InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 77 78 79 80 81 82 83 84 85 (of 90 pages)
Ozo and Nengi in the garden Nengi just dey take style touch breast. |
Kiddi dey do commentary as dem dey dance Better commentary |
Housemates dancing Dem dey give us short clip of how tomorrow go be At least these ones dey dance, unlike pepper dem |
Lazyyouth4u:Wetin e dey do, fit worse pass all these things put together, no reason am. Some Mafia guys no dey drink, smoke, womanize, gossip or shout, but no make dem catch you for corner. |
Dansuqi: Ozo don turn standard. ![]() |
Mercy go just dey cry for house Why she no come this season, jam Kiddwaya? She just go carry gbese with American accent, no money. Chai! This life no balance |
I hope those telemundo-watching mamas enjoyed that performance. Erica gats appeal to the voting public, and they love a good soap opera |
All this drama, and party never start, shayo never land, highness never set Anybody wey talk say tomorrow no go dey lit, try yourself no buy fuel first. |
MizzD:The guy don dey observe am since that first night. Hope say she don ready one banging dress for tomorrow, make she use finish work on top him head Kiddwaya must surrender. ![]() |
aroundnaija:loneliness is a feeling, my guy. You fit dey surrounded by people, and you go still feel lonely. |
Eeghe:You sabi |
Acidosis:Omo, na the koko be that. No be she ask all these babes make dem dey dull. |
Erica say she go ey there for Kidd, she go be him psychologist, when e dey talk of all the things wey e been no free cry for. Ewu! See premium Telemundo love ![]() |
Even Ozo fans dey accuse people of crying for highlights, if we talk say he and Dora show na for highlights, dem go dey vex |
spinna:I swear Na people wey dey smile pass, get wahala pass They can be very depressed, na wetin make all these Ismailas no dey too make me craze. See Robin Williams wey commit suicide. This babe get abandonment issues, daddy issues. Person wey her papa no dey her life, even as e dey alive. Some things dey pain. |
Zyxzzzz:Nobody ask you to buy am. Kidd and Erica don tiff Dora and Ozo highlights. |
Kidd is such an understanding person. This guy is more than just a rich kid. He has empathy, he's intelligent. Kidd issa gem |
Kidd just dey hype this babe. Who talk say e love her? I don dey believe that person. |
Erica dey cry say she dey feel all alone. She say she dey used to being alone, she's always alone, but she get like three people wey be her friends, but the people wey she think say na her friends for here, don disappoint her. She no dey see Kidd? Is he not her boyfriend? She no fit talk to am? |
Who beat Erica o |
Kiddwaya dey console Erica Babe dey cry serious tears. |
spinna:My guy, see am now. |
newguy1:all these ugly boys go just set use opportunity to beef fine boys, because babes no dey fight for you. Find your people and support, no set beef fine boys. E be like one snatch your babe |
Ozo say e no get relationship with anybody else for the house, and of all the girls, na only Dora w dey follow talk. E say Dora na one kf the nicest people, and w no wan make their friendship capsize on top this thing, because e dey vibe with her wella The guy dey use confidence talk the kind of person wey Dora be, like say e know am from house. She go shock you, bros. Dey your name now, women fit change am for you Ozo says if you give am relationship for house, or the friendship wey e get with Dora, e go choose the friendship over relationship. He think say she send him friendship. |
Why Ozor dey follow Eric talk this thing? If say na Neo, e for tell am say make e bone the babe, no time for plenty talk, but e dey follow this Zee World lover boy. Anyway, the guy no reason am say na issue, e say, e no know why dem dey turn small matter to big talk. This guy na serial friendzoner |
Ozo and Eric don set the matter Ozo dey tell Eric say Dora na him favorite person in the house. Eric say, w dey like say you dey play dem two Ozo say e no wan make e dey like that, because then, e go dey like say him dey insensitive, and no be so e be |
Lazyyouth4u:Na Dora dey very camera concerned for this conversation. She just dey drop lines "Leave all the trends on me" "Hope viewers enjoyed the show" She come dey turn herself to victim. She don see mugu. Soft boy |
Make Ozo leave this babe abeg She wan use the guy grab fans, and the mumu dey supply himself for the shalaye. I no like guys wey too dey friendly. If na Neo, e no go even siddon dey follow am yarn this talk. Ozo leave this babe. No be by force. |
Dora say make dem start dey do rotation fir their friendship. Tomorrow, dem no go look each other, next tomorrow, una go talk She dey insist make Ozo put himself in her situation. Abeg, which situation she think say she dey? |
Eeghe:He no even know if he wan do romance with Nengi. He just know say e no wan stop being friends with Dora |
Ozo and Dorothy, we're back. Ozo dey try make her understand say their friendship no suppose dey threatened by small things |
Lucy, nobody beg you to cook. If you no wan cook food, go sleep. Rico swavey cook for like 10 weeks, we no hear one word from am |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 77 78 79 80 81 82 83 84 85 (of 90 pages)
