You don see am inside red bowl before?
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:27pm On Jul 25, 2020
Erica don come meet the guys, she dey try set P for the guys, the way wey guys dey pick up girls for club

She get am
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:26pm On Jul 25, 2020
smellingKPEKUS:
omo from the begining of your post to the last makes no sense. guys use mney to get stuff done , girls use pussy
Everything wey you don dey talk since you enter this thread no make sense, but we gats manage am like that.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:25pm On Jul 25, 2020
tsquaure:
Kiddwaya is worried about the quality of the drinks they will get at the party
As a Moet & Chandon baby boy, that guy system fit no dey accept some kain low quality shayo
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:21pm On Jul 25, 2020
smellingKPEKUS:
las las non of these girls are innocent. e sure me say them Bleep them properly before them enter here
Thank God for them.

The guys sef for don correct better knacks, so, wetin bad if the girls don Bleep before dem enter house? You think say babes no suppose like kpansh?

The way wey you don dey beef these babes, you sure say you no dey collect from back?
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:16pm On Jul 25, 2020
Tolani looking peng, make BrightO no slack for her matter.

She go be correct babe for am, as e holy, she sef she no too holy; perfect
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:09pm On Jul 25, 2020
spinna:
This is what neo has been telling vee ..glam up small everyday so i can know i have a fine babe..he appreciates now
If e dey find glam up, before w know say him babe fine, then, e never ready.

Na just 5 days dem don dey that house, e no get who don glam up, but the fine settle, anyhow.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:08pm On Jul 25, 2020
Ozo don corner Erica, dey give her gist
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 8:01pm On Jul 25, 2020
DamonSalvatore:
compared to mercy, which rivalry miracle bin get?
Man's was cool with everyone

And mercy wasn't competitive ahbg.... Wetin you go call jackye then?
Teddy A rivalry pushed Miracle's market.

We no dey compare to anybody, we dey talk wetin happen.

Teddy A been dey drag sheggae comot from dem Miracle body. I no fit forget when e been dey insult them, say why Miracle go dey knack Nina for international TV, say e no get respect for am, na im Kayode release he and Bambam toilet parole that night.

Miracle v. Teddy A was a rivalry.

Same way Efe v. TBoss was a rivalry.

Mercy v. Tacha was a rivalry.

No be until dem begin dey drag hair, before something go be rivalry.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:56pm On Jul 25, 2020
smellingKPEKUS:
yeah but miracle was dull during the first few weeks. if laycon no take time,, dem go bounce am after this party. cos this party go produce new fans. i notice say he no even sabi dance
That Miracle dem year, once DJ just play 'One Corner' for party, everybody dey forget their home training grin
SportsRe: "The Super Eagles Thread: The Road To AFCON 2027, 2028 And 2030 World Cup by InSanety: 7:54pm On Jul 25, 2020
jihday:
Nigeria's 23 years old midfielder, Azuibuike Okechukwu pictured at his club's dinner party today
E be like dem no dey sew correct native abroad.


Anytime wey I see Diaspora people dey wear native, e dey always dey very drab and underwhelming.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:49pm On Jul 25, 2020
smellingKPEKUS:
you are correct. this show is not for introverts. but lets keep watching. remember miracle. his own was almost worst.
well, i dey wait may shayo enter their brain, their real colors co come out this nght
Wetin help Miracle na:

Ship
Bromance
Rivalry
Competitive Spirit


So far, Laycon never get any of these things, but make we see as the game dey go. E no sure me say anybody wey no get at least two of these things don win this show

Mercy been get:

Rivalry
Ship
Competitive Spirit


Efe been get:

Rivalry
Competitive Spirit
Situation(Ship)
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:37pm On Jul 25, 2020
Ka3na's make-up make sense
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:27pm On Jul 25, 2020
MizzD:
Praise don hype Erica say she fine die. The guys agreed. Neo said she looks like his ex undecided

Kiddi agreed she’s very pretty and referred to this first night outfit again. He called it a white dress grin. His eyes had been on her from day one. A billionaire with great eyes. I Stan tongue

That’s how uncle neo, tricky tee and I think Tochi said she’s very exposed..she go don get fans and that her eyes don tear. undecided

Kiddi does not pay any attention to the statements Borne out of complex from those boys:

Neo is excited he is with a London babe, as he has never been with one. So he does a shout out to London babes. Smh!

Anyway Praise has told them the babes have changed and don’t look like the people that have been with. The guys can’t wait to see them. I can’t wait too.
As nobody hype Neo babe, make e hype am
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:26pm On Jul 25, 2020
honortee:
I'm I the only one feeling this way. It looks to me that the guys are bonding together than the ladies. The guys in this season are more matured to me and well tolerating.
Guys dey always bond better than ladies, for any gathering. Na normal stuff.

Besides, all the ladies dey paint face now, so, dem no get time for the guys. Make those ones just chill, dey wait their babes.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:33pm On Jul 25, 2020
CallMeAthena:
What's the time for the party?
Dem say 10 PM o
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:31pm On Jul 25, 2020
Broobembem:
If them tell people to normalize socializing around and master the act of being lively in the midst of people, they'll say NO, but come to social media to brag about being "Introvert".

Boring pretenders are quick to tag themselves introvert because some foolish Nigerians see introvert as intelligent!

Laycon should juice up o! That guy got lots of loyal fans, but he keeps feeling somehow during group discussions. He's just not lively, I thought Nigha was a street boi with vibes, but he isn't.

Yes! He may not be in the same class with most of the housemates, but if he was a social Nigha with lively energy, it won't be noticeable!

Check during your school days, e dey always get one lively and social ajekpako in the midst of Ajebos, they'll always wanna be around him.

Make Laycon do something abeg! No be rap we go chop!! He should jazz up!
You think say na party people go full ground for Biggie house?

Una go hear say this show na social experiment, you go come dey shout "Why dem bring introverts come?" Everybody no suppose dey the same.

If dem bring crase people like Neo, dem go still bring laid-back people like Laycon. No be say the guy no wan interact, but as e no fine, no dey speak foreign English, e no hold bar, the babes dey rebuff am, make e hang himself? Wetin separate Laycon and Kiddi be say Kiddi dey more physically attractive and get money, but if na socialization, dem dey at par. No be Laycon try dance with Tolani, wey the babe cast am? If na you, how e go do you?

Na Small the guy small, e no kill person. The guy na artist, e mean say, e dey comot steady, he dey go shows, dey climb stage to perform. You think say correct introverts fit do all those ones?

Make una no dey talk this kain thing, because you no dey come correct. Na selective judgment be this, if you wan criticise anybody, dey consider all the factors on ground. No be everything be the fault of the casualty.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:55pm On Jul 25, 2020
At least people like Jeff, Seyi, Ike, and Nelson no dey this year.

All the guys dey dance.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:47pm On Jul 25, 2020
Neo dey give Wathoni moves grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:41pm On Jul 25, 2020
Why these babes dey paint face by this time?

No be 9 party be?
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:35pm On Jul 25, 2020
Make una ready

Some previously unknown housemates go catch eye, tiff fans today.

Top of the list na Tolanibaj and Prince.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:33pm On Jul 25, 2020
Proceedings for this thread dey always sweet.

Na from play play yarns, insult dey enter. E no get who dey immune from am, e dey always funny to read.

E be like, na just to leave some gist when you can, before insult enter, and you pick offence.


Which kain grandma make-up Lucy do so?
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety:
I no believe say people been dey talk say these guys dey boring.

At this time last year, how many talking points una been get? Last night alone, dem give us like five different talking points. Pepper Dem no give us reach that amount for two good weeks.

See premium entertainment.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 4:43pm On Jul 25, 2020
NewDelhi:
Then if you can't use a tampon then use a pad
E get wetin dem dey call guys wey dey put mouth for woman matter like this.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 4:42pm On Jul 25, 2020
Why women dey follow some mumu guys drag menses talk for this thread?

Una no sabi spot who no get sense, ignore am?

Na wetin make women dey always get plenty issues, dem go dey drag mumu talk with mumu people. E fit be say that guy dey clean menses blood steady, e go come online dey form hard guy.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 4:34pm On Jul 25, 2020
I feel say people dey underrate Prince, because e no dey talk plenty, him papa no be billionaire and e no yellow.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:20pm On Jul 25, 2020
stephleena:
kidwayya wants to prepare a special dish.. he's placed the milk and sliced plantains on fire..he tells Erica to help him slice the garlic and others..

while he does the cheese and the rest.

Erica has her doubts, he told her to trust him on this one.. he'll do his thing.


pls vee should leave her Sharp sharp.....




haters Comman see billionaire cooking,
grin grin
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 2:10pm On Jul 25, 2020
GrammarChecker:
The internet is not a British colony; both spellings are correct
Nairaland caters to citizens of a British colony mainly, there is still a 'most correct', if na JAMB, you don fail am.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:35pm On Jul 25, 2020
Dansuqi:
Some ladies may not have that feminine traits
Female ladies na tautology, guy

Female and feminine no be the same thing.
TV/MoviesRe: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 1:11pm On Jul 25, 2020
GrammarChecker:
favorite
I don catch you today.

It is "favourite"

British colony, British English.

That thing wey you spell so, na American English, dem fit penalise you for exam if you use that English.

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 75 76 77 78 79 80 81 82 83 (of 90 pages)