₦airaland Forum

Welcome, Guest: Register • Login • With Google • Trending • Recent • New

Stats: 3,345,925 members, 8,520,188 topics. Date: Tuesday, 17 November 2026 at 01:17 PM

Toggle theme

InSanety's Posts

Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 80 81 82 83 84 85 86 87 88 (of 90 pages)

TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:23pm On Jul 24, 2020
Ka3na don dey talk to her village people for room.


She dey alone dey yarn, "Everybody's true colors will soon come out, you want to be 2faced in this house?...let's play people in this game"

This mumu think say na she be the realest for the house, because she marry ancestor for money.
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:20pm On Jul 24, 2020
Erica no sabi fry plantain.

Common to remove the thing from fire, she dey do smeh-smeh, I never see.
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:19pm On Jul 24, 2020
Zyxzzzz:
When will arena game start
Dem fit don do replacement for Arena games with Betway Sports Trivia wey dem do this afternoon
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:15pm On Jul 24, 2020
Guess Who?

TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:06pm On Jul 24, 2020
Broobembem:
Gangster indeed! Make them comot am first!
Something wey dem don comot before.

E be like you no too dey watch the show.
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 7:04pm On Jul 24, 2020
Zoroaster:
i'm Tired of this shipping rubbish abeg
I want a solo player to win..
Laycon looks like the man
Hope say you get money to vote, because those people wey like Ship, dem dey vote like mad.

Whether you tire or not, no concern them. Put your money where your mouth is
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:58pm On Jul 24, 2020
Zyxzzzz:
Lolz how true is this ?
Idiotic, considering measures were taken to ensure none of the HMs have the virus.

Las las, dem go just pay FG extra money, all these things na fear tactics by Nigerian politicians looking for more money.
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:56pm On Jul 24, 2020
milann:
na weak people de fight soft people.
You sabi
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:54pm On Jul 24, 2020
Broobembem:
Neo and Prince are using Durag to hide their real facial looks! cheesy cheesy
Dem still fine, anyhow.

Durag just dey give them gangsta look
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:52pm On Jul 24, 2020
Zoroaster:
Praise just got verified on i.g
E no hard to get verified now, na people wey no sabi dey hype those kain things


Nengi don reach 200k followers for IG sef
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:49pm On Jul 24, 2020
ArchAngeI:
Neo is using Afam soup to eat indomie

I have given up cry
Wetin be Afam soup?
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:49pm On Jul 24, 2020
DamonSalvatore:
which Nelson again huh
Prince name na Nelson
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:47pm On Jul 24, 2020
Munzy14:
As a Nigerian, e no good to be soft o...If others pick u as soft, na so fight fight go deh hungry them where u deh...grin
na wetin make na mad people full this country, and dem dey take pride in the madness. You go see victims of abuse dey talk "Omo, this country na for hardened criminals"

Na dem inspire my moniker. Everywhere insanity
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:42pm On Jul 24, 2020
amehrada:
Small voltage, she don dey cry. And how is Ka3na a bully nau? Shebi na trouble we been dey find.

I like how she shake the house small.
Some people dey sensitive, e no dey hard them to dey upset or to cry.
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:40pm On Jul 24, 2020
stephleena:
I hope I recall all..

team white:
ozo.

Nengi

Eric.

praise

laycoon.

Tolani banj.

Lucy.

katreena.

Neo.

Prince( not so sure sha]


Team black:

Erica.

Kidwayya.

TrickyTee.

Tochi.

Bright.

Dorothy.

Kaisha

Wathoni.

Lilo.



Team white won with 19 points.

Team black 16 points.
Na team black get 19 points, team white lose
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:38pm On Jul 24, 2020
Amya:
Ceec doesn't have fans in week 1 same as Tboss. Drama sometimes bring in the fans. I said sometimes o grin
Na heartbreak bring CeeC fans. After she and Tobi scatter, some people come dey pity her, women scorned, come join forces on top her head.

Who scorn Ka3na?
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:37pm On Jul 24, 2020
Ka3na don dey talk yawo again.

"I'm a real person...." Blah blah blah.

Broke Lucy follow her dey yarn, "I don't like 2-face people...." Blah blah blah.

This one wey never see diamond for her life, na inside gutter get her las las
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:27pm On Jul 24, 2020
Ka3na wey no even pay people to trend her, dey carry quarrel.

Maybe her oyibo husband go dey send dollars for her, if not, na one way ticket


Prince don come meet Wathoni, siddin with her dey ask if she dey okay. Nice guy. E dey advise her make she no let anybody get to her, because the longer dem dey house, the more confrontation go dey.

Nice guy
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:24pm On Jul 24, 2020
Eyah, Wathoni dey room only her, e be kike she dey reason the quarrel with Ka3na. She no happy at all
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:22pm On Jul 24, 2020
Erica dey laugh for one side, she come talk say na Prince face fine pass for house, because the structure na die
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:19pm On Jul 24, 2020
yunafa:
zahel is an Egyptian football club. He was not wrong but the question said country.
E no get any Egyptian club wey dem dey call Zahel

Zaire na wetin be country before.

If dem no call Zaire, dem no correct for that question
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:17pm On Jul 24, 2020
Lol

I pity this Ka3na
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:07pm On Jul 24, 2020
gameboy727:
Ka3na is just setting herself up for nomination. Her eyes go soon clear.
E fit be say she keep voting money, if not, I no know where her arrogance from come
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:06pm On Jul 24, 2020
Munzy14:
leave that akpa-amu, I understand, students are currently indisposed....ASUU + covid-19 grin cheesy
You no fit even tag me with your chest.

See your life.

I go see you for school when COVID finish sha. No come beg me for garri o, I no go give you.
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:02pm On Jul 24, 2020
Ka3na wey be 27, dey ask Wathoni wey be 29, "Am I your mate?"

Wetin we no go see for Biggie house, on top land and diamond
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 6:00pm On Jul 24, 2020
CharmyBliz:
Ka3na wants to fight wathoni

Underrating her cos of hersmall statue
I hate people like that ehn
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:58pm On Jul 24, 2020
ArchAngeI:
football in america is American football


Football is wrong, that's why they wrong soccer, they should have failed them
This is Nigeria.

Soccer is wrong.

We use football here, we are a British colony, no be American English we dey use. Why you no hear "Liverpool Soccer Club'?

If na American football, dem go talk 'American football'
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:57pm On Jul 24, 2020
Ka3na na just razz babe.

That person wey talk say e fit be say she kill her oyibo husband, how far? You get information for us?
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:55pm On Jul 24, 2020
Whoch sports is the king of sports?

They answered 'football'

Lay on say na 'soccer ' dem talk

Another quarrel. Ka3na asking Wathoni "Am I your mate?"

You big reach, wetin carry you come BBN?
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:48pm On Jul 24, 2020
nazablossom:
Should come and see o grin

Munzy collect your sub grin
abeg, call me if e answer.
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:38pm On Jul 24, 2020
stephleena:
ozo is good ohh!

laycoon hugs him sef
At least when e talk say e go school, you no go drag am
TV/Movies › Re: BBNaija 2020 Live Updates Thread by InSanety: 5:35pm On Jul 24, 2020
nazablossom:
I hope you will be the next Eze, since n'unu achupuna Eze na obi ya grin
I never see am post better update since.

I no know which eze e dey bring, hope no be me.

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 80 81 82 83 84 85 86 87 88 (of 90 pages)