Wendoworld's Posts
Nairaland Forum › Wendoworld's Profile › Wendoworld's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 14 15 16 17 18 19 20 21 (of 21 pages)
come who be the admin of that 20 manager league now make una open am now na 18 teams i dey see their, wetin dey happen now abi the person don forget em job ni |
omo i don dey for door of the cup ooo my opponent dey lead me with 60-48 but as i dey see am, if arsenal go play and dem add the score na em be say na me go show the guy door because me and the guy both get hageland for our team i pray say if na belle dey turn hageland before make appendix start to dey worry am now so em no go play i can survive with the rest^^^^^^^@PHAROH me and you no be mate, infact your joke funny sha but you too no go wan use cow head do pendant now and na who tell you say we dey for bottom me i no know about that wan ooo wetin me i know before be say na me dey carry first from back before but another person don take over from me , but all in all keep on dreaming like joseph muki you say make rooney my capitaini no score ![]() shey you too don see say you don use grand pepe do tiro ![]() |
chei omo na who say make i come here come make mouth now @muki come abeg no talk say rooney no go score again ooo if you no wan see my red eye ooo be warned ![]() |
mukina2:omo muki village correct no be small at least things change small mystikal:thanks but i don try am more than a million times but na still the same opata the thing dey yarn why una go do am for only twenty people make una try enlarge size now abeg if na even one more for me the thing dey pain me oo, well sha |
[quote author=~Borat~ link=topic=302710.msg5203373#msg5203373 date=1262027771]I dont think that league is full, feel free to join[/quote]i try to join but the stuff dey talk say the league is no more accepting new entrys abeg make una help me out i go like join abeg oo any help ![]() |
YES I DON LAND FROM VILLAGE!!!!and i see say my otumopo dey answer me from there becos my first opponent for the fantasy cup i tear am jaku jaku, the second one na one life wey remain e use run for me as i beat am reach , now the next person na kill i go kill am because i dey vex God save all of una wey enter that 20 league say i no hear about am on time i for show una pepe but why i come enter 66 position instead of 64 for table now na who dey try dat kind wayo thing with me![]() |
e be like say rooney dey use juju for me i make d guy captain since i join and na once d guy make me smile. i dey wonder why the guy still be my captain but the juju no let me collect the armband from am, but dem say na till person know d kind sickness wey dey wory am before e know d kind medicine wey e go go buy 4 market, this week point don confirm say na rooney dey do me , abeg i no know who be my oponet o wey i go flog o ![]() |
mukina2: ![]() agabaI23:see jamb question dey there you never know wetin go happenmake una just let me go my village come back make una come see wetin we dey call okwe ![]() |
mukina2:omo no be small thing where you dey when i dey talk say i enter for week9, but tough no be dat on ejustify say i dey last becos i remember one guy wey we enter thesame week even go on to pass debosky wey dey cry say em enter for week7 , my own case i no understand the game before i go rush buy all those useles players wey i buy and when i go soji my self, time don pass so i dey sell dem week buy week dey replace dem, BUT THE WHOLE ISSUE BE SAY I NEED TO GO BACK TO VILLAGE E BE LIKE SAY NA THERE MY NETWORK FAILURE DEY COME FROM but no stress na me go still carry the leaugue all those galacticos and co. dem dey ba eleja yan (yoruba adage) ![]() |
mukina2: ![]() |
i dey do reshufflement for my whole team abeg any SCOUT around wey fit show me a very good talented midfielder wey no cost lets say like 3.8milla becos the only players wey i see for here my money no reach and the fpl people no gree make i owe dem even common 100 thousand , na the thing wey dey pain me for this fpl be dat you no fit borrow money, if say dem allow dat one i for chop gbese pass man utd ![]() |
;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d ;d :p |
^^^^^^^^^^^^^ something else like? abeg giva example next time ![]() |
abeg who fit tell me wetin glen johnson dey look for for up ![]() |
i no fit watch the match again but i dey boil where i dey for that beach boy mum wey dey post ![]() |
nice translation f.u.ck Zap up ![]() |
my tv dey mess up (live streaming) ![]() |
where arshavin dey ![]() |
I TALK AM BEFORE SAY SINCE CHELSEA DRAW MANURE GO LOSS AND ARSE-NAL GO HAMMER SOME PEOPLE WAIT MAKE MATCH FINISH BEFORE THEM GO TALK WHY SOME PEOPLE DEY HERE DEY COMPLAIN SAY ROONEY AND REFREE DEY KEEP MALICE DAT IS WHY DEM NO FIT SCORE HMMMMMM AT LAST SHA THE SCORE NA 0-1 MODERATOR PLEASE TAKE NOTE ![]() |
[font=Lucida Sans Unicode][font=Lucida Sans Unicode][font=Lucida Sans Unicode][size=8pt][size=8pt][size=8pt][size=8pt][size=8pt]yes i talk am chelsea draw manure loos and arse-nal go HAMMER[/size][/size][/size][/size][/size][/font][/font][/font] ![]() |
man u must loose this game yes carew don enter to finish, hehehe haw haw haw , o neil no gree sit down again yansh don dey pain am with wetin dey happen for field na who sit down go hungry i still dey surprise say fergie still sit down abi em dey wait make ereach 80 something minute ni ![]() |
abeg moderator take note of the scores o jare ;Dnow moving on , man utd is next ![]() |
cabali: cabali:bros wey am na ![]() |
everton don dey fall back dem no play like say dem dey look for goal at all e be like say the draw don bell full dem shey na mikel play dat shot that shot abi my eye dey deceive me |
everton lever don dey cut ![]() |
viperman:my guy na 3-3 of which drogba carry juju come field and aiyegbeni two carry come so naija juju and cotonue juju make we see the wan wey go win , ;Dyes and while we are still talking drogba don order for em juju boot ![]() |
GOOOOOOOOOOOOOOAAAAAAAAAAALLLLLLLLLLLLLLLLLLLLLLLLLLLLLLLLLLLLL luis sarah ![]() |
abeg shey dem no dey pay this everton player ni see how chelsea players dey run pass dem like say no be human being dem dey play with ![]() |
Sam Milla:what about that ![]() |
nateevs:becos yak use em normal yansh ride am ![]() |
see yakubu ooo and em ajeku goal oooo ![]() |
abi the person don forget em job ni
because me and the guy both get hageland for our team i pray say if na belle dey turn hageland before make appendix start to dey worry am now so em no go play i can survive with the rest
and na who tell you say we dey for bottom

