₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,331,276 members, 8,449,527 topics. Date: Tuesday, 21 July 2026 at 10:51 PM

Toggle theme

Nigerialabalaba's Posts

Nairaland ForumNigerialabalaba's ProfileNigerialabalaba's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 74 pages)

InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba:
Agbalowomeri:
Na like this Ololo take start o grin
How u take know say no be ololo dey whine una sef?

Dem don dey recommend Ololo to mentor am to start yeye hedge fund nah.

Pesin wey no sabi ololo and wey no sabi dis format awesomej dey use na su egbe as fela talk am.

If hin fit double money, e no go dey hustle dey market am here. Na so hin hustle full every page hia for nsempa. If na my aunties dey do dis kain tin, osita go don remove dia wig sef.

Wen locomotive dey hustle japaul to carry people go where dem no know, una dey drag am taya. Now awesomej dey show audio massive 'profit' screenshots yet still dey hustle for more funds & dey enjoy support from hin paddy paddy here, u just call ololo but u no call awesomej out wella or report am to mods.

Before pesin dey believe anybody wey dem talk like awesomej dey flash screenshots, make una remember say nobody fit form Van dame for dis market. Many high and mighty don collect. Some go jail while some kpai and carry people's money go yonder.

Late Okumagba wey get almighty BGL collect wella so tey market humble am and put am for jail before hin kpai sef.

No go troway ur money o. Every mallam na d CEO of hin kettle. Dis place na faceless forum, no believe any pesin wey dey show u screenshots of audio money for hin portfolio o.

Snake oil business kolewek hia o. Igi pawpaw o ni wo pawa o

+-+

PoliticsRe: Former President Muhammadu Buhari Returns To Kaduna (Photos & Video) by Nigerialabalaba: 1:56pm On Feb 28, 2025
naptu2:
Buhari Sallau @Buharisallau1






Bashir Ahmad @BashirAhmad



https://x.com/BashirAhmaad/status/1895184829483720763?t=ywA1Q63l9bEaJ4St01aKfA&s=19[/quote]E don talk am before say na KD him go retire
InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba: 1:50pm On Feb 28, 2025
ositadima1:
You have no idea what is going on. The only reason Ukraine has lasted this long is because of U.S. backing. It is the U.S. that has been supplying them with weapons, sanctioning Russia, and spreading anti-Russian propaganda through the media. The U.S. was practically doing everything for Ukraine.

Now that U.S. policy has changed, the war is over. It was the U.S. that pushed them into fighting in the first place. Ukraine cannot defeat Russia—just compare the size and resources of both countries.

As I said, very soon, most of the sanctions imposed by the U.S. will be lifted, and Russia will once again be allowed to flood the market with oil. Let’s watch as things unfold.
Nigerialabalaba:
U never get update.

Ukraine no dey fight to win again. Na to dey destroy Russia oil assets to keep oil price high till Trump go leave office.

U go see wetin some anti-Putin Europe countries go do. Dem go dey dash Zelensky drones to dey destroy Russia oil till Trump go leave office or hin head go reset. Na same format Putin use for Biden,abi no be so?
A talk am o. Ukraine no dey fight Russia for battle field again, na Russia oil industry Ukraine dey fight. OsitaBaba no gree.

Ukraine with EU go do spoiler for Trump and Putin for 4 years till democrats go come back. Ukraine don become fly wey perch on top ur blokos, shey u go fit use hammer crush am ni?

Igi pawpaw o ni wo pawa o.

InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba: 10:33pm On Feb 19, 2025
ositadima1:
You have no idea what is going on. The only reason Ukraine has lasted this long is because of U.S. backing. It is the U.S. that has been supplying them with weapons, sanctioning Russia, and spreading anti-Russian propaganda through the media. The U.S. was practically doing everything for Ukraine.

Now that U.S. policy has changed, the war is over. It was the U.S. that pushed them into fighting in the first place. Ukraine cannot defeat Russia—just compare the size and resources of both countries.

As I said, very soon, most of the sanctions imposed by the U.S. will be lifted, and Russia will once again be allowed to flood the market with oil. Let’s watch as things unfold.
U never get update.

Ukraine no dey fight to win again. Na to dey destroy Russia oil assets to keep oil price high till Trump go leave office.

U go see wetin some anti-Putin Europe countries go do. Dem go dey dash Zelensky drones to dey destroy Russia oil till Trump go leave office or hin head go reset. Na same format Putin use for Biden,abi no be so?

InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba: 9:33pm On Feb 19, 2025
ositadima1:
How will Oando & Co fare now that it is evident the price of crude may tank? Zelensky will take the deal, and most of the sanctions on Russia will be lifted.
Zelensky dey para like the fury of woman hand don touch. Since Monday, e dey bomb oil assets of Russia/Putin and dey destroy Trump for media so tey Trump too don fire am back

Link
https://twitter.com/realDonaldTrump/status/1892242622623699357?t=6rTFW-m4ANgn9pEvh6zZOg&s=19

Oil sef dey rise wella so anyone wey sabi go dey load oil company shares wella.

Dis trouble Trump dey look for, na oil, metals and commodities especially food go reap am o.

Even Hamas no send Trump wen Trump dey foam for mouth las week. Iran sef don reply am today say make he bring am on say no be Iran e go dey form VanDamme for.

Zelensky go drag d war till Trump sef go leave WH like Putin do for Biden. Elemi lo ma last o.

Shine una eyes wella. Igi pawpaw o ni wo pawa o.

InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba: 10:39pm On Feb 13, 2025
Streetinvestor2:
Na amadioha go kill you and yours out of envy.Yeye commission agent looking for people to scam.You think because you collect commission means you are into real estate. Hungry clown. I am ready for you.If your type cross my lane in real life.I swear I will remove your head from your useless body with the way I hate this useless moniker.
Streetinvestor2:
I can not live any shithole in the Sw because you can not give what you don't have.Mentiin one igbo billionaire in the SW beside lagos. We have many in the North in kano,kaduna,jos etc.The igbos only send thr boys to sw to just have a small branch.
The SW are far poorer than igbos.I am not interested in your dirty people so what will I be doing living in any shithole. Look at osun,kwara,editing na taxi drivers full everywhere with abaddon houses. All owners have relocated to lagos to survive
Anyone wey still dey fight u or reply u for hia suppose sabi why u no get peace.

Na the whole Yoruba people and Yorubaland u hate because dem no be Ibo like u.

InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba: 9:05pm On Feb 08, 2025
Martialfc80:
Can you please recommend some fundamentally sound stocks for someone like me who isn't interested in short term trading?
Ogami, go buy agric/food company and mining company den troway face. U go thank nsempa lata
InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba: 6:41pm On Feb 06, 2025
KarlTom:
Edit thisimmediatetly!
Ogami , tell dat Apollomaster to edit d nonsense hin 2 type. Shey Tinubu na hin Papa mate abi na so e dey insult hin papa too.

Na yeye pikin wey dey insult hin Papa go come online like mikeapollo come insult anoda pesin Baba . So na house dem dey send dem kind to so dat hin mama and Papa wey no train am well too go collect.

I hate nonsense and ingredient o.
InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba: 4:47am On Jan 03, 2025
eziokwunwoko:
Pa Emma, current price, Suprisepebble and emmaodet: Please what are your spreadsheet saying about a Beta Glass Plc.
Abeg I need your wonderful analysis.
I am loyal as you boy
Oga mi, hny, dis na new year and ur 8th year for NL yet all ur own na to dey give assignment to people and dey embarrass dem by calling dem out to do things for you every time. E no good nah. Haba.

Just pick one book or watch YouTube videos wey go explain dis simple tasks to you so you go learn how to do it and stop dis bad behavior.

I just weak when I read all ur posts and na so so begi begi people to dey do task for you.
Even wen dem ignore u, u go still bring anoda one stock to take beg dem and give dem work. Haba.

Abeg try do dis one by urself and share d answer for us too here. No be for u to dey collect collect alone and dey use people head since 2017, u too fit give. Dis na new year abeg repent.

Igi pawpaw o ni wo pawa o.
InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba: 3:34pm On Dec 07, 2024
designking:
Oando is Tinubu family business and Wale is just a front.
U sabi d meaning of d crime u dey commit so na prison you dey go so. Na lie go kee una las.

Oando don warn una say make all of una wey no get sense make una go borrow sense yet una no dey hia word.

Oando no be family business and PBAT no dey among pesins wey get Oando. No go dey deceive people. In fact, if u say PDP and former VP Atiku thru Volpi dey part of d major owners of Oando before dem pay Volpi hin money dem borrow from him, u for correct small but dat PBAT side na lie and u go collect like Farotimi collect from Baba Afe Babalola.

Dat sense wey una no get, una go get am by force.

InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba: 2:45pm On Sep 25, 2024
crownprince2017:
This is an assignment for you, after 5 to 10 years of harvest u will notice a reduction in the yields, if you are an investor and business man u claimed u are, records should be your guidance, even fertilizer has limitations. Land do get old just like human being and more over where did ellahlakes promised farming has commenced in that article or in another article regarding that farm.

I will be waiting for your logical response n not emotional ones. grin grin
U be correct pesin with correct info jo.

Leave d man abeg. Even primary school pupil sabi say soil dey age and na from primary school dem don teach us about crop rotation so dat d soil no go dey quick old. No be pesin like him u suppose dey argue abeg. Dat na why e good to go school. Soil quality for agriculture no be only fertilizer, plants need all d natural organisms wey dey help to renew d soil quality during and after farming. Dat na why UN dey push for organic farming. Commercial farming dey over-labour soil wey don age and old. If hin truly farm e suppose sabi dis tins and not to dey argue with u sef.

If pesin dey for faceless forum dey fight efrybody upandan,how u tink e go be for real life? Even from d plenty locations and relocation hin say he don do hin audio farming ,u go don sabi say he go like trouble for real life and dat na why dem dey chase am away with hin wahala. Just leave am abeg.
Igi pawpaw o ni wo pawa o.
InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba: 1:53pm On Sep 24, 2024
Omooloriredade:
You could take the above to the bank until the meeting at the farm happened. Apparently, CBO still has more shares to offload but rather than let it drag on for too long (tight band above N3), arranged an investor presentation with stockbrokers only. How is that even allowed? Next trading day after meeting, SP starts to climb with huge volumes. It's not dumping. Ellah Lakes is attempting to meet free float requirement by distributing its shares. CBO and Brokers will determine how the stock trades until there is significant news. They believe it's cheap due to its higher Net Asset Value per share and the what has been achieved so far on the "audio" cheesy farm. Na them sabi.

Roll call of attendees below. Did anyone's face look familiar? Would someone be kind enough to find out the Private placement price please?

I know Ellah Lakes directors opted for a portion of their salary in shares. Bullish!!! Quite a positive except that Mr Chuka is on a very FAT salary for a company with little to no revenue. Anyway, the future appears bright so can be overlooked. cheesy

Disclaimer - Not a buy or sell recommendation.
Na wa o. Na real farm dressing all of dem wear take do yanga pose.

And na only dat same Chuka Mordi no get potbelly for the picture.

K1 don talk am finish say na pesin wey get potbelly dey suppose dey in charge of money becos dem don belleful so dem no go chop our money.
Igi pawpaw o ni wo pawa o.

InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba: 2:41pm On Sep 13, 2024
designking:
Today was a very positive trading day. A lot of Nairaland most discussed stocks grew.

My portfolio grew by over ₦240k today.
Na ur foolishness go give u sense las las.

Na ur details full everywhere for internet yet u no get sense to cover ur small yam wey dey germinate. If dem kidnap u or ur loved ones now, how many kidnapper go understand say dis one u take dey show off here na paper profit and no be real money yet?

Dat na why e good for every parent to dey pray for a child wey get sense not just a child.

Abeg comot dis ur tashere joor. U tink say u dey among foolish crowd?
Tí iṣu ẹni bá ta, a ńfọwọ́ bòó jẹ ni. If one's yam is well- formed, chop am under wraps says a Yoruba proverb.

Igi pawpaw o ni wo pawa o.

InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba: 2:07pm On Sep 12, 2024
Streetinvestor2:
Nice reply. Why is the interest only on Oando.If you are sure of true value in it.Then go and sleep and have peace of mind over your investment like we do with sound stocks..It is beginning to look real as per your claim on oando media campaign here..lol.
Una no get shame.
Make u dey use one of ur plenty monikers dey reply yourself ehn.. jest kwantinue ehn.
After u don reset with dis moniker, u con bring out ur oda moniker.
Na urself u dey do o.

PoliticsRe: Dapo Akande Nominated For International Court Of Justice Judge By UK Government by Nigerialabalaba: 8:34am On Sep 10, 2024
LegendHero:
No, impossible.

Kekere Ekun and Dapo Akande must fulfil the mandate to make sure internationally acclaimed terrorists like Boko Haram, IPOB, and Bandit leaders like Nnamdi Kanu, Bello Turji, and etc were made to face the firing squad.

I won’t leave them until they fulfil that.
Gbamsolutely
InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba: 8:20am On Sep 10, 2024
ojeysky:
If I have spare cash I will have top up those 2 in my portfolio
My oga, make I help you, you see dat @bolded ehn, na there your solution dey o.

U suppose ask urself say why u no get spare cash? If u fit answer dat question wella, walahi, ur breakthrough don land.

Na so so many people wish dem go get spare cash but many of dem no serious with financial prudence and many people no even dey face dem work wella enough so tey dem go fit earn more money.

I no say u be part of dem o but e go good make we dey ask ourselves correct questions and answer am correctly.

Why u no get spare cash?

Why u no fit buy wetin u want?

Why u no fit give ur family d kind good life u dey always wish for dem?

Why u no fit give ur mama and papa money and buy dem plenty good tins?

Why u no fit chop belleful sef?

Why u no fit take break and go enjoy a well deserved rest?

Why u no fit give back to those people wey don help u and even sacrifice for you?

Why u no fit dey top up ur investments regularly?

Why u no dey ever get spare cash and savings sef?


Igi pawpaw o ni wo pawa o
PoliticsRe: Court Freezes 13 Bank Accounts Linked To Suspected Terrorist, Henry Okocha by Nigerialabalaba: 7:31pm On Aug 30, 2024
zeuss:
What sort of terrorist can henry okocha possibly be...... kidnappers and bandits have account officers minding their accounts doing giveaways and showing themselves freely
Since u sabi dem bandit wella, u sef be bandit niyen.
InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba: 7:25pm On Aug 30, 2024
Nigerialabalaba:
Despite losses and missing Q2 forecast, Eterna Oil’s share price continues to rise
https://nairametrics.com/2024/08/28/despite-losses-and-missing-q2-forecast-eterna-oils-share-price-continues-to-rise/

Dis na eterna wey dey full bid o, dem bad belle people no warn people about eterna, na Oando wey buy multibillion assets wey dey fetch dollars na hin dem dey warn people about. Yeye bad belle people!


Eterna wey make loss and on top dat, na naira eterna dey make,una no give una yeye warning to people make dem no buy eterna na oando wey no dey market una dey yarn nonsense about becos of una bad belle.

Na una presco, wapco, prestige, dnsugar, nascon go cast las las and we go dey hia to remind una say na d bad una dey wish others happen to una. Bad belle people wey leave leprosy con dey treat lapalapa. Shior angry

Nobody hia fit even buy Oando again becos d gate don close and even if Oando reach N200, make una no buy, nobody send una.

Make una happy for Oando shareholders, una no gree hear because of bad belle and una na desperately wicked, envious and jealousy people. Na all of una portfolio go cast las las as una dey wish bad for other people.

If u dey hia dey follow dis people, ur portfolio go cast too. Avoid dis bad belle people if u no wan ur portfolio to cast join.
Igi pawpaw oni wo pawa o.

Make una warn people about return of kidnapping for SE again too becos e go affect companies wey dey southeast
Una don dump Eterna and Tantalizer on people.
I pity d people wey dey follow una bad belle people. If u dey hia and u like no hear word, las las na u dem go chop as breakfast and lunch.

Na so una go dey cast one by one.

After dumping eterna and Tantalizer for ur head, na prestige and cutix dem dey plan to dump for ur head again.

Igi pawpaw oni wo pawa o.

PoliticsRe: We Are Ready To Conduct Interview For Okpebholo In Pidgin - Reuben Abati by Nigerialabalaba: 2:34pm On Aug 29, 2024
Yeyenatu. Awon ti elluPee wey go still lule
PoliticsRe: Fearless In October Protests - Punch Editorial by Nigerialabalaba: 2:22pm On Aug 29, 2024
ogododo:
https://punchng.com/fearless-in-october-protests/
Dem dey use style dey give d protest free advertising. Make security officers ji ma sun o
InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba:
Despite losses and missing Q2 forecast, Eterna Oil’s share price continues to rise
https://nairametrics.com/2024/08/28/despite-losses-and-missing-q2-forecast-eterna-oils-share-price-continues-to-rise/

Dis na eterna wey dey full bid o, dem bad belle people no warn people about eterna, na Oando wey buy multibillion assets wey dey fetch dollars na hin dem dey warn people about. Yeye bad belle people!


Eterna wey make loss and on top dat, na naira eterna dey make,una no give una yeye warning to people make dem no buy eterna na oando wey no dey market una dey yarn nonsense about becos of una bad belle.

Na una presco, wapco, prestige, dnsugar, nascon go cast las las and we go dey hia to remind una say na d bad una dey wish others happen to una. Bad belle people wey leave leprosy con dey treat lapalapa. Shior angry

Nobody hia fit even buy Oando again becos d gate don close and even if Oando reach N200, make una no buy, nobody send una.

Make una happy for Oando shareholders, una no gree hear because of bad belle and una na desperately wicked, envious and jealousy people. Na all of una portfolio go cast las las as una dey wish bad for other people.

If u dey hia dey follow dis people, ur portfolio go cast too. Avoid dis bad belle people if u no wan ur portfolio to cast join.
Igi pawpaw oni wo pawa o.

Make una warn people about return of kidnapping for SE again too becos e go affect companies wey dey southeast

InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba:
If u dey hia and if u like, dey read and dey believe all dis yeye tunrenchi against Oando and come miss am, u go regret am.

Na so dem dey badmoutu Oando even when e dey N4 so tey dem confuse dia gullible followers not to buy Oando but to dey buy wapco, Zenith, Dangcem, now Oando go up so tey almost touch N50, instead of dem to swallow dem pride and cover dia shame, dem still dey yarn so dat dia gullible followers eyes no go open say na blind people dey lead dem.

Prophetutocha, Ogg and auntymi ymcy, abeg no tell anybody anything again. Let dem follow d advice of dia audio-billionaires. Dem go look 4 Oando dem no go get. Make dem still dey buy and wait for dem wapco and MTN.

Some people wey don suppose buy Oando dis morning wen e dey full offer for 29+ don miss becos dem dey waste dia time reading and believing d nonsense dem dey yarn against Oando hia. Las las, na stones una go take break una heads las las 🙄

Igi pawpaw oni wo pawa o
PoliticsRe: ‘Don’t Wait Till Nigerians Start Stoning You’ – Primate Ayodele Tells Tinubu by Nigerialabalaba: 1:08pm On Jan 05, 2024
Even Jonathan wey spoil everything dem no stone na Tinubu wey dey fix am dem go com stone. Yeye dey smell
InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba: 1:06pm On Jan 05, 2024
yMcy56:
Oga labalaba, too much multiverse money! grin
You no come even send my Xmas chicken during Xmas.
Happy New Year o. grin
Hahahahahaha......U too much, u full ground Mamami. I still dey loyal to ur govt o.

Japaul bus don dey carry me go where I know o grin
FamilyRe: At What Age Should A Father Stop Bathing His Daughter? by Nigerialabalaba: 12:22pm On Jan 05, 2024
Dilijingsly:
Am a family man and taking care of my children is not a big issue, my daughter is a year and a old . The big question is at what age should i stop bathing her?
10 patapata
InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba:
yMcy56:
GTB @43!!
ZENITH @42!
The banks are not slowing down at all.....

* Much funds entering the market*
Mama niyen, happy new year. Na u be my Person of The Year 2023 o.
Dis year, na C&I leasing I dey shine my light & dey buy. I go still dey buy Japaul too die die.

Igi pawpaw o ni wo pawa o.
PoliticsRe: RIVERS state assembly: Why defect if you have a veto proof majority? by Nigerialabalaba: 9:16pm On Dec 13, 2023
Na because similaye Fubara don do wetin dem say musiliu Obanikoro do to city hall to d state house of Assembly nau
InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba: 9:14pm On Dec 13, 2023
Much has been said about the P&G exit. Here’s another view:

“*More on P&G and lessons to learn!*


Know Thy Market
- 𝕿𝖞𝖊 𝕾𝖙𝖗𝖆𝖙𝖊𝖌𝖎𝖘𝖙

I have heard it said that P&G left Nigeria because of bad governance policies - policy summersaults, forex issues, and then its repatriation issues. And the like

Possibly.

But I doubt.

I suspect its due more to wrong Strategy.

I suspect P&G had the wrong Market Strategy.

So P&G lost to competition...

To that ghost called 'market forces'

In every single product category P&G operated in within Nigeria, at least one product entered the market in the last few years, and stole their market share.

P&G makes Ariel detergent. Pray tell...who uses that expensive product in these hard times? Why would Ariel sell when there are brands like Good Mama, Viva, Sunlight, Klin and Zip in the market - offering similar quality at lower prices?

The Nigerian market is more price conscious than brand conscious.

How about diapers? Molfix (from Turkey) entered the Nigerian market 2 years ago and basically snatched the market from underneath all the top players by providing basic functionality at an affordable price point.

The lesson is this:

Know Thy Market.

P&G should have gone to learn from a company like....Cadbury

Cadbury operates in 52 countries.

Every year Cadbury global celebrates their top selling product in all of their 52 countries.

Most years a product from Nigeria wins.

That product is called:

TomTom

TomTom has the right strategy.

Targeted at, and well suited for, the peculiarities of Nigeria's socio economic circumstances.

TomTom knows their market.....cold.

It will therefore be difficult for one company from Turkey or China to enter the Nigerian market and take on TomTom successfully.

Know Thy Market.

A simple lesson that P&G did not learn.

𝕿𝖞𝖊 𝕾𝖙𝖗𝖆𝖙𝖊𝖌𝖎𝖘𝖙. 07.12.23”

Igi pawpaw o ni wo pawa o
RomanceRe: The Pre Wedding Picture That Got Everyone Talking by Nigerialabalaba: 4:20pm On Dec 11, 2023
mcdon024:
I came across this pre wedding picture and thought I should share. What's your thoughts on this kinda picture?

The comments from the post is even funnier than the picture
Two Oloshos don jam
InvestmentRe: Nigerian Stock Exchange Market Pick Alerts by Nigerialabalaba: 4:09pm On Dec 11, 2023
Yoast:
Culture will always eat strategy for breakfast. Our bad culture generally is the number one reason we are in a big mess. So sad
Pesin wey join P&G for 2005 na small boi. Dat same P&G don be sector leader since wen dat pesin dey primary school just like Nigerian Cable & Wires wey don kaput now. All dis indomie generation dey always tink say d tori of everything today start for year 2000 and above. Yeye. Company wey no sharp, competitors go beat am wella! No mercy o. Tell am about Tiger foods wey buy Dangote flour but na gbese until dem return am to Dangote for N1 as dem no get sense. Dat same Dangote flour, Olam pay billions to buy am from Dangote. Me I no send any business wey competitors dey beat now, na so dem too beat people wey dem meet for market before o.


Hogwarthtrades:
The statement of "only mining company that has mine" is not true, Thor exploration is a "Canadian" company based in nigeria (Though listed on LSE and Canada),it has gold mines in Osun state, Lithium exploration is underway as well.
Oga mi, Thor no be Naija company and dem no dey sell dem stocks for our Nigeria Stock Exchange o.


Read wetin Aruna Kebira said about Multiverse for dis last weekend.

• What is driving the growth in Multiverse? Is it a good buy at N9.39?


Multiverse is also in the business of gold mining, and if you watch the New Gold ETF in the market, you will discover that there have been a lot of activities there.

At the failure of other sectors of the world economy, Investors are jostling to hold Gold as a store of value. Market participants believed that if that is true, there would be value in Multiverse and all that it does, considering the low price at which it was trading.
https://stocksng.com/stock-market-review-december-11-2023/

Igi pawpaw o ni wo pawa o.
EducationRe: Got My First Carryover, Please Help I’m Dying by Nigerialabalaba: 12:16pm On Dec 08, 2023
Christianoir:
I’ve been writing exam since i haven’t gotten any carryover…Just had one today God cry[u] cry cry I feel disgusted and ashamed.. since I started writing exams since Monday all my grade have been A throughout
It cbt exam once you finish writing you will see your score

I wrote and score 40/100 which is F (carryover)
The course wasn’t that hard..I read it, it was time
60 questions to answer 20min too small.

I don’t know what to do….this is my first
This is my first carryover course since
It breaking me down

I don’t even have to zeal to read for next course again
Soroniyen

1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 74 pages)