Nduchucks's Posts
Nairaland Forum › Nduchucks's Profile › Nduchucks's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 305 306 307 308 309 310 311 312 313 (of 315 pages)
naijaking1:ok, because i no wan read dat book wey i suspect say na revisionist history, I go concede one point. make we assume say the concept of araba don exist well before de 1966 coup. despite dat asupmtion, de araba wey happen for 1966 na direct reaction to the 1966 coup in my view. dem go bomb sardauna house for kaduna and sakwato, kill balewa, left igbo leaders alone; shortly thereafter araba start. na which other ting you tink say cause that particular araba, if no be de coup? @naijaking; i no go respond to ya other post, na distraction wey no get use. i know say una no believe in freedom. if i like, my name go be nnamdi. wettin concern una with dat. |
Onlytruth:i no know say you be immature person. i no go stoop to ya level, just think well before you come here with false information. people like me go call you out. learn how to disagree without being disagreable from people like naijaking. at least him no dey urinate for body and throw tantrum when his points are challenged. ewu can bia |
Onlytruth:i no be proud person, so if you give me facts I go accept ya correction. niger delta people, ijaw, ogoni, etc; say dem no be igbo, so you no fit force dem to be igbos. if oil dey for any part of south east besides niger delta area, make you name de area and i go apologise to you. i dey wait. i sure say you no go run away from de simple question. dis no be about tribalism. either oil dey for igbo land or e no dey. me i say oil no dey for igbo land, at least dem never find oil there. if I wrong, tell me where de oil wells of igbo land dey. |
gowaga68:we no go let revisionists come here to tell lies. you ask say na wetting cause araba? well, nothing like araba ever took place anywhere in the north before 1966. na after nzeogwu chukwuma carryout coup where dem kill the highly loved sardauna of sakwato, tafa balewa, and other northern leaders while sparing igbo leaders wey araba start. before dat time everybody lived in harmony me i believe say araba be direct result of dat coup. |
naijaking1:oh boy, make you no allow niger delta people hear you calling them Igbos. i don warn you. de onshore oil wey nigeria dey get na from niger delta people land. Igbo people no get oil for south east! |
someone mentioned araba. de sad ting be say, hausas, Yorubas, midwesterners, etc follow participate. de sad history be say, mob of people from all tribes except igbos participated in this particular lynching of igbos. if una come here dey talk say araba na atrocity wey only northerners carryout, una no sabi de truth. na one of de saddest periods of nigerian history be dat. |
naijaking1:oh boy, why you no fit discuss without spewing ya tribalism. try this one time OK. see ya statement wey i challenge here: naijaking1:you claim say muslim leaders no go like 2 party system because of numerical inferiority. i point out say for southwest, muslims plenty pass christians and dat moslems obviously outnumber christians for north. you fit disagree with census figures but most people know say, moslems plenty pass christians for nigeria. if to say you argue say dem dey almost even, i for reason with you sef. now tell us, na which authority or data wey you base you assumptions? I mean de assumptions wey you take reach de conclusion wey i quote above? no name calling, just tell me where you get de data wey you use. i no be proud person, if you prove me wrong i go accept am, but no bring untruths come here dey pass am as gospel. by the way, if you no sabi read pigin, i dey sorry for you. dat ya excuse don old. no use my pigin as excuse, especially when my arguement superior to ya own. |
where de relatives of dis woman na? make dem come save am, before savages and uncivilized mob kill am. na dis kind attitude wey dey make governing dis people quite a challenge! |
you don come again to dey attempt to dribble like say ya name be maradonna. de only ting wey you no like be say, i challenge ya conclusion and give you small hint as to why you are wrong. instead make you bring counter point to butress ya points, na tribal rants and religious bigotry you fit come up. i'm on to ya gimmicks! you no fit pretend say you no get my point. you begin shout muslim north, like say dat go help you make ya point. de fact remains dat, muslims plenty for nigeria pass christians. that was the issue of contention, all ya other rants dey completely irrelevant to the discussion here. so carry ya tribalism and riligious bigotry comot for here. |
naijaking1:why you like to discredit yaself with dishonest disinformation na? ya analysis and conclusion dey completely wrong as usual. even illiterates know say for southwest, muslims plenty pass christians and we know say de north na overwhelmingly muslims. so how you take reach ya own conclusion? my conclusion be say, you dey politically uncivilized. ya own savvy na to dey support the elite group wey you belong to. make you tanda for london or germany dey comment about possible political makeup of nigeria instead make you sef come run for office. many of una no get clue as to how government dey run for nigeria at all, una dey quite naive. |
Beaf:i know say una no like to hear bitter truth. i know de tings wey i see for warri, for a town wey get refinery and shell and government dey pollute their air daily, de people deserve much more. ya tribalism no let you see road again, ko? if na person wey come from south make de same statement wey i make, i suppose you for accept am. na dat kind attitude wey you get dey continue to keep una under servitude. olodo. |
i travel go warri recently and the pictures wey dey here are not helpful at all to de common people for warri. de roads wey me i see full of okadas and corrupt ak47 totting police officers manning illegal checkpoints. most of de roads dey for bad shape. i go inside market to go see mallams wey fit buy or sell foreign currency, but de houses wey line up de streets dey enough to make person cry. na poverty and desperation dey for people eyes. dem tell me make i hold my small bag well before somebody come try to snatch am from me. of course the living quarters wey shell oil company, establish for their employees dey OK. but from de tings wey I see, my conclusion be say, warri is a disgrace of a city! de leaders wey mismanage all de money instead of developing dat place need to be arrested. warri needs serious help, make una no try paint unhelpful pictures here. |
enemies of progress don start again. na for diaspora many of una go rot. |
why una dey waste time with dis kind article? nobody dey implicated here, especially yar'adua. de letter no mention president anywhere and all dem need to do na to say de document false and case closed. if government claim say de document fake, how sahara go prove am? sahara reporters and sowore need to grow up and take their journalism to de next level. many of their stories dey too journalistically uncivilized. de foolish government sef! dem forget say dem get sovereignty inside any of their embassies for any country. if dem wan catch el rufai, make dem just lure am say him passport don ready, but make him come pick am up or tell am make him come for another interview. once him enter embassy, dem go arrest am. shikena! nobody for dat government fit touch el-rufai or ribadu. ribadu enter nigeria dem no arrest am, una sabi why? na because if court case start, de accused go reveal damaging information wey fit bring de whole government down. |
naijaking1:see ya warped logic! soludo don deny publicly say him follow collect egunje. you accept de prima facie denial as gospel truth and undisputed evidence say soludo dey innocent! na now, i know say you no serious. everybody expect soludo to deny de allegations. but for you to conclude say de denial na evidence of innocence show say you be gullible person. truth be say, you sef be one of de elite wey dey benefit from loot. i sure say you no dey live with ogoni people and you no be trader for ariara market. |
Today for Abuja: Mallam go buy dollar: N151 Mallam go sell you dollar: N152.5 demand for dollar don drop o. naira de appreciate like crazy. |
@Beaf. ok, make we no derail de thread. i hope say you don realize say de bribery affair no be rumours as you been dey imply. i gave you newspaper account where sanusi talk say cbn and efcc go investigate, and as usual you no respond to dat post. i know say if i mention mend, de criminals, you go jump. do de right ting, admit say de soludo bribery allegation no be rumours. but if you dey wait make any nigerian court sentence soludo, if guilty, you go wait tire. |
Beaf:why you dey give me de kind credit wey i no deserve? e be like say i don impress you well well, you sabi say na small ting dey required to impress small minds ![]() btw, de day wey i hear say you and ya mend people don blow up one of de mansions of una thieving leaders, i go know say una serious. dis one wey una dey blow up pipeline wey dey result to more polution and possible cancer and other diseases for una people, makes no sense at all. amphibian vehicles dey on their way. |
Rooneyboy:make you no apologize because you express ya opinion na, me sef dey express my opinion. de ting wey intelligent people dey do na to bring counter-point if dem no agree with any post. i go appreciate if you express your disagrements with de tings wey i talk, make we discuss am as gentlemen/gals. i sure say you no be intellectual midget, so i dey wait to hear your points. i no go call you names yet until I read ya reply. |
Beaf:beaf, dis one no be rumors at all. read dis excerp from daily trust: The Central Bank of Nigeria [CBN] will shortly launch an investigation to determine if any of its past or present officials received bribes allegedly paid to Nigerian officials in order to secure contracts for the printing of polymer naira notes, its Governor Sanusi Lamido Sanusi said in Istanbul, Turkey yesterday. Sanusi, who is attending the annual summer meeting of the World Bank and International Monetary Fund, spoke exclusively to Daily Trust.go read de rest for daily trust web site. no smoke without fire. |
Beaf:beaf, na de same ting una talk when people say ibb tief money, same ting when dem say obasanjo sef carry money go, yet again una need evidence to carry Alams (de man wey run comot from london dressed like a woman) go court. na now i know say na inside bubble you dey live, i sure say no be for nigeria you dey. you people are so ignorant of what's going on. food for thought - if head of state wan move $billions wey him steal comot for naija na cbn chief go help am do am. if dat kind ting happen during soludo's term; who you tink say go charge am to court? anyone wey dey wait make dem charge soludo go court, go wait for a very long time. |
biggjoe:you say you understand, but your inference still wrong. it is not difficult to bring those people to book in nigeria, IT IS IMPOSSIBLE!!! if na lie I dey talk, name one ex governor, ex president, or ibori level criminal, wey una don bring to book. hope say you see de point wey i dey make. @naijaking1; you don take ya humour dodge me again you go answer my questions properly one day. I still dey watch you. |
biggjoe:oh boy, you sabi read at all? you sef answer my question: how many ex Governors, ex- Presidents, or any of your thieving elites have ever been convicted in your civilized Nigerian court system? una dey here dey talk of lynching and mob action; una don forget say, de tings wey ibori and the rest of de thieving elites don do una pass mob action. i suspect say you sef follow dem share inside de spoil. |
naijaking1:dat ya excuse no go work. we all know that you are brilliant enough to fully understand what you've been asked. biko nwanne m, stop hiding, answer de question. |
naijaking1:some people still dey bury head inside sand like ostrich. de above comment show gross ignorance of de modus operandi of de legal system for nigeria. people siddon for america or uk dey expect american justice for naija. according to de above logic, ibb, abacha, ibori, and others like dem, dey completely innocent and make una leave dem alone until naija court find dem guilty. una know say, so far, court don find many many of de thieving elite guilty. naijaking: ya homework be dis: name one ex governor, ex-president, or other thieving elite wey dem don convict of any crime for naija? |
Today for Abuja (Unchanged): Mallam go buy dollar: N153 Mallam go sell you dollar: N154.5 |
@naijaking1 and coolG; sooner or later wind go blow, fowl yansh go open. de ting wey I no understand be, why una no champion de cause of the ordinary niger delta people with de same vigor wey una take dey yap about ibori, soludo, or any of de elite wey don rob una blind? na people like una still dey wait for evidence say ibb and abacha steal any money from treasury. ![]() |
people like naijaking1 and beaf go soon come tell us say dis news na another means to bring about some northern agenda. dem go soon say una need to give Soludo due process since nobody don convict am for any court. Ibori sef dey innocent until court find am guilty. ![]() de ting wey I no understand be say, why dem no shout due process throughout de time wey de elites dey marginalize both de commoner of niger delta and de almanjiris of de north? |
[quote author=~Bluetooth link=topic=332028.msg4663575#msg4663575 date=1254641117]Check link http://www.thisdayonline.com/nview.php?id=156134[/quote]from ya link: "It took a lot of pleas from top government officials present and members of his entourage to get Tompolo summon up courage to make his brief speech at the event. Tompolo, who was billed to make a speech after the Defence Minister and Chairman of the Presidential Committee on Amnesty, Maj-Gen Godwin Abbe, (rtd), Governor Emmanuel Uduaghan of Delta State and Chief Tony Anenih had all spoken, became jittery, bemused and confused and could not put himself together to make the speech. Sensing that he was having problems with spoken English, there were suggestions to him to speak in his native language while somebody would translate from the audience. After about five minutes of dilly-dallying ,he managed the terse remarks." make una see de bolded part above o. illiterates like tomfoolu, dey fight noble fight courageously with their lives. mainwhile de educated ones wey be cowards dey hide for diaspora - defending their thieving governors, and bank crooks wey dem don catch red handed. these cowards dey shout due process all over nairaland defending thiefs. in de maintime, de irresponsible coward commentators never do a single ting to pressure state or federal government about de plight of de niger delta people. instead make dem do dat, dem dey use all their energy to support their elite brothers in banking thievery. when amphibian weapons and advisers reach naija from israeli in a few weeks, and so-called gbomo gbomo is himself captured, people go know say crime no get long life. make una see one of their leaders here dey threaten new war: [flash=400,400] https://www.youtube.com/watch?v=x44Xv8h5Mfs&color1=0xb1b1b1&color2=0xcfcfcf&hl=en&feature=player_embedded&fs=1[/flash] |
Fhemmmy:you fit do all dat na. for example if you open ya dom account for first bank, new york branch, you fit fund am from abroad and you fit do many transactions online. as for buying dollars from bank, if you submit all de paperwork and you get legitimate business reason, dem go sell you dollar for bank rate. |
mun gwode Allah! we tank God! [list] [li]ateke don surrender[/li] [li]tomfoolu go surrender on saturday[/li] [li]sanusi de sanitize de banking industry[/li] [li]oil prices dey stabilize[/li] [li]chinese money by the billions go soon enter nigeria[/li] [li]more foreign money go enter as investment for recapitalization of 8 banks[/li] [li]amphibian weaponry with advisers from israeli go soon land[/li] [li]imf sef talk say our economy dey grow[/li] [/list] wettin all these tings mean? happy days are ahead ![]() |
@poster, if na denounce, you wan denounce ya citizenship, you don denounce am already. but if na renounce wey you wan renounce am, you go need to go do am for courtroom. i advise you make you no go for nigerian courtroom for de renouncement - if you think small you go know why. ![]() |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 305 306 307 308 309 310 311 312 313 (of 315 pages)



