₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,330,557 members, 8,446,014 topics. Date: Wednesday, 15 July 2026 at 11:05 PM

Toggle theme

Wendoworld's Posts

Nairaland ForumWendoworld's ProfileWendoworld's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 16 17 18 19 20 21 (of 21 pages)

PoliticsRe: Spreading Rumors That Our President Is Dead Is Unpatriotic And Ungodly by wendoworld(m): 11:33am On Nov 26, 2009
No body dey pray make d guy kaput but if na to kaput go make am step down then lipsrsealed because even if d guy dey use walking stick e go still dey there.Some say make e resign. Una don forget say na naija we dey talk about? sad unless na miracle go happen be dat.
The guy regime be like statue e no go front e no go back e just dey there shaaa. At least we know say d former leaders draws go back but this yaradua time, me i know understand o.

@poster, o boy u need like 40 indocide tablet to clear ur head and to open ur eye. Trust me u will thank me later cool wink.And i recömend d same for those of u wey no fit see the truth and say it like e suppose be.Abeg make una tell me one good thing this regime don do to make an average or the poor citizen of naija happy. I hear one person say e resolve the niger/delta issue amicably. So the thing wey happen for uniport na ami wetin we go call that wan  huh Some naija ppl sha.

Though no be d man death go cure naija oo becos all those developed country wey u see so, their citizens no just shout for newspaper go back home go relax.(just as we go come nairaland come do) them put their ranting into life fcking action. So for me i believe say na we still dey give dis people d fucking chance. NOBODY WAN DIE BUT WE WAN GO HEVEN. Like wan person said just my own fucking opinion
Dating And Meet-up ZoneRe: Married But Want Some Adventure by wendoworld(m): 10:58am On Nov 25, 2009
Come all dis useless pretenders make una free d guy now ahah. Shey the one wey una dey do under no pass dis wan? because em come out come talk una wan kil am.Abeg make una go find work do if una no get any
RomanceRe: My Fiancee Is Hiv Positive, I Love Her And Still Want To Go On With The Marriage by wendoworld(m): 9:40am On Nov 25, 2009
Omo all those people wey dey talk say the guy na fool just because em wan go on with d girl no well ooo angry una need to go update una self about the aids teaching b4 una come here they show us say una brain dey under una leg, I wonder hw ppl like una still get d brain to dey operate d computer wey una dey use type rubbish self, Na wa oo

@poster, Nothing again i wan tell u wey others never tell u, But wetin i fit add be say, , Hmmm u see d thing wey love go cos for dis life,even love power no go fit control am. So think wisely b4 u make any decision o
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Nairaland Fantasy Football League 2009/2010 by wendoworld(m): 10:17pm On Nov 24, 2009
omo my mouth no fit open talk my own score sad e be like say i need to go back to my skool of managing or make i go re-read my fantasy football manual, i need am, hmmmmm sad
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Sunderland vs Arsenal [1-0] on Saturday 21st November by wendoworld(m): 6:13pm On Nov 21, 2009
dayokanu God no go let you die so dat e go happen for your eye  grin
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Sunderland vs Arsenal [1-0] on Saturday 21st November by wendoworld(m): 6:03pm On Nov 21, 2009
fellow gunners make una no worry na we still get am this season, if we no get PSL we go get CHAMPIONS LEAGUE one of them must get to arsenal cool

but haaaaaa arsenal fall my hand today cry
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Sunderland vs Arsenal [1-0] on Saturday 21st November by wendoworld(m): 5:52pm On Nov 21, 2009
i nor understand again ooo see sunderland dey play like say na dem dey look for goal undecided
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Sunderland vs Arsenal [1-0] on Saturday 21st November by wendoworld(m): 5:42pm On Nov 21, 2009
this guys dem wan do us strong thing ooo see papa zenden
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Sunderland vs Arsenal [1-0] on Saturday 21st November by wendoworld(m): 5:36pm On Nov 21, 2009
cold don dey catch baba wenger
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Sunderland vs Arsenal [1-0] on Saturday 21st November by wendoworld(m): 5:32pm On Nov 21, 2009
omo fire don burn me ooo chai i don surfer
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Sunderland vs Arsenal [1-0] on Saturday 21st November by wendoworld(m): 5:17pm On Nov 21, 2009
HNIC:
You Olodo times 2
You couldn't give any explanation for the jersey, u dey yarn rubbish
You still dey yarn about Hleb here
Go and bring him back from Stutgart naaah
na the guy get time to waste to dey lecture you now, you no hear english self, so tey you no wetin you dey talk, you ask say make i tell you which match we wear blue no be say make i explain why we wear blue, for hleb matter i say if i remember abeg when to dey remember something turn to crime my guy? undecided
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Sunderland vs Arsenal [1-0] on Saturday 21st November by wendoworld(m): 5:05pm On Nov 21, 2009
omo e be like say those guys dey miss the honourable VP abeg oo make dem forget the guy and shower in goals i cant wait to see how that votron mensah go look like and moreover chesky don dey hammer wolves ooo shocked

[quote author=~Sauron~ link=topic=354860.msg4970866#msg4970866 date=1258818822]It depends on the shorts the HOME team is wearing.
Sunderland wear their RED stripes on black shorts. . . . . .Arsenal being the AWAY side would have to change their DEEP BLUE shorts to WHITE to avoid colour clash. Majority of the fans like you are colour blind so it is always important that both sides wear contrasting shades. grin grin grin[/quote]abeg help me tell the guy wetin dey worry am, abeg grin
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Sunderland vs Arsenal [1-0] on Saturday 21st November by wendoworld(m): 4:45pm On Nov 21, 2009
see mensah dey form votron ooooo angry and e go pain me for am when arsenal go fire like 3 enter for em face grin grin grin
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Sunderland vs Arsenal [1-0] on Saturday 21st November by wendoworld(m): 4:36pm On Nov 21, 2009
see combination oooo shocked i no fit count how many vitamins this guys style of play dey give me for body including high b.p self grin
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Sunderland vs Arsenal [1-0] on Saturday 21st November by wendoworld(m): 4:33pm On Nov 21, 2009
the viper:
pple plz concentrate of watching the most entertaining team in the world and the next kings of epl while the red and white army will take sunderland to the cleaners. abi the black cats think say we bi manure? see John Mensah with that Ghana old school type of hair cut.
grin ;Dno mind the guy he think say na250A.D we still dey em no know say that time don pass
HNIC:
@wendoworld
we've won blue but never on white!
get ithuh?
sorry oo bros i no know say na combination of cloth you come look ooo wink grin
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Sunderland vs Arsenal [1-0] on Saturday 21st November by wendoworld(m): 4:24pm On Nov 21, 2009
HNIC:
@wendoworld
u are d outdated one dude
mention a match this season where we've won blue over white!
EM EM I NO FIT REMEMBER FOR NOW BUT WE DON WEAR BLUE THIS SEASON OGA



IF I DEY SEE THIS ROSICKY OF A GUY NA SWEAR I DEY SWEAR FOR HLEB WHERE EVER EM DEY because IF I REMEMBER THE TWO OF THEM COMBINATION NA COMBINATION WEY BAD OOOO. THE IDIOT USE EM LONG TROAT SPOIL EVERYTHING, WELL I KNOW SAY WHEREEVER HE DEY NOW BODY GO DEY TELL AM angry
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Sunderland vs Arsenal [1-0] on Saturday 21st November by wendoworld(m): 4:19pm On Nov 21, 2009
ABEG MUKINA AND CRIZTAL ABEG MAKE UNA NO EDIT MY POST LIKE DAT NOW AT LEAST TURN AM UPSIDE DOWN, AH AH angry
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Sunderland vs Arsenal [1-0] on Saturday 21st November by wendoworld(m): 4:13pm On Nov 21, 2009
wetin do eduardo shey em just Bleep finish dey come field? huh
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Nairaland Fantasy Football League 2009/2010 by wendoworld(m): 4:09pm On Nov 21, 2009
see me see trouble i don beaf so tey i know see road say rosicky don come back and i don finish my transfer for the week


@mykali
what is greater and more powerfull than fasting and prayers i never see ooo cool because na wetin una dey follow fight be that
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Sunderland vs Arsenal [1-0] on Saturday 21st November by wendoworld(m): 4:04pm On Nov 21, 2009
HNIC:
when did we start wearing blue on white?
i thought the jersey was blue on blue
bros you dey outdated? huh grin
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Sunderland vs Arsenal [1-0] on Saturday 21st November by wendoworld(m): 4:03pm On Nov 21, 2009
omo my boys are on please tell a broda to tell a friend to tella friend of his who will tell a father to tell his friend etc abeg i no fit shout
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Nairaland Fantasy Football League 2009/2010 by wendoworld(m): 3:36pm On Nov 21, 2009
mukina you know understand, i dey allegic to drogba for real life but e no reach fantasy side at all though i never get am for my team but e dey among those people wey i dey pray 5weeks injury for just make i for fit afford am when em stock fall cool
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Nairaland Fantasy Football League 2009/2010 by wendoworld(m): 2:45pm On Nov 21, 2009
@mykali
no let muscle pull catch you for ur croosed toe ooo, we the enemy of drogba (for real life no be for fantasy ooo grin) don confirm say the goat go sit down for bench today, wink cool
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Nairaland Fantasy Football League 2009/2010 by wendoworld(m): 1:46pm On Nov 21, 2009
@mukina
na true na, grin shey this fantasy people wan tell me say no 2milla player for premiership?even our own dear walcot wey never play since dem dey market am 7.7milla omo the thing don tire me, undecided well sha my target na lampard as i dey wait make he come down to atleast 6 or 5.5milla cool make em come warm bench for me small tongue, you no see wetin big money spending do borat? e dey wish say person wey get heart problem go play sad na wa ooo
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Nairaland Fantasy Football League 2009/2010 by wendoworld(m): 11:25am On Nov 21, 2009
omo i dey first seriously ooo angry angry angry angry as i dey para dey buy players i dey look for the one of 2milla i no see huh na dem fit do am now ooo as our big big money players dey give some of my friends dem global crunch undecided
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Nairaland Fantasy Football League 2009/2010 by wendoworld(m): 11:02am On Nov 18, 2009
Paulifendu:
Nearly everyone, if not everyone on nairaland fpl has drog and/or rvp in his/her team
so i aint scared.
The same points i'd waste in getting rid of them is the same points everyone one else will, so no shaking
But its the buying thats the trick! wink tongue
bros, abeg no vex, me i no even get any of them for my team i join for week9 so i no know about the game na so i just go select wrong players sad when my eye clear embarassed omo most of those guys don dey cost the whole arsenal squad amount. so since i don learn small about the game na, i come wear my prayer worrior clothe with fasting and prayer so na the result be that, so na to wait when them prize go fall like commodities for stock market cool,

for those of una wey believe say una fit sleep beside lion and nothing go happen. well, lipsrsealed grin grin cry
na im be dat ooo kiss
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Nairaland Fantasy Football League 2009/2010 by wendoworld(m): 3:24pm On Nov 17, 2009
abeg ooo i know call names oooo!!! grin, but na true now, them say if one person own no spoil the other person own no go better undecided maybe now wey all those guys get injury their money go come down at least some of us wey wan buy them since but no get the cash go fit buy them put for our bench make dem dey warm am till them ready to play wink, i dey wait till lampard go come down to 5milla tongue , maybe i go consider buy am sha undecided
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Nairaland Fantasy Football League 2009/2010 by wendoworld(m): 11:49am On Nov 17, 2009
buhahahahaha grin cry grin grin grin cry somepeople don go use tooth brush and closeup go wash teeth for python wink some of una wey buy superstar full teams this na una time to shine since rvp lampard and co.s them don get injury, jo ooooo
HealthRe: What's Your Preferred Birth Control Method? by wendoworld(m): 11:36pm On Nov 10, 2009
posakosa:
^^^^^ lots of virgins do that-----get bleeped in the ass.
buhahaha grin angry wetin come be the meaning or the need of the virginity then?
HealthRe: What's Your Preferred Birth Control Method? by wendoworld(m): 10:36pm On Nov 10, 2009
[quote author=££VICTOR££ link=topic=349435.msg4897669#msg4897669 date=1257876567]I have the best and Perfect Method,

Man, F*ck her in the ASS cool

100% Birth Conrol grin[/quote]guy wat if the thing turn from her ass to her lipsrsealed nko,
throttler:
frog jump method. lipsrsealed
wat if na that type of rambo thick sperm enter you? that wan dey gum pass super glue ooo
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Nairaland Fantasy Football League 2009/2010 by wendoworld(m): 11:14pm On Nov 09, 2009
jo oooooooo mi o le fi ori malu shey pendant ooo shocked, last week 42 almost hit my target but na only 4 players come feild the others go chop while others go out with their opeke, this week well those my guys dem say make i manage 31 say we go see next week wink, so i dey expect more than the as usual in the next game week cool jo ooo we coming out so straight from abackayard so watsh out grin
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Arsenal Vs Tottenham [3-0] on Saturday, 31st October by wendoworld(m): 2:51pm On Oct 31, 2009
jo ooo mi o le kiri gala ni BRT lane o, na wetin spurs try be dat o. eyin olote e.g borat e jo e face front.my bois dem dey para we dey go untop 6 or 4.@borat this one no be westham their name na spurs i no remember their real name now til we pass the amount of laters wey form spurs. wait i dey come make i tel mx bois dem say we need more. cool

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 16 17 18 19 20 21 (of 21 pages)