Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi - Literature (25) - Nairaland
Nairaland Forum › Entertainment › Literature › Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi (336541 Views)
1 2 3 ... 22 23 24 25 26 27 28 ... 51 Reply (Go Down)
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 3:49pm On Aug 13, 2018 |
WarriFirstBorn:the story is for matured mind,u shouldn't be able to guess next episode,but for what happened there,trust me,i will still recall later |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Johnsown1(m): 4:27pm On Aug 13, 2018 |
wizsolzy:The thing vex Me, and is not the first time |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Johnsown1(m): 4:29pm On Aug 13, 2018 |
Youngzubi:Kedu nke na-eme brotherly, |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by okafor200(m): 4:30pm On Aug 13, 2018 |
Youngzubi:looks like this ur first episode for ur new tori na for drunkards dem me i don carry two container of pami come con still sidon for front seat dey wait for the next episodes abeg anybody make self won come make him carry ogogoro join body abeg because me i like drink make dem mix na that one dey shark pass |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 4:49pm On Aug 13, 2018 |
Johnsown1:adim nma,nwane nmadu,okwa e pass time ka'm nna eme ne'ba o ![]() |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 4:51pm On Aug 13, 2018 |
okafor200:the tori himself na drunkard dey tell am ![]() |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by okafor200(m): 4:56pm On Aug 13, 2018 |
Youngzubi:yes o brotherly me i come here con catch fun o but i no know wether una go fit allow me and my friends dem we reach like 200 plus all of us carry pami and hot with shaku shaku come na front seat we won go sidon help us tell pradioc make him unlock the padlock make we enter abeg go sidon high! Abi pradioc don go train that him parrot mouth? Ahhhhh faji-ke all the way |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Johnsown1(m): 4:58pm On Aug 13, 2018 |
Youngzubi:Onweroo, ji sike na nke ina-eme, ba anyi bu anyi noo, anogho ano ofu ebe ekiri mmuo |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 5:11pm On Aug 13, 2018 |
Johnsown1:tem!! tem!! brotherly,this one na my blood oya go read BOTTLE WARRIORS,make sure u halla me once u land for the thread |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Nobody: 6:17pm On Aug 13, 2018 |
abeg, youngzubi, how much u thief from the bank and wey my own share |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Pinkfeet: 6:54pm On Aug 13, 2018 |
pradoic:thanks for mention |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 7:15pm On Aug 13, 2018 |
debbycreamy:lol we'er still waiting for spana to say something about it,the guy just die the matter like that |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by christheair(m): 7:29pm On Aug 13, 2018 |
U see dis spana guy eeeh eeh... Dat boy na good fucknizer he rugged die.... Baba zubi. I delph cap comot for ur brain. After u na u ah swear ![]() |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by wizsolzy(m): 8:21pm On Aug 13, 2018 |
Pinkfeet:Ah ah pinkfeet after all these years on NL how can u be doing these things.. how can u quote a whole update |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Nobody: 9:09pm On Aug 13, 2018 |
Abeg make una mention me for the next episode |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 9:38pm On Aug 13, 2018 |
christheair:thank you since you'er new here show some love and kindly click on this link to vote me for the literature award https://www.nairaland.com/4652535/nomination-thread-august-5k-award/8 |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by astute28: 10:42pm On Aug 13, 2018 |
i dey gbadun ur tory he they sweet me like say i won cum inside woman |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Ann2012(f): 10:52pm On Aug 13, 2018 |
Youngzubi:I don land gidigba ![]() |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Euphorica(f): 5:43am On Aug 14, 2018 |
Youngzubi u dey do us bad ooo
Aint fair
Cnt wait 4 ur nxt UpdateSsSsS #Wehdonesir# |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by christheair(m): 9:24am On Aug 14, 2018 |
Youngzubi:I don do am tey tey... |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 12:35pm On Aug 14, 2018 |
Episode 34 The Game! --------------- i sidon for couch wey dey inside my room as i watch vicky do her feminine thing,i just dey wonder how gawd go take creat peson beautiful finish and him go still spend 50mins dey do facial make up,anyway e dey every woman blood e nor even take me up to 20mins to get myself ready,as i don already go collect spata car key onto say nah him Benz i won take carry vicky go her place "Hot!!",she yan from wia she bin sidon dey look mirror "watin,i yan "two minutes more please!,she yan "nah u sabi,just nack am enter ya head say once 12 nack gbam! ,i no follow u go anywhere again,i yan "awww,u sound offended,why "zed"i yan "oops!!,ok lets go she yan as she stand begin waka come meet me for wia i sidon ontop bed,mmua!! she sample me better kiss "you sabi joor,oya waka make i follow u for back,i yan as she lead the way down stairs most of my guys nor dey house,nah only bobo wey don dey arrange him luggage onto say nah tomorrow him go travel,so nah packing things him dey busy dey do we reach outside,i waka go open front passenger side for her before i close door,waka enter driver side as the gateman run go open the gate,jejely i give the moto engine life as we zoom off with vicky directing me on which way to take,i high mayorkun che che wey dey boom for spana music player omo the bass just fill everywhere as i drive enter express i know say una go don dey wonder,the money wey we thief how e take go,well e go well,as i won take train my boys,i nor won make dem dey always put money first,no watin i want nah success first asin mission well accomplished before payment comes to mind,nahim make me carry all the money go lock inside one secret room for my house,nah just early this morning we go settle am before going back to bed,the money huge as we divide am equal,then we carry one portion go keep in the name of the gang so e mean say e belong to nobody,e belong to everybody "take that way,its more traffic free,vicky yan as i turn the steering go left divert route enter one fine street like that,the journey continues one thing with lagos state nah their road connection,walahi i comot cap for dem,only if just 20 more state out of the 39 abi 35 wey we get for Nigeria fit copy and be like lagos state ahswear naija for better pass dubai "na me talk am,just take for instance yesterday wey striker bin drive us go meet our clients for eko hotel wey dey ikeja chisos!! i just dey look fly over bridge,pedestrians bridge and road cleaners everywhere,every junction get him own road traffic officers controlling them,abi nah traffic light i won begin talk about that one e remain small make people dey hold am for hand as touch light dey waka becos e full everywhere,unlike the state wia i from come,Chai the traffic light there that one nah if u manage see traffic light at all e go bend neck reach ground sotey u sef go begin reason am say nah street light be that"is not as if i dey mention enugu o!,me spata and Stevo just sidon for moto dey use eyes do Christmas for ourselves till striker carry us reach eko hotel the only problem we encounter nah wen those ladies begin drag me sey nah me dem want,omo that one nah long matter if not for big nama's intervention we for no chop their ponani that day, "thats my street over there,vicky said pointing at one street wey dey my left side,i match brake as i begin drive slow-slow onto say nah street i dey now not express again i slow my speed wella"drivers take note" "we stop for front of one fine storey building with brown gate,she yan me say make i horn "after like 5sec a young police officer waka come open gate for us,as i drive enter their compound i notice something but i just comot my mind for there onto say her papa fit be rich man so nahim make police officers full every wia inside the compound "welcome to my humble home she yan "i swear humble nobi small o,see mansion Chai "yea!,i grew up loving the house as a lovely home not until my dad and mum had a very serious marital issues,simply becos my mum couldnt give birth to a male child,so just early this year my dad shocked us by packing out from here,he moved down to another part of lagos where he got married to another lady,it was a very very tragedy issue,it really broke my heart,infact this my once beloved house became a home of bitterness ,but i thank gawd as fate planned it my dad had a very terrible issue with that her so called new wife that he ran back here,he went on his kneels begging us to forgive and take him back,most of all i was glad that my mum still found somewhere in her heart to forgive him,as am talking to you we are together now as one big family again!!,she concluded with a scream "wow! wow!!,what a hilarious love story,hmm i go like yan this kind love story one day o!,i yan as she begin laff "like seriously yours gonna be something else,lets go in please i dont want to keep my guest standing,see i can bore you with my unending gist o!,she yan as she drag my hand like i be small pikin, i follow her waka inside "wow inside their house cool as Ac just dey blow everywhere,we sight a woman,fair in complexion,vicky confirmed my guess as she run go hug the woman as she begin shout "mummy!!!!!!" "after 2mins of hugging like death no fit do us apart,dem finally part as the woman fix her gaze on me, omo jejely i humble myself stand up from the couch wey i don already balance dey watch tv,i bow my head as i yan "goodafternoon ma!, "my son how you,mama vicky yan "am fine ma,i yan "thank you for taking good care of my daughter,since she is not hurt,am really pleased with you,she yan "ah! thank uvtoo ma,for ya appreciation,i yan "mum where is dad,vicky ask her ma'le "in his room up stairs,her mama yan "ok let me go and call him,he needs to greet my friend before he leaves,vicky yan as she begin climb stairs go up so young man,what's your name and what do you do for a living,vicky mama ask me as soon as vicky comot omo i begin cook gbeducious lie sharpaly,em! am zubby,and i work with the state deputy governor,i yan checking if i don make mistake,nah that time i carry head up look ceiling till my eye jam the picture frame wey hang for wall,i look am well as my heart beat begin skip 8 beats per sec,no e nor fit be oga frank,gawd please help me turn back of that picture please becos only seeing him for that picture dey make me faint "hello! young man am talking to you",vicky mama voice jab me "eh!"i yan "what's the matter,why the sudden sweat,Jesus Christ!,the woman yan as surprise full her face "what!!!!!!!!!,man voice shout as i look the direction my eye and oga frank own jam waaa!!!!! to be continued..... |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Danchoco(m): 1:02pm On Aug 14, 2018 |
Oga Frank again......u beta leave her daughter before e sentence u. |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by wizsolzy(m): 1:22pm On Aug 14, 2018 |
In danny s voice" Oga frank ege! U nd him ege! ![]() |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by pradoic(m): 1:37pm On Aug 14, 2018 |
now is time for spana to be finally cut off!!!,am sure oga frank would av dealt with u mercilessly before ur saviour go land |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Damibiz(m): 2:02pm On Aug 14, 2018 |
Tor,e don start |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by ngenec: 2:02pm On Aug 14, 2018 |
This story is getting interesting in daily basis |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by pacifust058(m): 2:35pm On Aug 14, 2018 |
Cheezos!! |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Iamicekid(m): 2:44pm On Aug 14, 2018 |
Lol... Bad guy, Frank no fit jare you don get back up now u got to summon courage |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by mydeporch(f): 2:59pm On Aug 14, 2018 |
Holy shitttt.......my first comment since av bn reading.....hmnnnnn...u nd Oga frank again....wetin go happen now ![]() |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by rowdymind(m): 7:08pm On Aug 14, 2018 |
Of All Demons Na The One Wey Hold Koboko You Go Jam, Spana Own Dun Kpafuka.
Oga Frank For Code Na Ehn Whc Kind Yawa Be This Sef.
Youngzubi Longest Time. |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(op): 7:26pm On Aug 14, 2018 |
rowdymind:brotherly nah u wey turn ghost reader,even if others no won contribute u nor suppose join..... |
| Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by rowdymind(m): 7:39pm On Aug 14, 2018 |
Youngzubi:Paddy Never Stone Me Fes, Me And You Na 11 Jus Say Man Get Pkenty Things For Head. Oya Dont Worry I Gat Your Six |
1 2 3 ... 22 23 24 25 26 27 28 ... 51 Reply
Life Of A Rugged Guy +21 • Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi • I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi • 2 • 3 • 4
[story] My Life As A Yahoo Boy • 1985.... 1987.... 2014--[a Crime Story] • Twine (A Drama Series)


