Nduchucks's Posts
Nairaland Forum › Nduchucks's Profile › Nduchucks's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 308 309 310 311 312 313 314 315 (of 315 pages)
[quote author=must_a_far link=topic=323981.msg4550555#msg4550555 date=1253045057]ok we'll make this a 2 way street. answer the your question. the current govt is legitimate.[/quote]lol, who send you come here, I go vex for you if Kobojunkie use this same methodology wey you wan take avoid my question. as long as ya name no be jesus, make you no answer my question with another question. shikena. you fit answer my question, after dat ask ya own. dat is de ting wey dey fair. if my first question dey hard for you, ngwannu, make i ask you another question: You get Nigerian passport wey you don take enter another country? or you sef come from ghana. ![]() |
[quote author=must_a_far link=topic=323981.msg4550505#msg4550505 date=1253044387]what determines the legitimacy or lack of?[/quote]i no trust ya question. explain wettin you mean by "determine the legitimacy" |
My problem with Nigeria is we are not engaging the best minds we have and going out to ensure we extract the best details from all these conference and negotiate excellent deals for ourselves. There are millions who are quick to accuse the west of shortchanging Africans and Africa, yet fail to realize that the reason why these people continue to have an upper hand is that they send their best where they need them to be and so they continue to get the best of the deal as a result.any person wey disagree with de above, na indubitably a dan banza. na correct talk be dat. Nigeria needs a good nuclear deal to possibly end the power problem. How does sending this woman help us take advantage of the opportunities that may present themselves at this conference? What the heck? We never reach the stage or level where we can relax, and send a doh doh out to represent us yet.you don start again, ko? make you do analysis fairly and in a balanced manner, you no gree. you come dey write dis kind ting. you know de constitution of de Nigerian delegation wey Turai lead go de conference? what if I tell you say na the best minds wey we get on Nuclear issues for naija she follow go? me sef go ask you make you provide source of ya information, if you no get, den na pure speculation you dey do. They were at least elected by a fractio of the population ofcourse, and allowed to stay on by the Nigerian peoplee be like say you sef share one or two dribbling traits with Maradonna. na so you go answer my question? ok make I rephrase. if you tink say nigerian government dey legitimate answer yes, otherwise no. no long ting. trust me, no be trap i dey set for you, i tink say i fit learn from you sef. you sabi say, dis place na ariara market place of ideas. make you no fear, answer me. ![]() |
Kobojunkie:i no go copy all ya write-up here. i see say you dey very passionate about ya position. me sef admire dat kind passion. correct me if i dey wrong, but i tink say no matter wettin dis firstlady go do for de conference, it is clear say nothing go justify her attendance for ya eyes. i no fit change dat one. having said dat, i tink say you express de kind frustration wey most nigerians, particularly de ones wey dey for diaspora dey typically express. i beg make i ask you one small question, you gree or you no gree say de current government dey legitimate? no be trick question o. I just wan see whether i fit learn one or two tings. |
Kobojunkie:ol' boy, dat same last paragraph talk say she go meet with "IAEA on the agency's Programme of Action Against Cancer Theraphy (PACT)". make you try research de activities of dat body, you go find out say she fit do much more than de tings wey you itemize there. de connections wey she fit make go benefit her NGO immensely. but if you tink say her meetings no get any benefit for the NGO, na ya opinion be dat, my own opinion be say you wrong. either way, i sure say you agree with me say our first lady or at least her office deserve respect.
|
Kobojunkie:e be like say, i dey waste my time with you. take ya time o, time is money. na for where i talk say de NGO be de only ting wey she go do for de conference? de ting wey i talk be say, dat na her main reason to go there. she will also attend de other meetings with de rest of de delegation from naija. her presense go add small prestige while de rest of de technicians go iron out technical issues. shikena! tell me wettin dey intrinsically wrong with dat. |
Kobojunkie:abeg no make me laugh, you dey ask for source? ngwanu see de last paragraph of ya post, make I repost am here: Mrs. Turai would also hold discussions with officials of the IAEA on the agency's Programme of Action Against Cancer Theraphy (PACT) on behalf of her International Cancer Centre, Abuja (ICCA as well as inaugurate the Nigerian Embassy's website, before meeting the Austrian chapter of the Nigerians In Diaspora Organisation (NIDO).you tell us say de NGO na her own, meaning say she be a main sponsor, yet you dey ask me for source? give me a break. @folafizzle; kai dan iska ne. you be case ![]() |
Kobojunkie:I no tink say Turai go discuss any issues wey relate to rocket science or other technical issues for de conference and nobody expect say she go do dat. her main issue na to lobby for the said NGO and meet some of those other people wey you mention as de first lady of Nigeria. simple |
Beaf:ngwanu replace "Office of the first lady" with "ceremonious Position of the first lady". before i continue to discuss dis issue with you, i want make you go find out whether de NGO wey Turai go lobby for, International Cancer Centre, Abuja , na worthy cause. before you conclude, just remember say, na fellow nigerians wey get cancer dat center go benefit. de cause dey bigger than Turai or even dis conference. |
Beaf:you fit call me any name wey you want, but me i prefer not to get personal because if i jam people like you for road sef, you go faint before i talk. again, what is intrinsically wrong with make una respect de office of our first lady, even if una no respect e lady. first lady go conference to go drum up support for worthy NGO, una dey here dey talk rubbish. una get any idea de things wey de NGO dey do, una know how many lives wey their activities don save? make una get real abeg. |
Today for Abuja: Mallam go buy dollar: N156.5 Mallam go sell you dollar: N158 |
nethacker:ol'boy/gal, you dey funny, but you no make any point wey worth comment. Beaf:Beaf, e be like say you be character, i go tell you which kind soon enough, and by de way, na wettin be jjc. but in all seriousness, many a first lady dey represent their husbands for dis kinds of conference. e dey disrespectful to begin bad mouth Turai because she dey perform her duty as first lady. every fool know say she no be nuclear expert, i confirm dat fact because, you sef imply de same ting - i sure say you no be albert einstein. ![]() i go repeat myself, make una begin organize politically, if una get de smarts to organize and drive yar'adua and pdp comot for office. if una no fit respect de first lady of our dear country, at least make una show small respect for de office of first lady. shikena |
Beaf:Beaf, I no get patience for people wey get groundnut sized brain o, i don warn you now. i go advise you make you sef begin organize to vote dem comot for office to show ya frustration, no come here dey disrespect our first lady. we know say some of una dey come from ghana and other puny states, come dey take style insult us here. |
nigerians be nigeria's worst enemies. many people wey dey comment here dey too lazy to find out whether our Nuclear experts dey attend de conference as well. Turai no go attend de technical sessions, but una dey here foolishly dey make assumption. de report wey original poster site wrote dis: Mrs. Turai would also hold discussions with officials of the IAEA on the agency's Programme of Action Against Cancer Theraphy (PACT) on behalf of her International Cancer Centre, Abujaall her meetings na in her capacity as first lady, and she get vested interest for de International Cancer Centre way dey for Abuja. noting wrong with make she go lobby for research money and tools. the technical experts wey follow go de conference go handle the technical aspects. make una leave Turai alone. if una no like de government, make una organize and vote dem commot for office. |
naijaking, you still dey act like say you no understand wetting i dey talk since, ko? well i no believe you. Hear you: When Sanusi began to act recklessly with people's money, concerned shareholders like me ought to take notice de issue wey i get with you be say, you no take notice of de recklessness of the CEOs with de same enthusiasm wey you take dey criticise sanusi and cbn. thus, reasonable people go conclude say your reaction dey unbalance and was probably tribal based. i don tell you before, if you balance your write-up well well, you no go hear from people like me. I stilll dey watch you. |
naijaking1:na de bolded statement wey i don dey try extract from you since. de wey you dey come across dey make people like me tink say you no want make anyone hold de CEOs accountable. your disagreement na de method wey sanusi take handle de condition wey him see for de banking industry. Time will tell whether Sanusi style get wisdom. I no get issue with you again. but i go dey watch you like hawk and go try help you balance your posts with moderation. ![]() |
Jakumo:Oga Jakumo, e be like say you don watch the cartoon movie, Robin Hood, na for there wey I first hear dis ya expression. ![]() |
naijaking1:naijaking, you don start dis ya dribbling like Maradona again. you dey try to minimize the size of de bad loans, right? you don forget say, CBN recover almost N70billion within 2 weeks, yet de banks still no get enough capital. nobody dey talk about crime here. why e hard you to admit say any bank CEO along with their directors of any bank, wey issue band loans to the tune of several trillion naira, should be held accountable? i no dey talk of criminal accountability o. be honest enough to say these CEOs bear some responsibiliies here. you fit disagree with sanusi methods, or de way way efcc handle de matter, but na only dishonest person no fit talk say these CEOs get culpability and share responsibility for the crisis. be man enough to admit that. i agree with you in a lot of the issues here, but try call a spade, a spade. |
naijaking1:naijaking, you dey mixup 2 issues in an apparent dishonest attempt wey you wan take put wool cover our eyes. de principle of presumption of innocense na good ting and up till now, no court don convict de CEOs of any finacila crime. court system go determine their innocense or guilt in due time. de second issue be say, regulatory agency (CBN) talk say these banks through their CEOs issue gazillion naira worth of non performing loans. as de loans don turn out to be bad loans, no be the CEOs and the board dey responsible? we no need court system to tell us this obvious fact. non of de CEOs dispute say dem give out de loans, they all gree say de loans dey bad. na de CEOs make bad decision and na their responsibility to safeguard depositor's and sharholders funds wey dem don abdicate. dis issue dey too plain and simple and I no understand your stance at all. abeg help me understand. Note dat i no dey talk of de financial crimes allegations, but de bad judgements wey de CEOs make. I dey wait. |
naijaking, you dey accord de accused CEOs courtesy such as, make dem face courts bla bla bla. Their cases don enter court system already and court don grant some of dem bail sef. but why you no give me de same courtesy? you just accuse me say i get fake igbo name and call me Mallam. na so your justice be, right? you just dey assume tings without proof. one ting dey indisputable, if any bank's CEO and board members, for any bank anywhere in de world, give out loans, and de loans suck out de life inside de banks and vaporize deposits of ordinary people, to de point say na CBN loan de banks dey take operate; common sense go tell us say de CEOs and board of directors must be held accountable. firing dem na one such accountabiliy. cbn get legal right to fire dem according to law wey national assembly pass - at least until supreme court tell us otherwise. why e dey difficult for you to hold these CEOs and directors accountable? make you try explain dat one to me, maybe I dey miss someting. your due process excuse no hold water at all, because de court system dey handle the cases with due process. |
dem for don invoke spirit before na. spirit for don protect cecilia from arrest. anyway cecilia go soon come out on bail and plea bargain. i tink say these people be christians, why dem dey invoke spirits again. ![]() |
sealworld:when i read dis kind comment, i no get choice but to conclude say some people wey dey post here be dullards of the highest order. ok i gree say efcc never arrest some greedy politicians, but wettin dat one get to do with bank chiefs wey dem dey accuse of wrongdoing? your logic dey like de following: police arrest tief wey steal N100 from market woman, tief say police must release am because police never arrest de other tiefs wey steal N50,000 yet - tief come accuse police of hidden agenda!! hello!!!!!! |
naijaking, i like de passion wey you take dey defend ya position, keep it up. we go see whether in de long term, you dey correct. if time prove say your judgement dey accurate, i go come back praise your wisdom. in de maintime, one of de people wey dey dear and near to ya heart, Ogbeni Erastus Akingbola don go report to UK police o. maybe you never see de thread, but i dey wait to see your perspective on the report. e be like say, Akingbola dey implement him own due process well well. oya, we dey wait for ya reaction. |
eeeyaah, dis man get integrity no be small. person wey carry himself go police station must not be guilty. de only problem be say, UK authorities no dey look for am, yet. why him no carry him personal jet, fly zoom, go Lagos? i sure say efcc for gi am executive treatment. potential barawo banza. |
naijaking1:I admit say i guilty small of laziness because i no check de tory for bbc and reuters. my post just suggest say make people look objectively at things. However, people like you dey only look at issues from tribal lenses, dat no dey helpful and in fact e dey irresponsible. Just in case you dey ignorant, de banks wey dem bailout for your USA, experience de same letter of credit issue. correspondent banks wey dey handle banks other than the 5 banks no get reason to refuse any letter of credit. if you be correspondent bank, e dey prudent to verify say any of de 5 banks fit still honour their letters of credits, especially de ones tendered by businesses wey dey owe billions of naira. if una no know, many of de defaulted loans resulted to the issuance of these letters of credit, so if any bank no honour dem until dem receive reclarification, na prudent thing. dis no be tribal matter at all. de thing wey dey happen go clean up de banking industry and by de time wey dust settle, Nigerian banking institutions will be better off, foreign investments go flow. abeg, Abokina, post me the Reuters and bbc link about the tory. I don search and no other reputable news agency carry de news. if you no fit show me de links from Reuters or bbc, den i go assume say dis report dey almost criminal as de effect of dis kind rumours no good at all. I dey wait for ya links. |
dgreatrock:i now know say you no dey serious. if person be CEO of an organization, no be dat person get responsibility for de safeguarding of depositor's monies? if CEO and him board make loan decisions wey bring de bank to its knees, no be de CEO and de board wey responsible? if you no understand dis simple fact, why you come here dey argue? I know say you sabi de truth but just dey play with people minds here. you no fool me at all. de only sense wey you make na to suggest say make we wait until courts make determinations of culpability. I agree with dat one, in de maintime, CBN deserve benefit of de doubt. since you talk say you know my identity because someone call me Mallam, me sef go assume say you be one of de beneficiaries of de non performing loans. efcc dey look for you ![]() |
na de same news paper wey dey agressively defend de CEOs wey EFCC arrest don begin publish de kind irresponsible article wey dey confuse people and wey no reflect the real truth. i go warn una make una use good judgement as una dey process news. make una remember say dis same guardian newspaper is owned by non other than the Ibru Group. And who be one of de most prominent CEOs wey EFCC arrest? non other than Cecilia Ibru! |
why some of una una dey compare Ghana to Nigeria? There is no comparison na. if dem yab us too much make we just go annex dem def. Some of our people sef dey there, as indigenes, hausa speaking and yoruba speaking Ghanaians. For the record: Lovely naija population: 150million + ghana population: a puny 23million ( same as population of Lagos State) Lovely naija GDP (2008): $335.4 billion ghana GDP: puny $34billion i no go talk again, make ghana sharappp, shikena.
|
naijaking1:nwanne m, you don disappoint me small. de Mallam wey you call me, not once but three times, in my opinion, is not wettin we go call, term of endearment. you don dey display unexpected tribalism, if not racism. make you chill and be objective. try to understand say reasonable people fit disagree. having said that one, i go add say, if CBN and Sanusi no take action and dem allow those banks to fail, de tory for no good for de sharholders and directors alike. cbn tell us say de banks need serious capitalization because dem don empty their treasuries, you dey here dey talk say CBN make stupid mistake. You follow dem do audit? or you no believe say na loans from CBN wey been dey keep de banks afloat and without de loans dem go go bankrupt? as cbn don stop dem from running thier banks with loans, how you tink say de banks for survive if Sanusi no give dem lifeline of N420billion? I go give cbn and Sanusi benefit of de doubt. and as you talk time will tell. na de tribal lenses wey we dey take do analysis dey kill us, and you, of all people, wey get above average education still dey allow tribalism factor inside ya analysis. For that, I dey disappointed. |
I know say adebayo vex say Arsenal let am go, but de way wey de boy act today dey a bit unprofessional. why him go taunt Arsenal fans? him don make some permanent enemies be dat, de boy no get sense at all. him need to chill because, de boy dey only one injury away from being dropped like a smelly woman. Nkita ara. ![]() |
I remember 3 and a half years ago when dollar exchange rate na N147 for parallel (black) market. one and a half years later, de rate drop reach N117. Now de rate na N159. I tink say as niger delta dey under control and oil prices dey arround $70/b, de rate go drop. The important ting be say make we no get erratic changes, like N200 today, N170 the next day, and then N185 after, like de rate been dey fluctuate before dem replace Soludo. So far, sanusi don stabilize de rate, at least for de past few weeks, de changes no dey too erratic. |
many of you people wey dey criticise the article, need to remember say de author express him opinion and nothing more. for democracy, na him right be dat. if una get de ability make una go write una own article na; make una call am rejoinder. some of una remind me of retards wey no sabi kick football 20 yards, wey come dey criticize Arsenal coach because of substititution wey him make during a premiership game. at de end of the day, courts go determine whether na Sanusi or the people accused of financial crime go enter prison. make we wait and see. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 308 309 310 311 312 313 314 315 (of 315 pages)

my ears dey for ground
, maybe no be only me know your true ID Shocked