Olahmi05's Posts
Nairaland Forum › Olahmi05's Profile › Olahmi05's Posts
Me self go soon surprise someone millions when time comes by God grace.. Nah small time |
Me self wan add join.. No allow your phone 📱 spoil or get stolen because phone don cost. Keep your belongings.God will help US in Jesus Name. AMEN. Me and my Family will not lack in Jesus Name. AMEN |
8 ![]() |
Her bestie leaked her secret to her husband.. That why he left her . Advice of the day.. Don't leak your deepest secret to your Best friend and don't allow your man know your bestie.. No bestie in relationship ooo. |
The spirit of your mom is fighting your Aunty through Sister.. Tell Your auntie to pray and fast so that God can touch your sister Heart.. The spirit is angry with her ... Peace be onto you. |
Dey wan disguise. No panic. Is dis protest or gathering of people wey Dem don give them 3k-5k.. August 1. We going out to say NO TO BAD GOVERNMENT.# PEACE PROTEST. Hunger dey now. No Job for the youths. Imagine spending your year's in school without no Job. God go HELP US. STAY SAFE ON THAT DAY ABEG. AUGUST 1. |
Make them never block the plug abeg oo. My Money never complete still hustling to get money..l know my dreams will come to pass 🙏 one Day.. Ireland Loading.... |
![]() |
Earth wey I dey my eyes dey see shege. Nah moon remain make we go enjoy life.. Dis life hee no just balance.. Person wey poor wey God bless bless wey make am. That same person no go look for money again oo. Nah another thing he go dey find.. That life for you. God abeg Bless me and My Family. Make my story change for good. Nah beg I dey beg because I know dre is nothing you can't do. AMEN |
Hunger dey our land.. Nah billboard dey put for display.. God Abeg no forget me and my family... Let your MERCY Speak us. |
Both of them wear dre uniform holding dre weapon. M sure Nigeria is not for gentle People. Is either u don craze before or u don dey craze small small. KOLOMENTAL ![]() Have never gotten 200 likes before |
Omo dis food too Small. Is like they count the fried rice and jollof rice for you. person no fit eat dis and call anyone say 'come and eat' nah to just dey one corner chop am. The price will soon come down very soon .. By Next Two months the price of things will go down. But Please next time You fit try Swallow and let us know the Difference. |
See the Joy. His broken heart removed. Now gotten a new Heart.. Am happy for you Man. The smile is for his Ex Girlfriend ![]() |
Make I no lie. Them don see you finish. Because how can someone accuse you without no prove. That unfair Let me advise you. No collect food from anyone even if they is party. Cook your own food and if u can't cook go and get a girlfriend. No greet anybody. Maybe Good Morning. Do as if u no see them. And the last one. Make u sure u no leave ur key or cloth outside ooo because them no go pack am for you oo Sha no say nah only you dey live the compound. About Car issue. I don't know how u go do that one oo Maybe u go put am for your pocket. I don't Sha don't Carry anybody. Lastly. Make friends with them. Okay. You are more mature than them. Think of possible solution that you can do. God will help. Just matter of time . Within 1-2weeks they will come n meet you and beg you. Just give them space.... |
Guys go buy your calculator ooo because you go need am for dis tournament ![]() |
Maybe Baba don try play am.. E no get luck.. M sure nah Man United, Chelsea or Barcelona spoil him Ticket. Reno why you no try Afcon make you stake high and power Choose Under 2.5 for Nigeria games ![]() |
Victory |
I will call the police .. Don't Stress me . After all police is our friend.. No TIME |
Probably the Ex has sex video or sex pics of the bride.. The Ex threaten the bride.. Hmmm .. Omo if nah me . I go cancel it nii ooo but I don't pray for it to happen to me. |
My Dear Sister why u no dey use cutleries eat shawarma and pizza . No be everything u go dey use cutleries.The fun eating with your hand is more than that especially when the swallow is Hot . Eating with my child Hood friends In the same plate. If u are not fast enough. You no go chop anything . So with dis few points of My. Wash your hands with soap and water before you eat.That why my hand strong .Gbam. |
It depends how hungry I am . Sometimes I brake the rule's especially when I see my food. I can't play with it. |
I dream about it nii oo. Bet on it |
Correct Score ... 4-1 or 3-1.. Don't miss it .. |
Restored ko ![]() Restoration nii ![]() Abeg shift jare. |
I can't see the pretty wives abi nah my eye dey pain me ![]() |
VAR check ✅. |
God will continue to Provide for you in Jesus Name. God Bless Your Family 🙏. |
If God start to dey punish them . U go pity them. Very Soon God will soon punish them.. Even dre family will not go unpunished with the way people die of hunger. Watch out.. Imagine Giant of Africa suffering as if we no get Papa or Mama. God will save us from dis evil leader's that are leading us.. Why people no go Japa.. If we no talk now.. We go shout later. |
Please God save us and protect our family. Tins dry for here. Baba God open a way for me. |
Season never start Them don don do us shege Pro max. Se Nah Chelsea be the only club nii. Abeg let the players focus. |
The most painful thing about our country is that.. We have scholars in dis country but yet some low IQ are the leader's leading us. How I wish they can do an examine for all the Minister's. Even our President too. OMO we need scholars to lead us.. We are the professor.. God Bless our country Nigeria. |


.. Don't Stress me . After all police is our friend.. No TIME
. Eating with my child Hood friends In the same plate. If u are not fast enough. You no go chop anything
especially when I see my food. I can't play with it.