InSanety's Posts
Nairaland Forum › InSanety's Profile › InSanety's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 78 79 80 81 82 83 84 85 86 (of 90 pages)
fitzmayowa:She no know. Na she I pity pass Her age mates dey settle quarrel, she dey start am. |
DrakeBlend:I hate greedy girls If some women dey share ugly men like Osho baba, why Dora no fit share fine boy like Ozo? |
Ka3na and Lucy, 2 lousy people dey talk about how dem dey clear people. I hope no be Wathoni issue dem still set talk, all these local fowl. |
MamBi:Ikebe go always win bobbie. Make she no vex. Na yansh people dey go do surgery for, pass brezz, e get why |
eleshin:Na wetin e dey try talk. She dey vex because of am, e take style dey pain her, but she gats moves |
Ozo leaves and Dorathy goes "That was such an episode, hope you guys enjoyed the entertainment" Babe, if na plan you plan am, e no sweet again, we no dey enjoy planned work |
MamBi:Can't a man have a woman and a female bestie? Is he asking for too much? A yansh to grab and a bobbie to sleep on |
Dora no kike make Ozo dey make jokes about their entanglement. She insists she will remove herself at some point. Dora, abeg remove yourself when you're ready, you don tell am as e dey do you. Ozo dey give closing remarks. |
sonymax16:She no want friendship. Who send Eric to do commentary, abeg? |
MamBi:I no know I Normally, na Nengi suppose dey complain say her guy dey follow this babe. I never see bestie dey talk "I don't want to be in the middle..." Dey like make Laycon go dey tell Erica, "I don't want to be in the middle of you and Kiddwaya" |
Ozo say, when dem ask am for spec, he stated, "Physically...(Nengi is my spec)" E no mean say, e no fit dey friendly. She say make e no dey put her fir middle of the situation, Ozo say e no know which situation she dey the middle. Eric don join them, as mediator. Dora ask Eric, "I'm kn the middle, he is on the left, who is on the right?" Eric think am, come answer, "The other babe...Nengi" |
Dora say na money bring her come, and she no get time for other distractions. She say she dey follow am talk more than she dey follow Lucy, Ozo say e no mean, say nothing dey, make babe get make friends Dorothy say no be she dey talk "Pronce is my spec, meanwhile she dey follow am talk", say make e no dey shout her name, dey call Nengi spec Dora no even want hear Ozo. Na wa |
Dora say she dey plan to remove herself from the situation with Ozo, because she no like how dem dey look her for house. Eyah, the babe is suffering for being friendly with Nengi guy |
Dora said Ozo keeps sitting next to her, and e dey make her look somehow, because some housemates dey reason say, why she dey siddon near am, since the guy like another person |
Beorn:I know somebody. Naija born and raised. If she speak pidgin for you, you go just dey laugh. She no dey speak at all, dem plenty. No be all Naija be Naija. E get some people wey dey this country, wey no dey this country. You think say those 2face dem children wey dey speak correct fune, go fit speak better pidgin, if dem old? All these malo girls for Abuja sef, dem no sabi |
lovedoctor26:She no dey pretend. I sabi person wey no fit speak pidgin, as Erica dey talk, na so the babe dey talk. Me sef, I been don old finish when I learn my own, so, I know as e dey be |
Beorn:As in, you never see who no sabi speak pidgin? |
Dem dey yab Erica, say she no sabi speak pidgin. She say she sabi, dem ask her to speak, she just dey make mistake. Ajebo |
Who dey? |
MizzD:him net tear, so, dem comot am |
As Biggie forget am, na so Housemates go forget BrightO for nomination. Amen |
If no be say BrightO stand up, Biggie don forget am finish ![]() |
Is BrightO a joke to biggie? Why dem dey give feedback when everybody never do? |
Biggie said everyone failed. Abeg, Bright O don do? |
Eric glove tear sef Na so him hand big reach. |
martineverest:E no mean Na still animal kill Steve Irwin. |
This Erica body dey always shake during tasks Always so nervous, like say na job interview. How she take dey act sef? |
Neo time. My guy |
Dansuqi:Nobody has won. |
Lilo finished |
Kiddi finish am |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 78 79 80 81 82 83 84 85 86 (of 90 pages)
