₦airaland Forum

Welcome, Guest: Register • Login • With Google • Trending • Recent • New

Stats: 3,346,370 members, 8,522,646 topics. Date: Saturday, 21 November 2026 at 05:55 PM

Toggle theme

Nimshi's Posts

Nairaland Forum › Nimshi's Profile › Nimshi's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 28 29 30 31 32 33 34 (of 34 pages)

Islam › Re: Muslims: What's Your Favorite Ayah Or Surah In The Quran? by Nimshi: 5:37am On Sep 23, 2008
Alahu Akbar!

One of my favourites is:

[5.51] O you who believe! do not take the Jews and the Christians for friends; they are friends of each other; and whoever amongst you takes them for a friend, then surely he is one of them; surely Allah does not guide the unjust people.

We can learn many things from the Holy Quran. Alahu Akbar!
Christianity Etc › Re: Creationism Takes A Huge Hit by Nimshi: 10:48pm On Sep 22, 2008
Ok; as you don log comot. Anytime wey you reload, make you answer dat quesion on wetin you talk about Relativity and nuclear weapons.

Try, my small bros. Try.
.
Christianity Etc › Re: Creationism Takes A Huge Hit by Nimshi: 10:42pm On Sep 22, 2008
imhotep:
@Nimshi
You have provided no proofs. You are dodging the issues. Artful dodger.
My small bros, no vex; but your quesion, like di first one ", .disprove the existence of God", hmnnn, dem talk say no foolish quesion, bros, hmnnn, see, dat quesion dey di same level as: "disprove the existence of a pink sky elephant with eyes all over him tail".

You don sabi now?
.
Christianity Etc › Re: Creationism Takes A Huge Hit by Nimshi: 10:40pm On Sep 22, 2008
imhotep:
The theory of relativity has been verified time and again. The existence of nuclear weapons is abundant proof for this.
Chief, how? Which Relativity una dey talk about o?
.
Christianity Etc › Re: Creationism Takes A Huge Hit by Nimshi: 10:23pm On Sep 22, 2008
imhotep:
I've been waiting for two experiments on this forum:
1) to disprove the existence of God (I've been waiting for 9 months now),
2) to show how one organism evolves into another eg 'apes evolving to Man' (don't chicken out by saying that it takes 200 million years to occur)

I'm still waiting. Or do we need to consult the Pope for this againhuhhuh?
Chairman, as you dey take write so, na im be dey clear say you no even sabi; no vex o; truth dey dey bitter sometimes. Na una dey make evolutionists dey call creationists yeye people; but sha no be all creationists be yeye people. See am so:

1) You, as you dey so, you fit disprove the existence of a pink sky elephant with eyes all over him tail?
2) You, as you dey so, you fit show how you you dey take piss for toilet?

Make we face #1 as e be say e match your yeye challenge. You no fit. Wetin dat one tell you?

Meanwhile, you talk true small; the Bishop of Rome sabi book well well; but sha all di book wey him sabi, e no mean say him no go dey support yeye yeye people like Cardinal Bernard Law; Mr. Law na fugitive; we sabi am well well as him take tun go dey hide for Vatican; di thing wey him do, no betta person go even dey think am: how MoG go dey dey involve in molestation (code word for rape, eh) of small small children. On tope of dat, when him reach Vatican, Papa Ratzinger dash am big post join. Anyways, dat one na digress, only to show you say just because say person sabi book well well, e no mean say him head correct.

If you dey follow-follow, male you shone your face well well.
.
Christianity Etc › Re: Creationism Takes A Huge Hit by Nimshi: 5:08pm On Sep 22, 2008
Okay Pastor; you talk correct. To dey chop bread alone go hard, even Agege bread dey tire person.

Anyways, person surprise as you talk say Adam arrive before the plants. I no dey even compare with anything wey evolution talk yet; na as bible take say e happen.
.
Christianity Etc › Re: Creationism Takes A Huge Hit by Nimshi: 2:38pm On Sep 22, 2008
[quote author=Mad_Max link=topic=173945.msg2835467#msg2835467 date=1222072174]Evolution is a possibility, it's not yet a fact.[/quote]Chairman, why una still dey talk like dis? Ehn? Man don tire o. If una wan join discussion with evolutionist, dis kain statement no be correct o.

Pastor AIO:
Man pre existed even the herbs of the fields.
Pastor, e be like say una no sabi di bible wey una dey carry do Pastor o; man before the plants? Na real wah. Bros, no vex o; but sha you suppose don sabi bible pass dis one. You for check am nah: wetin adam for dey chop before Eve land? Fish?

.
Education › Re: Who Know Lagos Postal Code by Nimshi: 2:30pm On Sep 22, 2008
switchmax:
hey,
the post code of lagos is 01 while that of abuja is 09 it is when you are dealing with people outside nigeria you can add the 234+01
Na wah o! Di way wey people dey take confidence spread information wey no dey correct! Chei! Switch: wetin you write no be postcode for letter wey dem send by post; na wetin human being dey dial for phone be dat.


[quote author=Brash! link=topic=108493.msg2836227#msg2836227 date=1222082976]does Lagos have one?![/quote]Yes o. Different different part of Lagos get different postal code. Na one of di things wey dem dey do to make letter wey dem send for post to reach fast fast. And I fit tell you say e dey work well well. If you get post office box, or say you sabi person wey get, tell dem to ask for dem post office wetin be dem postal code. I no sure for other States, but for Lagos, postal code dey work like magic.
.
Education › Re: Why Are We Paying So Much For University Education In Nigeria? by Nimshi: 7:33am On Sep 22, 2008
How much be di tuition fees wey u dey talk? For which universities?
Education › Re: Who Know Lagos Postal Code by Nimshi: 7:30am On Sep 22, 2008
mecussey:
please who knows lagos postal code
What part for Lag?

Dem don dey use postal code for Naija now, especially for Lagos. If you know di are, may be we fit helep small.
.
Business › Re: Are Nigerian Banks As Shiny As They Look? by Nimshi: 7:20am On Sep 22, 2008
ayotee2000:
Sanusi Lamido Sanusi holds degree[/b]s [b]in economics from the Ahmadu Bello University, Zaria, Nigeria, and in Shari’ah and Islamic Studies from the International University of Africa, Khartoum, Sudan.

Born in Nigeria in 1961, Sanusi is a member of the Fulani ruling family in Kano, being a grandson of the 11th Fulani Emir, Muhammadu Sanusi. Sanusi started his working career as an academic, teaching economics at the Ahmadu Bello University from 1983-1985. He then moved into banking, working first as a merchant banker with Icon Ltd (a subsidiary of Morgan Guaranty Trust Bank of New York and Barings Brothers of London) and after his studies in the Sudan as a risk manager with the United Bank for Africa plc, one of the largest banks in Nigeria. In September 2005 he was invited to the Board of Nigeria's largest retail bank, First Bank of Nigeria PLC and he is currently the Executive Director in charge of the Risk and Management Control Directorate of First Bank. Sanusi is a writer who has over the years participated in debates on politics, religion and society in Nigeria. He has also been invited to speak at international conferences in several countries. He has recently focused his writings on religion and the state, as well as the question of interpreting Islam in modernity. He has contributed articles to a number of publications on shari'ah in Nigeria and also presented papers at several international conferences, in addition to participating actively in public debates in the Nigerian press. Most of his articles are available on the internet.

http://www.zamyn.org/162-Lamido-Sanusi.html
lipsrsealed
As you see for di bold part above, wetin dem fit write for Lamido Sanusi for banking, e light pass wetin Sarah Palin get.

No be player hating o, na so we see am for now.
.
Christianity Etc › Re: Creationism Takes A Huge Hit by Nimshi: 3:06am On Sep 22, 2008
imhotep:
By the way, the creation story(ies) in Genesis are allegorical. Not to be taken literally.
Chei! Chairman, I bin forget dis one.

But sha e be like say you don get betta idea o!

Soooo, as the stories dey allegorical, we must not take dem literally, soooo e fit be say di creation story work through evolution, ko? And if we take example (exmaple only, eh) say 1000 years fit be like one day at di time of Peteru, and we do extrapolation backwards, e fit be say "one day" for Genesis fit be several thousand years, ko? Bros, na idea bi dis o! May be na wetin Vatican go settle for be dis, eh. Dem must carry all di Cardinals with ogbonge big bibg degrees, including Papa Ratzinger enter dis theory. You try sha.

But sha may be I no understand wetin you mean; you go fit explain?

God bless o.
.
Christianity Etc › Re: Creationism Takes A Huge Hit by Nimshi: 2:59am On Sep 22, 2008
imhotep:
Show me ONE experiment that verifies the theory of evolution. Just one!
Chairman, first of all, I no need to show you one experiment; di problem be say wetin your write just show people say e like say you no sabi di meaning of "theory" as dem dey use am for science. Na wahala be dis o; because wehen we dey argue in favour of Baba God di Creator, we must know wetin we dey yarn.

Second: as you take ask say "Show me ONE experiment that verifies the theory of evolution" (na me add di bold o), e go dey make all di people (both creationists & evolutionists & everyone in between & outisde) wey sabi di things to laugh small. You sabi why? Even if you know, I go tell you: to 'prove' scientific theory, no be verification dey important pass, na falsification. Shuoo! Na so. Bros, dis thing no hard o. Na correct bullet wey we need when we dey yarn with evolutionist wey sabi wetin dem dey talk.

.
Christianity Etc › Re: Creationism Takes A Huge Hit by Nimshi: 5:01pm On Sep 21, 2008
Evolution is still a THEORY and highly incomplete. I don't see why I should believe anyone who tells me that he knows EXACTLY what happened 4 million years ago! Am I supposed to exercise FAITH in this?
Bros, no vex o; na wah o. You for try confirm wetin "theory" mean as you say na "only".

Meanwhile, as you no sabi wetin happen 4 million years ago, you dey there when Creation dey happen? You no dey, I no dey, so wich ones you dey?

No vex bros.
Christianity Etc › Re: Honest Questions by Nimshi: 1:12pm On Sep 21, 2008
Chei! Sis pilgrim.1, thank you as you send me go see dat other discussion. I don rush thru write sumtin. I go read more more. You try o, for here & for there; you too much.
Christianity Etc › Re: Moral Victory: Religious Exploitation, And The New American Creed by Nimshi: 1:09pm On Sep 21, 2008
Sis pilgrim.1, thank ou plenty much for direction to dis discussion. I don try read thru, I com find sth wey you write:

Let me first slice through G. Smith's take on the subject before going on to make other remarks on his arguements. According to what you posted, four things stand out:

(1) Smith reiterates my point that the very core of atheism is the denial of the existence of God - nothing less or short of that. Many people of atheistic leanings today like to lean towards the reductionist idea of viewing atheism as merely "a lack of belief" in the existence of God or gods; but as we have seen, that would include a whole lot of people who do not identify themselves as atheists - such as was the case with Thomas Huxley who rather coined the term "agnostic" instead of standing up to be counted as an atheist. The underlying element in atheism proper is the denial of the existence of God, and this is clearly indicated in Smith's quote above.
Na you I quote so, na me put di bold.

Hmnn, no be so o. In fact, wetin G. H. Smith explain na di opposite of di bold. Atheism, at di very core, at di very basic, no be denial at all. Atheism na "absence", absence of belief in God. Dat na why di example of pikin wey dem just born dey helep well well: 1-week old pikin no sabi God; e no fit deny God, e no fit affirm God. Di pikin na atheist. So therefore, all of us, na atheist we be when dem born us. Denial of God na one type of atheism; na explicit atheism; na critical atheism.

As for Huxley, e fit betta small make we leave am; why? Because 'agnostic' no fit tell us whether person believe in God or not; person wey be "agnostic" fit be theist or atheist. IF we look am well well, we go see say agnostic no be option number 3 after (1) theism, and (2) atheism. But e fit become number 3 if and only if (chei, na arithmetic class be dat o) we mis-define atheism.

If we remember as Huxley take do invention for di word "agnostic", all dis go come clear like pure water inside clean nylon bag.
.
Christianity Etc › Re: Honest Questions by Nimshi: 11:03am On Sep 21, 2008
Well, as you don post dis one now, person fit ask: you don find dat definition of atheism? Abi you never find? If fit supply di definition wey dey basic:

Anywhere wey you find absence of belief in God, god, Gods, gods, na atheism you don find be dat. Betta example to use na pikin wey dem just born: new pikin no believe in God, d pikin na atheist. Na so we be, including you, when dem born us. I hope say dat one go fit helep well well.

.
Education › Re: Nigerians And Spelling Errors! It Keeps Getting Worse! by Nimshi: 10:50am On Sep 21, 2008
Quote from: CGO on August 29, 2008, 02:41 AM
It's appauling that a large population of our so called educated Nigerians \
Chief CGO,

if to say you be doctor, person for talk say make you commot di typhoid wey dey your face befor you go try treat me malaria. Anyway sha, we live to learn, as our ancestors them them dey talk. See am:

na be "so-called"? Na you write "so called" o.

You see so? Nobody dey perfect.

Enjoy.

If them don mention this one befor, that one mean say na steal I steal am. If e no correct, make una straight the K-leg for my grammar.

.
Christianity Etc › Re: Honest Questions by Nimshi: 10:41am On Sep 21, 2008
Hehe. .

On Rationalism:

In epistemology and in its broadest sense, rationalism is "any view appealing to reason as a source of knowledge or justification" (Lacey 286). In more technical terms it is a method or a theory "in which the criterion of the truth is not sensory but intellectual and deductive" (Bourke 263).

source: again from Wikipedia
Dis na di reason why we must separate rationalism from atheism. When wed ey discuss religion ans atheism, rationalists be special type of atheists, dem dey call dem explicit atheists. Your post here na hammer on top of di nail becos: rationalists wey be atheists na explicit atheists dem be; why? Because dem go argue say belief in God, god, Gods or gods dey irrational, rationalism must use reason to justify everything; so rationalists dey critical, because dem reject existence and/or belief in God, god, Gods or gods. So then, I must agree with you say rationalism no be strictly issue about non-belief in God.

Sooo, my sister, what about di other part: say atheism no be strictly issue about 'non-belief' in God?

.
Christianity Etc › Re: Honest Questions by Nimshi: 10:31am On Sep 21, 2008
Bo, I no go lie - na office I dey sidon this morning because na ma shift. So quiet and boring - but wetin I go do? I work small, attend to clients. . . when them no dey and I get small break, I visit the forum and yan opata. Meanwhile, I sidon here dey listen to one of my favourite pastors online - Charles ('Chuck') R. Swindoll.

Na evening I go attend service after my shift for office.
Hard work no dey (always) kill; me sef just return from shift.

Make God dey bless our hadiwork.
.
Christianity Etc › Re: Honest Questions by Nimshi: 10:17am On Sep 21, 2008
(3) in my view, atheism and rationalism are not strictly issues about non-belief in God. I'm sure many who are inclined thereto have matters that cut across politics, philosophy, science, etc. Perhaps, these too can be expressed in the various sections accordingly.
Na me put di bold o, no be you. But sha, abeg, make you educate me small for di bold part. Why you write so?
.
Family › Re: Babashola Rhodes by Nimshi: 9:57am On Sep 21, 2008
Babashola Rhodes? Hmnnn , why? E dey alive o.

Why you dey find am?

And, my dear Mr. olanajim: why una call dis new poster yeye person?

Person wey dey ask no dey too miss road o,
.
Christianity Etc › Re: Honest Questions by Nimshi: 9:48am On Sep 21, 2008
Sister Pilgrim.1, no be Sunday for una side? Una no dey go Church? Abi una don return? smiley

Abeg, make una find Church enter for Sunday o. Di one wehn I like, Ed Young, e don enter; nice blue T-shirt, pretty jeans, white sneakers, plus body wey dey kampe; for over 50, na God blessing. Creflo Dollar just finish. For Sunday, na so we dey enjoy.

God bless you.

Mr. mazaje: anytime wey una like, make we talk betta. Also Mr. Chrisbenogor (as I see say you dey around dis Sunday morning too), we all na one big family. We fit argue disagree well well, but we go fit chop together from di same plate, or, at least commot food from di same pot. Repects to everyone.
.
Christianity Etc › Re: Honest Questions by Nimshi: 9:39am On Sep 21, 2008
Mr. mazaje: I just read your post #2, for where you bin write:

athiest and rationalist have never claimed to posses the ONLY truth, only thiest do, especially christains and moslems. with them its either jesus/allah or eternal perdition,
My bros, hmnnn, no be so o.

First of all, no be all atheists be rationalists; e no good make we merge dem together.

Second of all, no be all theists dey claim say de get truth o. You go find some theists, dem go tell you say dem dey always search for truth correct. And as for the Moslem & Christian brothers & sister, no be all of dem be like dat. We must try be careful to merge everybodi. No be say na only you get di fault o, me ma sef dey do am sometimes.

My favourite senior pastor don enter TV. I dey come.
.
Christianity Etc › Re: Honest Questions by Nimshi: 9:31am On Sep 21, 2008
My people, abeg; dat sharp guy for physics, him name na Hawking; Stephen Hawking.

bawomolo: di person wey dem dey talk na Richard Dawkins. Him of him books "The God Delusion" dey vex church people well well. One oda guy wey dey vex church people, plus mosque people, na Christopher Hitchens; Hitchens na yeye man small, but sha him book "God is Not Great" funny too mush; church people no like am. Him style different from Dawkins own.

Wetin me I sabi be say as Church get pelenty branch, na im atheists too get plenty. For person to define atheism, e dey easy; too easy kwanu. Consider person wey be theist, him believe in God, a god, gods, or Gods. Person wey be a-theist, for am, belief in God or god or gods or Gods dey absent; shikena. You no need to be professor, or begin try philosophy, or any oda yeye fancy thing to be atheist. When dem born you, you be atheist. Why because: you no believe in any god or God or gods or Gods dat time. People no dey sruggle with all these kain atheism. Di one wey dem no like, na di one wey di atheism dey explicit.

Enjoy o.
.
Christianity Etc › Re: Can A Christian Work At A Brewery? by Nimshi: 9:07am On Sep 21, 2008
Yeye nonsense.

Even Jesus work part time for instant-party brewery.

If people drunk, na dem wahala be dat.

Person wey put rat poison for food, na di fault of di chemist wey mix di poison?

Everytin for im own use, for the right quantity.

As dem talk for bible: na wine dey make person heart jolly.

.
Politics › Re: Ndi Okereke-Onyuike Arrested By EFCC Over Obama Xtravaganza! by Nimshi: 9:04am On Sep 21, 2008
Obodo country with yeye short memory!

So, wetin happen to all di money?

No more noise, shey?

Wein happen to all di money wey dem say dem collect from Mrs. Ndidi?

All of dem together, including Madam Ndi, dem be yeye official 419 people.
.
Investment › Re: Stock Market Tips For Nigerians by Nimshi: 7:31pm On Feb 20, 2008
February 20, 2008

The shares of AFRICAN PETROLEUM PLC was placed on technical suspension following the receipt of their application to do an Offer for Subscription of 199,070,721 at N250 per share and a rights issue of 262,929,279 at N230 per share.
Very funny!

Who's buying this PO?
.
Career › Re: Two Offers: A Banking Job And An Engineering Job by Nimshi: 5:19am On Feb 13, 2008
What are his goals? How much working experience has he got? Is the engineering job relevant to his training?

Here's an experience from an engineer I know who'd chosen to work in a bank when faced with similar options: he stuck with the bank for a year, got a promotion (for excellent performance in credit & marketing, within a year), and then left the bank - which is now one of the biggest - for an engineering job with a take-home of about 55% of the bank salary. Satiafaction is important, along with synergy regarding your set goals. If the engineering job will give him the time to think and plan and execute his plans, he's got to make a good assessment of the value of his time.

If he needs to save money for, say, further education, he needs to think quite carefully. Some engineers have done this. He'll need to compute the correct amount that could be saved from the different jobs and compare them fairly. His personal circumstances are important in this decision. If he's able to put sentiments aside and focus on his goals and plans for the future, he'd 've started on the road to making a good decision.
.
Investment › Re: Stock Market Tips For Nigerians by Nimshi: 4:17pm On Feb 08, 2008
NAMPAK NIGERIA PLC- The Nigerian Stock Exchange placed the
shares of the company on full technical suspension on
Monday February 4, 2008. The board of the company suspects
that the audited accounts for year ended September 30, 2007
might be unreliable as there was an overvaluation of
returnable packaging stocks. Further investigation by the
company suggests that there might be other misstatements
and irregularities in the financial position of the company
as at that date. The company has already suspended its
proposed Annual General Meeting earlier slated for January
23, 2008.
Plainly speaking: NAMPAK cooked the books.

.

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 28 29 30 31 32 33 34 (of 34 pages)