Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,726 members, 7,809,770 topics. Date: Friday, 26 April 2024 at 02:35 PM

NewsinPidgin's Posts

Nairaland Forum / NewsinPidgin's Profile / NewsinPidgin's Posts

(1) (2) (3) (of 3 pages)

Romance / See Cute Couple Wey Just Marry For November Don Die Throwey For Accident by NewsinPidgin(f): 7:03pm On Feb 05, 2018
Dis one na very sad news as e don turn black February for the family of Mr and Mrs Ehimen Ifijeh. Sotey people wey no even sabi dem dey cry, dey roll for ground... Even dey ask Baba God why dis kind thing go do these fine couple.

D pictures of dia engagement bin dey everywhere for internet last year and na so everybody dey like like dia picture and based on say d guy sef kon get Baby face.

Mr Shadrach Ehimen Ifijeh bin marry him fine chocolate candy wife on the 18th of November, 2017 wey be say e never even reach 3months.

But na so dem kiss d world bye bye dis weekend as d two of dem kpai for accident.

According to one of dia close padi dem, she yan say Mr and Mrs Ehimen wey she like to dey call JoJo and Shady bin dey go wedding for Warri before dem kon go get accident wey carry dia life.

Everywhere for internet now dey very sad as people just dey go dia Facebook pages go dey cry.

God go epp us o


RIP JOJO
RIP SHADY


Source: http://newsinpidgin.ng/see-cute-couple-wey-just-marry-for-november-don-die-throwey-for-accident/

Education / Police Don Arrest Uniuyo Sug Presido And Oda Nans Members For Attempted Murder by NewsinPidgin(f): 11:04am On Nov 28, 2017
D Bayelsa State Police Command don arrest three suspects wey get hand for d death of one Magam Elvis wey be student of d University of Uyo during elections for coordinators of d National Union of Nigerian Students (NANS) wey bin hold for d Federal University Otuoke over d weekend.

D police follow confam say dem get for dia custody eight students including Bayelsa NANS President, Perewari Benjamin as him bin dey involved for armed robbery and cultism.

State Commissioner of Police, Mr Asuquo Amba wey parade d suspects on Monday for d Command headquarters yan say e det very bad say elections wey dem bin wan do for NANS coordinators kon turn bloody.

According to am, for situation where students wey dey represent universities and higher institutions for d South- South zone kon dey use fire arms wey lead to d death of one student and students kon dey involve diaself for robbery against innocent citizens’ call for great concern.

Amba say him dey very disappointed based on say even as dem deploy plenty security go d venue of d elections, dem bin still fit smuggle firearm wey kon kill another student, while another one escaped.

Him say dem arrest five suspects wey be Akpan Esuabanga Okon, Aaron Wisdom, Duff Gabriel Enyeneokpan, Etefia Otobong Harrison with Akwaoso Uwankmfon and say all of dem na University of Uyo students as dem bin wan kill one Tonye Samuel of University of Port Harcourt during NANS registration for FUO.

“ On Sunday, d Command bin deploy 11 patrol teams kon join with d Army/NSCDC/Otuoke Vigilantee/ University Internal security go FUO premises to go provide security for d NANS national elections. D Vice- Chancellor, FUO, Prof Accra Seth Jaja bin don addres all d students say make dem dey law abiding and say only delegates wey don dey accredited go fit enter d hall for d elections. Later na so we hear gunshot from d crowd outside d hall. Na so one Magam Elvis of University of Uyo die as a result of bullet wound injury. Dey don carry him body go put for mortuary for autopsy. Dey don arrest three suspects, Emmanuel Ebere, Obiakarije Innocent and Inbong Okon Ben for suspected murder”

Amba follow yan say Benjamin wey be NANS Bayelsa Presido, with seven other suspects from Niger Delta University, wey be Asari Enagob, Suoguai Bina, Ibe Ogbonna, Igbanibo Tari, Ekperi Kenneth, Kemefie Ebimene and Chukuma Lawrence from Imo State Polytechnic hijack one commercial vehicle from Ayo Kehinde, kon rob am of him Tecno phone and N50,000 cash.

Him still open up say dem collect two locally made single barrel pistol, two live ammunition, five.9mm live ammunition and two charms were from d suspects.

Amba kon assure say dem go charge d students go court when dey complete dia investigations, kon beg parents say make dem discourage dia pikin dem from crime as d Police go make sure say criminals face d full wrath of d law.



#confamtori



Source: http://newsinpidgin.ng/police-don-arrest-uniuyo-sug-presido-oda-nans-members-for-attempted-murder/
Education / Dey Don Kill One University Of Uyo Student For Nans Convention For Bayelsa by NewsinPidgin(f): 10:10am On Nov 28, 2017
Dem shoot one University of Uyo student kill am yesterday for d Zonal Convention of National Association of Nigerian Students (NANS) Zone B, for Bayelsa State.

As informate take carry am, d student name na Elvis, aka Jega and him na Diploma Law Student. Na so dem shoot am during accreditation of delegates for d Federal University, Otuoke, Bayelsa - wey be wia dem do d Zonal Convention.

Reports say na when d factional members of d NANS Akwa Ibom contingent bin dey get quarrel during accreditation of delegates, na imm dey shoot d guy kill am.

Dey kon later rush am go hospital, na dia dey kon confam say hin don kpai.

When dem contact Bayelsa State Police Public Relations Officer (PPRO), DSP Asinim Butwat, him confam d gbege kon talk day dey don follow arrest d oda members of d University of Uyo/Akwa Ibom delegation.

More details dey waka for road dey come.

#insideuniuyo

#NANS #NigerianStudents #Convention


Source : http://newsinpidgin.ng/dem-don-shoot-one-uniuyo-student-kill-am-for-nans-zone-b-convention/

Sports / Super Eagles Match With Zambia No Go Hold On Saturday – Angry Akwa Ibom Youths by NewsinPidgin(f): 10:55am On Oct 06, 2017
Up to 200 youths for two communities don threaten to stop d Super Eagles match against Zambia on Saturday.

Youths for d two communities, Obio Etoi and Obio Ofot, where d Godswill Akpabio International Stadium, Uyo dey, don swear to scatter everything for d World Cup qualifying match wey Nigeria and Zambia go play dis weekend.

Dey want make d Akwa Ibom state government fulfill dia promises to dem if dey want make d match go on in peace.

Youths from d communities wey reach about 200 with plenty placards yan say even as dem get dat kind fine beautiful stadium for dia side, say plenty members of d communities still dey unemployed, many of dem go get wetin to do while d state government no gree construct roads inside dia communities as dem bin agree before dem build d stadium.

Sunday Peters, wey be d youth leader of Obio Etoi village, wey lead d protesters, yan say since 2011 when Julius Berger start work for d stadium, d villagers no get anything to show for am.

Him talk say;

“D company bin block all diversion ways to d community with dia heavy equipment and machines, and at some point we bin sell our land to maintain d road. Na why we dey cry to d state government and we go continue to cry until dem do”.

As him take put am, because of dis tin wey Julius Berger do, d communities around d stadium don become flooded as most water ways don dey blocked by dia equipment. Eteidung Ezekiel Inyang Ekott, wey be d village head of d Obio Etoi, kon talk say d youths’ action no be to disturb d Super Eagles’ match wey dey come d communities, but to attract government attention to dia promises to d communities.

Him talk say dey bin don send plenty letters already from him palace to d state government to remind dem of wetin dem dey face for dia communities but dey don ignore dem.

Ephraim Inyang, wey be d state Commissioner of Works, wey come d protest venue with Charles Udo, wey be d Information Commissioner, talk say dem bin don mark d road for construction. Him still talk say dem go soon start work for dia in a week time.


#confamtori

Source: http://newsinpidgin.ng/super-eagles-match-with-zambia-no-go-hold-on-saturday-angry-akwa-ibom-youths/

Education / Uniuyo Don Change Dia School Fees/ Course Registration Website by NewsinPidgin(f): 12:01pm On Oct 05, 2017
University of Uyo, wey dey Akwa Ibom State, don change dia payment and course registration website for 2017/2018 session, as dem talk say, e no go dey available for d portal wey e dey before.

Dem don talk say any Student wey wan register or pay school fees, make hin visit, ePortal.

Uniuyo management don talk say, make any person wey get questions, complaint, enquiry go school portal office, wey dey dia town Campus.

#confamtori

Source:http://newsinpidgin.ng/uni-uyo-don-change-dia-school-fees-course-registration-website/

Romance / Woman Who Paid Man To Marry Her, Threatens To Stop His Wedding (photos) by NewsinPidgin(f): 10:10am On Oct 05, 2017
Kata Kata don dey for Facebook just yesterday night as one gospel artiste, Patience Akpabio comot for Facebook kon tell d whole world say another lady, Owoidoho Johnson bin pay one Maike Francis to marry am and now d guy wan marry anoda woman, wey her name be Deborah Nkorok.

Dis Pat Akpabio na Godswill Akpabio wey be former Governor of Akwa ibom state, sister-in-law as she marry him brother and now, people just dey rush enter her facebook wall to go check who she dey talk about.

She tell d lady say she dey desperate and coward, kon talk say her money no fit do anything and say nothing wey she do go stop dis Mike and Deborah wedding.

But now, d question na shey Brother Mike collect money from Sister Owoidoho hand to marry am?

see d screenshots for here:

#confamtori

source :http://newsinpidgin.ng/pat-akpabio-don-threaten-one-lady-with-her-facebook-post/

Celebrities / Re: Timaya Don Call Eedris Abdulkareem Idiot Fool For Ig by NewsinPidgin(f): 12:57pm On Sep 29, 2017
nikkypearl:
Who is Idris again

Hahahaahaahaaa... Google am na
Celebrities / Re: Timaya Don Call Eedris Abdulkareem Idiot Fool For Ig by NewsinPidgin(f): 12:52pm On Sep 29, 2017
Day11:
Timaya...Thats my man

Na so!
Celebrities / Re: Timaya Don Call Eedris Abdulkareem Idiot Fool For Ig by NewsinPidgin(f): 12:51pm On Sep 29, 2017
Oluwasaeon:
Lol Mr Kogberegbe
No time...je kan mo

I dey teh you... Him no get joy at all
Celebrities / Timaya Don Call Eedris Abdulkareem Idiot Fool For Ig by NewsinPidgin(f): 12:43pm On Sep 29, 2017
Recently, we don see as Eedris Abdulkareem dey insult we Naija artistes dem. . . Him insult Tubaba, Dbanj, Patoranking and plenty odas. Now, na Timaya hin enter.

But Timaya don comot for IG about 40mins ago tell am say him na fucking idiot.

Ti maya open up talk say him bin be Eedris backup artiste, him dey pay money by himself go shows and say Eedris bin dey treat am like nobody.

Him still tell am say make him go find work do. . . Say y him just dey hate on people?

Watch d video for here;

http://newsinpidgin.ng/timaya-don-shut-eedris-abdulkareem-up-call-am-idiot-fool/

#confamtori

Politics / Magnus Abe Na Our Lionel Messi For Guber 2019 - Rivers APC Leaders by NewsinPidgin(f): 12:07pm On Sep 29, 2017
Magnus Abe Na Our Lionel Messi For Guber 2019 - Rivers APC leaders

Big Big APC Oga dem been gather yesterday for Pitakwa (Portharcourt) for one ogbonge waka wey dem call #TheMeeting. APC party people from every corner for Rivers state and delegate wey dem invite been come fully to put head together base on how dem wan make 2019 Rivers Governorship election be, Even sef , Lawmakers wey dey represent people for state and for Abuja, before before Commissioners, Special Advisers, Local Government Chairmen and plenty plenty people wey get say for Rivers state politics matter as dem put ear for ground , hear as things dey go on for the party from 23 LGA wey dey the state.

The people for #TheMeeting still come agree oh say make the APC for the state make dem dey on dia own, make dem no allow any body push dem around, make dem allow anybody wey get ambition make e come out, base on dis dem take time call our Senator Magnus Abe, make him come contest as Governor for 2019, say Magnus na d only person dem believe say go fit do d right thing for Rivers state.

Hear d gist …

One Ogbonge Oga for Rivers state wey be Senator Wilson Ake, follow talk say

People wey follow Magnus Abe na people wey don decide to follow truth, say for 2015, we go pitch, come bench our own lionel messi, we come loose, dis time again for 2019 we don get another match, and the coach dey yarn say we go bench lionel messi again, we go gree that kain coach ? e no dey possible to bench messi for match wey you wan win, Magnus Abe be our Lionel Messi and we go support am , say e no be crime to support magnus and anybody wey say na crime no sabi wetin him dey yarn.

Another Oga wey be Lawmaker for National Assembly still chook mouth join wetin other people dey yarn say Him dey speak on behalf of every body wey dey for National Assembly , say nobody fit kill Magnus Abe ambition,say make nobody deceive anybody.



Oga Allwell Onyesor follow talk say

Magnus Abe na capable politician wey dey sabi wetin dey for dis 21st century, we dey call am make him come run as governor, say time to waste no dey again

#TheMeeting still come yarn say dem dey tell God thank you base on how him take keep Oga Presidoo as him return from him medical trip as dem agree to dey loyal to the party and the country as we go celebrate our 57 independence anniversary.

Source: http://newsinpidgin.ng/group-ginger-magnus-to-run-for-governor/

Celebrities / Peter Okoye Calls Himself An Upcoming Artiste, Tells His Bro To Stop The Shades by NewsinPidgin(f): 10:45am On Sep 29, 2017
Peter Okoye don comot about 40mins ago for Instagram to tell him brother say him don move on. Say make him allow am get peace. Say him no get any beef with am o.

Dis one na him reaction to d tweet wey him brother, Paul, put for Twitter.

Him screengrab Paul post kon write things under. See am for here;

Education / Anambra State University Don Turn Robbery Zone by NewsinPidgin(f): 2:00pm On Sep 26, 2017
Anambra State University (ANSU) don dey get record of robbery cases as students wey go house unto d strike don come back dey lament as thieves don move almost everything comot for dia room finish.

One of d students wey him name be Kevin Andre come back yesterday only to see say hin house dey disorganized and him tins no dey again.

Na so him go Facebook go post pictures of d window wey dem break open to move hin things.

For Facebook, Kevin Andre write say;

ANSU don finish me, person get mind rob me, my bed, my wears, my bags, my kitchen utensils, my documents, even original waec result and my school fee receipts.
Dat person no fit ever succeed for dis lyf. ���

Na so people kon dey drop comments, some follow talk as dem rob dem too.

Abeg, dis one no gel at all... Make AKSU do something about d security of dia students.

#confamtori


Source: http://newsinpidgin.ng/anambra-state-university-don-turn-robbery-zone/

Celebrities / Wizkid Don Enter Guinness Book Of Records 2018 by NewsinPidgin(f): 11:49pm On Sep 21, 2017
Wizkid na 27-year-old Nigerian singer, him follow kon be songwriter. D real name wey him papa and mama give am na Ayodeji Balogun, but everybody know am as Wizkid as na him stage name be dat and dey don already put am for next year edition of Guinness book of records.

Dis record come so unto d hand wey him get for Drake ogbonge single, One Dance. D single bin tight and e break record.

#confamtori

Source: http://newsinpidgin.ng/%e2%80%8bwizkid-don-enter-guinness-book-of-records-2018/

Education / Re: University Of Uyo Begins Post-Utme Screening Exercise Today by NewsinPidgin(f): 10:10am On Sep 19, 2017
joey4sheva:
How did today's own go?


me na blogger... no be me screen dem my broda
Education / Re: University Of Uyo Begins Post-Utme Screening Exercise Today by NewsinPidgin(f): 9:46am On Sep 18, 2017
ubongoton:
Am in Fu*k Asap

Wetin happen?
You bin think sat dem postpone am?
Education / University Of Uyo Begins Post-Utme Screening Exercise Today by NewsinPidgin(f): 9:22am On Sep 18, 2017
[center][/center]For d weekend wey pass so, plenty people don dey carry info up and down say Uniuyo don shift dia screening exercise go anoda day unto d ASUU strike and based on say plenty plenty oda schools, even Unilag sef postpone dia own.

I hope say some people no go shock when dey hear say d exercise still dey and na today, 18th September na imm Uniuyo dey start dia own.

Newsinpidgin media bin dey Uniuyo live dis morning and even hold up sef dey Ikpa road wey d school dey unto say students full everywhere dey wait make dem open gate. Students full both the First gate and annex gate. . . But d main gate bin dey closed and dis na unto say dey want make d students follow one route enter d school premises so dem go search dem well dey sure say dem no be thieves as nowhere dey safe again.

Na brown envelope just full everywhere as all d candidates dem carry dia files dey wait. No be small money market people go make today like dis ehn. If you dey find business to do, rush down go Uniuyo gate go sell brown envelope, na him dey sell from today o.

I follow some people wey no be Post-UTME candidates talk and dem yan say before dem fit get access to Uniuyo, dem gatz show ID card and tell d security people wetin dem dey enter d school go find.

Dem bin don tell d candidates dem say make dem dey dia screening venues for 8:00AM for d dates wey dia faculties give dem.

D screening dates and venues of d candidates dey d Post-UTME Registration Slip wey dem print comot.

Wetin dem tell d Candidates to carry come for d screening exercise na:

1. One Passport Photograph (Red Background )
2. Post-UTME Screening Registration Slip
3. Original JAMB Result Slip
4. O'Level Certificate (Original & Photocopies)


We for Newsinpidgin wish all d candidates success for dia screening.


#confamtori

Source: http://newsinpidgin.ng/uniuyo-post-utme-screening-don-start-today/

Politics / Akwa Ibom At 30: All You Need To Know About Orange September by NewsinPidgin(f): 12:39pm On Sep 15, 2017
Orange September na plenty plenty events wey dem don line up to showcase d diverse and sweet colours of Akwa ibom collective history, Unity and d plenty handwork wey we get.

Na unto say Akwa Ibom state go clock 30years dia year, na him d State Ministry for Culture and Tourism launch d #OrangeSeptember campaign to take mark Akwaibom state birthday.

Una remember one of our posts wey carry about 90men wey dem paint orange wey waka round d state, na still unto d Akwaibom at 30 matter.

Dey don line d events to be 6 days of better jollification and excitement. Na d list of events with dia dates and venues dey here so:

16th Sept orange Festival

17th Sept Dise Exhibition

18th Sept Ibom Food Fest

19th Sept Orange Music Fiesta

20th sept styles of Akwa Ibom

22nd sept Ndoko Akwa Ibom

You fit go www.orangeseptember.ng to get more informate. Follow dem on Social Media; Facebook @AKSOrangeSeptember, Instagram: @OrangeSeptember, Twitter: @OrangeSeptember_aks


#confamtori

Source: newsinpidgin.ng

Romance / Re: See Naija Babes That Cannot Marry A Man That Earns 35k by NewsinPidgin(f): 9:22am On Sep 13, 2017
sluvy4tune:
Even me sef


I no fit marry woman wey dey earn 35k


Truth is that we should always be what we desire

I told a lady sometime ago that I cannot marry a poor lady and she called me a gold digger

Haba Anty is not even Your Own gold am digging oh



Hahahaaahaaahaaaa... Na wetin person want, him dey get sha
Crime / Re: Director In Lagos Ministry Of Youths Commits Suicide by NewsinPidgin(f): 4:40pm On Sep 12, 2017
Make God EPP us o... I no say e no easy sha but suicide too much na
Romance / Re: See Naija Babes That Cannot Marry A Man That Earns 35k by NewsinPidgin(f): 3:31pm On Sep 12, 2017
favourmic:



You know weting i dey talk nah cos laides ehn nah problems

Guys sef get dia own for body o
Religion / Former Catholic Priest, Rev. Patrick Edet Is Getting Married by NewsinPidgin(f): 3:30pm On Sep 12, 2017
Founder of Grace Family Outreach, Rev. Patrick Edet go soon say, “I do”. Info wey dey reach Hinteractive Nigeria from d grapevine don open say d Former Catholic priest, wey just resign him Catholic priesthood, dey follow prepare to take things go forward as him wan resign from celibacy, wey be doctrine of Catholic Church wey forbid priests from marrying.

One very close family member of Rev. Patrick Edet wey say make dem no reveal him face o yan Hinteractive say d famous clergy don dey for romantic relationship for some time with perform wey she don confirm to be Rev. Edet’s heartthrob.

D sourve dey live with Rev. Patrick Edet and d person still yan say d would-be bride don dey come find d preacher on a norm for a very long time now. Our informant don refuse to reveal him girlfriend identity and when d wedding go take place.

D source yan say:
“Wetin I fit talk na say my brother go soon marry. When and where him go do am, nobody never know”

Dey don make efforts to reach Rev. Edet ontop dis matter but all d plans don fail as d preacher no gree grant interviews or reply him messages.

When Rev. Patrick Edet first announce him resignation from Catholic priesthood, plenty mouth bin don argue say hin na ‘rebel’ and him dey do am so him go fit face him love life.

Many analysts bin support d argument say Rev. Patrick go walk down the aisle but no one expect am to come very soon.

Info wey Hinteractive Nigeria get na say d wedding bells go ring sooner dan we expect.


Source : H!nteractive Exclusive

Read more for: http://newsinpidgin.ng/%e2%80%8bformer-catholic-priest-rev-patrick-edet-wan-marry/

Romance / Re: See Naija Babes That Cannot Marry A Man That Earns 35k by NewsinPidgin(f): 3:22pm On Sep 12, 2017
midehi2:
See their faces, I hope they earn more than that


If kids like this are saying such, then men are in trouble grin

Lol... I no know o
Romance / Re: See Naija Babes That Cannot Marry A Man That Earns 35k by NewsinPidgin(f): 3:22pm On Sep 12, 2017
vingeophysicist:
BUT I ONLY SEE KIDS OOO.I SEE NO ADULT

Lol... Check well
Romance / Re: See Naija Babes That Cannot Marry A Man That Earns 35k by NewsinPidgin(f): 3:22pm On Sep 12, 2017
beatcoins:
These ones are the lost ones of this generation. They dont even know the role of a woman in a home. You think say marriage na to get man wey go buy you phone & makeup abi? Continuu

Abeg come EPP me preach give dem.
Romance / Re: See Naija Babes That Cannot Marry A Man That Earns 35k by NewsinPidgin(f): 3:21pm On Sep 12, 2017
Evaberry:
This 35k story again

E no weak you as e weak me?
Romance / Re: See Naija Babes That Cannot Marry A Man That Earns 35k by NewsinPidgin(f): 3:21pm On Sep 12, 2017
favourmic:
in Nigeria now guys cannot ask girls .."HAVE U EATEN" in Nigeria again...Cos when u do.. What u will hear is.. "Nope... I am broke.. Don't even have food stuff..Right now i borrowed my friends phone to chat with u.. No money to fix my phone ... I used my money to do a business and they duped me I don't know how to get the money back, All my friends that I trust Disappointed me and I don't want to look like I am a beggar but I really need help now.... Anything u can send... Will send my account number to you now... Or I can come for the weekend if u send transport fare"
..My brother she didn't ask what's the problem of your generation...Do you want to kill him, pls direct your problem to GOD..


���
Bros, you dey talk like say you get experience

1 Like

Romance / See Naija Babes That Cannot Marry A Man That Earns 35k by NewsinPidgin(f): 2:49pm On Sep 12, 2017
Serious gbege and wahala don dey Facebook especially for d Akwa ibom community as people just dey yab demselves, dey throwey harsh words based on say some girls comot come kon talk say dem no fit marry guy wey deg earn ordinary 35k.

One babe for Facebook wey be Abang Maryrose comot kon write say:

"Shey you fit marry guy wey dey collect 35k as salary per month?
As for me ehn, I no fit even date dat kind guy. . . 35k wey no fit even buy my phone.
Ladies, wetin una think o?

Na so anoda babe wey her Facebook name na Peace Mitchie Oluwatuyi follow comot write say;

If you fit marry man wey dey collect 35k per month, God go give you dat one o. Even my Bible talk say God no go give me wetin I no fit handle. I no fit handle 35k salary man, you wey fit handle am, carry go! God go give you iyeh?

See d screenshot for here:

Source: http://newsinpidgin.ng/some-girls-don-talk-say-dem-no-fit-marry-guy-wey-dey-earn-35k/

Celebrities / Re: ​bobrisky Don Talk How Him Get N15million To Take Do Him Birthday by NewsinPidgin(f): 1:01pm On Sep 12, 2017
cummando:

For this mumu case I blame the mama.....funny enough I sabi the stupid boy from small...

You dey call am boy? Him na chic o

1 Like

Celebrities / Re: ​bobrisky Don Talk How Him Get N15million To Take Do Him Birthday by NewsinPidgin(f): 11:33am On Sep 12, 2017
cummando:
This is why abortion take style good sometimes


��������
But na una go still condemn d girls wey do am o.

1 Like

Celebrities / Re: ​bobrisky Don Talk How Him Get N15million To Take Do Him Birthday by NewsinPidgin(f): 11:33am On Sep 12, 2017
DjAndroid:
I spit on him!


Lol..Him sha dey make him money o.
Celebrities / Re: ​bobrisky Don Talk How Him Get N15million To Take Do Him Birthday by NewsinPidgin(f): 11:32am On Sep 12, 2017
NOC1:
Inukwa, I pray my babe do not read this post she might decide to be stingy with her thing. mtcheeww, i pay her above 40k monthly if she go stingy i save my money till i find another babe.


������
Bros, hold your babe tight o.

(1) (2) (3) (of 3 pages)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 73
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.